Gênesis 32
Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs ARA
1 Jakob kon go en own way and God angels kom meet am.
1 Também Jacó seguiu o seu caminho, e anjos de Deus lhe saíram a encontrá-lo.
2 Wen Jakob si dem, e kon sey, “God dey for dis place!” So e name di place Mahanaim.
2 Quando os viu, disse: Este é o acampamento de Deus. E chamou àquele lugar Maanaim.
3 Jakob send message go meet en broda Esau for Seir wey dey for Edom land
3 Então, Jacó enviou mensageiros adiante de si a Esaú, seu irmão, à terra de Seir, território de Edom,
4 and e tell dem sey, “Make una tell my oga Esau sey: Dis na wetin yor savant Jakob tok, ‘I don dey stay with Laban since kon rish naw.
4 e lhes ordenou: Assim falareis a meu senhor Esaú: Teu servo Jacó manda dizer isto: Como peregrino morei com Labão, em cuja companhia fiquei até agora.
5 I get difren animals, man and woman savants. I just sey make I kon tell my oga, so dat e go forgive mi.’ ”
5 Tenho bois, jumentos, rebanhos, servos e servas; mando comunicá-lo a meu senhor, para lograr mercê à sua presença.
6 Leta, di messenja kom back kon tell Jakob sey, “Wi go meet yor broda Esau and E dey kom meet yu and 400 men dey with am.”
6 Voltaram os mensageiros a Jacó, dizendo: Fomos a teu irmão Esaú; também ele vem de caminho para se encontrar contigo, e quatrocentos homens com ele.
7 Den Jakob kon dey fear and en mind nor setol. E divide both di pipol wey dey with am and di animals into two group,
7 Então, Jacó teve medo e se perturbou; dividiu em dois bandos o povo que com ele estava, e os rebanhos, e os bois, e os camelos.
8 bikos e tink sey, “If Esau kom attack one group, den di oda group for di oda side go run.”
8 Pois disse: Se vier Esaú a um bando e o ferir, o outro bando escapará.
9 Jakob kon sey, “My papa Abraham and Isaak God, di Oga God wey tell mi sey, ‘Make yu go back to yor kountry and yor family, so dat I go do good for yu,’
9 E orou Jacó: Deus de meu pai Abraão e Deus de meu pai Isaque, ó Senhor , que me disseste: Torna à tua terra e à tua parentela, e te farei bem;
10 I nor deserve all di good tins and kindness wey Yu don show mi, yor savant, bikos na with only my rod I take cross Jordan River, but naw, I don divide my family and propaty into two.
10 sou indigno de todas as misericórdias e de toda a fidelidade que tens usado para com teu servo; pois com apenas o meu cajado atravessei este Jordão; já agora sou dois bandos.
11 Abeg, make Yu save mi from Esau my broda; bikos I dey fear sey e fit kom attack mi, my wifes and my shidren.
11 Livra-me das mãos de meu irmão Esaú, porque eu o temo, para que não venha ele matar-me e as mães com os filhos.
12 Yu bin sey, ‘I go really do good for yu kon make yor shidren plenty like san-san wey nobody fit kount.’ ”
12 E disseste: Certamente eu te farei bem e dar-te-ei a descendência como a areia do mar, que, pela multidão, não se pode contar.
13 So Jakob stay der dat nite and from all di tins wey e get, e kon send some present go give en broda Esau.
13 E, tendo passado ali aquela noite, separou do que tinha um presente para seu irmão Esaú:
14 Di present na two hundred woman goat, twenty man goat, two hundred iyu, twenty ram,
14 duzentas cabras e vinte bodes; duzentas ovelhas e vinte carneiros;
15 thirty kamel wey get betta milk for breast and dia shidren, forty melu and ten bull, twenty woman donkey and ten man donkey.
15 trinta camelas de leite com suas crias, quarenta vacas e dez touros; vinte jumentas e dez jumentinhos.
16 E pak dem give en savants and dem separate dem, den e sey, “Make una dey go for front and make una make sure sey dem nor join togeda.”
16 Entregou-os às mãos dos seus servos, cada rebanho à parte, e disse aos servos: Passai adiante de mim e deixai espaço entre rebanho e rebanho.
17 E tell di savant wey dey front-front sey, “Wen my broda Esau meet and ask yu sey, ‘Na who bi yor oga? Where yu from dey kom? Who get all dis animal wey yu dey guide?’
17 Ordenou ao primeiro, dizendo: Quando Esaú, meu irmão, te encontrar e te perguntar: De quem és, para onde vais, de quem são estes diante de ti?
18 Den make yu sey, ‘Dem bi yor savant Jakob own. E send dem as gift kon give yu, Esau awa oga. Jakob sef dey kom for awa back.’ ”
18 Responderás: São de teu servo Jacó; é presente que ele envia a meu senhor Esaú; e eis que ele mesmo vem vindo atrás de nós.
19 E still kommand di sekond one with all di oda savants for en front wey dey follow di gifts sey, “All of una must tell my broda Esau di same tin wen una meet am.
19 Ordenou também ao segundo, ao terceiro e a todos os que vinham conduzindo os rebanhos: Falareis desta maneira a Esaú, quando vos encontrardes com ele.
20 Una must sey, ‘Yor savant Jakob dey kom for back.’ ” Jakob tink for en mind sey, “I go first beg am with di gifts wey I dey send go for front. Afta dat one, I go meet am, den may bi e go fit forgive mi.”
20 Direis assim: Eis que o teu servo Jacó vem vindo atrás de nós. Porque dizia consigo mesmo: Eu o aplacarei com o presente que me antecede, depois o verei; porventura me aceitará a presença.
21 So e send di gifts go for front, while e kon sleep for en kamp dat nite.
21 Assim, passou o presente para diante dele; ele, porém, ficou aquela noite no acampamento.
22 For nite, Jakob kwik-kwik take en two wife, en two savant and en eleven shidren kon go Jabbok wotaside.
22 Levantou-se naquela mesma noite, tomou suas duas mulheres, suas duas servas e seus onze filhos e transpôs o vau de Jaboque.
23 E take dem cross di wota with all di tins wey e get.
23 Tomou-os e fê-los passar o ribeiro; fez passar tudo o que lhe pertencia,
24 So na only Jakob kon dey. Den en and one man fight till day break.
24 ficando ele só; e lutava com ele um homem, até ao romper do dia.
25 Wen di man si sey e nor fit beat Jakob, e kon shift di bone for Jakob lap komot from where e dey.
25 Vendo este que não podia com ele, tocou-lhe na articulação da coxa; deslocou-se a junta da coxa de Jacó, na luta com o homem.
26 Den di man sey, “Make yu allow mi dey go, bikos day don dey break.”
26 Disse este: Deixa-me ir, pois já rompeu o dia. Respondeu Jacó: Não te deixarei ir se me não abençoares.
27 Den di man ask Jakob, “Wetin bi yor name?”
27 Perguntou-lhe, pois: Como te chamas? Ele respondeu: Jacó.
28 Den di man sey, “Dem nor go koll yu Jakob again, but from today go, na Israel dem go dey koll yu, bikos yu don fight with God and man and yu don win.”
28 Então, disse: Já não te chamarás Jacó, e sim Israel, pois como príncipe lutaste com Deus e com os homens e prevaleceste.
29 Den Jakob ask am, “Abeg make yu tell mi yor name.”
29 Tornou Jacó: Dize, rogo-te, como te chamas? Respondeu ele: Por que perguntas pelo meu nome? E o abençoou ali.
30 So Jakob koll di place Penuel, kon sey, “I don si God face-to-face and I still dey alive.”
30 Àquele lugar chamou Jacó Peniel, pois disse: Vi a Deus face a face, e a minha vida foi salva.
31 E nor fit waka well as e dey pass Penuel land, bikos of en lap wey dey pain am, so sun kon dey beat am.
31 Nasceu-lhe o sol, quando ele atravessava Peniel; e manquejava de uma coxa.
32 Dat na why till today, Israel pipol nor dey chop di meat wey dey lap, bikos di man tosh Jakob lap.
32 Por isso, os filhos de Israel não comem, até hoje, o nervo do quadril, na articulação da coxa, porque o homem tocou a articulação da coxa de Jacó no nervo do quadril.
Atalhos do teclado
- Capítulo anterior←
- Próximo capítulo→
- Versículo anteriork
- Próximo versículoj
- Limpar seleçãoEsc
- Esta ajuda?
Estude este capítulo no WhatsApp
Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Gênesis 32, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.