Gênesis 35
Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs ARA
1 Den God tell Jakob, “Make yu go Bethel go stay. Make yu build one altar for God for where E for appear to yu wen yu dey run from Esau yor broda.”
1 Disse Deus a Jacó: Levanta-te, sobe a Betel e habita ali; faze ali um altar ao Deus que te apareceu quando fugias da presença de Esaú, teu irmão.
2 So Jakob tell en hold family and doz wey dey with am sey, “Make una skata all di oda gods wey dey with una. Make una go wosh unasef kon shange una klot.
2 Então, disse Jacó à sua família e a todos os que com ele estavam: Lançai fora os deuses estranhos que há no vosso meio, purificai-vos e mudai as vossas vestes;
3 Naw, make wi dey go Bethel. Den I go build altar for God wey dey ansa mi wen I dey trobol and E always dey with mi for anywhere wey I dey go.”
3 levantemo-nos e subamos a Betel. Farei ali um altar ao Deus que me respondeu no dia da minha angústia e me acompanhou no caminho por onde andei.
4 So dem give Jakob all di oda gods wey dey with dem and di rings wey dey dia ears. Jakob beri dem under one oak tree near Shekem
4 Então, deram a Jacó todos os deuses estrangeiros que tinham em mãos e as argolas que lhes pendiam das orelhas; e Jacó os escondeu debaixo do carvalho que está junto a Siquém.
5 and dem kon start dia journey. Di towns wey dey dat aria dey fear God and fear nor gri let dem porshu Jakob and en shidren.
5 E, tendo eles partido, o terror de Deus invadiu as cidades que lhes eram circunvizinhas, e não perseguiram aos filhos de Jacó.
6 Jakob and all di pipol wey dey with am kon rish Luz (wey bi Bethel naw) wey dey Kanaan land.
6 Assim, chegou Jacó a Luz, chamada Betel, que está na terra de Canaã, ele e todo o povo que com ele estava.
7 E build one altar for der kon koll am El Bethel (wey mean God house), bikos na for der God for show ensef to am wen e dey run from en broda.
7 E edificou ali um altar e ao lugar chamou El-Betel; porque ali Deus se lhe revelou quando fugia da presença de seu irmão.
8 (Deborah wey bi Rebekah nurse kon die and dem beri am under di oak tree for Bethel; so dem kon koll di place “Oak wey dem for dey kry.”)
8 Morreu Débora, a ama de Rebeca, e foi sepultada ao pé de Betel, debaixo do carvalho que se chama Alom-Bacute.
9 Afta Jakob kom back from Paddan Aram, God appear to am again kon bless am.
9 Vindo Jacó de Padã-Arã, outra vez lhe apareceu Deus e o abençoou.
10 God tell am, “Yor name na Jakob, but pipol nor go koll yu Jakob again; na Israel dem go dey koll yu.” So, God koll am Israel.
10 Disse-lhe Deus: O teu nome é Jacó. Já não te chamarás Jacó, porém Israel será o teu nome. E lhe chamou Israel.
11 Den God tell am, “Na mi bi di God wey get pawa. Yu go dey fruitful and yor propaty go plenty! One nashon; even many nashon go kom from yu and kings go dey join yor shidren-shidren!
11 Disse-lhe mais: Eu sou o Deus Todo-Poderoso; sê fecundo e multiplica-te; uma nação e multidão de nações sairão de ti, e reis procederão de ti.
12 Di land wey I give Abraham and Isaak, I go gi-am to yu and yor shidren-shidren.”
12 A terra que dei a Abraão e a Isaque dar-te-ei a ti e, depois de ti, à tua descendência.
13 Den God leave am for di place where E for dey tok to am.
13 E Deus se retirou dele, elevando-se do lugar onde lhe falara.
14 So Jakob arrange some stone for di place where God for tok to am. E kon use drink take do ofrin for God, den e pour oil put.
14 Então, Jacó erigiu uma coluna de pedra no lugar onde Deus falara com ele; e derramou sobre ela uma libação e lhe deitou óleo.
15 Jakob kon koll di place where God for tok to am Bethel.
15 Ao lugar onde Deus lhe falara, Jacó lhe chamou Betel.
16 Dem travel from Bethel go Efrat wey far from der small. Rashel kon dey labor and di belle dey pain am well-well.
16 Partiram de Betel, e, havendo ainda pequena distância para chegar a Efrata, deu à luz Raquel um filho, cujo nascimento lhe foi a ela penoso.
17 Wen di labor don strong well-well, di pesin wey won help am born kon tell am, “Make yu nor fear, bikos na anoda boy yu won born.”
17 Em meio às dores do parto, disse-lhe a parteira: Não temas, pois ainda terás este filho.
18 As Rashel dey breath like who won die, e kon koll di pikin Ben Oni. But Israel koll am Benjamin.
18 Ao sair-lhe a alma (porque morreu), deu-lhe o nome de Benoni; mas seu pai lhe chamou Benjamim.
19 So Rashel die and dem beri am for di road wey dem dey pass go Efrat (wey bi Betlehem naw).
19 Assim, morreu Raquel e foi sepultada no caminho de Efrata, que é Belém.
20 Jakob put one mark on-top di grave, so dem dey koll di place Rashel Grave kon rish today.
20 Sobre a sepultura de Raquel levantou Jacó uma coluna que existe até ao dia de hoje.
21 Den Israel kontinue en journey kon go stay for Migdal Eder.
21 Então, partiu Israel e armou a sua tenda além da torre de Éder.
22 As Israel dey for di land, Reuben kon go sleep with Bilhah, en papa girl-friend and Israel kon hear wetin happen. Jakob get twelf sons:
22 E aconteceu que, habitando Israel naquela terra, foi Rúben e se deitou com Bila, concubina de seu pai; e Israel o soube. Eram doze os filhos de Israel.
23 Di sons wey Leah born na Reuben wey bi Jakob first pikin, Simeon, Levi, Judah, Issakar and Zebulun.
23 Rúben, o primogênito de Jacó, Simeão, Levi, Judá, Issacar e Zebulom, filhos de Lia;
24 Di sons wey Rashel born na Josef and Benjamin.
24 José e Benjamim, filhos de Raquel;
25 Di sons wey Bilhah, Rashel savant born na Dan and Naftali.
25 Dã e Naftali, filhos de Bila, serva de Raquel;
26 Di sons wey Zilpah, Leah savant born na Gad and Asher.
26 e Gade e Aser, filhos de Zilpa, serva de Lia. São estes os filhos de Jacó, que lhe nasceram em Padã-Arã.
27 So Jakob kom back kon meet en papa Isaak for Mamre, wey dey Kiriat-Arba (wey bi Hebron naw), di place where Abraham and Isaak stay.
27 Veio Jacó a Isaque, seu pai, a Manre, a Quiriate-Arba (que é Hebrom), onde peregrinaram Abraão e Isaque.
28 Isaak stay for one hundred and eighty years.
28 Foram os dias de Isaque cento e oitenta anos.
29 Den Isaak kon die go join en grand-grand papa dem. E old well-well before e die and e live en life komplete. En sons Esau and Jakob kon go beri am.
29 Velho e farto de dias, expirou Isaque e morreu, sendo recolhido ao seu povo; e Esaú e Jacó, seus filhos, o sepultaram.
Atalhos do teclado
- Capítulo anterior←
- Próximo capítulo→
- Versículo anteriork
- Próximo versículoj
- Limpar seleçãoEsc
- Esta ajuda?
Estude este capítulo no WhatsApp
Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Gênesis 35, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.