Gênesis 39
Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs VC
1 Naw, dem kon take Josef kom Egypt and Potifa, one Fero offisa and di bodyguard oga for Egypt kon buy Josef from Ishmael pipol wey bring am kom der.
1 José foi conduzido ao Egito, e Putifar, um oficial egípcio do faraó, chefe da guarda, comprou-o aos ismaelitas que o levavam.
2 God dey with Josef and evritin dey betta for am, even as e dey for en Egypt oga house.
2 O Senhor estava com José, e tudo lhe prosperava. Morava na casa do seu senhor, o egípcio.
3 En oga kon si sey God dey with am and God dey make evritin wey Josef do, betta.
3 Seu senhor viu que o Senhor estava com ele e lhe fazia prosperar tudo o que empreendia.
4 Potifa kon like Josef well-well as Josef dey serve am, so e make am oga ova all di savants for en house and evritin wey e get.
4 José conquistou a simpatia do seu senhor, que o empregou ao seu serviço, pondo-o à testa de sua casa e confiando-lhe todos os seus bens.
5 From dat time, Potifa make Josef as pesin wey go dey kare for evritin wey dey en house and God kon dey bless Potifa house. Bikos of Josef, God blessing dey for evritin wey e get, both for di house and for di field.
5 Desde o momento em que José tomou o governo de sua casa e de todos os seus bens, o Senhor abençoou a casa do egípcio, por causa de José: a bênção do Senhor desceu sobre tudo o que lhe pertencia, na casa como nos campos.
6 So Potifa leave evritin wey e get for Josef make e kare for dem. So di only tin wey koncern Potifa for di house, na to chop.
6 Ele entregou todos os seus negócios a José, sem mais se preocupar de coisa alguma, exceto do que se alimentava. Ora, José era belo de corpo e de rosto.
7 Afta sometaim, en oga wife kon dey like am, den di woman tell am, “Make yu kom sleep with mi.”
7 E aconteceu, depois de tudo isto, que a mulher de seu senhor lançou seus olhos em José e disse-lhe: "Dorme comigo."
8 But Josef nor gri and e sey, “Si, bikos of mi, my oga nor even dey borda shek anytin for di house again and e don make mi dey kontrol evritin wey e get.
8 Mas ele recusou: "Meu senhor, disse-lhe ele, não me pede conta alguma do que se faz na casa, e confiou-me todos os seus bens.
9 Na mi big pass for dis house and my oga don give mi evritin escept yu, bikos yu bi en wife. So wetin go make mi do dis kind wikedness kon sin against God?”
9 Não há maior do que eu nesta casa; ele nada me interdisse, exceto tu, que és sua mulher. Como poderia eu cometer um tão grande crime e pecar contra Deus?"
10 As di woman dey tok to Josef evriday sey make e sleep with am or stay small with am, Josef nor dey listin to am.
10 Em vão se esforçava ela todos os dias, falando a José; ele não consentia em dormir com ela e unir-se a ela.
11 But one day wen Josef enter inside di house go do en work and all di oda savants nor dey inside di house,
11 Certo dia, tendo ele entrado na casa para fazer seus serviços, e não se encontrando ali ninguém da casa,
12 di woman kon hold en klot dey sey, “Make yu sleep with mi.” But e run komot di house kon leave en klot for di woman hand.
12 ela segurou-o pelo manto, dizendo: "Dorme comigo!" Mas José, largando-lhe o manto nas mãos, fugiu.
13 Wen di woman si sey Josef don leave en klot for en hand run komot from di house,
13 Vendo a mulher que ele lhe tinha deixado o manto nas mãos e fugido,
14 e kon koll di men for di house dey sey, “Si, my husband don bring one Hibru pesin make e kom take us do yeye. Josef won kon sleep with mi naim I shaut well-well.
14 chamou a gente de sua casa e disse-lhes: "Vede: trouxeram-nos este hebreu para a casa a fim de que ele abuse de nós. Este homem veio-me procurar para dormir comigo, mas eu gritei.
15 As Josef know sey I dey shaut and kry, e kon run komot di house, but e forget sey en klot dey near mi.”
15 E vendo que eu me punha a gritar, deixou seu manto ao meu lado e fugiu."
16 So di woman keep di klot until en husband kom,
16 E guardou junto de si as vestes de José até a volta de seu senhor.
17 den e tell am di same story sey, “Di Hibru savant wey yu bring kom dis house, waka enter my room won kon take mi do yeye.
17 E fez-lhe a mesma narrativa: "O escravo hebreu, disse ela, que nos trouxeste, veio à minha procura para abusar de mim.
18 But as soon as I bigin shaut dey kry, e kon run komot di house and e leave en klot.”
18 Mas, pondo-me a gritar, deixou o seu manto ao meu lado e fugiu."
19 As di oga hear di word wey en wife tell am sey, “Dis na how yor savant trit mi,” e kon dey vex for Josef.
19 Ao ouvir isto de sua mulher, contando-lhe como se tinha comportado com ela o seu servo, ele enfureceu-se,
20 So Josef oga karry Josef go put for prison. Na only pipol wey di king arrest dey-dey for di prison where dem karry Josef go.
20 e lançou José na prisão, onde se encontravam detidos os prisioneiros do rei. E José foi encarcerado.
21 But God dey with Josef kon show am as E love am rish and E make di pesin wey dey guide di prison, love Josef well-well too.
21 O Senhor estava com ele. Mostrou-lhe sua bondade e fez que ele conquistasse a simpatia do chefe da prisão.
22 So di pesin wey dey guide di prison put all di prisonas for Josef kare. Na Josef bi oga for evritin wey dem dey do.
22 Este confiou a José todos o presos que ali se encontravam, e nada se fazia sem sua ordem.
23 Di pesin wey dey guide di prison nor kare about anytin wey dem sey make Josef do or look afta, bikos God dey with Josef. Anytin wey e do, God dey make am susid.
23 O chefe da prisão não fiscalizava nada do que fazia José, porque o Senhor estava com ele e fazia-lhe prosperar tudo o que empreendia.
Atalhos do teclado
- Capítulo anterior←
- Próximo capítulo→
- Versículo anteriork
- Próximo versículoj
- Limpar seleçãoEsc
- Esta ajuda?
Estude este capítulo no WhatsApp
Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Gênesis 39, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.