Filipenses 4
Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs NVI
1 My brodas, sistas and friends wey I love, I dey hongry to si una, bikos una dey make mi proud. My friends wey I love, make una stand well inside Christ!
1 Portanto, meus irmãos, a quem amo e de quem tenho saudade, vocês que são a minha alegria e a minha coroa, permaneçam assim firmes no Senhor, ó amados!
2 I dey beg Euodia and Sintike make dem gri togeda inside Christ.
2 O que eu rogo a Evódia e também a Síntique é que vivam em harmonia no Senhor.
3 Yes, my good friends, I still dey tell una, make una help dem. Dem try as dem dey prish di gospel with mi, both Klement and my oda ko-workers, wey dia name dey inside Christ Life Book.
3 Sim, e peço a você, leal companheiro de jugo, que as ajude; pois lutaram ao meu lado na causa do evangelho, com Clemente e meus demais cooperadores. Os seus nomes estão no livro da vida.
4 Make una always dey happy inside Christ. I dey tok again sey, make una dey happy!
4 Alegrem-se sempre no Senhor. Novamente direi: alegrem-se!
5 Make evribody know sey una nor like wahala, bikos Jesus go soon kom.
5 Seja a amabilidade de vocês conhecida por todos. Perto está o Senhor.
6 Make una nor let anytin worry una for mind. Instead, for evry kondishon wey una dey face, make una ask God thru prayer for evritin wey una nid and make una always dey tank am, as una dey pray.
6 Não andem ansiosos por coisa alguma, mas em tudo, pela oração e súplicas, e com ação de graças, apresentem seus pedidos a Deus.
7 Den God peace wey pass wetin human being fit undastand, go guide una heart and mind, inside Christ.
7 E a paz de Deus, que excede todo o entendimento, guardará os seus corações e as suas mentes em Cristo Jesus.
8 Finally, my brodas and sistas, tins wey bi true; wey get respet; wey fine; wey pipol dey tok good about; wey good well-well; wey rish to praiz, na dis kind tins una suppose to dey tink about.
8 Finalmente, irmãos, tudo o que for verdadeiro, tudo o que for nobre, tudo o que for correto, tudo o que for puro, tudo o que for amável, tudo o que for de boa fama, se houver algo de excelente ou digno de louvor, pensem nessas coisas.
9 So anytin wey una learn, hear and si mi dey do, make una dey do dem too. And di God wey dey give us peace, go dey with una.
9 Tudo o que vocês aprenderam, receberam, ouviram e viram em mim, ponham-no em prática. E o Deus da paz estará com vocês.
10 I dey happy well-well inside Christ, bikos una don finally show sey, una dey tink about how I dey manage. (I know sey una get mi for mind before, but una nor get shance to do anytin for mi).
10 Alegro-me grandemente no Senhor, porque finalmente vocês renovaram o seu interesse por mim. De fato, vocês já se interessavam, mas não tinham oportunidade para demonstrá-lo.
11 I nor dey tok dis one bikos I nid anytin, but na bikos I don learn to dey okay for any kondishon wey I si mysef.
11 Não estou dizendo isso porque esteja necessitado, pois aprendi a adaptar-me a toda e qualquer circunstância.
12 E get sometaim wey I nor get and sometaim, I dey get plenty. But for evry kondishon, I don learn how to dey okay, weda my belle full or I dey hongry; weda I get plenty or I nor get anytin at-all.
12 Sei o que é passar necessidade e sei o que é ter fartura. Aprendi o segredo de viver contente em toda e qualquer situação, seja bem alimentado, seja com fome, tendo muito, ou passando necessidade.
13 I fit do evritin thru Christ wey dey give mi pawa.
13 Tudo posso naquele que me fortalece.
14 But una try well-well as una help mi wen I dey trobol.
14 Apesar disso, vocês fizeram bem em participar de minhas tribulações.
15 Filippi pipol, una know sey, wen I komot from Masidonia, for di time wen I just start to prish di gospel, na una bi di only church wey help mi and na only una dey follow mi share for my happiness and sofa.
15 Como vocês sabem, filipenses, nos seus primeiros dias no evangelho, quando parti da Macedônia, nenhuma igreja partilhou comigo no que se refere a dar e receber, exceto vocês;
16 Bikos even for Tesalonika, una still send tins kom give mi.
16 pois, estando eu em Tessalônica, vocês me mandaram ajuda, não apenas uma vez, mas duas, quando tive necessidade.
17 I nor dey tok dis bikos I wont gift, but make una for gain from dis work wey una dey do.
17 Não que eu esteja procurando ofertas, mas o que pode ser creditado na conta de vocês.
18 Naw, I get evritin wey I nid, bikos Epafroditus don give mi di tins wey una send. And na dis bi di ofrins wey dey make belle sweet God.
18 Recebi tudo, e o que tenho é mais que suficiente. Estou amplamente suprido, agora que recebi de Epafrodito os donativos que vocês enviaram. Elas são uma oferta de aroma suave, um sacrifício aceitável e agradável a Deus.
19 My God go give una evritin wey una nid, bikos of en glory and propaty wey dey inside Jesus Christ.
19 O meu Deus suprirá todas as necessidades de vocês, de acordo com as suas gloriosas riquezas em Cristo Jesus.
20 Make evribody give glory to God awa Papa, forever and ever. Amen.
20 A nosso Deus e Pai seja a glória para todo o sempre. Amém.
21 Make una greet God pipol wey dey for Christ.
21 Saúdem a todos os santos em Cristo Jesus. Os irmãos que estão comigo enviam saudações.
22 God pipol wey dey here dey greet una too, especially doz ones wey kom from Caesar house.
22 Todos os santos lhes enviam saudações, especialmente os que estão no palácio de César.
23 Make awa Oga God Jesus Christ grace dey with una spirit.
23 A graça do Senhor Jesus Cristo seja com o espírito de vocês. Amém.
Atalhos do teclado
- Capítulo anterior←
- Próximo capítulo→
- Versículo anteriork
- Próximo versículoj
- Limpar seleçãoEsc
- Esta ajuda?
Estude este capítulo no WhatsApp
Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Filipenses 4, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.