Filipenses 3
Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs BKJ
1 Finally, my brodas and sistas, make una happy bikos una get Christ. I dey rite di same tin give una again, bikos e go help una.
1 No mais, meus irmãos, regozijai no Senhor. Escrever-vos as mesmas coisas não me é penoso, mas para vós é segurança.
2 Make una shine una eye, bikos of doz wey dey bihave like dogs and wiked pipol wey dey ponish dia body!
2 Guardai-vos dos cães, guardai-vos dos maus obreiros, cuidado com a mutilação.
3 Na wi bi di really sekonsishon; di pipol wey dey woship God thru en Spirit; pipol wey dey happy inside Christ and wi nor dey put awa hope for wetin pipol dey do.
3 Porque a circuncisão somos nós, que adoramos a Deus em espírito, e nos regozijamos em Cristo Jesus, e não temos confiança na carne.
4 Aldo my own rizin important too. If anybody tink sey e get betta rizin to put hope for wetin human being dey do, mi Paul, get pass dem.
4 Embora eu também possa ter confiança na carne; se algum outro homem pensa que pode confiar na carne, ainda mais eu:
5 Dem sekonsaiz mi eight days afta dem born mi. I kom from Israel, Benjamin tribe and I bi Hibru man. I bin dey live akordin to di law, bikos I bi Farisee.
5 Circuncidado ao oitavo dia, da linhagem de Israel, da tribo de Benjamim, hebreu de hebreus; no tocante à lei, um fariseu,
6 Bikos I really won do God work, I kon dey kause sirious wahala for di pipol wey dey di church. I do evritin just as di law sey make wi do, so dat wi go dey good for God eye. So, I nor get any fault.
6 segundo o zelo, perseguidor da igreja; no tocante à justiça que está na lei, irrepreensível.
7 But all dis tins wey I si as gain, I kon kount dem to bi nor-tin bikos of Christ.
7 Mas as coisas que para mim eram consideradas como ganho, reputei-as como perda por Cristo.
8 Nor bi only doz ones, but naw, I dey look evritin as nor-tin, wen I kompare am with Christ, my Oga God wey I know and I trowey evritin, bikos of am. True-true, I dey look all doz tins as yeye, so dat I go fit gain Christ,
8 E, na verdade, tenho também por perda todas as coisas, pela excelência do conhecimento de Cristo Jesus, meu Senhor; pelo qual sofri a perda de todas estas coisas e as considero como esterco, para que possa ganhar a Cristo,
9 kon bi one with am. My raitiousness nor kom from di law, but I dey raitious thru my faith for Christ. Bikos na thru faith God take make us dey raitious with am.
9 e seja achado nele, não tendo a minha própria justiça que vem da lei, mas a que vem pela fé de Cristo, a justiça que vem de Deus, pela fé.
10 Wetin I wont na to know am and di pawa wey wake Christ from deat; to sofa wetin e sofa; to bi as e bi wen e die,
10 Para conhecê-lo, e o poder da sua ressurreição, e a participação em seus sofrimentos, sendo feito conforme à sua morte;
11 so dat mi too go still wake-up from deat, as e wake.
11 para ver se, de alguma maneira, eu possa chegar à ressurreição dos mortos.
12 Nor bi sey I don get evritin wey I wont or God don make mi pafet, but I dey try make I get di prize wey dey kom from God kon hold am as Jesus Christ whole mi.
12 Não que já a tenha alcançado ou que seja perfeito; mas prossigo para alcançar aquilo para o que fui também alcançado por Cristo Jesus.
13 My brodas and sistas, I nor look mysef like sey I don get evritin wey I wont. Bikos I dey tink of only one tin wey bi: To forget di tins wey don pass kon dey porshu di ones wey dey front
13 Irmãos, não julgo que o haja alcançado; mas uma coisa faço, e é que, esquecendo-me das coisas que atrás ficam e avançando para as coisas que estão diante de mim,
14 and as I put my mind for dis tins, I dey try to get di prize wey bi life for heaven; prize wey make God koll us thru en pikin, Jesus Christ.
14 prossigo para o alvo, pelo prêmio da soberana vocação de Deus em Cristo Jesus.
15 So wi wey don mature for Christ, make wi get dis kind mind. But if una dey tink difren tins, I bilive sey God go show una di trut.
15 Por isso todos quantos já somos perfeitos, tenhamos este mesmo sentimento; e, se sentis alguma coisa de outra maneira, Deus deve revelar ainda esta a vós.
16 So, make wi kontinue to follow di rules wey wi dey follow.
16 Porém, naquilo a que já chegamos, andemos segundo a mesma regra e sintamos a mesma coisa.
17 My brodas and sistas, make una dey live like mi and dey learn from odas wey dey follow us as ezample.
17 Irmãos, sede também meus seguidores, e marcai os que assim andam, segundo o exemplo que tendes em nós.
18 Bikos I don tell una before and I dey tok am again with tears for my eye sey, di way many pipol dey bihave, dey show sey dem bi enemies to Christ cross.
18 (Porque muitos há, dos quais muitas vezes vos disse e agora também digo a vós, chorando, que eles são inimigos da cruz de Cristo.
19 Dem go end for hell; na dia belle bi di god wey dem dey serve. Tins wey suppose make dem shame, naim dey make dem happy and na only tins for dis world dem dey tink about.
19 Cujo fim é a destruição, cujo deus é o seu ventre, e cuja glória é a sua vergonha, que só pensam nas coisas terrenas).
20 But wi bilong to heaven and wi dey wait awa Savior wey kom from der, wey bi Oga God Jesus Christ.
20 Mas a nossa cidadania está nos céus, de onde também esperamos o Salvador, o Senhor Jesus Cristo,
21 E go use en pawa wey make am Oga God for evritin, take shange dis awa ordinary body and awa body go kon bi like en own wey get glory.
21 que transformará o nosso corpo vil, para ser conforme o seu corpo glorioso, de acordo com o trabalho pelo qual ele é capaz de submeter todas as coisas para si mesmo.
Atalhos do teclado
- Capítulo anterior←
- Próximo capítulo→
- Versículo anteriork
- Próximo versículoj
- Limpar seleçãoEsc
- Esta ajuda?
Estude este capítulo no WhatsApp
Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Filipenses 3, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.