Gálatas 2
Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs NAA
1 Afta fourteen years, I kon go back to Jerusalem with Banabas and Titus.
1 Catorze anos depois, fui outra vez a Jerusalém com Barnabé, levando também Tito.
2 I go der bikos of di revelashon wey I receive, den I tell dem about wetin I dey prish give Gentile pipol. But I tok with di oga dem, so dat dem go dey sure sey, I dey prish Christ message.
2 Fui em obediência a uma revelação. E lhes apresentei o evangelho que prego entre os gentios — mas fiz isso em particular aos que pareciam de maior influência —, para não correr ou ter corrido em vão.
3 Titus dey with mi; even doh en na Greek pesin, dem nor sey e must sekonsaiz.
3 Mas, nem mesmo Tito, que estava comigo, sendo grego, foi obrigado a submeter-se à circuncisão.
4 Dem diskuss dis matter, bikos of di fake brodas with dia wayo wey dem take dey spy di freedom wey Christ give us, so dat dem go fit make us dia slave.
4 E isto surgiu por causa dos falsos irmãos que se haviam infiltrado para espreitar a liberdade que temos em Cristo Jesus e nos reduzir à escravidão.
5 But wi nor give dem shance, so dat di trut wey dey di gospel, go last for una.
5 A esses não nos submetemos por um instante sequer, para que a verdade do evangelho permanecesse entre vocês.
6 But doz wey tink sey dem bi oga, (wetin dem bi, nor mean anytin to mi; bikos God nor dey support bad tin); dem wey bi leaders for di church nor add anytin to my message.
6 E, quanto àqueles que pareciam ser alguma coisa — o que eles foram, no passado, não me interessa; Deus não aceita a aparência do homem —, esses, digo, que pareciam ser de maior influência, nada me acrescentaram.
7 But dem kon si sey na God sey make I prish en word to pipol wey dem nor sekonsaiz, just as E sey make Pita prish to doz wey dem sekonsaiz,
7 Pelo contrário, quando viram que me havia sido confiado o evangelho da incircuncisão, assim como a Pedro foi confiado o evangelho da circuncisão
8 (Bikos na thru God pawa Pita take prish to Jew pipol and na di same pawa I take dey prish give Gentile pipol too),
8 — pois aquele que operou eficazmente em Pedro para o apostolado da circuncisão também operou eficazmente em mim para com os gentios —
9 so wen James, Pita and John wey bi leaders for di church, si sey God give mi grace, dem kon dey support mi and Banabas sey, “Make wi dey prish give Gentile pipol and doz wey dem sekonsaiz.”
9 e, quando reconheceram a graça que me foi dada, Tiago, Cefas e João, que eram reputados colunas, estenderam a mim e a Barnabé a mão direita da comunhão, a fim de que nós fôssemos para os gentios e eles fossem para a circuncisão.
10 But dem sey make wi always remember poor pipol and na wetin dey my mind to do, bi dat.
10 Somente recomendaram que nos lembrássemos dos pobres, o que também me esforcei por fazer.
11 But wen Pita kom Antiok, I kon shalenge am, bikos wetin e do, nor good.
11 Quando, porém, Cefas veio a Antioquia, resisti-lhe face a face, porque havia se tornado repreensível.
12 Pita dey chop with Gentile pipol until some pipol wey James send, kom rish der. As Pita si dem, e kon stop to chop with Gentile pipol, bikos e dey fear di pipol wey kom, since dem bilive sey evribody must sekonsaiz.
12 De fato, antes de chegarem alguns da parte de Tiago, ele comia com os gentios; quando, porém, chegaram, começou a afastar-se e, por fim, separou-se, temendo os da circuncisão.
13 Oda Jew pipol kon dey pritend like Pita, sotey Banabas join dem too.
13 E também os demais judeus se fizeram hipócritas juntamente com ele, a ponto de o próprio Barnabé ter-se deixado levar pela hipocrisia deles.
14 But wen I si sey dem nor dey do wetin dem rite for God word, I kon tell Pita for dia front, “If yu wey bi Jew, dey do like Gentile pipol, how yu wont take make Gentile pipol live like Jew pipol?”
14 Quando, porém, vi que não procediam corretamente segundo a verdade do evangelho, eu disse a Cefas, na presença de todos: “Se você, que é judeu, vive como gentio e não como judeu, por que quer obrigar os gentios a viverem como judeus?”
15 Wi bi Jew pipol bikos of how dem born us and wi nor bi Gentile pipol wey bi sinnas.
15 Nós, judeus por natureza e não pecadores dentre os gentios,
16 Wi know sey nobody dey free from God judgement, bikos na so di law tok and pipol go only dey free, if dem get faith for Christ. Since wi don bilive Christ, wi suppose to dey do good thru di faith wey wi get for Christ and nor bi to dey do wetin di law tok and wi nor go dey free from judgement, wen wi do only wetin di law tok.
16 sabendo, contudo, que o homem não é justificado por obras da lei, e sim mediante a fé em Jesus Cristo, também temos crido em Cristo Jesus, para que fôssemos justificados pela fé em Cristo e não por obras da lei, pois por obras da lei ninguém será justificado.
17 Make wi dey kommit sin as wi dey try to do good, bikos wi get faith for Christ? If na so, dat mean sey Christ don dey support sin!
17 Mas, se nós, procurando ser justificados em Cristo, fomos também achados pecadores, será que isto significa que Cristo é ministro do pecado? De modo nenhum!
18 Naw, if I dey ripair di law wey I don first skata, dat mean sey I dey break God law.
18 Porque, se volto a edificar aquilo que destruí, a mim mesmo constituo transgressor.
19 As for di law, I don die to am, so dat I go fit dey alive with God.
19 Porque eu, mediante a própria lei, morri para a lei, a fim de viver para Deus. Estou crucificado com Cristo;
20 I don die with Christ for cross, so nor bi mi dey live again, but na Christ dey live inside mi. Di life wey I dey live naw, na bikos of di good tins wey God pikin do inside mi, bikos e love and die for mi.
20 logo, já não sou eu quem vive, mas Cristo vive em mim. E esse viver que agora tenho na carne, vivo pela fé no Filho de Deus, que me amou e se entregou por mim.
21 I nor go trowey God grace; bikos if na wetin di law tok go make pesin good, den Christ die for nor-tin!
21 Não anulo a graça de Deus; pois, se a justiça é mediante a lei, segue-se que Cristo morreu em vão.
Atalhos do teclado
- Capítulo anterior←
- Próximo capítulo→
- Versículo anteriork
- Próximo versículoj
- Limpar seleçãoEsc
- Esta ajuda?
Estude este capítulo no WhatsApp
Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Gálatas 2, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.