Gênesis 21
Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs NVI
1 God kon visit Sarah just as E sey E go do and E kon do wetin E promise Sarah.
1 O Senhor foi bondoso com Sara, como lhe dissera, e fez por ela o que prometera.
2 So Sarah get belle and e born boy for Abraham for en old age for di real time wey God don tell am.
2 Sara engravidou e deu um filho a Abraão em sua velhice, na época fixada por Deus em sua promessa.
3 Abraham koll di pikin wey Sarah born, Isaak.
3 Abraão deu o nome de Isaque ao filho que Sara lhe dera.
4 Wen di pikin don rish eight days, Abraham sekonsaiz am, just as God kommand am make e do.
4 Quando seu filho Isaque tinha oito dias de vida, Abraão o circuncidou, conforme Deus lhe havia ordenado.
5 (Naw Abraham na hundred years wen Sarah born Isaak.)
5 Estava ele com cem anos de idade quando lhe nasceu Isaque, seu filho.
6 Sarah kon sey, “God don make mi laf. Evribody wey hear wetin don happen, go follow mi laf.”
6 E Sara disse: "Deus me encheu de riso, e todos os que souberem disso rirão comigo".
7 Sarah still sey, “Na who for fit tell Abraham sey Sarah go ever born pikin? Yet I don born boy for am for en old age!”
7 E acrescentou: "Quem diria a Abraão que Sara amamentaria filhos? Contudo eu lhe dei um filho em sua velhice! "
8 Di pikin grow kon stop to suck. Abraham do betta party for di day wen Isaak stop to suck.
8 O menino cresceu e foi desmamado. No dia em que Isaque foi desmamado, Abraão deu uma grande festa.
9 But one day, di pikin wey Hagar, Sarah savant wey kom from Egypt, born for Abraham kon dey laf Isaak and Sarah kon si dem,
9 Sara, porém, viu que o filho que Hagar, a egípcia, dera a Abraão estava rindo de Isaque,
10 so e tell Abraham, “Make yu porshu dis slave and en pikin, bikos di slave pikin nor go fit follow my pikin share for di propaty!”
10 e disse a Abraão: "Livre-se daquela escrava e do seu filho, porque ele jamais será herdeiro com o meu filho Isaque".
11 Abraham nor like wetin Sarah tok, bikos Ishmael na en pikin too.
11 Isso perturbou demais Abraão, pois envolvia um filho seu.
12 But God tell Abraham, “Make yu nor vex about di boy or yor slave wife. Just do evritin wey Sarah dey tell yu, bikos na thru Isaak yor shidren-shidren go plenty.
12 Mas Deus lhe disse: "Não se perturbe por causa do menino e da escrava. Atenda a tudo o que Sara lhe pedir, porque será por meio de Isaque que a sua descendência há de ser considerada.
13 But I go still make di slave pikin big, bikos en too na yor pikin.”
13 Mas também do filho da escrava farei um povo; afinal ele é seu descendente".
14 So very early for di next day, Abraham take some food and wota kon give Hagar. E put di food for Hagar shoulder, gi-am en pikin kon sey make dem dey go. So dem go kon dey waka anyhow for Beersheba wildaness.
14 Na manhã seguinte, Abraão pegou alguns pães e uma vasilha de couro cheia d’água, entregou-os a Hagar e, tendo-os colocado nos ombros dela, despediu-a com o menino. Ela se pôs a caminho e ficou vagando pelo deserto de Berseba.
15 Wen di wota don finish, Hagar kon put di pikin under one bush
15 Quando acabou a água da vasilha, ela deixou o menino debaixo de um arbusto
16 kon go sidan for anoda side wey far from where e put di pikin; bikos e tok for en mind sey, “I nor go fit dey look am until e die.” So Hagar kon sidan far from di pikin as e dey kry.
16 e foi sentar-se perto dali, à distância de um tiro de flecha, porque pensou: "Não posso ver o menino morrer". Sentada ali perto, começou a chorar.
17 But God hear di boy vois. God angel koll Hagar from heaven kon ask am, “Hagar! Na wetin happen? Make yu nor fear, bikos God don hear di boy vois from where e for dey kry.
17 Deus ouviu o choro do menino, e o anjo de Deus, do céu, chamou Hagar e lhe disse: "O que a aflige, Hagar? Não tenha medo; Deus ouviu o menino chorar, lá onde você o deixou.
18 So get up! Go help di boy stand make yu hold am for hand, bikos I go make en shidren-shidren plenty well-well.”
18 Levante o menino e tome-o pela mão, porque dele farei um grande povo".
19 Den God kon make Hagar si one well wey get wota. Hagar go fill di wota bag wey e karry with wota and e kon give di boy wota drink.
19 Então Deus lhe abriu os olhos, e ela viu uma fonte. Foi até lá, encheu de água a vasilha e deu de beber ao menino.
20 God dey with di boy as e dey grow. E stay for di wildaness kon turn to who dey shot bow and arrow.
20 Deus estava com o menino. Ele cresceu, viveu no deserto e tornou-se flecheiro.
21 E stay for Paran wildaness. En mama go Egypt go bring wife kom for am.
21 Vivia no deserto de Parã, e sua mãe conseguiu-lhe uma mulher da terra do Egito.
22 For dat time, King Abimelek and Fikol wey bi kommander for en soja kon tell Abraham sey, “God dey with yu for evritin wey yu dey do.
22 Naquela ocasião, Abimeleque, acompanhado de Ficol, comandante do seu exército, disse a Abraão: "Deus está contigo em tudo o que fazes.
23 Naw make yu promise for God present sey yu nor go deceive us, awa shidren and awa shidren-shidren. Make yu loyal to us for dis kountry where yu dey stay as strenja, just as wi dey loyal to yu.”
23 Agora, jura-me, diante de Deus, que não vais enganar-me, nem a mim nem a meus filhos e descendentes. Trata a nação que te acolheu como estrangeiro com a mesma bondade com que te tratei".
24 Abraham ansa, “I promise.”
24 Respondeu Abraão: "Eu juro! "
25 But Abraham kon tell Abimelek about di well wey one of en savant seize.
25 Todavia Abraão reclamou com Abimeleque a respeito de um poço que os servos de Abimeleque lhe tinham tomado à força.
26 Abimelek ansa, “I nor know who do dis tin and yu nor even tell mi. I neva hear about am until today.”
26 Mas Abimeleque lhe respondeu: "Não sei quem fez isso. Nunca me disseste nada, e só fiquei sabendo disso hoje".
27 Abraham take some sheep and kattle kon give King Abimelek and di two of dem kon enter agriment.
27 Então Abraão trouxe ovelhas e bois, deu-os a Abimeleque, e os dois firmaram um acordo.
28 Den Abraham separate seven iyu lamb from di oda animals
28 Abraão separou sete ovelhas do rebanho,
29 and Abimelek kon as am, “Wetin make yu do like dat?”
29 pelo que Abimeleque lhe perguntou: "Que significam estas sete ovelhas que separaste das demais? "
30 Abraham ansa, “Yu must take dis seven iyu lamb from mi, so dat e go show sey I true-true dig dis well.”
30 Ele respondeu: "Aceita estas sete ovelhas de minhas mãos como testemunho de que eu cavei este poço".
31 Dat na why e koll di place Beersheba, bikos Abraham and Abimelek enter agriment for der.
31 Por isso aquele lugar foi chamado Berseba, porque ali os dois fizeram um juramento.
32 Afta dem don make dis agriment for Beersheba, Abimelek and Fikol kon go back to Filistia.
32 Firmado esse acordo em Berseba, Abimeleque e Ficol, comandante das suas tropas, voltaram para a terra dos filisteus.
33 Den Abraham plant tamarisk tree for Beersheba and e woship di Oga God wey bi di God forever for der.
33 Abraão, por sua vez, plantou uma tamargueira em Berseba e ali invocou o nome do Senhor, o Deus Eterno.
34 Abraham stay for Filistia pipol land tey small.
34 E morou Abraão na terra dos filisteus por longo tempo.
Atalhos do teclado
- Capítulo anterior←
- Próximo capítulo→
- Versículo anteriork
- Próximo versículoj
- Limpar seleçãoEsc
- Esta ajuda?
Estude este capítulo no WhatsApp
Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Gênesis 21, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.