Gênesis 34
Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs ARA
1 Dinah wey bi Leah dota wey e born for Jakob go visit di wimen for di land.
1 Ora, Diná, filha que Lia dera à luz a Jacó, saiu para ver as filhas da terra.
2 Hamor wey kom from Hiv, wen e pikin Shekem wey bi di prince for di land si di girl, e seize am kon sleep and disgrace am.
2 Viu-a Siquém, filho do heveu Hamor, que era príncipe daquela terra, e, tomando-a, a possuiu e assim a humilhou.
3 Den en mind nor gri komot di girl body again. E love di girl kon dey tok to am well.
3 Sua alma se apegou a Diná, filha de Jacó, e amou a jovem, e falou-lhe ao coração.
4 So Shekem tell en papa Hamor sey, “Make yu help mi get dis girl make e bi my wife.”
4 Então, disse Siquém a Hamor, seu pai: Consegue-me esta jovem para esposa.
5 Naw Jakob hear sey dem don rape and sleep with Dinah en dota. But en boys pikin dey di field with en animals, so Jakob nor tok until dem kom back.
5 Quando soube Jacó que Diná, sua filha, fora violada por Siquém, estavam os seus filhos no campo com o gado; calou-se, pois, até que voltassem.
6 So Hamor wey bi Shekem pikin kon meet and tok to Jakob.
6 E saiu Hamor, pai de Siquém, para falar com Jacó.
7 By dis time, Jakob sons don kom back from di field, but as soon as dem hear wetin happen, dem kon dey vex well-well, bikos wetin e do nor good at-all, bikos dis kind tin nor suppose happen for Israel.
7 Vindo os filhos de Jacó do campo e ouvindo o que acontecera, indignaram-se e muito se iraram, pois Siquém praticara um desatino em Israel, violentando a filha de Jacó, o que se não devia fazer.
8 But Hamor beg dem sey, “My pikin soul dey una sista hand. Abeg make una give di girl to am as en wife.
8 Disse-lhes Hamor: A alma de meu filho Siquém está enamorada fortemente de vossa filha; peço-vos que lha deis por esposa.
9 Make una allow us marry from una. Make una give us una dotas and make una marry awa dotas too.
9 Aparentai-vos conosco, dai-nos as vossas filhas e tomai as nossas;
10 Una go dey stay with us and una fit enter dis land wen ever una wont. Make una stay and sell for here kon get propaty for here too.”
10 habitareis conosco, a terra estará ao vosso dispor; habitai e negociai nela e nela tende possessões.
11 Shekem still tok to Jakob and en sons sey, “Make una forgive mi and anytin wey una ask mi, I go give una.
11 E o próprio Siquém disse ao pai e aos irmãos de Diná: Ache eu mercê diante de vós e vos darei o que determinardes.
12 Make una ask mi for big bride prize and gifts and I go give una evritin wey una ask for. All I wont na make una give mi una sista as my wife.”
12 Majorai de muito o dote de casamento e as dádivas, e darei o que me pedirdes; dai-me, porém, a jovem por esposa.
13 Jakob sons ansa Shekem and en papa Hamor with wayo, bikos e don disgrace dia sista, Dinah.
13 Então, os filhos de Jacó, por causa de lhes haver Siquém violado a irmã, Diná, responderam com dolo a Siquém e a seu pai Hamor e lhes disseram:
14 Dem sey, “Wi nor fit do dis tin; wi nor fit give awa sista to pesin wey dem neva sekonsaiz, bikos dat go bi disgrace for us.
14 Não podemos fazer isso, dar nossa irmã a um homem incircunciso; porque isso nos seria ignomínia.
15 Na only one tin go make us agri with una and dat na if una go gri bi as wi bi and evry man among una go sekonsaiz.
15 Sob uma única condição permitiremos: que vos torneis como nós, circuncidando-se todo macho entre vós;
16 Den wi go give una awa sista kon take una own too; wi go stay with una and wi go bi one family.
16 então, vos daremos nossas filhas, tomaremos para nós as vossas, habitaremos convosco e seremos um só povo.
17 But if una nor go listin to us and nor gri sekonsaiz, den wi go take awa dota and wi go-go.”
17 Se, porém, não nos ouvirdes e não vos circuncidardes, tomaremos a nossa filha e nos retiraremos embora.
18 Dis tin wey dem tok sweet Hamor and en pikin, Shekem.
18 Tais palavras agradaram a Hamor e a Siquém, seu filho.
19 So di yong man nor waste time as e go do di tin wey dem tell am, bikos e love Dinah, wey bi Jakob pikin well-well. True-true, na en dem dey honor pass for en papa house.
19 Não tardou o jovem em fazer isso, porque amava a filha de Jacó e era o mais honrado de toda a casa de seu pai.
20 So Hamor and en pikin Shekem kom di town gate kon tok to all di men for di town sey,
20 Vieram, pois, Hamor e Siquém, seu filho, à porta da sua cidade e falaram aos homens da cidade:
21 “Dis men nor dey look for trobol; make dem stay for awa land kon sell with us, bikos di land big rish for all of us. Make wi marry dia dotas as awa wifes and make wi give dem awa dotas as dia wifes too.
21 Estes homens são pacíficos para conosco; portanto, habitem na terra e negociem nela. A terra é bastante espaçosa para contê-los; recebamos por mulheres a suas filhas e demos-lhes também as nossas.
22 But na only for one kondishon di men go agri to stay with us as one family and na sey, evry man among us go sekonsaiz as dem sekonsaiz too.
22 Somente, porém, consentirão os homens em habitar conosco, tornando-nos um só povo, se todo macho entre nós se circuncidar, como eles são circuncidados.
23 If wi do wetin dem tok, all dia animals and propaty go bi awa own. Make wi just gri with dem and dem go stay with us.”
23 O seu gado, as suas possessões e todos os seus animais não serão nossos? Consintamos, pois, com eles, e habitarão conosco.
24 All of dem leave di gate afta dem don listin to Hamor and en pikin Shekem and all di men kon go sekonsaiz, dat is all of dem wey kom di town gate.
24 E deram ouvidos a Hamor e a Siquém, seu filho, todos os que saíam da porta da cidade; e todo homem foi circuncidado, dos que saíam pela porta da sua cidade.
25 So for di third day, wen all of dem still get sore, two among Jakob sons, Simeon and Levi, Dinah brodas, take swod go fight di town kon kill all di men.
25 Ao terceiro dia, quando os homens sentiam mais forte a dor, dois filhos de Jacó, Simeão e Levi, irmãos de Diná, tomaram cada um a sua espada, entraram inesperadamente na cidade e mataram os homens todos.
26 Dem kill Hamor and en pikin Shekem with di swod, take Dinah komot from Shekem house, den dem kon go.
26 Passaram também ao fio da espada a Hamor e a seu filho Siquém; tomaram a Diná da casa de Siquém e saíram.
27 Jakob sons kom di town where dem for kill all di men kon pak dia propaty and skata di town, bikos dem don disgrace and rape dia sista.
27 Sobrevieram os filhos de Jacó aos mortos e saquearam a cidade, porque sua irmã fora violada.
28 Dem take dia animals and all di propaty wey dey di town and di field.
28 Levaram deles os rebanhos, os bois, os jumentos e o que havia na cidade e no campo;
29 All dia propaty, dia shidren and dia wifes, dem katch dem kon skata der.
29 todos os seus bens, e todos os seus meninos, e as suas mulheres levaram cativos e pilharam tudo o que havia nas casas.
30 Den Jakob tell Simeon and Levi sey, “Una don turn mi to dirty wey dey smell to di pipol for dis land, Kanaan pipol and Periz pipol, bikos of di wahala wey una put for my head. My pipol nor plenty and if dem gada demsef kon attack mi, dem go distroy both mi and my family.”
30 Então, disse Jacó a Simeão e a Levi: Vós me afligistes e me fizestes odioso entre os moradores desta terra, entre os cananeus e os ferezeus; sendo nós pouca gente, reunir-se-ão contra mim, e serei destruído, eu e minha casa.
31 But dem sey, “So e good as e trit awa sista like ashawo?”
31 Responderam: Abusaria ele de nossa irmã, como se fosse prostituta?
Atalhos do teclado
- Capítulo anterior←
- Próximo capítulo→
- Versículo anteriork
- Próximo versículoj
- Limpar seleçãoEsc
- Esta ajuda?
Estude este capítulo no WhatsApp
Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Gênesis 34, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.