Gênesis 41

Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs NAA

Sair da comparação
NAA Nova Almeida Atualizada 2017
1 Afta two years, Fero kon dream. As e stand near River Nile,
1 Passados dois anos completos, Faraó teve um sonho e eis que estava em pé junto ao rio Nilo.
2 e kon si seven melu wey fat and fine well-well dey kom out from di river go chop for di field.
2 Do rio subiam sete vacas de boa aparência e gordas e pastavam no meio dos juncos.
3 Den e si seven melu wey dirty and tin dey kom for dia back from di river too and dem stand near di fat ones.
3 Após elas subiam do rio outras sete vacas, de aparência feia e magras; e pararam junto às primeiras, na margem do rio.
4 Den, di tin melu kon swallow di seven fine and fat melu and Fero kon wake-up.
4 As vacas de aparência feia e magras engoliam as sete vacas de boa aparência e gordas. Então Faraó acordou.
5 Den e sleep again kon dream anoda dream: E si seven korn head dey grow for one korn stik and dem dey fine and big well-well.
5 Tornando a dormir, sonhou outra vez. De uma só haste saíam sete espigas cheias e boas.
6 Den e still si anoda seven korn head wey tin and wey sun don burn small and dem dey grow kom out too.
6 E após elas nasciam sete espigas mirradas e queimadas pelo vento leste.
7 Di seven tin korn kon swallow di seven fat and fine ones. Den Fero wake-up kon si sey na dream e dey dream.
7 As espigas mirradas devoravam as sete espigas grandes e cheias. Então Faraó acordou. Tinha sido um sonho.
8 For morning, en mind nor rest, so e sey make dem koll all en majishan, priest, doz wey dey si wetin go happen and juju pipol for Egypt. Fero tell dem en dreams, but nobody fit tell am wetin dem mean.
8 De manhã, ao despertar muito perturbado, mandou chamar todos os magos do Egito e todos os seus sábios. Contou-lhes os seus sonhos, mas não havia ninguém que pudesse dar a interpretação.
9 Den di man wey dey serve wine for Fero kon tell am, “Na today I know sey I don sin.
9 Então o copeiro-chefe disse a Faraó: — Hoje me lembro das minhas ofensas.
10 I remember wen Fero vex for mi en savants kon put mi for prison for di bodyguards oga house; both mi and di shief baker.
10 Quando Faraó ficou irado com os seus servos e me pôs na prisão, na casa do comandante da guarda, a mim e ao padeiro-chefe,
11 Wi two dream difren dream for di same nite and di dream get dia own meaning.
11 tivemos um sonho na mesma noite, eu e ele. Sonhamos, e cada sonho tinha o seu próprio significado.
12 Naw e get one yong Hibru man for der and e bi di guide oga savant. Wi tell am wetin wi dream and e tell di two of us wetin awa difren dreams mean.
12 Achava-se conosco um jovem hebreu, escravo do comandante da guarda. Contamos a ele os nossos sonhos, e ele nos deu a interpretação, a cada um segundo o seu sonho.
13 Evritin happen just as e tell us. Fero give mi my work back kon hang di shief baker.”
13 E tal como nos interpretou, assim aconteceu: eu fui restituído ao meu cargo, e o outro foi enforcado.
14 Den Fero sey make dem go koll Josef kom. So dem take Josef kwik-kwik komot from di prison kon shave en hair and shange en klot, den dem take am go meet Fero.
14 Então Faraó mandou chamar José, e o fizeram sair às pressas da masmorra. Ele se barbeou, mudou de roupa e foi apresentar-se a Faraó.
15 Fero kon tell Josef, “I dream one kind dream and e nor get anybody wey fit tell mi wetin di dream mean. But I don hear about yu sey yu dey fit tell pipol wetin dia dream mean.”
15 Este lhe disse: — Tive um sonho, e não há quem o interprete. Porém ouvi falar a respeito de você que, quando ouve um sonho, é capaz de interpretá-lo.
16 Josef kon ansa Fero, “I nor get dat kind pawa, but God go tok thru mi, so dat yu awa king go dey okay.”
16 José respondeu: — Isso não está em mim; mas Deus dará resposta favorável a Faraó.
17 Den Fero tell Josef, “I dream sey I stand near Nile river.
17 Então Faraó disse a José: — No meu sonho, eu estava em pé na margem do Nilo,
18 Den I si seven melu wey fine well-well dey kom out from di river go chop for di field.
18 e eis que subiam dele sete vacas gordas e de boa aparência e pastavam no meio dos juncos.
19 Den I still si seven dirty and tin melu dey kom for dia back from di river too and dem stand near di fat ones. I neva si dat kind dirty and tin melu before.
19 Após estas subiam outras vacas, fracas, muito feias e magras. Eu nunca tinha visto vacas tão feias, em toda a terra do Egito.
20 Di dirty melu kon swallow di fine ones.
20 E as vacas magras e ruins devoravam as primeiras sete vacas gordas.
21 Wen dem don chop di fat ones finish, nobody go know sey dem chop anytin, bikos dem still tin as dem bi. Den I kon wake-up.
21 E, depois de as terem engolido, não davam aparência de que as tinham devorado, pois o aspecto delas continuava ruim como no princípio. Então acordei.
22 “I still dream si seven korn head dey grow for one korn stik and dem fine and big well-well.
22 Depois, vi, em meu sonho, que sete espigas saíam da mesma haste, cheias e boas.
23 Den I si anoda seven korn head wey tin and wey sun don burn small dey grow kom out too.
23 Depois delas nasceram sete espigas secas, mirradas e queimadas pelo vento leste.
24 Di tin ones kon swallow di fat ones. So I tell all my priest and majishan, but nobody fit tell mi wetin di dreams mean.”
24 As sete espigas mirradas devoravam as sete espigas boas. Contei isso aos magos, mas ninguém foi capaz de me dar a interpretação.
25 Den Josef tell Fero, “Di two dream wey Fero dream get di same meaning. God don show Fero wetin E wont do.
25 Então José respondeu: — O sonho de Faraó é apenas um; Deus revelou a Faraó o que ele vai fazer.
26 Di seven fat melu na seven years and di seven good korn na seven years too. Di two dreams get di same meaning.
26 As sete vacas boas serão sete anos; as sete espigas boas, também sete anos; o sonho é um só.
27 Di seven tin melu wey kom afta di fat ones na still seven years and di bad korn wey still kom afta di good ones, na seven years wen honga go dey.
27 As sete vacas magras e feias, que subiam após as primeiras, serão sete anos, bem como as sete espigas mirradas e queimadas pelo vento leste serão sete anos de fome.
28 Dis na wetin I go tell Fero: God don show Fero wetin E won do.
28 — Esta é a palavra, como acabo de dizer a Faraó: Deus manifestou a Faraó o que ele vai fazer.
29 Seven years dey kom wen good tins go happen for Egypt.
29 Eis que vêm sete anos de grande abundância por toda a terra do Egito.
30 But afta dat seven years, anoda seven years wey honga go dey evriwhere dey kom and evribody go forget di first seven years. Di honga go konfuse di land.
30 Depois virão sete anos de fome. Toda aquela abundância será esquecida na terra do Egito e a fome consumirá a terra;
31 Pipol nor go remember di tins wey di land get before, bikos di honga go strong well-well.
31 e não será lembrada a abundância na terra, por causa da fome que seguirá, porque será gravíssima.
32 God show Fero di dream two times, bikos na as God wont make e bi, bi dat and God go soon make am happen.
32 O sonho de Faraó foi repetido, porque a coisa é estabelecida por Deus, e Deus se apressa a fazê-la.
33 “So make Fero fine one man wey good and get sense kon make am oga ova di land for Egypt.
33 — Agora, pois, Faraó devia escolher um homem ajuizado e sábio e encarregá-lo de dirigir a terra do Egito.
34 Den make Fero choose one pesin wey go supavise di whole land for Egypt, so dat if dem divide all di tins for Egypt into ten, dem go kollect five part keep for di time wen evritin dey good.
34 Faraó devia fazer isto: pôr administradores sobre a terra e recolher a quinta parte dos frutos da terra do Egito nos sete anos de fartura.
35 For dis good years wey dey kom, make dem gada all di food wey remain. And make Fero kommand dem to keep korn and oda tins, so dat di town go get food and dem go dey keep dem.
35 Esses administradores deviam ajuntar toda a colheita dos bons anos que virão, recolher cereal por ordem de Faraó, para mantimento nas cidades, e guardá-lo em armazéns.
36 Make dem keep all dis food for di land until di seven years wey honga go dey, go start. Like dis, di land go fit survive di honga.”
36 Assim, o mantimento servirá para abastecer a terra nos sete anos da fome que haverá no Egito, para que a terra não seja destruída pela fome.
37 Dis advise dey good for Fero ear and all en ofisas.
37 O conselho agradou a Faraó e a todos os seus oficiais.
38 So Fero kon ask en ofisas, “Wi go fit si anoda pesin wey bi like Josef, pesin wey God Spirit dey with?”
38 Então Faraó perguntou aos seus oficiais: — Será que poderíamos achar alguém melhor do que José, um homem em quem está o Espírito de Deus?
39 So Fero tell Josef, “Bikos God don make yu know all dis tins, e nor get anybody wey wise and good like yu!
39 Depois, Faraó disse a José: — Visto que Deus revelou tudo isto a você, não há ninguém tão ajuizado e sábio como você.
40 Na yu go take kare of my house and all my pipol go obey yor kommand. Na only mi, di king go dey great pass yu.”
40 Você será o administrador da minha casa, e todo o meu povo obedecerá à sua palavra. Somente no trono eu serei maior do que você.
41 Fero kon tell Josef, “Si! I don put yu as oga ova evribody for Egypt.”
41 E Faraó disse mais a José: — Eis que eu o constituo autoridade sobre toda a terra do Egito.
42 Den Fero take en own ring from en hand kon wear am for Josef own. E wear en fine klot for Josef kon put gold shain for en neck.
42 Então Faraó tirou o seu anel-sinete da mão e o pôs no dedo de José. Mandou que o vestissem com roupas de linho fino e lhe pôs no pescoço um colar de ouro.
43 Fero gi-am di shariot wey di pesin afta di king dey ride and e sey, “Make una knee down for am!” So Fero make am oga ova all di land for Egypt.
43 E o fez subir na sua segunda carruagem, e clamavam diante dele: “Inclinem-se todos!” Desse modo, deu-lhe autoridade sobre toda a terra do Egito.
44 Fero still tell Josef, “Na mi bi Fero, but unless yu sey so, nobody go ever fit enter Egypt.”
44 Disse ainda Faraó a José: — Eu sou Faraó, mas sem a sua ordem ninguém poderá fazer nada em toda a terra do Egito.
45 Fero kon koll Josef, Zafenat-Paneah. E still gi-am Asenat wey bi Potifara dota, priest for On, so dat di woman go bi Josef wife. So Josef kon dey kontrol di whole Egypt.
45 E Faraó chamou José de Zafenate-Paneia e lhe deu por mulher Asenate, filha de Potífera, sacerdote de Om. E José percorreu toda a terra do Egito.
46 For dis time, Josef na thirty years wen e start to serve Fero and dey kommand evribody for Egypt. Na Fero make Josef oga for di whole Egypt.
46 José tinha trinta anos de idade quando se apresentou a Faraó, rei do Egito, e andou por toda a terra do Egito.
47 For di seven years wey food dey, wetin di land produce kon many well-well.
47 Nos sete anos de fartura a terra produziu com abundância.
48 Josef take all di food wey remain for Egypt for dat seven years kon keep dem for di main towns. Josef keep food wey dem gada for all di towns.
48 E José ajuntou todo o mantimento que houve na terra do Egito durante os sete anos e o guardou nas cidades; o mantimento do campo ao redor de cada cidade foi guardado na mesma cidade.
49 Di korn and rice wey Josef keep, many well-well like san-san wey dey near sea and e nor fit measure dem again, bikos dem too plenty.
49 Assim, José ajuntou muitíssimo cereal, como a areia do mar, até perder a conta, porque ia além das medidas.
50 Asenat, Priest Potifara for On pikin, wey bi Josef wife, born two sons for Josef before di honga start.
50 Antes de chegar a fome, nasceram dois filhos a José, os quais lhe deu Asenate, filha de Potífera, sacerdote de Om.
51 Josef koll di first-born Manasseh kon sey, “True-true, God don make mi forget all my wahala and my papa house,”
51 Ao primogênito José chamou de Manassés, pois disse: “Deus me fez esquecer todo o meu trabalho e toda a casa de meu pai.”
52 E koll di sekond boy, Efraim bikos e sey, “True-true, for di land where I for dey sofa, God don make mi fruitful.”
52 Ao segundo deu o nome de Efraim, pois disse: “Deus me fez próspero na terra da minha aflição.”
53 Den di seven years wen tins good for Egypt kon finish.
53 Passados os sete anos de abundância que houve na terra do Egito,
54 And di seven years for honga kon start just as Josef tok sey e go bi. Honga dey for di whole world, but food dey for Egypt.
54 começaram os sete anos de fome, como José havia predito. E havia fome em todas as terras, mas em toda a terra do Egito havia pão.
55 Wen evribody for Egypt don dey sofa, bikos of di honga, di pipol kon kry go meet Fero make e give dem food. But Fero tell dem, “Make una go meet Josef and anytin wey e tell una, make una do am.”
55 Quando toda a terra do Egito começou a sentir a fome, o povo clamou a Faraó por pão; e Faraó dizia a todos os egípcios: — Vão falar com José e façam o que ele disser.
56 As di honga dey evriwhere for di world, Josef kon open di store where e keep food put kon dey sell food give Egypt pipol. Di honga for di whole Egypt strong well-well.
56 Havendo, pois, fome sobre toda a terra, José abriu todos os celeiros e vendia aos egípcios; porque a fome aumentava na terra do Egito.
57 Pipol from evry kountry dey kom buy food from Josef for Egypt, bikos di honga strong well-well.
57 E todas as terras vinham ao Egito para comprar de José, porque a fome aumentava em todo o mundo.

Ler em outra tradução

Comparar com outra

Estude este capítulo no WhatsApp

Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Gênesis 41, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.