Gênesis 31
Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs VC
1 Jakob kon hear sey, Laban shidren dey sey, “Jakob don take evritin wey bi awa papa own and naw, e don get money well-well.”
1 Jacó ouviu as palavras dos filhos de Labão, que diziam: "Jacó tomou tudo o que é de nosso pai, e é às suas custas que ele se tornou de tal forma rico."
2 So Jakob kon si sey Laban nor dey do as e dey do with am before.
2 Observou também, pela fisionomia de Labão, que este não tinha mais para com ele os sentimentos de antes.
3 Den God tell Jakob, “Make yu go back to yor papa and yor family and I go dey with yu.”
3 O Senhor disse a Jacó: "Volta para a terra dos teus pais, para a tua parentela, e eu estarei contigo."
4 So Jakob sey make dem koll Rashel and Leah kom meet am for di field
4 Então Jacó mandou Raquel e Lia vir ao campo junto dos seus rebanhos:
5 and e tell dem, “E klear sey una papa nor like mi again. But di God wey bi my papa God always dey with mi.
5 "Vejo, disse-lhes ele, pelo semblante de vosso pai, que ele não é mais para comigo o mesmo que antes. Mas o Deus de meu pai está comigo.
6 Una know sey I don serve una papa with all my mind and pawa,
6 Sabeis que servi a vosso pai o melhor que pude,
7 yet una papa wont shit and short-pay mi. But God nor gri make una papa wound mi.
7 enquanto ele zombou de mim, mudando dez vezes o meu salário; mas Deus não lhe permitiu causar-me prejuízo.
8 If una papa sey, ‘Di animals wey get spot go bi yor pay,’ dat mean sey all di animal wey dem born with spot for body go bi my own and if una papa sey, ‘Di one wey get mark go bi yor pay,’ den all di animals wey dem born with mark for dia body, go bi my own too.
8 Quando ele dizia: os animais malhados serão o teu salário, todas as ovelhas davam à luz cordeiros malhados, e se dizia: os animais riscados serão o teu salário, todas as ovelhas davam à luz cordeiros riscados.
9 Like dis, God don give mi many of una papa animals.
9 Foi Deus mesmo que tomou o rebanho de vosso pai para me dar.
10 For di time wen animals dey sleep with each oda, I look kon si for dream sey di goats wey dey sleep with di oda animals, get mark, spot and dem dey black.
10 No tempo em que os animais deviam conceber, eu levantava os olhos e via em sonhos que os bodes que cobriam as cabras eram listados, malhados e manchados.
11 Den God angel tell mi for di dream, ‘Jakob,’ so I ansa, ‘Na mi bi dis!’
11 Um anjo de Deus disse-me em sonhos: Jacó! Eis-me aqui, respondi.
12 Di angel sey, ‘Make yu si and know sey, all di goats wey sleep with di oda animals, get spot, mark and dem black, bikos I don si evritin wey Laban dey do yu.
12 Levanta os olhos e vê: todos os bodes que cobrem as cabras são listados, malhados e manchados, porque eu vi tudo o que te fez Labão.
13 Bikos na mi bi di God wey dey for Bethel, di place where yu for anoint stone kon make vow. Naw, make yu get up komot from dis land, den go back go meet yor pipol.’ ”
13 Eu sou o Deus de Betel, onde tu me consagraste uma estela e me fizeste um voto. Agora, vamos, sai daqui e volta para a terra de tua família."
14 Den Rashel and Leah ansa, “E still get anytin wey remain for us for awa papa house?
14 Raquel e Lia responderam: "Resta-nos porventura ainda alguma parte de herança na casa de nosso pai?
15 E nor dey trit us like strenjas naw? Bikos e don sell us and e don really chop di money.
15 Não nos tratou ele como estrangeiras, vendendo-nos e devorando o nosso dinheiro?
16 All di money and propaty wey God don take from awa papa hand, na wi and awa shidren get dem.”
16 Toda a riqueza, que Deus tomou de nosso pai, é para nós e para nossos filhos. Faze, pois, o que Deus te disse."
17 So Jakob kon put en wife and shidren on-top kamel.
17 Levantou-se, pois, Jacó, e fez montar seus filhos e suas mulheres nos camelos.
18 E karry all en animals, all en propaty wey e don get, di animals wey e buy for Paddan Aram den e kon dey go Kanaan Land go meet en papa Isaak.
18 Levou consigo todos os seus rebanhos, todos os bens que tinha ajuntado, o rebanho que lhe pertencia, adquirido em Padã-Arã, e partiu para junto de seu pai Isaac, na terra de Canaã.
19 As Laban go kare for en sheep, Rashel kon tif en papa gods for di house.
19 Raquel, aproveitando um momento em que seu pai fora tosquiar suas ovelhas, roubou os terafim de seu pai;
20 Jakob deceive Laban di Aramean, bikos e nor tell dem sey e won go.
20 e Jacó enganou Labão, o arameu, ocultando-lhe sua fuga.
21 E go with evritin wey e get. E cross Eufrates River den e kon face di hill kountries for Gilead.
21 Fugindo, pois, com tudo o que era seu, atravessou o rio e dirigiu-se para a montanha de Galaad.
22 Wen dem tell Laban for di third day sey Jakob don run,
22 Três dias depois, soube Labão da fuga de Jacó.
23 e take en men with am kon porshu Jakob for seven days. E katch am for di hill kountries for Gilead.
23 E, tomando consigo seus irmãos, perseguiu-o durante sete dias de marcha, e alcançou-o na montanha de Galaad.
24 But God kom meet Laban for dream for nite kon tell am, “Make yu mind wetin yu go tell Jakob, weda e dey good or bad.”
24 Deus, porém, apareceu num sonho noturno a Labão, o arameu, e disse-lhe: "Guarda-te de dizer algo a Jacó."
25 Laban meet Jakob for where e dey. Naw Jakob don build tent for di hill and Laban and en men still build tent for dat aria too.
25 Labão alcançou, pois, Jacó. Este havia levantado sua tenda na montanha, enquanto Labão e seus irmãos tinham plantado a sua na montanha de Galaad.
26 So Laban tell Jakob, “Wetin make yu just deceive mi kon karry my dotas dey go like pipol wey dem katch with swod?
26 Labão disse a Jacó: "Que fizeste? Tu me enganaste, e conduziste minhas filhas como prisioneiras de guerra!
27 Why yu play wayo run kon deceive mi? But yu for tell mi, so dat I go free yu with good mind kon play instrument and sing betta song for yu.
27 Por que fugiste dessa forma, e me lograste em lugar de me avisar? Eu te teria despedido com manifestações de júbilo e com cânticos, ao som do tamborim e da harpa.
28 Why yu nor allow mi tell my grand-shidren and dotas bye-bye? Si, wetin yu do so, nor dey good at-all.
28 Não me deixaste beijar meus filhos e minhas filhas! Procedeste como um insensato.
29 If I won wound yu, I go fit do am. But yor papa God tell mi yestiday nite for dream sey, ‘Make yu mind wetin yu go tell Jakob, weda e dey good or bad.’
29 Eu poderia agora fazer-vos mal, mas o Deus de teu pai disse-me na última noite: Guarda-te de dizer algo a Jacó.
30 And naw yu just dey go, bikos e don tey wey yu dey won go yor papa house, but wetin make yu tif my gods?”
30 E, se partiste somente porque tinhas saudade da casa paterna, então por que roubaste os meus deuses?"
31 Jakob ansa Laban, “Na fear kause am, bikos I tink sey yu go take yor shidren from mi with force.
31 Jacó respondeu-lhe: "Tive medo, ao pensar que poderias tirar-me tuas filhas;
32 But anybody hand wey yu for si yor gods, go die. For all dis men present make yu point di tin wey I karry wey bi yor own, den make yu take am.” Naw Jakob nor know sey na Rashel tif di gods.
32 quanto aos teus deuses, porém, seja morto aquele que os tiver consigo! Examina o que está comigo, em presença de nossos parentes, e retoma o que é teu." Ora, Jacó ignorava o roubo de Raquel.
33 So Laban enter Jakob room and Leah room with di two savant own, but e nor si anytin. Den e komot from Leah room kon enter Rashel own.
33 Labão entrou na tenda de Jacó, na de Lia e na das duas escravas, mas nada encontrou. Saindo da tenda de Lia, entrou na de Raquel.
34 Naw, Rashel don take di gods kon put dem for kamel den e sidan put. Laban look evriwhere for di tent, but e nor si dem.
34 Esta havia tomado os terafim e, colocando-os na sela do camelo, sentou-se em cima. Labão revistou toda a tenda, sem nada encontrar.
35 Den Rashel tell en papa, “Make my oga nor vex sey I nor fit stand, bikos I dey si my period.” So e look evriwhere and e nor si di gods.
35 Raquel disse ao seu pai: "Não se irrite o meu senhor, se não posso levantar-me em sua presença, pois acho-me agora com a indisposição que costuma vir às mulheres." Revistou, pois, mas não encontrou os terafim.
36 Den Jakob kon dey vex well-well for Laban sey, “Na wetin I do? Na wish sin I kommit wey make yu porshu mi like dis?
36 Jacó encolerizou-se então contra Labão, e acabrunhou-o de censuras: "Qual é o meu crime?, disse-lhe ele. Qual é o meu pecado, para que te irrites desse modo contra mim?
37 Yu don shek evritin wey I get; wetin yu don si wey bi yor own? Make yu bring am kom out before my men and yor men, so dat dem go tok put for dis matter.
37 Revistaste todas as minhas bagagens: que encontraste do que é teu? Mostra-me aqui em presença de meus parentes e dos teus, e sejam eles juízes entre nós dois.
38 “I don dey with yu for twenty years naw. Yor animals wey get belle dey always born and I neva for one day chop one among yor animals.
38 Há vinte anos que estou em tua casa: tuas ovelhas e tuas cabras não abortaram, não comi os carneiros do teu rebanho.
39 Anytin wey wiked animal chop, I nor dey bring dem kom meet yu, I dey karry di cross by mysef. Yu dey ask of am from my hand, weda dem tif am for nite or day time.
39 Nunca te trouxe os animais estraçalhados pelas feras. Eu os repunha, pois tu o exigias, quer fossem roubados de dia, quer de noite.
40 Na der I dey-dey: for day time, di sun dey waya mi and for nite, kold dey won kill mi and sleep dey komot my eyes.
40 Eu era queimado de dia pelo calor, e de noite pelo frio, e o sono fugia dos meus olhos.
41 For dis twenty years wen I dey for yor house. I serve yu for fourteen years for yor two dotas and six years for di animals, but yu still dey short-pay mi anyhow.
41 Eis já vinte anos que estou em tua casa; servi-te catorze anos por tuas duas filhas, seis anos pelos teus rebanhos, e dez vezes modificaste o meu salário.
42 If my papa God, Abraham God and di Pesin wey Isaak dey fear nor dey with mi, true-true yu for porshu mi go without anytin. God si my mind and di work wey I dey do with my hand, naim make am tok to yu yestiday nite.”
42 Se o Deus de meu pai, o Deus de Abraão, o Deus terrível de Isaac não se tivesse posto de meu lado, tu me terias hoje despedido com as mãos vazias. Deus viu minhas penas e meus trabalhos, e na última noite ele pronunciou-se.
43 Den Laban ansa Jakob, “Di girls na my pikin, di shidren na my shidren, di animals na my animals and evritin wey yu dey si so, na my own. But wetin go make mi ponish my dotas and di shidren wey dem born?
43 Labão respondeu a Jacó: "Estas filhas são minhas filhas, estes filhos, meus filhos, e estes rebanhos, meus rebanhos: tudo o que vês é meu. Que farei eu agora contra minhas filhas, ou contra os filhos que elas deram ao mundo?
44 So make yu kom make wi enter agriment; dat is yu and mi. And dat one go show sey wi don setol.”
44 Vamos, façamos juntos um pacto que nos sirva de testemunho a nós dois."
45 So Jakob take one stone kon set am as pila for der.
45 Jacó tomou uma pedra e erigiu-a em estela,
46 Den Jakob tell en men, “Make una gada stones.” And dem gada many stones wey high like mountin den dem kon chop for der.
46 e disse aos seus parentes: "Trazei pedras." E, tendo juntado muitas, fizeram um monte, sobre o qual comeram.
47 Laban koll am Jegar-Sahaduta, but Jakob koll am Galeed.
47 Labão chamou-o Yegar-Saaduta, e Jacó, Galaad.
48 Laban kon sey, “Dis stones na witness between yu and mi today.” Dat na why dem koll am Galeed
48 Labão disse: "Este monte é hoje testemunha entre mim e ti",e por isso deu-se-lhe o nome de Galaad,
49 and Mizpa, bikos e sey, “Make di Oga God dey wosh mi and yu, even wen wi nor dey togeda again.
49 e também Mitspa, porque Labão disse ainda: "Que o Senhor nos vigie a nós ambos, quando nós nos tivermos despedido um do outro.
50 “If yu opress my dotas or if yu marry anoda wife follow my dotas, aldo nobody dey to si us, but God na awa witness.”
50 Se maltratares minhas filhas, e se tomares outras mulheres além delas, não é um homem que estará conosco. Mas toma cuidado, pois é Deus que será testemunha entre nós."
51 Den Laban tell Jakob, “Si dis stones and di pila wey wi build between us.
51 Labão disse ainda a Jacó: "Vês este monte de pedras e esta estela que levantei entre mim e ti.
52 Na dem go bi witness and I nor go ever pass di stones kom meet yu and yu too nor go ever pass kom meet mi, bikos yu won kon fight mi.
52 Este monte é testemunho, e igualmente esta estela, de que eu não ultrapassarei este monte para o teu lado, e que tu não ultrapassarás este monte e esta estela para o meu lado para nos fazer mal.
53 Abraham and Nahor God, dia grand-papa God go judge between yu and mi.”
53 O Deus de Abraão, o Deus de Nacor, o Deus de seus pais seja juiz entre nós!" E Jacó jurou pelo Deus terrível de Isaac.
54 and Jakob offa sakrifice for di hill kon koll en men kom chop bread. Dem chop bread kon sleep for di hill dat nite.
54 Ofereceu um sacrifício sobre a montanha e convidou seus parentes para comer. Comeram e passaram a noite na montanha.
55 Very early for di next morning, Laban wake-up kon kiss en grand-shidren and en dotas, den e bless dem. Den Laban kon go en house.
55 No dia seguinte pela manhã, Labão beijou seus filhos e suas filhas; abençoou-os e retomou o caminho de sua casa.
Atalhos do teclado
- Capítulo anterior←
- Próximo capítulo→
- Versículo anteriork
- Próximo versículoj
- Limpar seleçãoEsc
- Esta ajuda?
Estude este capítulo no WhatsApp
Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Gênesis 31, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.