Gênesis 24

Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs ACF

Sair da comparação
ACF Almeida Corrigida Fiel
1 Abraham don old well-well and God don bless am for evritin.
1 E era Abraão já velho e adiantado em idade, e o SENHOR havia abençoado a Abraão em tudo.
2 One day, Abraham tell en savant wey old pass, di one wey dey guide di house sey, “Make yu put yor hand under my lap.
2 E disse Abraão ao seu servo, o mais velho da casa, que tinha o governo sobre tudo o que possuía: Põe agora a tua mão debaixo da minha coxa,
3 Den promise with di Oga God name, di God for heaven and eart sey yu nor go allow my pikin marry one for doz local Kanaan wimen.
3 Para que eu te faça jurar pelo Senhor Deus dos céus e Deus da terra, que não tomarás para meu filho mulher das filhas dos cananeus, no meio dos quais eu habito.
4 Instead, make yu go my village go meet my relashon kon find wife among dem for my pikin Isaak.”
4 Mas que irás à minha terra e à minha parentela, e dali tomarás mulher para meu filho Isaque.
5 Di savant ask, “But wetin I go do if di woman nor gri follow mi kom back to dis far land? Make I take yor pikin go back to di land wey yu from kom?”
5 E disse-lhe o servo: Se porventura não quiser seguir-me a mulher a esta terra, farei, pois, tornar o teu filho à terra donde saíste?
6 Abraham ansa, “Make yu nor take my pikin go back to dat land!
6 E Abraão lhe disse: Guarda-te, que não faças lá tornar o meu filho.
7 Oga wey bi di God for heaven wey take mi komot from my papa house and di land wey my pipol dey, naim promise mi wen E promise sey, ‘I go give dis land to yor shidren-shidren.’ So God go send en angel go for yor front, so dat yu go si one good wife for der kon bring kom give my pikin.
7 O Senhor Deus dos céus, que me tomou da casa de meu pai e da terra da minha parentela, e que me falou, e que me jurou, dizendo: À tua descendência darei esta terra; ele enviará o seu anjo adiante da tua face, para que tomes mulher de lá para meu filho.
8 But if di woman nor won follow yu kom back, dis swear nor go do yu anytin. But make yu nor take my pikin go back to dat land!”
8 Se a mulher, porém, não quiser seguir-te, serás livre deste meu juramento; somente não faças lá tornar a meu filho.
9 So di savant put en hand under en oga Abraham lap kon promise sey e go do as Abraham tok.
9 Então pôs o servo a sua mão debaixo da coxa de Abraão seu senhor, e jurou-lhe sobre este negócio.
10 Den di savant take ten kamel from en oga own kon go with difren gifts from en oga, just as e wont. E travel go Aram Naharaim aria for Nahor town.
10 E o servo tomou dez camelos, dos camelos do seu senhor, e partiu, pois que todos os bens de seu senhor estavam em sua mão, e levantou-se e partiu para Mesopotâmia, para a cidade de Naor.
11 E make di kamel knee down near di well wey dey outside di town. Dat na evening time wen di wimen dey kom fetch wota.
11 E fez ajoelhar os camelos fora da cidade, junto a um poço de água, pela tarde, ao tempo que as moças saíam a tirar água.
12 E kon pray, “My Oga God, wey bi my masta Abraham God, make Yu guide mi today. Make Yu dey good to my oga Abraham.
12 E disse: Ó Senhor, Deus de meu senhor Abraão, dá-me hoje bom encontro, e faze beneficência ao meu senhor Abraão!
13 I stand near dis well and di pipol wey dey stay dis town, dia dotas go kom fetch wota.
13 Eis que eu estou em pé junto à fonte de água e as filhas dos homens desta cidade saem para tirar água;
14 I go tell one among dem sey, ‘Abeg make yu give mi wota drink.’ Den make di one wey Yu don choose for yor savant Isaak ansa, ‘Make yu drink and I go give yor kamel make dem drink too.’ Like dis, I go know sey Yu dey good to my oga.”
14 Seja, pois, que a donzela, a quem eu disser: Abaixa agora o teu cântaro para que eu beba; e ela disser: Bebe, e também darei de beber aos teus camelos; esta seja a quem designaste ao teu servo Isaque, e que eu conheça nisso que usaste de benevolência com meu senhor.
15 Before e pray finish, Rebekah kon dey kom with en wota pot for en shoulder. E bi Betuel pikin and en grand-mama na Milka (Milka na Abraham broda wife, Nahor).
15 E sucedeu que, antes que ele acabasse de falar, eis que Rebeca, que havia nascido a Betuel, filho de Milca, mulher de Naor, irmão de Abraão, saía com o seu cântaro sobre o seu ombro.
16 Di girl fine well-well. E neva sleep with anybody for en life. Rebekah go di well, fetch wota put for en pot kon dey kom back.
16 E a donzela era mui formosa à vista, virgem, a quem homem não havia conhecido; e desceu à fonte, e encheu o seu cântaro e subiu.
17 Den Abraham savant run go meet am kon sey, “Abeg make yu give mi small wota drink from yor pot.”
17 Então o servo correu-lhe ao encontro, e disse: Peço-te, deixa-me beber um pouco de água do teu cântaro.
18 Rebekah ansa, “My oga, make yu drink,” den di girl kwik-kwik karry en pot put for en hand kon gi-am wota drink.
18 E ela disse: Bebe, meu senhor. E apressou-se e abaixou o seu cântaro sobre a sua mão e deu-lhe de beber.
19 Wen di girl don do like so, e kon sey, “I go fetch wota for yor kamel until dem don drink beleful too.”
19 E, acabando ela de lhe dar de beber, disse: Tirarei também água para os teus camelos, até que acabem de beber.
20 So di girl kon pour all di wota wey dey en pot inside where di kamels go for drink, den e run go back go fetch more wota until all di kamel don drink beleful.
20 E apressou-se, e despejou o seu cântaro no bebedouro, e correu outra vez ao poço para tirar água, e tirou para todos os seus camelos.
21 Di man just kwayet dey look am just to know if God don make en travel get head or not.
21 E o homem estava admirado de vê-la, calando-se, para saber se o Senhor havia prosperado a sua jornada ou não.
22 Afta di kamels don drink finish, di man bring one gold ring wey dem dey put for nose and two gold shain for waist kon gi-am to di girl.
22 E aconteceu que, acabando os camelos de beber, tomou o homem um pendente de ouro de meio siclo de peso, e duas pulseiras para as suas mãos, do peso de dez siclos de ouro;
23 Den e ask di girl, “Na wish pesin pikin yu bi?” Abeg make yu tell mi, “Yor papa go get any empty room for mi wey I fit sleep put dis nite?”
23 E disse: De quem és filha? Faze-mo saber, peço-te. Há também em casa de teu pai lugar para nós pousarmos?
24 Rebekah ansa, “I bi Betuel pikin and na Milka and Nahor born Betuel.
24 E ela lhe disse: Eu sou a filha de Betuel, filho de Milca, o qual ela deu a Naor.
25 Yes, wi get plenty food for yor kamel and wi get room for strenjas.”
25 Disse-lhe mais: Também temos palha e muito pasto, e lugar para passar a noite.
26 Di savant kon bow for groun woship God.
26 Então inclinou-se aquele homem e adorou ao Senhor,
27 E kon sey, “Make praiz bi God own, my oga Abraham God, bikos Yu don show mi yor love wey nor dey fail and as Yu dey good to my oga family.”
27 E disse: Bendito seja o SENHOR Deus de meu senhor Abraão, que não retirou a sua benevolência e a sua verdade de meu senhor; quanto a mim, o SENHOR me guiou no caminho à casa dos irmãos de meu senhor.
28 Di girl kon run go house go tell en family evritin wey happen.
28 E a donzela correu, e fez saber estas coisas na casa de sua mãe.
29 Naw, Rebekah get one broda wey en name na Laban and e run go meet di man for di well.
29 E Rebeca tinha um irmão cujo nome era Labão, o qual correu ao encontro daquele homem até a fonte.
30 Wen e si di shain for en sista hand and di ring for en nose kon hear wetin en sista tok wen e sey, “Dis na wetin di man tok”, e run go meet di man for where e for still stand near en kamels. Laban kon tell am,
30 E aconteceu que, quando ele viu o pendente, e as pulseiras sobre as mãos de sua irmã, e quando ouviu as palavras de sua irmã Rebeca, que dizia: Assim me falou aquele homem; foi ter com o homem, que estava em pé junto aos camelos, à fonte,
31 “Make yu kom stay with us, bikos God don bless yu! Wetin make yu stand for outside di town wen I get room for yu and I go fit prepare somewhere for yor kamels?”
31 E disse: Entra, bendito do Senhor; por que estás fora? pois eu já preparei a casa, e o lugar para os camelos.
32 So di man follow Laban go house and Laban pak all di load komot di kamel back kon klean, feed and give di man and di kamel drivers wota make dem take wosh dia legs.
32 Então veio aquele homem à casa, e desataram os camelos, e deram palha e pasto aos camelos, e água para lavar os pés dele, e os pés dos homens que estavam com ele.
33 Wen dem serve food for dem, e kon sey, “I nor go chop until I don tok wetin I won tok.”
33 Depois puseram comida diante dele. Ele, porém, disse: Não comerei, até que tenha dito as minhas palavras. E ele disse: Fala.
34 E kon sey, “I bi Abraham savant.
34 Então disse: Eu sou o servo de Abraão.
35 God don really bless my oga and e get evritin wey e wont. Oga God don gi-am sheep, kattle, gold, silva, man and woman savants, kamel and donkey.
35 E o SENHOR abençoou muito o meu senhor, de maneira que foi engrandecido, e deu-lhe ovelhas e vacas, e prata e ouro, e servos e servas, e camelos e jumentos.
36 My oga wife Sarah born only one pikin for am wen dem don old and my oga don give di pikin evritin wey e get.
36 E Sara, a mulher do meu senhor, deu à luz um filho a meu senhor depois da sua velhice, e ele deu-lhe tudo quanto tem.
37 My oga make mi swear wen e sey, ‘For here wey I dey stay, yu nor go marry any Kanaan woman give my pikin Isaak,
37 E meu senhor me fez jurar, dizendo: Não tomarás mulher para meu filho das filhas dos cananeus, em cuja terra habito;
38 but make yu go my family house go find wife for my pikin.’
38 Irás, porém, à casa de meu pai, e à minha família, e tomarás mulher para meu filho.
39 “But I tell my oga sey, ‘Wot of if di woman sey e nor go follow mi kom?’
39 Então disse eu ao meu senhor: Porventura não me seguirá a mulher.
40 E kon ansa mi, ‘God wey I dey serve, go send en angel follow yu go. E go make yor journey well and yu go si wife for my pikin from among my papa family.
40 E ele me disse: O Senhor, em cuja presença tenho andado, enviará o seu anjo contigo, e prosperará o teu caminho, para que tomes mulher para meu filho da minha família e da casa de meu pai;
41 Yu go dey free from di swear if yu go meet my family and dem nor gri give di girl to yu. True-true, yu go dey free.’
41 Então serás livre do meu juramento, quando fores à minha família; e se não te derem, livre serás do meu juramento.
42 “Wen I rish di well today, I kon pray sey, ‘My Oga wey bi my oga Abraham God, if Yu know sey Yu go make my journey well, make evritin happen as dem suppose bi.’
42 E hoje cheguei à fonte, e disse: Ó Senhor, Deus de meu senhor Abraão, se tu agora prosperas o meu caminho, no qual eu ando,
43 As I stand near di well so. Wen di rite girl go kom fetch wota, I go tell am, ‘Make yu give mi wota from yor pot make I drink.’
43 Eis que estou junto à fonte de água; seja, pois, que a donzela que sair para tirar água e à qual eu disser: Peço-te, dá-me um pouco de água do teu cântaro;
44 Den di girl go ansa, ‘Make yu drink and I go fetch give yor kamels too.’ Den na dat girl go bi di one wey di Oga God don choose for my oga pikin.
44 E ela me disser: Bebe tu e também tirarei água para os teus camelos; esta seja a mulher que o SENHOR designou ao filho de meu senhor.
45 “Before I pray finish inside my heart, I kon si Rebekah dey kom fetch wota with en wota pot for en shoulder. So I tell am, ‘Make yu give mi wota drink.’
45 E antes que eu acabasse de falar no meu coração, eis que Rebeca saía com o seu cântaro sobre o seu ombro, desceu à fonte e tirou água; e eu lhe disse: Peço-te, dá-me de beber.
46 E kon kwik-kwik put en pot down from en shoulder kon sey, ‘Make yu drink and I go give yor kamels wota too.’ So I drink and e kon give my kamel dem drink too.
46 E ela se apressou, e abaixou o seu cântaro de sobre si, e disse: Bebe, e também darei de beber aos teus camelos; e bebi, e ela deu também de beber aos camelos.
47 Den I ask am, ‘Na wish pesin pikin yu bi?’ Di girl ansa, ‘I bi Betuel wey en papa na Nahor and na Milka born Betuel for Nabor.’ So, I kon put di ring for en nose and di shain for en hand.
47 Então lhe perguntei, e disse: De quem és filha? E ela disse: Filha de Betuel, filho de Naor, que lhe deu Milca. Então eu pus o pendente no seu rosto, e as pulseiras sobre as suas mãos;
48 “Den I bow woship God wey bi my oga Abraham God, bikos na-im lead mi for di korrect way, so dat I go meet my oga Abraham broda Nahor grand-pikin.
48 E inclinando-me adorei ao SENHOR, e bendisse ao SENHOR, Deus do meu senhor Abraão, que me havia encaminhado pelo caminho da verdade, para tomar a filha do irmão de meu senhor para seu filho.
49 Naw, if una go show sey una dey good to my oga, make una tell mi. But if una nor gri, make una still tell mi too, so dat I go-go back.”
49 Agora, pois, se vós haveis de fazer benevolência e verdade a meu senhor, fazei-mo saber; e se não, também mo fazei saber, para que eu vá à direita, ou à esquerda.
50 Den Laban and Betuel ansa, “Dis na as God wont am. Wetin wi wont nor mean anytin.
50 Então responderam Labão e Betuel, e disseram: Do Senhor procedeu este negócio; não podemos falar-te mal ou bem.
51 Na Rebekah stand so for yor front. Make yu take am dey go, so dat e go bi yor oga Abraham pikin wife, just as God don tok am.”
51 Eis que Rebeca está diante da tua face; toma-a, e vai-te; seja a mulher do filho de teu senhor, como tem dito o SENHOR.
52 Wen Abraham savant hear wetin dem tok, e bow face groun kon woship God.
52 E aconteceu que, o servo de Abraão, ouvindo as suas palavras, inclinou-se à terra diante do Senhor.
53 Den e bring gold, silva, klot and oda tins kon give dem to Rebekah. E still give some betta gifts to Rebekah broda and mama.
53 E tirou o servo jóias de prata e jóias de ouro, e vestidos, e deu-os a Rebeca; também deu coisas preciosas a seu irmão e à sua mãe.
54 Afta, en and di men wey dey with am kon chop and dem stay der dat nite till day break. Wen dem wake-up di next morning, Abraham savant kon sey, “Make I dey go naw go meet my oga.”
54 Então comeram e beberam, ele e os homens que com ele estavam, e passaram a noite. E levantaram-se pela manhã, e disse: Deixai-me ir a meu senhor.
55 But Rebekah broda and mama kon ansa, “Make di girl still stay with us for like ten days, den e fit kom meet una.”
55 Então disseram seu irmão e sua mãe: Fique a donzela conosco alguns dias, ou pelo menos dez dias, depois irá.
56 But di savant tell dem, “Make una nor keep mi, God don make my journey get head. Make una let mi go meet my oga naw.”
56 Ele, porém, lhes disse: Não me detenhais, pois o SENHOR tem prosperado o meu caminho; deixai-me partir, para que eu volte a meu senhor.
57 Den dem sey, “Make wi hear from di girl mout.”
57 E disseram: Chamemos a donzela, e perguntemos-lho.
58 So dem koll Rebekah kon ask am, “Yu wont follow dis man go?”
58 E chamaram a Rebeca, e disseram-lhe: Irás tu com este homem? Ela respondeu: Irei.
59 So dem kon give dia sista Rebekah to di man, but some savant follow am, with Abraham savant and en men.
59 Então despediram a Rebeca, sua irmã, e sua ama, e o servo de Abraão, e seus homens.
60 Dem bless Rebekah kon sey:
60 E abençoaram a Rebeca, e disseram-lhe: Ó nossa irmã, sê tu a mãe de milhares de milhares, e que a tua descendência possua a porta de seus aborrecedores!
61 Den Rebekah and en wimen savant klimb di kamel kon follow Abraham savant. So Abraham savant take Rebekah go.
61 E Rebeca se levantou com as suas moças, e subiram sobre os camelos, e seguiram o homem; e tomou aquele servo a Rebeca, e partiu.
62 Naw, Isaak kom from Beer Lahai Roi, bikos e dey stay for Negev.
62 Ora, Isaque vinha de onde se vem do poço de Beer-Laai-Rói; porque habitava na terra do sul.
63 As evening dey rish, Isaak kon go di field go relax. Den e look kon si sey some kamel dey kom.
63 E Isaque saíra a orar no campo, à tarde; e levantou os seus olhos, e olhou, e eis que os camelos vinham.
64 Wen Rebekah look, e kon si Isaak. E kom down from en kamel
64 Rebeca também levantou seus olhos, e viu a Isaque, e desceu do camelo.
65 kon ask Abraham savant, “Na who bi dat man for di field wey dey waka kom meet us?”
65 E disse ao servo: Quem é aquele homem que vem pelo campo ao nosso encontro? E o servo disse: Este é meu senhor. Então tomou ela o véu e cobriu-se.
66 Di savant tell Isaak evritin wey happen.
66 E o servo contou a Isaque todas as coisas que fizera.
67 Den Isaak take Rebekah enter en mama room. E take am as en wife kon love am. So, Rebekah make Isaak mind rest, afta en mama don die.
67 E Isaque trouxe-a para a tenda de sua mãe Sara, e tomou a Rebeca, e foi-lhe por mulher, e amou-a. Assim Isaque foi consolado depois da morte de sua mãe.

Ler em outra tradução

Comparar com outra

Estude este capítulo no WhatsApp

Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Gênesis 24, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.