Ezequiel 4
Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs ARIB
1 God sey, “Man pikin, make yu take one stone kon put am for yor front den draw Jerusalem put.
1 Tu pois, ó filho do homem, toma um tijolo, e pô-lo-ás diante de ti, e grava nele uma cidade, a cidade de Jerusalém;
2 Tie am well-well! Make wall round am, den guide am with sojas and betta iron gate.
2 e põe contra ela um cerco, e edifica contra ela uma fortificação, e levanta contra ela uma tranqueira; e coloca contra ela arraiais, e põe-lhe aríetes em redor.
3 Make yu take one iron pan kon set am up like wall between yu and di town. Den turn make yu face Jerusalem to show sey dem nor go fit eskape wen dia enemies dey kom distroy dem. Dis go bi warnin to Israel pipol.
3 Toma também uma sertã de ferro, e põe-na por muro de ferro entre ti e a cidade; e olha para a cidade, e ela será cercada, e tu a cercarás; isso servirá de sinal para a casa de Israel.
4 “Den, sleep with yor left side kon put Israel sins on-top yor body. And for di days wey yu take sleep with yor left side, Israel pipol sin go dey yor head.
4 Tu também deita-te sobre o teu lado esquerdo, e põe sobre ele a iniqüidade da casa de Israel; conforme o número dos dias em que te deitares sobre ele, levarás a sua iniqüidade.
5 Na mi know di nomba of days wey yu go bear dia sins rish and na three hundred and ninty days wey go ripresent di years wey dem don sin.
5 Pois eu fixei os anos da sua iniqüidade, para que eles te sejam contados em dias, trezentos e noventa dias; assim levarás a iniqüidade da casa de Israel.
6 “Wen yu don komplete dis days, yu go sleep again, but dis time, yu go sleep with di rite and Judah sins go dey yor head. I don sey dis one go bi forty days. One day go ripresent one year.
6 E quando tiveres cumprido estes dias, deitar-te-ás sobre o teu lado direito, e levarás a iniqüidade da casa de Judá; quarenta dias te dei, cada dia por um ano.
7 Yu go turn face where yu tie di iron pan put kon tok against am sey;
7 Dirigirás, pois, o teu rosto para o cerco de Jerusalém, com o teu braço descoberto; e profetizarás contra ela.
8 Look! I go tie yu with rope, so dat yu nor go turn anyhow until di days don komplete.
8 E eis que porei sobre ti cordas; assim tu não te voltarás dum lado para o outro, até que tenhas cumprido os dias de teu cerco:
9 “Naw, take some bread, beans, lentil, millet and korn kon put dem for one kontaina, den make yu chop from dem. Na di same days wey yu take sleep, yu go take chop and na three hundred and ninty days.
9 E tu toma trigo, e cevada, e favas, e lentilhas, e milho miúdo, e espelta, e mete-os numa só vasilha, e deles faze pão. Conforme o número dos dias que te deitares sobre o teu lado, trezentos e noventa dias, comerás disso.
10 Evriday, di food wey yu go chop must nor heavy pass half pound and make e bi for di same time wey use choose.
10 E a tua comida, que hás de comer, será por peso, vinte siclos cada dia; de tempo em tempo a comerás.
11 And na one and half lita of wota yu go dey drink evriday.
11 Também beberás a água por medida, a sexta parte dum him; de tempo em tempo beberás.
12 Yu go use dry human being shit take make fire where yu go take bake di bread wey yu go dey chop evriday and na for where evribody go for si yu.”
12 Tu a comerás como bolos de cevada, e à vista deles a assarás sobre o excremento humano.
13 God still sey, “Dis na to show how Israel pipol go chop food wey dia law sey make dem nor chop. Dat time, I go don skata dem go difren place.”
13 E disse o Senhor: Assim comerão os filhos de Israel o seu pão imundo, entre as nações, para onde eu os lançarei.
14 But I ansa, “God wey get pawa well-well, make Yu nor do am like dat! Since I small, I neva chop food wey di law dey forbid or chop animal wey die on en own or wey wiked animal kill. I neva chop any food wey nor klean.”
14 Então disse eu: Ah Senhor Deus! eis que a minha alma não foi contaminada: pois desde a minha mocidade até agora jamais comi do animal que morre de si mesmo, ou que é dilacerado por feras; nem carne abominável entrou na minha boca.
15 So God sey, “Okay! I go allow yu use melu shit, instead of human being own.”
15 Então me disse: Vê, eu te dou esterco de bois em lugar de excremento de homem; e sobre ele prepararás o teu pão,
16 God still sey, “Man pikin, I go remove bread from Jerusalem. Di pipol go dey measure di food and wota wey dem dey drink, so dat e nor go finish.
16 Disse-me mais: Filho do homem, eis que quebrarei o báculo de pão em Jerusalém; e comerão o pão por peso, e com ansiedade; e beberão a água por medida, e com espanto;
17 Dia bread and wota go finish; dem go dey for pain and dem go die finish, bikos of dia sin.”
17 até que lhes falte o pão e a água, e se espantem uns com os outros, e se definhem na sua iniqüidade.
Atalhos do teclado
- Capítulo anterior←
- Próximo capítulo→
- Versículo anteriork
- Próximo versículoj
- Limpar seleçãoEsc
- Esta ajuda?
Estude este capítulo no WhatsApp
Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Ezequiel 4, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.