Ezequiel 9

Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs VC

Sair da comparação
VC Versão Católica
1 Den I hear God shaut, “Una wey won go ponish di town, make una bring una gun, swod and knife kom.”
1 Depois ouvi gritar com voz forte: Aproximai-vos, vós, os guardas da cidade, trazendo cada um de vós o instrumento de destruição.
2 At wons, six men just kom out from di nort gate for di temple, each of dem karry swod. E get one man among dem wey wear linen and e whole sometin for hand wey e won take rite. All of dem kon stand near di bronze altar.
2 Surgiram então, do pórtico superior que olha para o norte, seis homens trazendo cada um na mão o instrumento de destruição. Encontrava-se no meio deles um personagem vestido de linho, trazendo à cintura um tinteiro de escriba. Entraram para se colocar de pé ao lado do altar de bronze.
3 Den Israel God glory raiz-up from di creatures wey get feada kon move go di temple gate. God koll di man wey wear linen kon tell am,
3 Então a glória do Deus de Israel se elevou de cima do querubim, onde repousava, até a soleira do templo. Chamou o Senhor o homem vestido de linho, que trazia à cintura os instrumentos de escriba,
4 “Make yu pass thru evriwhere for Jerusalem kon mark di pipol front head; pipol wey dey face trobol and wahala, bikos of all di bad tins wey dey happen for di town.”
4 e lhe disse: Percorre a cidade, o centro de Jerusalém, e marca com uma cruz na fronte os que gemem e suspiram devido a tantas abominações que na cidade se cometem.
5 I hear wen God tell di oda men sey, “Make una follow am pass thru di town kon bigin kill pipol and make una nor sorry or leave anybody.
5 Depois, dirigindo-se aos outros em minha presença, disse-lhes: Percorrei a cidade, logo em seguida, e feri! Não tenhais consideração, nem piedade.
6 Make una kill both old and yong pipol; weda na papa, mama or pikin. But make una nor tosh anybody wey get di mark for en head. Make una start from my temple.” So dem kon start with di leaders wey dey der.
6 Velhos, jovens, moços, moças, crianças e mulheres, matai todos até o total extermínio; precavei-vos, todavia, de tocar em quem estiver assinalado por uma cruz. Começai por meu santuário. Começaram pelos anciãos que encontraram defronte ao templo,
7 God sey, “Skata di temple! Make dead body full inside! Make una start to kill!” So dem start to kill di pipol wey dey for di town.
7 Manchai o templo, disse-lhes, e enchei de cadáveres os adros; em seguida saí! E foram-se eles para prosseguir o morticínio na cidade.
8 Na only mi dey der wen dem start to kill. So I fall face groun kon shaut, “Oga God wey get pawa well-well, na so Yu dey vex for Jerusalem? Yu wont kill evribody wey dey Israel?”
8 Permanecendo só durante esse massacre, prostrei-me de face contra a terra, e gritei: Ah! Senhor Javé, ides exterminar o que resta de Israel, desencadeando vosso furor contra Jerusalém.
9 God ansa, “Israel and Judah pipol don sin well-well. Dem don kill pipol for di land and dem nor dey obey my law again. Dem sey mi God don leave dem and I nor dey si wetin dem dey do.
9 A falta de Israel e de Judá é grande, muito grande, respondeu-me: a terra transborda de sangue e a cidade extravasa de perversão, porque dizem entre eles: o Senhor abandonou a terra! O Senhor não enxerga mais nada!
10 But I nor go sorry for dem. Na wetin dem do oda pipol, na di same tin I go do dem.”
10 Está bem! Eu, de minha parte, não terei complacência, mostrar-me-ei impiedoso, farei recair sobre a sua cabeça o peso de seu proceder.
11 Den di man wey wear linen klot, kom back kon tell God sey, “I don do as Yu sey make I do.”
11 Depois disso reapareceu o personagem vestido de linho, que trazia à cintura os instrumentos de escriba. Vinha prestar contas. Fiz o que me ordenastes.

Ler em outra tradução

Comparar com outra

Estude este capítulo no WhatsApp

Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Ezequiel 9, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.