Gênesis 37
Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs ARA
1 Jakob kon go stay for di land where en papa bin stay for Kanaan.
1 Habitou Jacó na terra das peregrinações de seu pai, na terra de Canaã.
2 Na Jakob story bi dis: Josef wey bi seventeen years dey kare for di sheep with en brodas. Naw e bi small boy wey dey work with en papa wifes, Bilhah and Zilpah sons. Josef kon tell en papa bad tins about dem.
2 Esta é a história de Jacó. Tendo José dezessete anos, apascentava os rebanhos com seus irmãos; sendo ainda jovem, acompanhava os filhos de Bila e os filhos de Zilpa, mulheres de seu pai; e trazia más notícias deles a seu pai.
3 Israel love Josef pass all en sons, bikos e don old before dem born am, so e kon make one special koat for am.
3 Ora, Israel amava mais a José que a todos os seus filhos, porque era filho da sua velhice; e fez-lhe uma túnica talar de mangas compridas.
4 Wen Josef brodas si sey dia papa like am pass dem, dem kon hate Josef and dey tok to am anyhow.
4 Vendo, pois, seus irmãos que o pai o amava mais que a todos os outros filhos, odiaram-no e já não lhe podiam falar pacificamente.
5 Josef dream and wen e tell en brodas about wetin e dream, dem kon hate am more-more.
5 Teve José um sonho e o relatou a seus irmãos; por isso, o odiaram ainda mais.
6 E tell dem sey, “Make una listin to my dream:
6 Pois lhes disse: Rogo-vos, ouvi este sonho que tive:
7 E get many korn for di field centre. At wons my korn stand up for di centre and una korn kon bow down for am!”
7 Atávamos feixes no campo, e eis que o meu feixe se levantou e ficou em pé; e os vossos feixes o rodeavam e se inclinavam perante o meu.
8 Den en brodas ask am, “So yu really tink sey yu go rule ova us or get pawa pass us?” So dem kon hate am more-more, bikos of di dream and wetin e tok.
8 Então, lhe disseram seus irmãos: Reinarás, com efeito, sobre nós? E sobre nós dominarás realmente? E com isso tanto mais o odiavam, por causa dos seus sonhos e de suas palavras.
9 Den, Josef dream anoda dream kon tell en brodas. “Make una si, I dream anoda dream. For dis dream, di sun, di moon and eleven stars kon bow down for mi.”
9 Teve ainda outro sonho e o referiu a seus irmãos, dizendo: Sonhei também que o sol, a lua e onze estrelas se inclinavam perante mim.
10 Wen e tell en papa and en brodas, en papa shaut for am kon sey, “Wetin bi dis dream wey yu dey dream? So mi, yor mama and all yor brodas go really kom bow down for yu?”
10 Contando-o a seu pai e a seus irmãos, repreendeu-o o pai e lhe disse: Que sonho é esse que tiveste? Acaso, viremos, eu e tua mãe e teus irmãos, a inclinar-nos perante ti em terra?
11 Josef brodas kon dey jealous am, but wetin Josef tok, en papa keep am for mind.
11 Seus irmãos lhe tinham ciúmes; o pai, no entanto, considerava o caso consigo mesmo.
12 Wen en brodas don go find food for dia papa animals near Shekem,
12 E, como foram os irmãos apascentar o rebanho do pai, em Siquém,
13 Israel kon tell Josef, “Yor brodas dey for di field near Shekem. Make yu kom make I send yu go meet dem.”
13 perguntou Israel a José: Não apascentam teus irmãos o rebanho em Siquém? Vem, enviar-te-ei a eles. Respondeu-lhe José: Eis-me aqui.
14 So Jakob tell am, “Make yu go si as yor brodas and di animals dey, den kon tell mi weda dem dey okay.” So Jakob send am go from Hebron Valley.
14 Disse-lhe Israel: Vai, agora, e vê se vão bem teus irmãos e o rebanho; e traze-me notícias. Assim, o enviou do vale de Hebrom, e ele foi a Siquém.
15 Wen Josef rish Shekem, one man kon si am dey waka anyhow for di field, so di man ask am, “Na wetin yu dey find?”
15 E um homem encontrou a José, que andava errante pelo campo, e lhe perguntou: Que procuras?
16 Josef ansa, “I dey find my brodas. Abeg make yu tell mi where dem and di animals dey.”
16 Respondeu: Procuro meus irmãos; dize-me: Onde apascentam eles o rebanho?
17 Di man kon sey, “Dem don komot dis aria, bikos I hear wen dem dey sey, ‘Make wi go Dotan.’ ” So Josef find en brodas go Dotan.
17 Disse-lhe o homem: Foram-se daqui, pois ouvi-os dizer: Vamos a Dotã. Então, seguiu José atrás dos irmãos e os achou em Dotã.
18 Wen Josef brodas si am dey kom from far and before e rish where dem dey, dem kon plan to kill-am.
18 De longe o viram e, antes que chegasse, conspiraram contra ele para o matar.
19 Dem tell each oda, “Si di oga wey sabi dream dey kom!
19 E dizia um ao outro: Vem lá o tal sonhador!
20 Make wi kill-am, trowey en body put for gutta, den wi go tell papa sey na wiked animal chop am. Den wi go si wetin go happen to en yeye dreams!”
20 Vinde, pois, agora, matemo-lo e lancemo-lo numa destas cisternas; e diremos: Um animal selvagem o comeu; e vejamos em que lhe darão os sonhos.
21 Wen Reuben hear wetin dem tok, e kon save Josef from dia hand wen e sey, “Make wi nor kill-am!”
21 Mas Rúben, ouvindo isso, livrou-o das mãos deles e disse: Não lhe tiremos a vida.
22 Reuben still sey, “Make wi nor put blood for awa head! So make wi trow am for gutta for here inside dis wildaness, but make una nor tosh am at-all.” (Reuben tok like dis so dat leta, e go-go save Josef give en papa.)
22 Também lhes disse Rúben: Não derrameis sangue; lançai-o nesta cisterna que está no deserto, e não ponhais mão sobre ele; isto disse para o livrar deles, a fim de o restituir ao pai.
23 Wen Josef rish where en brodas dey, dem komot en fine koat for en body, di one wey e papa make for am.
23 Mas, logo que chegou José a seus irmãos, despiram-no da túnica, a túnica talar de mangas compridas que trazia.
24 Den dem take am kon trow am put for one deep gutta. (Di gutta dey empty; wota nor dey inside.)
24 E, tomando-o, o lançaram na cisterna, vazia, sem água.
25 Wen dem sidan make dem bigin chop, dem kon si some karavan wey karry Ishmael pipol dey kom from Gilead. Dia kamel karry spice, balm and myrrh dey go Egypt.
25 Ora, sentando-se para comer pão, olharam e viram que uma caravana de ismaelitas vinha de Gileade; seus camelos traziam arômatas, bálsamo e mirra, que levavam para o Egito.
26 Den Judah kon tell en brodas, “Wetin wi go gain if wi kill awa own broda kon kover en blood?
26 Então, disse Judá a seus irmãos: De que nos aproveita matar o nosso irmão e esconder-lhe o sangue?
27 So make wi sell am give dis Ishmael pipol, but make wi nor kill-am, bikos e still bi awa broda; awa flesh and blood.” En brodas kon agri with wetin e tok.
27 Vinde, vendamo-lo aos ismaelitas; não ponhamos sobre ele a mão, pois é nosso irmão e nossa carne. Seus irmãos concordaram.
28 So wen Midian tradas dey pass, Josef brodas karry am komot di gutta kon sell am give Ishmael pipol for twenty silva. Den dem karry Josef go Egypt.
28 E, passando os mercadores midianitas, os irmãos de José o alçaram, e o tiraram da cisterna, e o venderam por vinte siclos de prata aos ismaelitas; estes levaram José ao Egito.
29 Leta, wen Reuben go back to di gutta, e kon si sey Josef nor dey der again! E tear en klot
29 Tendo Rúben voltado à cisterna, eis que José não estava nela; então, rasgou as suas vestes.
30 kon go meet en brodas sey, “Josef nor dey der again! So naw, where I won find am go?”
30 E, voltando a seus irmãos, disse: Não está lá o menino; e, eu, para onde irei?
31 So dem take Josef koat kon kill one small goat, den soak am inside di blood.
31 Então, tomaram a túnica de José, mataram um bode e a molharam no sangue.
32 Dem take di koat go give Jakob sey, “Dis na wetin wi si. Make yu look am well weda na yor pikin Josef own or not.”
32 E enviaram a túnica talar de mangas compridas, fizeram-na levar a seu pai e lhe disseram: Achamos isto; vê se é ou não a túnica de teu filho.
33 Jakob look am well kon sey, “Na my pikin own! One wiked animal don chop am! So, Josef don really die for wiked animal hand?”
33 Ele a reconheceu e disse: É a túnica de meu filho; um animal selvagem o terá comido, certamente José foi despedaçado.
34 Den Jakob tear en klot kon wear sak for body and e mourn for en pikin well-well.
34 Então, Jacó rasgou as suas vestes, e se cingiu de pano de saco, e lamentou o filho por muitos dias.
35 All en sons and dotas stand near am dey kounsol am, but e nor gri ansa dem. So Jakob kon kry well-well for Josef.
35 Levantaram-se todos os seus filhos e todas as suas filhas, para o consolarem; ele, porém, recusou ser consolado e disse: Chorando, descerei a meu filho até à sepultura. E de fato o chorou seu pai.
36 Naw, Midian pipol kon sell Josef for Egypt to Potifa, wey bi offisa to Fero and naim dey kaptain di guide dem.
36 Entrementes, os midianitas venderam José no Egito a Potifar, oficial de Faraó, comandante da guarda.
Atalhos do teclado
- Capítulo anterior←
- Próximo capítulo→
- Versículo anteriork
- Próximo versículoj
- Limpar seleçãoEsc
- Esta ajuda?
Estude este capítulo no WhatsApp
Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Gênesis 37, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.