Gálatas 1

Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs ACF

Sair da comparação
ACF Almeida Corrigida Fiel
1 Na mi Paul, rite dis leta, (nor bi human being make mi apostle, but na Jesus Christ and God awa Papa wey raiz am from deat).
1 Paulo, apóstolo (não da parte dos homens, nem por homem algum, mas por Jesus Cristo, e por Deus Pai, que o ressuscitou dentre os mortos),
2 Mi and di brodas wey dey here, dey greet una wey dey Galatia.
2 E todos os irmãos que estão comigo, às igrejas da Galácia:
3 Make God awa Papa and Oga God Jesus Christ grace and peace, dey with una.
3 Graça e paz da parte de Deus Pai e do nosso Senhor Jesus Cristo,
4 Na Jesus die for awa sins, bikos na so God awa Papa wont am.
4 O qual se deu a si mesmo por nossos pecados, para nos livrar do presente século mau, segundo a vontade de Deus nosso Pai,
5 Make all glory bi en own forever and ever! Amen.
5 Ao qual seja dada glória para todo o sempre. Amém.
6 I sopraiz sey una kwik turn back from di Pesin wey koll una with en grace kon bigin follow oda tishing.
6 Maravilho-me de que tão depressa passásseis daquele que vos chamou à graça de Cristo para outro evangelho;
7 Nor bi sey anoda gospel really dey, but some pipol dey disturb una, bikos dem won shange wetin wi prish about Christ.
7 O qual não é outro, mas há alguns que vos inquietam e querem transtornar o evangelho de Cristo.
8 But if wi (or angels wey kom from heaven) tish una difren tins from di one wey wi prish give una before, make God distroy us with fire!
8 Mas, ainda que nós mesmos ou um anjo do céu vos anuncie outro evangelho além do que já vos tenho anunciado, seja anátema.
9 As I tok before, I dey repeat am again, if anybody dey tish difren tins from di ones wey wi prish give una before, make God trow dat pesin for hell!
9 Assim, como já vo-lo dissemos, agora de novo também vo-lo digo. Se alguém vos anunciar outro evangelho além do que já recebestes, seja anátema.
10 Una tink sey, I dey try to do tins make pipol for like mi? Abi I dey do wetin God wont? Or I dey try to make belle sweet pipol? If I dey try to make belle sweet pipol, den I nor bi Christ savant again!
10 Porque, persuado eu agora a homens ou a Deus? ou procuro agradar a homens? Se estivesse ainda agradando aos homens, não seria servo de Cristo.
11 My brodas and sistas, I wont make una know sey di gospel wey I dey prish, nor bi human being give mi.
11 Mas faço-vos saber, irmãos, que o evangelho que por mim foi anunciado não é segundo os homens.
12 Bikos I nor get or learn am from anybody, but I get am thru di revelashon wey Christ give mi.
12 Porque não o recebi, nem aprendi de homem algum, mas pela revelação de Jesus Cristo.
13 Una don hear about di kind life wey I dey live before as Jew pesin; how I trobol di church kon dey try to distroy am.
13 Porque já ouvistes qual foi antigamente a minha conduta no judaísmo, como sobremaneira perseguia a igreja de Deus e a assolava.
14 I grow among Jew pipol kon know di relijon pass many of my mates for my kountry and I know my grand-grand papa dem tradishons.
14 E na minha nação excedia em judaísmo a muitos da minha idade, sendo extremamente zeloso das tradições de meus pais.
15 But God koll mi with en grace kon separate mi even before dem born mi.
15 Mas, quando aprouve a Deus, que desde o ventre de minha mãe me separou, e me chamou pela sua graça,
16 E show mi en pikin, so dat I go fit prish about am give Gentile pipol. I nor go meet anybody make e advise mi
16 Revelar seu Filho em mim, para que o pregasse entre os gentios, não consultei a carne nem o sangue,
17 and I nor go Jerusalem go meet pipol wey bi apostle before mi, but I komot der go Arabia, den I kon go back to Damaskus.
17 Nem tornei a Jerusalém, a ter com os que já antes de mim eram apóstolos, mas parti para a Arábia, e voltei outra vez a Damasco.
18 Afta three years, I go visit Pita for Jerusalem, so dat e go tell mi wetin I go do and I stay with am for fifteen days.
18 Depois, passados três anos, fui a Jerusalém para ver a Pedro, e fiquei com ele quinze dias.
19 But I nor go si any oda apostle apart from James, wey bi Jesus Christ broda.
19 E não vi a nenhum outro dos apóstolos, senão a Tiago, irmão do Senhor.
20 God dey si wetin I dey rite, bikos evritin wey I dey rite to una so, na true!
20 Ora, acerca do que vos escrevo, eis que diante de Deus testifico que não minto.
21 Afta dis, I kon go Siria and Silisia aria.
21 Depois fui para as partes da Síria e da Cilícia.
22 But di pipol for di church wey dey Judea, nor know mi.
22 E não era conhecido de vista das igrejas da Judéia, que estavam em Cristo;
23 Dem only dey hear sey, “Di pesin wey dey trobol us before, don dey prish di message wey e bin dey try to distroy.”
23 Mas somente tinham ouvido dizer: Aquele que já nos perseguiu anuncia agora a fé que antes destruía.
24 So dem kon dey praiz God bikos of mi.
24 E glorificavam a Deus a respeito de mim.

Ler em outra tradução

Comparar com outra

Estude este capítulo no WhatsApp

Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Gálatas 1, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.