Gênesis 42

Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs ARA

Sair da comparação
ARA Almeida Revista e Atualizada 1993
1 Wen Jakob hear sey food dey for Egypt, e kon tell en sons, “Wetin make una dey look each oda?”
1 Sabedor Jacó de que havia mantimento no Egito, disse a seus filhos: Por que estais aí a olhar uns para os outros?
2 E sey, “Si, I hear sey food dey for Egypt. Make una go der go buy food, so dat honga nor go kill us.”
2 E ajuntou: Tenho ouvido que há cereais no Egito; descei até lá e comprai-nos deles, para que vivamos e não morramos.
3 So ten among Josef brodas kon go Egypt go buy food.
3 Então, desceram dez dos irmãos de José, para comprar cereal do Egito.
4 But Jakob nor gri allow Benjamin, Josef broda follow dem, bikos e sey, “I nor wont make anytin happen to am.”
4 A Benjamim, porém, irmão de José, não enviou Jacó na companhia dos irmãos, porque dizia: Para que não lhe suceda, acaso, algum desastre.
5 So Israel shidren follow di oda pipol kon buy food for Egypt, bikos di honga strong well-well for Kanaan land.
5 Entre os que iam, pois, para lá, foram também os filhos de Israel; porque havia fome na terra de Canaã.
6 For dis time, na Josef dey rule di kountry and naim dey sell food give all di pipol. Wen en brodas kom meet am, dem bow face groun.
6 José era governador daquela terra; era ele quem vendia a todos os povos da terra; e os irmãos de José vieram e se prostraram rosto em terra, perante ele.
7 Wen Josef si en brodas, na wons e know dem, but e do like sey e nor know dem kon dey shaut for dem. E ask dem, “Na where una from kom?”
7 Vendo José a seus irmãos, reconheceu-os, porém não se deu a conhecer, e lhes falou asperamente, e lhes perguntou: Donde vindes? Responderam: Da terra de Canaã, para comprar mantimento.
8 Josef know en brodas, but dem nor know am.
8 José reconheceu os irmãos; porém eles não o reconheceram.
9 Den Josef remember di dream wey e dream about dem, so e tell dem, “Una bi tif! Una kon look weda una fit attack awa land!”
9 Então, se lembrou José dos sonhos que tivera a respeito deles e lhes disse: Vós sois espiões e viestes para ver os pontos fracos da terra.
10 But dem ansa, “No o-o! My oga, na food yor savants just kom buy o-o!
10 Responderam-lhe: Não, senhor meu; mas vieram os teus servos para comprar mantimento.
11 Na one papa all of us get o-o; wi bi good pipol o-o! Abeg, yor savants nor bi tif at-all.”
11 Somos todos filhos de um mesmo homem; somos homens honestos; os teus servos não são espiões.
12 But Josef sey, “Na lie, una kon si if una go fit attack awa land.”
12 Ele, porém, lhes respondeu: Nada disso; pelo contrário, viestes para ver os pontos fracos da terra.
13 En brodas ansa, “Yor savants na from one house and wi bi twelf boys. Na one man for Kanaan born all of us. Di one wey yong pass dey with awa papa and one don die.”
13 Eles disseram: Nós, teus servos, somos doze irmãos, filhos de um homem na terra de Canaã; o mais novo está hoje com nosso pai, outro já não existe.
14 But Josef sey, “Just as I tell una before, na tif una bi!
14 Então, lhes falou José: É como já vos disse: sois espiões.
15 Na so I go take test una: As long as Fero dey alive, una nor go komot here until una bring una yonga broda kom here.
15 Nisto sereis provados: pela vida de Faraó, daqui não saireis, sem que primeiro venha o vosso irmão mais novo.
16 One pesin among una go-go bring una broda kom, while di rest of una go stay here. Like dis, wi go know weda una dey tok trut. If not, as long as Fero dey alive, all of una na tif!”
16 Enviai um dentre vós, que traga vosso irmão; vós ficareis detidos para que sejam provadas as vossas palavras, se há verdade no que dizeis; ou se não, pela vida de Faraó, sois espiões.
17 Josef keep dem for prison for three days.
17 E os meteu juntos em prisão três dias.
18 For di third day, Josef kon tell dem, “Make una do as I tok and una go dey alive, bikos I dey fear God.
18 Ao terceiro dia, disse-lhes José: Fazei o seguinte e vivereis, pois temo a Deus.
19 If una really dey good, make una leave one among una broda for here, so dat una go fit take food go give una family wey dey hongry for Kanaan.
19 Se sois homens honestos, fique detido um de vós na casa da vossa prisão; vós outros ide, levai cereal para suprir a fome das vossas casas.
20 But una must bring una yonga broda kom meet mi. Den I go bilive una and una nor go die.” So Josef brodas do as e tok.
20 E trazei-me vosso irmão mais novo, com o que serão verificadas as vossas palavras, e não morrereis. E eles se dispuseram a fazê-lo.
21 Dem kon tell each oda, “Dem dey ponish us, bikos of awa broda Josef, bikos wi si en pain wen e dey kry make wi sorry for am, but wi nor gri listin to am. Na-im make all dis tins dey happen to us so!”
21 Então, disseram uns aos outros: Na verdade, somos culpados, no tocante a nosso irmão, pois lhe vimos a angústia da alma, quando nos rogava, e não lhe acudimos; por isso, nos vem esta ansiedade.
22 Reuben kon tell dem, “I nor tell una sey make una nor sin against di boy, but una nor gri listin to mi? So naw, wi must pay for di sin wey wi kommit!”
22 Respondeu-lhes Rúben: Não vos disse eu: Não pequeis contra o jovem? E não me quisestes ouvir. Pois vedes aí que se requer de nós o seu sangue.
23 (Naw, dem nor know sey Josef dey undastand wetin dem dey tok, bikos e dey speak Egypt language and anoda pesin dey interpret am give en brodas.)
23 Eles, porém, não sabiam que José os entendia, porque lhes falava por intérprete.
24 So Josef turn from dem kon dey kry. Wen e turn face dem again, e kon sey make dem go put Simeon for prison as all of dem dey look.
24 E, retirando-se deles, chorou; depois, tornando, lhes falou; tomou a Simeão dentre eles e o algemou na presença deles.
25 Den Josef orda sey make dem put food for dia bag kon put evribody money for dia bag back kon sey make dem help dem for dia journey. So en ofisas do as e tok.
25 Ordenou José que lhes enchessem de cereal os sacos, e lhes restituíssem o dinheiro, a cada um no saco de cereal, e os suprissem de comida para o caminho; e assim lhes foi feito.
26 So dem kon put dia food for dia donkey kon go.
26 E carregaram o cereal sobre os seus jumentos e partiram dali.
27 Wen dem dey rest, one among dem open en sak make e give en donkey food and e kon si en money inside di sak.
27 Abrindo um deles o saco de cereal, para dar de comer ao seu jumento na estalagem, deu com o dinheiro na boca do saco de cereal.
28 Den e tell en brodas, “Dem return my money give mi! E dey for inside my sak!” Dem sopraiz well-well kon turn face each oda with fear, den dem sey, “Na wetin God don do to us so?”
28 Então, disse aos irmãos: Devolveram o meu dinheiro; aqui está na boca do saco de cereal. Desfaleceu-lhes o coração, e, atemorizados, entreolhavam-se, dizendo: Que é isto que Deus nos fez?
29 Dem go back go meet dia papa Jakob for Kanaan kon tell am evritin wey happen dey sey,
29 E vieram para Jacó, seu pai, na terra de Canaã, e lhe contaram tudo o que lhes acontecera, dizendo:
30 “Di man wey bi di oga for Egypt tok to us bad kon trit us like sey wi bi tif.
30 O homem, o senhor da terra, falou conosco asperamente e nos tratou como espiões da terra.
31 But wi tell am sey, ‘Wi bi good pipol; wi nor kon spy or tif!
31 Dissemos-lhe: Somos homens honestos; não somos espiões;
32 Wi bi twelf brodas from one family and na one man born all of us. One don die and as wi dey tok, di yonga one dey with awa papa for Kanaan.’
32 somos doze irmãos, filhos de um mesmo pai; um já não existe, e o mais novo está hoje com nosso pai na terra de Canaã.
33 Den di man wey bi di oga for di land kon tell us, ‘Na like dis I go take know if una dey good as una tok. Make una leave one among una brodas for here kon take food go give una family wey dey hongry for Kanaan.
33 Respondeu-nos o homem, o senhor da terra: Nisto conhecerei que sois homens honestos: deixai comigo um de vossos irmãos, tomai o cereal para remediar a fome de vossas casas e parti;
34 But una must bring una yonga broda kon meet mi, so dat I go know sey una dey good and una nor bi tif. Den I go give una broda back to una and una go fit waka as una like for dis land.’ ”
34 trazei-me vosso irmão mais novo; assim saberei que não sois espiões, mas homens honestos. Então, vos entregarei vosso irmão, e negociareis na terra.
35 As dem dey remove di food from dia sak, all of dem kon si dia money inside dia sak! As dem with dia papa si di money, dem kon dey fear.
35 Aconteceu que, despejando eles os sacos de cereal, eis cada um tinha a sua trouxinha de dinheiro no saco de cereal; e viram as trouxinhas com o dinheiro, eles e seu pai, e temeram.
36 So dia papa Jakob kon tell dem, “Una won turn mi to who nor get pikin? Josef don die. I nor know wetin dey happen to Simeon naw. And naw una won kollect Benjamin too! Evritin just dey against mi.”
36 Então, lhes disse Jacó, seu pai: Tendes-me privado de filhos: José já não existe, Simeão não está aqui, e ides levar a Benjamim! Todas estas coisas me sobrevêm.
37 Den Reuben tell en papa, “Make yu kill my two sons, if I nor bring Benjamin kom back kom meet yu. Make yu put am for my hand and I go bring am back.”
37 Mas Rúben disse a seu pai: Mata os meus dois filhos, se to não tornar a trazer; entrega-mo, e eu to restituirei.
38 But Jakob ansa, “Benjamin nor go follow una go anywhere, bikos en broda don die and na only en remain naw. If anytin happen to am wen una dey travel, den una go just make mi die with pain.”
38 Ele, porém, disse: Meu filho não descerá convosco; seu irmão é morto, e ele ficou só; se lhe sucede algum desastre no caminho por onde fordes, fareis descer minhas cãs com tristeza à sepultura.

Ler em outra tradução

Comparar com outra

Estude este capítulo no WhatsApp

Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Gênesis 42, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.