Ezequiel 8
Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs NVI
1 Six years afta King Jehoiashin and Israel pipol dey Babilon as prisonas, for di fift day for di sixt mont, di leaders for Judah kom meet mi for my house and at wons God Spirit kon enter my body.
1 No quinto dia do sexto mês do sexto ano do exílio, eu e as autoridades de Judá estávamos sentados em minha casa quando a mão do Soberano Senhor veio ali sobre mim.
2 I si one vishon and di tin wey I si bi like human being. From en waist go down, e bi like fire wey dey burn, while from di waist kom up, e dey shine like bronze wey dem polish.
2 Olhei e vi uma figura como a de um homem. Do que parecia ser a sua cintura para baixo, ele era como fogo, e dali para cima sua aparência era tão brilhante como metal reluzente.
3 Di tin whole my hair with en hand. Den for dis vishon, God Spirit karry mi fly go Jerusalem. E take mi go di gate where dem dey pass for di nort side for di temple and one juju wey dey make God vex, dey der.
3 Ele estendeu o que parecia um braço e pegou-me pelo cabelo. O Espírito levantou-me entre a terra e o céu e, em visões de Deus, ele me levou a Jerusalém, à entrada da porta do norte do pátio interno, onde estava colocado o ídolo que desperta o zelo de Deus.
4 For der, I si God glory, just as I don si am before wen I dey Chebar River.
4 E ali, diante de mim, estava a glória do Deus de Israel, como na visão que eu havia tido na planície.
5 God kon tell mi, “Man pikin, look go di nort side.” I look and for der near di altar, I si di juju wey dey make God vex.
5 Então ele me disse: "Filho do homem, olhe para o norte". Olhei e, no lado norte, à porta do altar, vi o ídolo que desperta o zelo de Deus.
6 God tell mi, “Man pikin, yu si wetin dem dey do so? Si di yeye tins wey Israel pipol dey do for here! Dem dey porshu mi komot from my Holy Place. Yu go even si tins wey bad pass dis ones.”
6 E ele me disse: "Filho do homem, vê você o que estão fazendo? As grandes práticas repugnantes da nação de Israel, coisas que me levarão para longe do meu santuário? Mas você verá práticas ainda piores que estas".
7 So, E take mi go di gate for di kourtyard kon show mi di hole wey dey di wall.
7 Então ele me levou para a entrada do pátio. Olhei e vi um buraco no muro.
8 Den E sey, “Man pikin, break di wall.” I break am and I kon si one door.
8 Ele me disse: "Filho do homem, agora escave o muro". Escavei o muro e vi a abertura de uma porta ali.
9 E tell mi, “Go inside make yu si di bad and wiked tins wey dem don do for der.”
9 E ele me disse: "Entre e veja as coisas repugnantes e más que estão fazendo".
10 So I kon go look. Dem draw snake with oda bad animals and all dia juju for di wall.
10 Eu entrei e olhei. Lá eu vi, desenhadas por todas as paredes, todo tipo de criaturas rastejantes e animais impuros e todos os ídolos da nação de Israel.
11 Seventy Israel leaders dey der, plus Jaazanaya wey bi Shafan pikin. Each of dem whole wetin dem take dey burn incense and smoke dey kom out from am.
11 Na frente deles estavam setenta autoridades da nação de Israel, e Jazanias, filho de Safã, estava no meio deles. Cada um tinha um incensário na mão, e se elevava uma nuvem aromática de incenso.
12 God kon ask mi, “Man pikin, yu si wetin Israel leaders dey hide do? All of dem dey woship for one room wey juju full. Dem dey sey, ‘God nor dey si us! E don leave dis land.’ ”
12 Ele me disse: "Filho do homem, você viu o que as autoridades da nação de Israel estão fazendo nas trevas, cada um no santuário de sua própria imagem esculpida? Eles dizem: ‘O Senhor não nos vê; o Senhor abandonou o país’ ".
13 Den God tell mi, “Yu go si sey dem dey do tins wey even bad pass dis ones.”
13 E de novo disse: "Você os verá cometerem práticas ainda mais repugnantes".
14 So E take mi go di nort gate for di temple kon show mi wimen wey dey kry, bikos of dia juju, Tammuz.
14 Então ele me levou para a entrada da porta norte da casa do Senhor. Lá eu vi mulheres sentadas, chorando por Tamuz.
15 E kon ask mi, “Man pikin, yu dey si dat one so? Yu go si di ones wey worse pass dis one.”
15 Ele me disse: "Você vê isso, filho do homem? Você verá práticas ainda mais repugnantes do que essa".
16 So E take mi go inside di kourtyard for di temple. Near di Holy Place gate wey dey near di altar and di varanda, twenty-five men dey der. Dem back di Holy Place kon dey bow face di east, dey woship di sun as e dey raiz.
16 Ele então me levou para dentro do pátio interno da casa do Senhor, e ali, à entrada do templo, entre o pórtico e o altar, havia uns vinte e cinco homens. Com as costas para o templo do Senhor e os rostos voltados para o oriente, estavam se prostrando na direção do sol.
17 God kon tell mi, “Man pikin, yu dey si dat one too? All dis bad tins wey Judah pipol dey do and wey don spread for di land, nor do dem, but dem still dey do am for my Holy Place and e dey make mi vex for dem more-more. Si as dem dey curse mi for outside!
17 Ele me disse: "Você viu isso, filho do homem? Será algo corriqueiro para a nação de Judá essas práticas repugnantes? Deverão também encher a terra de violência e continuamente me provocar a ira? E veja! Eles estão pondo o ramo perto do nariz!
18 So, dem go feel my strong vexnashon. I nor go sorry or pity for dem. Dem go shaut well-well as dem dey pray give mi, but I nor go ansa or listin to dem.”
18 Por isso com ira eu os tratarei; não olharei com piedade para eles nem os pouparei. Mesmo que gritem aos meus ouvidos, não os ouvirei".
Atalhos do teclado
- Capítulo anterior←
- Próximo capítulo→
- Versículo anteriork
- Próximo versículoj
- Limpar seleçãoEsc
- Esta ajuda?
Estude este capítulo no WhatsApp
Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Ezequiel 8, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.