Gálatas 3

Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs ARC

Sair da comparação
ARC Almeida Revista e Corrigida 2009
1 Galatia pipol, una nor get sense at-all! Who turn una to fool naw? Bikos na for una front wi for show sey Jesus Christ die for cross!
1 Ó insensatos gálatas! Quem vos fascinou para não obedecerdes à verdade, a vós, perante os olhos de quem Jesus Cristo foi já representado como crucificado?
2 Na di tin wey I won know from una, bi dis: Una receive di Spirit, bikos una dey do wetin di law tok or na bikos una bilive wetin wi prish give una?
2 Só quisera saber isto de vós: recebestes o Espírito pelas obras da lei ou pela pregação da fé?
3 Na so una mumu rish? True-true, una start with di Holy Spirit, but naw, una won finish di work with human being pawa.
3 Sois vós tão insensatos que, tendo começado pelo Espírito, acabeis agora pela carne?
4 Una sofa dis many tins for nor-tin? True-true, una really sofa for nor-tin.
4 Será em vão que tenhais padecido tanto? Se é que isso também foi em vão.
5 Wetin make God give una di Spirit to do mirakle? Na bikos una do wetin di law tok or bikos una bilive wetin una hear?
5 Aquele, pois, que vos dá o Espírito e que opera maravilhas entre vós o faz pelas obras da lei ou pela pregação da fé?
6 Just as Abraham bilive God and God koll am raitious man,
6 É o caso de Abraão, que creu em Deus, e isso lhe foi imputado como justiça.
7 na so too, doz wey bilive, go bi Abraham shidren.
7 Sabei, pois, que os que são da fé são filhos de Abraão.
8 Dem rite for God word before sey, “E go asept Gentile pipol, wen dem get faith” and na dis make am tell Abraham before di time rish sey, “E go bless evribody, bikos of am.”
8 Ora, tendo a Escritura previsto que Deus havia de justificar pela fé os gentios, anunciou primeiro o evangelho a Abraão, dizendo: Todas as nações serão benditas em ti.
9 So pipol wey bilive, God go bless dem togeda with Abraham, bikos dem bilive.
9 De sorte que os que são da fé são benditos com o crente Abraão.
10 Pipol wey dey under di law and dem nor dey do evritin wey di law tok, dey under curse, bikos dem rite am sey, “E nor go betta for anybody wey nor dey do evritin wey dey di law.”
10 Todos aqueles, pois, que são das obras da lei estão debaixo da maldição; porque escrito está: Maldito todo aquele que não permanecer em todas as coisas que estão escritas no livro da lei, para fazê-las.
11 Dis one show sey, nobody dey good for God eye, bikos e dey obey di law. So anybody wey dey raitious, must live by faith.
11 E é evidente que, pela lei, ninguém será justificado diante de Deus, porque o justo viverá da fé.
12 Di law nor dey bring faith, but di pesin wey dey do wetin di law tok, go live by wetin e dey do.
12 Ora, a lei não é da fé, mas o homem que fizer estas coisas por elas viverá.
13 Christ don save us from di curse wey di law bring, bikos e die for cross for us (just as dem rite am, “Anybody wey dem hang for tree, curse dey en head”),
13 Cristo nos resgatou da maldição da lei, fazendo-se maldição por nós, porque está escrito: Maldito todo aquele que for pendurado no madeiro;
14 so thru Christ, Abraham blessings go kom meet Gentile pipol and wi go receive di Spirit wey God promise us, thru faith.
14 para que a bênção de Abraão chegasse aos gentios por Jesus Cristo e para que, pela fé, nós recebamos a promessa do Espírito.
15 My brodas and sistas, make I use wetin dey happen evriday for life take make ezample for una: Wen pipol don make agriment, nobody go fit trow di agriment for korna or add anytin join am.
15 Irmãos, como homem falo. Se o testamento de um homem for confirmado, ninguém o anula nem lhe acrescenta alguma coisa.
16 Wi know sey God make dis promise with Abraham and en pikin. God word nor sey, “to di shidren”, but e sey, “and to yor pikin,” and e mean only one and dat one, na Christ.
16 Ora, as promessas foram feitas a Abraão e à sua posteridade. Não diz: E às posteridades, como falando de muitas, mas como de uma só: E à tua posteridade, que é Cristo.
17 Na wetin I dey tok bi dis: Di law wey kom afta four hundred and thirty years, nor get pawa to break di agriment and promise wey God and Abraham don make before.
17 Mas digo isto: que tendo sido o testamento anteriormente confirmado por Deus, a lei, que veio quatrocentos e trinta anos depois, não o invalida, de forma a abolir a promessa.
18 Bikos if promise dey kom thru di law, den e nor bi promise again. But wi know sey, na thru promise, God take bless Abraham.
18 Porque, se a herança provém da lei, já não provém da promessa; mas Deus, pela promessa, a deu gratuitamente a Abraão.
19 Na awa sin make law dey and na so e go bi, until di pikin wey God promise, go kom and na thru angels, God take give us di law thru en profet.
19 Logo, para que é a lei? Foi ordenada por causa das transgressões, até que viesse a posteridade a quem a promessa tinha sido feita, e foi posta pelos anjos na mão de um medianeiro.
20 Wi know sey pesin wey bi middo-man dey stand between two pipol, but na only one God dey.
20 Ora, o medianeiro não o é de um só, mas Deus é um.
21 So di law dey against God promise? No! Bikos if di law dey give pesin life, den raitiousness go must kom thru di law.
21 Logo, a lei é contra as promessas de Deus? De nenhuma sorte; porque, se dada fosse uma lei que pudesse vivificar, a justiça, na verdade, teria sido pela lei.
22 But God word kondemn evritin and evribody under sin, so dat wi; di pipol wey bilive, go get God promise thru Jesus Christ.
22 Mas a Escritura encerrou tudo debaixo do pecado, para que a promessa pela fé em Jesus Cristo fosse dada aos crentes.
23 Before faith kom, wi dey under di law, bikos di law whole us like prisonas.
23 Mas, antes que a fé viesse, estávamos guardados debaixo da lei e encerrados para aquela fé que se havia de manifestar.
24 So na di law bi awa tisha before Christ kom, so dat wi go fit tok sey wi dey raitious thru faith.
24 De maneira que a lei nos serviu de aio, para nos conduzir a Cristo, para que, pela fé, fôssemos justificados.
25 But since faith don kom, wi nor dey under any tisha again.
25 Mas, depois que a fé veio, já não estamos debaixo de aio.
26 Bikos thru Jesus Christ, all of us don bikom God shidren by faith.
26 Porque todos sois filhos de Deus pela fé em Cristo Jesus;
27 Una wey dem don baptize inside Christ, don wear Christ for body like klot.
27 porque todos quantos fostes batizados em Cristo já vos revestistes de Cristo.
28 E nor matter weda una bi Jew or Greek pipol, savant or free pesin, man or woman, bikos all of una dey inside one body for Christ.
28 Nisto não há judeu nem grego; não há servo nem livre; não há macho nem fêmea; porque todos vós sois um em Cristo Jesus.
29 And if e bi sey una bilong to Christ, den una bi Abraham shidren and pipol wey go inherit wetin God promise.
29 E, se sois de Cristo, então, sois descendência de Abraão e herdeiros conforme a promessa.

Ler em outra tradução

Comparar com outra

Estude este capítulo no WhatsApp

Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Gálatas 3, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.