Gênesis 14
Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs BKJ
1 For dat time, Amrafel wey bi Shinar king, Ariok wey bi Ellasar king with Kedorlaoma wey bi Elam king and Tidal wey bi Goyim king
1 E aconteceu nos dias de Anrafel, rei de Sinar, Arioque, rei de Elasar, Quedorlaomer, rei de Elão, e Tidal, rei de nações,
2 kon gada go fight, Bera wey bi Sodom king, Birsha wey bi Gomorrah king, Shinab wey bi Admah king, Shemeba wey bi Zeboiim king and Bela king (di place wey dem also dey koll Zoar).
2 que estes fizeram guerra a Bera, rei de Sodoma, a Birsa, rei de Gomorra, a Sinabe, rei de Admá, e a Semeber, rei de Zeboim, e ao rei de Bela, que é Zoar.
3 Dis five kings join togeda for Siddim Valley (wey bi Salt Sea).
3 Todos estes foram reunidos no vale de Sidim, que é o mar de sal.
4 For twelf years, dem dey serve Kedorlaoma, but for di thirtint year dem kon fight against am.
4 Eles serviram doze anos a Quedorlaomer, e no décimo terceiro ano se rebelaram.
5 For di fourteent year, Kedorlaoma and di kings wey join togeda kon go win Refah pipol for Ashterot-Karnaim, Zuz pipol for Ham, Emite pipol for Shaveh Kiriataim
5 E no décimo quarto ano veio Quedorlaomer, e os reis que estavam com ele, e feriram os refains em Asterote-Carnaim, e os zuzins em Hã, e os emins em Savé-Quiriataim,
6 and Horite pipol for dia hill kountry wey stay Seir go rish El-Paran wey dey near di wildaness.
6 e os horeus no seu monte Seir, até El-Parã, que fica junto ao deserto.
7 Den dem go fight En-Mishpat (wey bi Kadesh) and dem win evry kountry wey dey for Amalek aria, even Amor pipol wey dey stay Hazazon Tamar.
7 E eles retornaram, e vieram a En-Mispate, que é Cades, e feriram toda a terra dos amalequitas, e também os amorreus, que habitavam em Hazazom-Tamar.
8 Den Sodom, Gomorrah, Admah, Zeboiim and Bela (wey bi Zoar) kings kon ready for war. Dem meet each oda for Siddim Valley with
8 E saiu o rei de Sodoma, e o rei de Gomorra, e o rei de Admá, e o rei de Zeboim, e o rei de Bela (esta é Zoar) e se ajuntaram à batalha contra eles no vale de Sidim,
9 Elam king, Ariok king, Amrafel king and Tidal wey bi king for some oda kountries. So na four kings dey go fight against five.
9 contra Quedorlaomer, rei de Elão, e Tidal, rei das nações, e Anrafel, rei de Sinar, e Arioque, rei de Elasar; quatro reis contra cinco.
10 Naw, Siddim Valley get some portor-portor. Wen Sodom and Gomorrah king dey run, some for en men kon fall enter di pit, while di rest, run go di hills.
10 E o vale de Sidim estava cheio de poços de betume, e os reis de Sodoma e Gomorra fugiram, e caíram ali, e os restantes fugiram para o monte.
11 Di four kings wey win di war, kollect all di propaty and food wey Sodom and Gomorrah get, den dem kon go.
11 E eles tomaram todos os bens de Sodoma e Gomorra, e todos os seus mantimentos, e foram no seu caminho.
12 Dem still karry Abram broda pikin, Lot and en propaty follow body, bikos Lot dey stay for Sodom.
12 E eles tomaram Ló, filho do irmão de Abrão, que habitava em Sodoma, e os seus bens, e partiram.
13 One pesin kon run go tell Abram wey bi Hibru. For dis time, Abram dey stay near Mamre wey bi Amor pipol oak. Dis Mamre na Eshkol and Aner broda. (All dis group don join Abram.)
13 E veio um que havia escapado, e contou a Abrão, o hebreu, pois ele habitava na planície de Manre, o amorreu, irmão de Escol e irmão de Aner; e estes eram confederados de Abrão.
14 Wen Abram hear sey dem dey karry en broda pikin go as slave, e kon koll en three hundred and eighteen men wey dem train well and dem born dis men for en house, den dem kon porshu di four kings go rish Dan.
14 E quando Abrão ouviu que o seu irmão foi levado cativo, ele armou os seus servos treinados, nascidos na sua própria casa, trezentos e dezoito, e os perseguiu até Dã.
15 So for nite, Abram divide en men against di four kings men kon win dem. E porshu dem go rish Hobah wey dey nort for Damaskus.
15 E ele se dividiu contra eles, ele e seus servos, à noite, e os feriu e os perseguiu até Hobá, que está à esquerda de Damasco.
16 E kollect evritin wey dem tif. E still bring en broda pikin, Lot and en propaty with all di wimen and evribody kom back.
16 E ele trouxe de volta todos os bens, e também trouxe novamente o seu irmão Ló, e seus bens, e também as mulheres, e o povo.
17 Afta Abram don beat Kedorlaoma and di kings wey dey with am, Sodom king kon go meet Abram for Shaveh Valley (wey dem dey koll Kings Valley).
17 E o rei de Sodoma saiu para encontrá-lo depois do seu retorno do massacre a Quedorlaomer e os reis que estavam com ele, no vale de Savé, que é o vale do rei.
18 Melkizedek wey bi Salem king kon bring wine and bread kom out. (Dis Melkizedek na di Most High God priest.)
18 E Melquisedeque, rei de Salém, trouxe pão e vinho, e ele era o sacerdote do Deus Altíssimo.
19 E bless Abram kon sey,
19 E ele o abençoou, e disse: Bendito seja Abrão do Deus Altíssimo, possuidor do céu e da terra.
20 Make all praiz bi di Most High God own,
20 E bendito seja o Deus Altíssimo, que entregou teus inimigos em tuas mãos. E lhe deu dízimos de tudo.
21 Den Sodom king kon tell Abram sey, “Abeg give mi di pipol, make yu take evry oda tin.”
21 E o rei de Sodoma disse a Abrão: Dá-me as pessoas, e toma os bens para ti.
22 But Abram ansa, “I raiz my hand to di Oga God, di Most High God wey kreate heaven and eart and I promise
22 E Abrão disse ao rei de Sodoma: Eu levanto a minha mão ao SENHOR, o Deus Altíssimo, o possuidor do céu e da terra,
23 sey I nor go take anytin wey bi yor own. Nor bi even yor rope or sandal. So dat yu nor go sey, ‘Na mi make Abram get money.’
23 que não tomarei nem um fio, nem a correia de uma sandália, e que não tomarei coisa alguma que é tua, para que não digas: Eu enriqueci a Abrão,
24 I nor go take anytin escept di food wey my men chop and di tins wey dem use. But make my men, Aner, Eshkol and Mamre take dia share.”
24 salvo tão somente o que os jovens comeram, e a parte dos homens que foram comigo, Aner, Escol e Manre; que eles tomem a sua parte.
Atalhos do teclado
- Capítulo anterior←
- Próximo capítulo→
- Versículo anteriork
- Próximo versículoj
- Limpar seleçãoEsc
- Esta ajuda?
Estude este capítulo no WhatsApp
Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Gênesis 14, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.