Ezequiel 7
Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs BKJ
1 God tell mi,
1 Além disso, a palavra do SENHOR veio a mim, dizendo:
2 “Man pikin, dis na wetin mi wey bi Oga God dey tell Israel pipol. Di end don rish for evriwhere for di land!
2 Também, tu filho do homem, assim diz o Senhor DEUS à terra de Israel: O fim, o fim vem sobre os quatro cantos da terra.
3 Una end don kom. Una go feel my vexnashon, bikos I dey judge una akordin to wetin una do. I go pay una back for all di bad-bad tins wey una don do.
3 Agora vem o fim sobre ti, e eu enviarei a minha ira sobre ti, e te julgarei de acordo com os teus caminhos, e recompensarei sobre ti todas as tuas abominações.
4 I nor go leave or sorry for una. I go ponish una for di bad tins wey una do, so dat una go know sey na mi bi God.”
4 E meu olho não te poupará, nem terei pena; mas eu recompensarei os teus caminhos sobre ti, e as tuas abominações estarão no meio de ti; e sabereis que eu sou o SENHOR.
5 Dis na wetin God wey get pawa tok: “Israel pipol, I go ponish una well-well.
5 Assim diz o Senhor DEUS: Um mal, um mal somente, eis que vem.
6 E don finish for una. Na una end bi dis. Una own don finish.
6 O fim vem, o fim vem, ele te observa; eis que vem.
7 Una wey dey di land, wahala dey kom meet una. Di time go soon rish wen una nor go dey do party for di juju house wey dey di mountin, but na so-so kry una go dey kry.
7 A manhã vem para ti, ó tu que habitas na terra. Vem o tempo; o dia da tribulação está perto, e não novamente o som dos montes.
8 E nor go tey before una go feel as my vexnashon strong rish. I go judge una akordin to wetin una do and I go pay una back for all di wiked tins wey una do.
8 Agora, em breve derramarei minha fúria sobre ti, e cumprirei minha ira sobre ti, e te julgarei de acordo com os teus caminhos, e te recompensarei por todas as tuas abominações.
9 I nor go sorry for una or show una mesi. I go ponish una for di bad tins where una don do, den una go know sey na mi bi God and na mi dey ponish una.”
9 E o meu olho não te poupará, nem terei pena; eu te recompensarei de acordo com os teus caminhos, e as tuas abominações que estão no meio de ti; e sabereis que eu sou o SENHOR que fere.
10 Si! Di day for strong wahala dey kom. Trobol go take-ova evriwhere and pipol go dey karry body anyhow.
10 Eis o dia, eis que vem; a manhã já se foi; a vara floresceu, o orgulho brotou.
11 Wahala don turn swod wey go ponish wiked pipol. Nor of dia tins go remain: dia money, propaty, happiness and glory, all of dem go vanish.
11 A violência se levantou em uma vara de perversidade; nenhum deles permanecerá, nem da sua multidão, nem de nenhum dos deles; nem haverá lamentação por eles.
12 Di time don rish! Di day don kom. Naw, doz wey dey buy nor dey happy and make doz wey dey sell, mourn, bikos God go ponish evribody.
12 Vem o tempo, o dia se aproxima; o que compra não se alegre, nem o vendedor lamente; porque a ira está sobre toda a sua multidão.
13 Doz wey dey sell nor go get dia money back wen dem still dey alive, bikos God vexnashon na for all of dem. All dis sinnas go die finish and nobody go remain.
13 Porque o vendedor não retornará àquilo que é vendido, embora ainda estejam vivos; porque a visão está tocando toda a sua multidão, que não retornará, nem ninguém se fortalecerá na iniquidade de sua vida.
14 Even doh sey dem blow di trumpet and all di sojas for Israel dey ready, nor of dem go gri go fight, bikos I dey vex for all of dem.
14 Tocaram a trombeta, para deixarem tudo preparado mas ninguém vai à batalha, porque a minha ira está sobre toda a sua multidão.
15 Pipol go dey fight each oda for street, but for house, na sickness and honga go dey der. Anybody wey dey outside di town go die for di fight and evribody wey dey house, na sickness and honga go kill dem.
15 A espada está fora, e a peste e a fome dentro; aquele que estiver no campo morrerá com a espada, e o que estiver na cidade, a fome e a peste o devorarão.
16 Some of dem go run go di mountin like doves wey run from valley. All of dem go kry, bikos of dia sins.
16 Mas aqueles que escaparem deles escaparão, e estarão nos montes como pombas dos vales, todos eles gemendo, cada um por sua iniquidade.
17 Evribody hand go dey weak and dia legs go dey shake.
17 Todas as mãos ficarão débeis, e todos os joelhos ficarão fracos como água.
18 Dem go wear sak as klot for body and dem go dey fall as dem dey waka. Dem go skrape dia head and na shame go follow dem.
18 E eles também cingir-se-ão com pano de saco, e o horror os cobrirá; e a vergonha estará sobre todas as faces, e a calvície sobre todas as suas cabeças.
19 Dem go trowey dia gold and silva for di street like sey na dirty, bikos gold or silva nor go fit save dem wen God vexnashon go kom and dem nor go fit use am get wetin dem wont or chop am like food and na dis gold and silva make dem sin.
19 Eles lançarão sua prata nas ruas, e o seu ouro será removido; sua prata e o seu ouro não serão capazes de livrá-los no dia da ira do SENHOR; eles não satisfarão suas almas, nem preencherão suas entranhas, porque isto é a pedra de tropeço da sua iniquidade.
20 Before-before, dem dey make yanga with dia fine-fine tins kon take di tins do juju. So na bikos of dis, God make dia money and propaty dey yuzles.
20 Quanto à beleza de seu ornamento, ele a pôs em majestade; mas eles fizeram as imagens das suas abominações e das suas coisas detestáveis; portanto eu a pus longe deles.
21 God sey, “I go let strenjas tif am from dem and pipol wey nor dey obey di law, go take all dia gold kon spoil am.
21 E eu a entregarei nas mãos dos estranhos por presa, e aos perversos da terra por despojo e eles a poluirão.
22 I nor go tok wen tif dey distroy and rob my temple.
22 Minha face eu também desviarei deles, e eles poluirão meu lugar secreto; porque os ladrões entrarão nele e o contaminarão.
23 So make dem prepare to shain my pipol, bikos na dead body full di land and na wahala full di town.
23 Faze uma corrente, porque a terra está cheia de crimes sangrentos, e a cidade está cheia de violência.
24 Di pipol wey bad pass, I go bring and let dem tif una house. Una men wey get pawa go run with fear wen I allow pipol kon skata where una for dey woship.
24 Portanto, eu trarei o pior dos pagãos, e eles possuirão suas casas; eu também farei a pompa dos fortes cessar, e seus lugares sagrados serão contaminados.
25 Trobol dey kom. Una go look for peace, but una nor go si am.
25 A destruição vem, e eles buscarão a paz, e não haverá nenhuma.
26 One diziz go follow anoda and na so-so bad-bad news una go dey hear. Una go beg di profets make dem tell una wetin dem si. Di priest nor go get anytin to tish di pipol and una eldas nor go fit give betta advise.
26 Dano virá sobre dano, e rumor haverá sobre rumor; então eles buscarão uma visão do profeta, mas a lei perecerá do sacerdote, e o conselho dos anciãos.
27 Di king go kry well-well; di prince nor go get hope again and di pipol go dey shake, bikos dem dey fear. I go ponish una for evritin wey una do and just as una judge oda pipol, na so too I go judge una. Den una go know sey na mi bi God!”
27 O rei lamentará, e o príncipe se vestirá de desolação, e as mãos do povo da terra serão incomodadas; eu farei a eles conforme o seu caminho, e de acordo com os seus méritos eu os julgarei, e eles saberão que eu sou o SENHOR.
Atalhos do teclado
- Capítulo anterior←
- Próximo capítulo→
- Versículo anteriork
- Próximo versículoj
- Limpar seleçãoEsc
- Esta ajuda?
Estude este capítulo no WhatsApp
Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Ezequiel 7, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.