Gênesis 30

Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs VC

Sair da comparação
VC Versão Católica
1 Wen Rashel si sey e nor fit born shidren for en husband, e kon dey jealous Leah, en sista. Den e tell Jakob, “Make yu give mi shidren or I go die!”
1 Raquel, vendo que não dava filhos a Jacó, teve inveja de sua irmã: "Dá-me filhos, disse ela ao seu marido, senão morro!"
2 Jakob kon dey vex with Rashel so e sey, “Na mi bi God wey neva give yu pikin?”
2 E Jacó irritou-se com ela. "Acaso, disse ele, posso eu pôr-me no lugar de Deus que te recusou a fecundidade?"
3 Rashel ansa, “I wont make yu sleep with my savant Bilhah, so dat e go born shidren for mi and I go kon get my own family thru am.”
3 Ela respondeu: "Eis minha serva Bala: toma-a. Que ela dê à luz sobre os meus joelhos e assim, por ela, terei também filhos."
4 So Rashel give en savant Bilhah to Jakob and Jakob kon sleep with am.
4 Deu-lhe, pois, por mulher sua escrava Bala, da qual se aproximou Jacó.
5 Bilhah get belle kon born boy pikin for Jakob.
5 Bala concebeu e deu à luz um filho a Jacó.
6 Den Rashel sey, “God don save mi. E don ansa my prayers kon give mi boy pikin.” Dat na why Rashel koll di pikin Dan.
6 Disse então Raquel: "Deus fez-me justiça. Ele ouviu minha voz e deu-me um filho." Por isso ela o chamou Dã.
7 Rashel savant Bilhah kon get belle again for Jakob and e still born boy.
7 Bala, escrava de Raquel, concebeu de novo e deu à luz um segundo filho a Jacó.
8 Den Rashel sey, “I don really fight betta fight with Leah, my sista and I don win.” So e koll di pikin Naftali.
8 Raquel disse: "Lutei contra minha irmã junto de Deus, e venci!" E deu ao menino o nome de Neftali.
9 Wen Leah si sey e nor fit born again, e kon give en savant Zilpah to Jakob.
9 Lia, vendo que não concebia mais, tomou sua escrava Zelfa e deu-a por mulher a Jacó.
10 E nor too tey before Leah savant Zilpah born boy for Jakob.
10 Zelfa, escrava de Lia, deu à luz um filho a Jacó.
11 Leah kon sey, “E good well-well!” So e koll di pikin Gad.
11 Lia disse: "Que sorte!" E chamou-o Gad.
12 Den Leah savant Zilpah born anoda pikin for Jakob.
12 Zelfa, escrava de Lia, deu à luz um segundo filho a Jacó.
13 Leah kon sey, “My belle dey sweet mi, bikos wimen go dey happy well-well, bikos of mi!” So e koll di pikin Asher.
13 Lia disse: "Que felicidade! As mulheres me chamarão ditosa." E chamou-o Aser.
14 So wen dem dey do di wheat feast, Reuben komot kon si some mandrake plants for di field, den e bring dem kon give en mama Leah. Rashel kon tell en sista Leah, “Make yu give mi some for di plant wey yor pikin bring.”
14 Um dia, por ocasião da ceifa, Rubem saiu ao campo e, tendo encontrado umas mandrágoras, levou-as à sua mãe Lia. Raquel disse a Lia: "Rogo-te que me dês as mandrágoras do teu filho."
15 But Leah ansa, “So my husband wey yu take neva do yu? Yu won still take my pikin mandrake too?”
15 Lia respondeu: "Já não é bastante o teres tomado meu marido, para que queiras ainda as mandrágoras do meu filho?" "Pois bem, tornou Raquel, em troca das mandrágoras do teu filho, que ele durma contigo esta noite."
16 Wen Jakob kom back from di field dat evening, Leah go meet am kon sey, “Yu must sleep with mi today o-o, bikos I don pay to get yu with my pikin mandrake.” So Jakob sleep with am dat nite.
16 À noite, quando Jacó voltou do campo, Lia saiu-lhe ao encontro: "Vem comigo, disse-lhe ela, eu te aluguei em troca das mandrágoras do meu filho." E Jacó dormiu com ela aquela noite.
17 God hear Leah prayer; so e kon get belle and e born anoda boy for Jakob for di fift time.
17 Deus ouviu Lia, que concebeu e deu à luz um quinto filho a Jacó.
18 Den Leah sey, “God don give mi my reward, bikos I give my savant to my husband make e sleep with am.” So e koll am Issakar.
18 "Deus, disse ela, recompensou-me por eu ter dado minha escrava ao meu marido." E o chamou Issacar.
19 Leah get belle again and e born di nomba six boy.
19 Lia concebeu ainda e deu à luz um sexto filho a Jacó.
20 Den Leah sey, “God don give mi betta gift. Naw, my husband go honor mi, bikos I don born six boys for am.” So e kon am Zebulun.
20 E disse: "Deus deu-me um belo presente; agora meu marido habitará comigo, pois que lhe dei à luz seis filhos." E o chamou Zabulon.
21 Afta, Leah born one girl kon koll am Dinah.
21 Depois disso, deu à luz uma filha, a quem chamou Dina.
22 Den God sorry for Rashel. E hear en prayer kon make am get belle.
22 Lembrou-se Deus de Raquel, ouviu-a e tornou-a fecunda.
23 Rashel get belle kon born boy. Den Rashel sey, “God don take my shame komot.”
23 Raquel concebeu e deu à luz um filho. "Deus, disse ela, tirou o meu opróbrio."
24 E kon koll am Josef wey mean, “Make God give mi anoda boy pikin.”
24 E chamou-o José, dizendo: "Dê-me o Senhor ainda outro filho!"
25 Afta Rashel don born Josef, Jakob kon tell Laban, “Make yu let mi go house go meet my own pipol for my own kountry.
25 Tendo Raquel dado à luz José, Jacó disse a Labão: "Deixa-me partir para a minha casa, na minha terra.
26 Make I take my wifes and my shidren follow body, bikos I don work for yu.”
26 Dá-me minhas mulheres e meus filhos, pelos quais te servi, a fim de que eu me vá; tu sabes quanto tempo servi em tua casa."
27 But Laban sey, “If really sey I dey good to yu, den yu go stay with mi, bikos my spirit tell mi sey, God bless mi, bikos of yu.”
27 Labão respondeu-lhe: "Se achei graça aos teus olho... reconheço que o Senhor me abençoou por causa de ti.
28 Laban still tell Jakob, “Make yu just tell mi wetin I go pay and I go pay yu.”
28 Fixa-me o que devo dar-te, ajuntou ele, e dar-te-ei."
29 Jakob ansa, “Yu know as I don work for yu and how I don kare for yor animals.
29 Jacó disse-lhe: "Tu sabes como te tenho servido, e como aumentaram os teus rebanhos graças a mim.
30 True-true, dem nor many wen I kom, but naw, wetin yu get don plenty well-well. God don bless yu for evriwhere wey I for work for yu. But naw, how long e go take before I go do sometin for my own family?”
30 Tinhas pouca coisa, antes de minha chegada, e tudo aumentou depois. O Senhor abençoou-te a cada um dos meus passos. Agora, quanto a mim, quando trabalharei eu para minha casa?"
31 So Laban ask, “Wetin yu wont make I give yu?”
31 "Que te hei de dar?", disse Labão. Jacó respondeu: "Não me darás nada. Se aceitas o que te vou propor, continuarei a apascentar e guardar o teu rebanho.
32 Make yu let mi waka round all yor animal kon komot di ones wey get spot or mark or wey black. Dis animals go bi my pay.
32 Vou hoje passar pelo meio de todos os teus rebanhos e pôr à parte, entre os cordeiros, todo o animal manchado, malhado ou negro, e entre as cabras, tudo o que é manchado ou malhado: isto será o meu salário.
33 Den my good go tok for mi leta, wen yu go si sey na only di ones wey yu give mi I take. If yu si any animal wey nor get mark, or spot or black, den make yu koll mi tif.”
33 Minha justiça testemunhará em meu favor para o futuro, quando vieres verificar o meu salário: tudo o que não for malhado ou manchado entre as cabras e negro entre os cordeiros, considerar-se-á como roubado."
34 Laban kon sey, “I gri! Make e bi as yu tok.”
34 "Está bem, disse Labão, seja como dizes."
35 So dat day, Laban komot all di animals wey get white spot, mark or wey black kon sey make en pikin kare for dem.
35 Naquele mesmo dia, pôs ele à parte os bodes malhados e manchados, todas as cabras malhadas ou manchadas, todas aquelas que estavam marcadas de branco, e todos os cordeiros negros; confiou-os aos seus filhos,
36 Den e separate dem from Jakob own with three days journey and Jakob kon dey kare for di oda animals.
36 e pôs à distância de três dias de jornada entre ele e Jacó, o qual apascentava o resto do rebanho de Labão.
37 But Jakob take fresh branches wey dem just kut from poplar, almond and plane tree kon peel dem until e si di white wood for inside.
37 Jacó tomou então varas verdes de álamo, de amendoeira e de plátano; tirou-lhes parte da casca, fazendo faixas brancas e deixando a nu o samo.
38 Den e put di tree wood for di wota where di animals for dey drink. E put dem for di animals front wen dem dey chop and dem kon drink di wota.
38 Colocou as varas assim preparadas sob os olhos das ovelhas, nas pias e nos bebedouros onde vinham beber. Indo a beber, entravam em calor.
39 Den wen di sheep dem sleep togeda for di branches front, dem kon dey born pikin wey get mark, spot and black.
39 E como entrassem no calor do coito diante dessas varas, concebiam cordeiros riscados, manchados e malhados.
40 Jakob kon separate doz animal from Laban own. Den wen di animals won sleep with each oda again, e kon turn dem face Laban own wey nor get spot and black. So e kon get animal for ensef and e nor mix dem with Laban own.
40 Jacó punha-os à parte, e voltava a face dos animais para o que era malhado e negro no rebanho de Labão. Constituiu assim rebanhos para si, que não se misturaram aos de Labão.
41 Wen di strong animals wey bi woman won sleep with man animal, Jakob go put di branches for wota, so dat dem go sleep togeda near di branches.
41 Além disso, Jacó só punha suas varas nos bebedouros sob os olhos das ovelhas em calor, a fim de que seu coito se fizesse perto das varas, quando se tratava de ovelhas vigorosas.
42 But if di animals dey weak, e nor go put di branches for dia front. Like dis, na Laban kon get all di weak animals and Jakob kon get di ones wey dey strong.
42 Quando eram fracas, não punha as varas, de sorte que os cordeiros raquíticos eram para Labão e os vigorosos para ele.
43 Like dis, Jakob kon get money, animals, both man and woman savant, kamel, donkey and plenty propaty.
43 Este homem tornou-se assim extremamente rico, e teve muitos rebanhos, escravas e escravos, camelos e jumentos.

Ler em outra tradução

Comparar com outra

Estude este capítulo no WhatsApp

Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Gênesis 30, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.