Ezequiel 5

Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs NVT

Sair da comparação
NVT Nova Versão Transformadora
1 God sey, “Man pikin, use sharp knife take kut yor hair and bear-bear. Put di hair for skale kon divide am into three part.
1 “Filho do homem, pegue uma espada afiada e use-a como navalha para raspar sua cabeça e sua barba. Use uma balança para pesar o cabelo e dividi-lo em três partes.
2 Burn di third part for fire afta yor work don finish. Take anoda part kon kut am anyhow for outside di town. Den make yu skata di remainin part for air and I go use my swod take distroy dem.
2 Coloque uma terça parte no meio do desenho de Jerusalém e, depois de encenar o cerco à cidade, queime o cabelo ali. Espalhe outra terça parte ao redor do desenho e corte-a com a espada. Espalhe a terceira parte ao vento, pois eu espalharei meu povo com a espada.
3 Make yu keep and tie some of di hair for yor klot.
3 Guarde apenas um pouco de cabelo e amarre-o em seu manto.
4 Yu go still take some kon trow dem for fire make dem burn. From der, one fire go spread go all Israel family.
4 Então, pegue alguns desses fios de cabelo e jogue-os no fogo, para que se queimem. Dali um fogo se espalhará e destruirá todo o Israel.
5 “Dis na wetin God wey get pawa dey tok: Na Jerusalem bi dis; I put am for difren nashon centre and difren kountries dey round am.
5 “Assim diz o S enhor Soberano: Esta é uma ilustração do que acontecerá a Jerusalém. Coloquei-a no centro das nações,
6 But Jerusalem nor do wetin I kommand and e show sey e wiked pass di oda nashons. E disobey mi pass all di kountries wey dey round am. Jerusalem rijet my kommand and e nor gri receive my laws.
6 mas ela se revoltou contra meus estatutos e decretos e foi mais perversa que as nações ao seu redor. Não quis obedecer a meus estatutos e decretos.
7 “So Jerusalem pipol make una listin: Na mi bi Oga God! Una nor gri obey my laws or tishings, instead una dey do wetin di oda nashons dey do. Una even sturbon pass di tribes wey dey near una.
7 “Portanto, assim diz o S enhor Soberano: Vocês são mais rebeldes que as nações vizinhas e não quiseram obedecer a meus decretos e estatutos. Nem sequer viveram de acordo com os padrões de justiça das nações ao seu redor.
8 “So mi God dey tell una sey I dey against una. Naw, all doz nashons go dey look as I dey ponish una, bikos una don bi my enemy.
8 Portanto, eu mesmo, o S enhor Soberano, estou contra vocês. Eu os castigarei publicamente diante de todas as nações.
9 Bikos of all di tins wey una do; tins wey I hate well-well. So I go ponish Jerusalem as I neva do before, but I nor go ponish dem like dat again.
9 Por causa de seus ídolos detestáveis, punirei vocês como nunca fiz antes e nunca voltarei a fazer.
10 Bikos of dis, for Jerusalem, papa and mama go chop dia pikin and shidren go chop dia papa and mama. I go ponish una and doz wey go remain wey nor die, I go skata dem for evriwhere for dis world.
10 Pais devorarão os filhos, e filhos devorarão os pais. Eu os castigarei e espalharei aos quatro ventos os poucos que sobreviverem.
11 “So as long as mi God dey alive and as una don spoil my temple with una juju and all di bad tins wey una dey do, I nor go sorry for una wen I dey distroy una.
11 “Tão certo como eu vivo, diz o S enhor Soberano, eu os destruirei completamente. Não terei compaixão alguma de vocês, pois profanaram meu templo com imagens repugnantes e pecados detestáveis.
12 Some of una go die bikos of honga; sickness go kill some; swod go kill anoda set for outside di town and di remain wons, I go skata dem for air kon porshu dem with my swod.
12 Uma terça parte de seu povo morrerá na cidade por doença e fome, uma terça parte será morta pelo inimigo fora dos muros da cidade, e eu espalharei uma terça parte aos quatro ventos e os perseguirei com minha espada.
13 So my vexnashon go end and my ponishment go rest for dia head, den I go dey okay. Wen all dis tins don happen, una go si, undastand and know sey na mi God, tok to una.
13 Por fim, minha ira se completará, e ficarei satisfeito. E, quando minha fúria contra eles tiver passado, todo o Israel saberá que eu, o S enhor , lhes falei segundo o meu zelo.
14 “All di pipol wey dey di oda nashons near una, wen dem waka pass, dem go dey laf and fool una, bikos of how God take distroy una land.
14 “Portanto, eu o transformarei em uma ruína, em objeto de insulto aos olhos das nações ao redor e para todos que passarem por ali.
15 Wen I vex kom ponish una, all di nashons near una, go fear. Dem go shake dia head and laf as dem dey look una.
15 Você se tornará alvo de insultos, zombarias e horror, e servirá de advertência para todas as nações ao redor. Elas verão o que acontece quando o S enhor , em sua ira, castiga uma nação e a repreende, diz o S enhor .
16 I go let honga kill una and una nor go si food chop. Una go feel my vexnashon like arrow wey dem take shot pesin.
16 “Farei chover sobre você as flechas mortais da fome, para destruí-la. A fome se tornará cada vez mais severa, até que desapareça todo suprimento.
17 So, I go send honga and wiked animals kom meet una and dem go kill una shidren. Na trobol and deat go dey una land and I go raiz my swod against una.
17 Além da fome, enviarei animais selvagens para atacá-la e devorar seus filhos. Doença e guerra a alcançarão, e trarei contra você a espada do inimigo. Eu, o S enhor , falei!”.

Ler em outra tradução

Comparar com outra

Estude este capítulo no WhatsApp

Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Ezequiel 5, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.