Gênesis 26

Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs ARA

Sair da comparação
ARA Almeida Revista e Atualizada 1993
1 Honga kon dey di land, just as e happen for Abraham time. So Isaak kon go Gerar where Abimelek wey bi Filistia pipol king dey stay.
1 Sobrevindo fome à terra, além da primeira havida nos dias de Abraão, foi Isaque a Gerar, avistar-se com Abimeleque, rei dos filisteus.
2 God appear to Isaak kon tell am, “Make yu nor go Egypt; but make yu stay for di land wey I go show yu.
2 Apareceu-lhe o Senhor e disse: Não desças ao Egito. Fica na terra que eu te disser;
3 Stay for dis land. Den I go dey with yu kon bless yu, bikos I go give all dis land to yu and yor shidren-shidren. I go do wetin I promise yor papa Abraham.
3 habita nela, e serei contigo e te abençoarei; porque a ti e a tua descendência darei todas estas terras e confirmarei o juramento que fiz a Abraão, teu pai.
4 I go make yor shidren plenty like di stars wey dey di sky and I go give dem all dis land. I go bless all di nashon for di world with yor shidren-shidren name.
4 Multiplicarei a tua descendência como as estrelas dos céus e lhe darei todas estas terras. Na tua descendência serão abençoadas todas as nações da terra;
5 All dis tins go happen, bikos Abraham obey mi kon keep all my words; my kommand, my rules and my laws.”
5 porque Abraão obedeceu à minha palavra e guardou os meus mandados, os meus preceitos, os meus estatutos e as minhas leis.
6 So Isaak kon stay for Gerar.
6 Isaque, pois, ficou em Gerar.
7 Wen di men for di place ask am about en wife, e kon tell dem sey, “Na my sista.” Fear nor fit let am sey, “Na my wife,” bikos e tink for en mind sey, “If I sey na my wife, di men for dis place go kill mi make dem for fit get Rebekah, bikos e too fine.”
7 Perguntando-lhe os homens daquele lugar a respeito de sua mulher, disse: É minha irmã; pois temia dizer: É minha mulher; para que, dizia ele consigo, os homens do lugar não me matem por amor de Rebeca, porque era formosa de aparência.
8 Afta Isaak don stay der tey, Abimelek wey bi Filistia pipol king kon look from window and e si Isaak dey play with en wife Rebekah.
8 Ora, tendo Isaque permanecido ali por muito tempo, Abimeleque, rei dos filisteus, olhando da janela, viu que Isaque acariciava a Rebeca, sua mulher.
9 So Abimelek koll Isaak kon sey, “Dis woman na yor wife! Wetin make yu sey, ‘Na my sista e bi?’ ”
9 Então, Abimeleque chamou a Isaque e lhe disse: É evidente que ela é tua esposa; como, pois, disseste: É minha irmã? Respondeu-lhe Isaque: Porque eu dizia: para que eu não morra por causa dela.
10 Den di king sey, “Wetin make yu do us like dis? Wot of if one of my men kon go sleep with yor wife? Den yu for don make us sin!”
10 Disse Abimeleque: Que é isso que nos fizeste? Facilmente algum do povo teria abusado de tua mulher, e tu, atraído sobre nós grave delito.
11 So Abimelek kommand all en pipol sey, “Anybody wey tosh dis man or en wife, must die.”
11 E deu esta ordem a todo o povo: Qualquer que tocar a este homem ou à sua mulher certamente morrerá.
12 Isaak harvest plenty well-well and e rish hundred times of wetin e plant dat same year, bikos God don bless am.
12 Semeou Isaque naquela terra e, no mesmo ano, recolheu cento por um, porque o Senhor o abençoava.
13 Isaak kon rish well-well. E dey prosper more-more until evribody know am.
13 Enriqueceu-se o homem, prosperou, ficou riquíssimo;
14 E get many sheep and kattle and en savant many well-well, so Filistia pipol kon dey jealous am.
14 possuía ovelhas e bois e grande número de servos, de maneira que os filisteus lhe tinham inveja.
15 So Filistia pipol karry san-san kon kover all di well wey Isaak papa savants, dig for di time wey Abraham dey der.
15 E, por isso, lhe entulharam todos os poços que os servos de seu pai haviam cavado, nos dias de Abraão, enchendo-os de terra.
16 Den Abimelek kon tell Isaak, “Make yu komot from here go anoda place, bikos di pawa wey yu get, don strong pass awa own.”
16 Disse Abimeleque a Isaque: Aparta-te de nós, porque já és muito mais poderoso do que nós.
17 So Isaak komot der kon go stay for Gerar Valley.
17 Então, Isaque saiu dali e se acampou no vale de Gerar, onde habitou.
18 Isaak kon open di well again wey en papa Abraham dig wey Filistia pipol kover afta Abraham don die. Isaak give dis well di same name wey en papa gi-am before.
18 E tornou Isaque a abrir os poços que se cavaram nos dias de Abraão, seu pai (porque os filisteus os haviam entulhado depois da morte de Abraão), e lhes deu os mesmos nomes que já seu pai lhes havia posto.
19 Wen Isaak savant dig for di valley kon si well wey get fresh wota,
19 Cavaram os servos de Isaque no vale e acharam um poço de água nascente.
20 di men for Gerar kworel with Isaak men kon dey sey, “Na wi get di wota!” So Isaak koll di well Esek, bikos dem follow am drag am.
20 Mas os pastores de Gerar contenderam com os pastores de Isaque, dizendo: Esta água é nossa. Por isso, chamou o poço de Eseque, porque contenderam com ele.
21 En savants dig anoda well, but dem still follow am drag am too, so Isaak koll di well, Sitnah.
21 Então, cavaram outro poço e também por causa desse contenderam. Por isso, recebeu o nome de Sitna.
22 Den e komot from der kon go dig anoda well. Nobody follow am kworel for dis one, so Isaak kon koll am Rehobot dey sey, “Naw Oga God don make room for us and wi go prosper for dis land.”
22 Partindo dali, cavou ainda outro poço; e, como por esse não contenderam, chamou-lhe Reobote e disse: Porque agora nos deu lugar o Senhor , e prosperaremos na terra.
23 From der, Isaak kon go Beersheba.
23 Dali subiu para Berseba.
24 God appear to am dat nite kon sey, “Na mi bi yor papa Abraham God. Make yu nor fear, bikos I dey with yu. Bikos of my savant Abraham, I go bless yu kon make yor shidren-shidren plenty.”
24 Na mesma noite, lhe apareceu o Senhor e disse: Eu sou o Deus de Abraão, teu pai. Não temas, porque eu sou contigo; abençoar-te-ei e multiplicarei a tua descendência por amor de Abraão, meu servo.
25 Den Isaak build one altar for der kon woship God. E put en tent for der and en savant kon dig anoda well.
25 Então, levantou ali um altar e, tendo invocado o nome do Senhor , armou a sua tenda; e os servos de Isaque abriram ali um poço.
26 Naw, King Abimelek don kom visit am from Gerar with en friend Ahuzzat and Fikol wey bi di sojas oga.
26 De Gerar foram ter com ele Abimeleque e seu amigo Ausate e Ficol, comandante do seu exército.
27 Isaak kon ask dem, “Wetin make una kom meet mi? Nor bi bikos una hate mi, naim make una porshu mi?”
27 Disse-lhes Isaque: Por que viestes a mim, pois me odiais e me expulsastes do vosso meio?
28 Dem ansa, “E klear sey God dey with yu. So wi kon sey, make peace dey between us: dat is between wi and yu. Make yu allow us make peace with yu,
28 Eles responderam: Vimos claramente que o Senhor é contigo; então, dissemos: Haja agora juramento entre nós e ti, e façamos aliança contigo.
29 so dat yu nor go ponish us, just as wi nor ponish yu, but wi dey always trit yu well, before wi even porshu yu with peace. Naw God don bless yu.”
29 Jura que nos não farás mal, como também não te havemos tocado, e como te fizemos somente o bem, e te deixamos ir em paz. Tu és agora o abençoado do Senhor .
30 So Isaak do party for dem kon celebrate.
30 Então, Isaque lhes deu um banquete, e comeram e beberam.
31 Very early for di next morning, Isaak and King Abimelek kon make peace with each oda. Isaak kon escort dem and dem kon komot without wahala.
31 Levantando-se de madrugada, juraram de parte a parte; Isaque os despediu, e eles se foram em paz.
32 Dat day, Isaak savant kon tell Isaak about di well wey dem dig sey, “Wi don si wota.”
32 Nesse mesmo dia, vieram os servos de Isaque e, dando-lhe notícia do poço que tinham cavado, lhe disseram: Achamos água.
33 So Isaak koll di well Shibah; dat na why dem dey koll di town till today, Beersheba.
33 Ao poço, chamou-lhe Seba; por isso, Berseba é o nome daquela cidade até ao dia de hoje.
34 Wen Esau don rish forty years, e kon marry Judit wey bi Beeri pikin and Beeri kom from Hit. E still marry Basemat wey bi Elon wey Het pikin born.
34 Tendo Esaú quarenta anos de idade, tomou por esposa a Judite, filha de Beeri, heteu, e a Basemate, filha de Elom, heteu.
35 Di matter nor kon make Isaak and Rebekah, happy.
35 Ambas se tornaram amargura de espírito para Isaque e para Rebeca.

Ler em outra tradução

Comparar com outra

Estude este capítulo no WhatsApp

Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Gênesis 26, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.