Gênesis 40

Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs ARIB

Sair da comparação
ARIB Almeida Revisada Imprensa Bíblica
1 Afta all dis tins don happen, di pesin wey dey serve wine for Egypt king and di pesin wey dey bake en bread kon make am vex.
1 Depois destas coisas o copeiro do rei do Egito e o seu padeiro ofenderam o seu senhor, o rei do Egito.
2 Fero wey bi king, vex well-well for en two ofisas
2 Pelo que se indignou Faraó contra os seus dois oficiais, contra o copeiro-mor e contra o padeiro-mor;
3 so e kon arrest dem put for prison for di bodyguard oga house where dem put Josef too.
3 e mandou detê-los na casa do capitão da guarda, no cárcere onde José estava preso;
4 Di oga for di guards kon choose Josef as di pesin wey go dey serve di two ofisas for prison. Dem stay for prison tey small.
4 e o capitão da guarda pô-los a cargo de José, que os servia. Assim estiveram por algum tempo em detenção.
5 One day, di two of dem; both di pesin wey dey serve wine and di baker for Egypt wey dey prison kon dream. Each of dem dream get en own meaning.
5 Ora, tiveram ambos um sonho, cada um seu sonho na mesma noite, cada um conforme a interpretação do seu sonho, o copeiro e o padeiro do rei do Egito, que se achavam presos no cárcere:
6 Wen Josef meet dem for morning, e si sey dia face nor dey okay.
6 Quando José veio a eles pela manhã, viu que estavam perturbados:
7 So e ask Fero ofisas wey dey prison with am for en masta house, “Wetin make una face bi like dis today?”
7 Perguntou, pois, a esses oficiais de Faraó, que com ele estavam no cárcere da casa de seu senhor, dizendo: Por que estão os vossos semblantes tão tristes hoje?
8 Dem ansa, “Wi dream one kind bad dream, but e nor get anybody wey fit tell us wetin di dreams mean.”
8 Responderam-lhe: Tivemos um sonho e ninguém há que o interprete. Pelo que lhes disse José: Porventura não pertencem a Deus as interpretações? Contai-mo, peço-vos.
9 So di one wey dey serve wine kon tell Josef en dream: “Inside my dream, e get one vine for my front.
9 Então contou o copeiro-mor o seu sonho a José, dizendo-lhe: Eis que em meu sonho havia uma vide diante de mim,
10 Di vine get tree branches. Di vine kon dey grow dey fine and e kon dey produce ripe-ripe grape.
10 e na vide três sarmentos; e, tendo a vide brotado, saíam as suas flores, e os seus cachos produziam uvas maduras.
11 Fero cup dey my hand, so I take di grape kon press am put for di cup den give di cup to Fero.”
11 O copo de Faraó estava na minha mão; e, tomando as uvas, eu as espremia no copo de Faraó e entregava o copo na mão de Faraó.
12 Den Josef tell am, “Na wetin yor dream mean bi dis: di three branches na three days.
12 Então disse-lhe José: Esta é a sua interpretação: Os três sarmentos são três dias;
13 For three days time, Fero go karry yu go back to yor ofis and yu go dey serve wine for Fero as yu dey do before.
13 dentro de três dias Faraó levantará a tua cabeça, e te restaurará ao teu cargo; e darás o copo de Faraó na sua mão, conforme o costume antigo, quando eras seu copeiro.
14 But make yu remember mi wen evritin dey okay with yu and make yu menshon mi to Fero wen di time rish, so dat I go komot from dis prison.
14 Mas lembra-te de mim, quando te for bem; usa, peço-te, de compaixão para comigo e faze menção de mim a Faraó e tira-me desta casa;
15 Bikos dem buy mi kom from Hibru land and for der, I nor do anytin wey make dem put mi for gutta.”
15 porque, na verdade, fui roubado da terra dos hebreus; e aqui também nada tenho feito para que me pusessem na masmorra.
16 Wen di man wey dey bake bread si sey di meaning dey good, e kon tell Josef, “I still dream too: three kake basket dey my head,
16 Quando o padeiro-mor viu que a interpretação era boa, disse a José: Eu também sonhei, e eis que três cestos de pão branco estavam sobre a minha cabeça.
17 and for di one wey dey top, difren kind food wey dem bake for Fero dey inside, but di birds dey chop am from di basket wey dey my head.”
17 E no cesto mais alto havia para Faraó manjares de todas as qualidades que fazem os padeiros; e as aves os comiam do cesto que estava sobre a minha cabeça.
18 So Josef ansa, “Na wetin yor dream mean bi dis: di three basket na three days.
18 Então respondeu José: Esta é a interpretação do sonho: Os três cestos são três dias;
19 For three days time, Fero go sey make dem hang yu for tree. Den birds go kom chop yor flesh.”
19 dentro de três dias tirará Faraó a tua cabeça, e te pendurará num madeiro, e as aves comerão a tua carne de sobre ti.
20 So e happen sey for di third day, wey bi Fero birtday, e kon do party for all en savants and e sey make dem release both di man wey dey serve am wine and di one wey dey bake.
20 E aconteceu ao terceiro dia, o dia natalício de Faraó, que este deu um banquete a todos os seus servos; e levantou a cabeça do copeiro-mor, e a cabeça do padeiro-mor no meio dos seus servos;
21 Di one wey dey serve wine, Fero gi-am en work back.
21 e restaurou o copeiro-mor ao seu cargo de copeiro, e este deu o copo na mão de Faraó;
22 But e hang di baker, just as Josef tell dem before.
22 mas ao padeiro-mor enforcou, como José lhes havia interpretado.
23 But di man wey dey serve wine nor remember Josef again and e kon forget am.
23 O copeiro-mor, porém, não se lembrou de José, antes se esqueceu dele.

Ler em outra tradução

Comparar com outra

Estude este capítulo no WhatsApp

Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Gênesis 40, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.