Ezequiel 44
Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs NVI
1 Den di man take mi go outside di gate for di east side for di temple aria. Dem klose di gate.
1 Depois o homem trouxe-me de volta para a porta externa do santuário, que dava para o lado leste, e ela estava trancada.
2 God kon sey, “From naw go, dem nor go ever open dis gate and as e dey so, na so e go dey. Dem nor go let human being use am, bikos mi di Oga wey bi Israel God, don pass am enter. E must dey klose like dat forever.
2 O Senhor me disse: "Esta porta deve permanecer trancada. Não deverá ser aberta; ninguém poderá entrar por ela. Deve permanecer trancada porque o Senhor, o Deus de Israel, entrou por ela.
3 Di prince wey dey rule naw fit go der go chop di holy food for my present. E go enter kon pass di big room for inside, go out.”
3 O príncipe é o único que poderá entrar e sentar-se dentro para comer na presença do Senhor. Ele entrará pelo pórtico da entrada e sairá pelo mesmo caminho".
4 Den di man take mi pass di gate for nort go di temple front. As I still dey look, I kon si God glory dey shine for di temple. At wons, I fall face groun
4 Então o homem levou-me até a frente do templo, passando pela porta norte. Olhei e vi a glória do Senhor enchendo o templo do Senhor, e prostrei-me, rosto em terra.
5 and God kon tell mi, “Man pikin, listin well-well to evritin wey yu hear and si. I go tell yu di rules and di laws for di temple. Listin well-well, so dat yu go know di pesin wey go fit enter and kom out from di temple and doz wey nor suppose enter.
5 O Senhor me disse: "Filho do homem preste atenção, olhe e ouça atentamente tudo o que eu lhe disser acerca de todos os regulamentos a respeito do templo do Senhor. Preste atenção à entrada do templo e a todas as saídas do santuário.
6 Go tell doz bad pipol wey dey Israel sey, mi God wey get pawa nor go sorry for dem again, bikos of di yeye tins wey dem dey do.
6 Diga à rebelde nação de Israel: ‘Assim diz o Soberano Senhor: Já bastam suas práticas repugnantes, ó nação de Israel!
7 Dem don dirty my temple, bikos dem dey allow pipol wey neva sekonsaiz enter. Pipol wey nor dey obey mi dey enter di temple wen dem dey offa animal give mi as sakrifice. So my pipol don break di kovenant with all dis yeye tins wey dem dey do.
7 Além de todas as suas outras práticas repugnantes, vocês trouxeram estrangeiros incircuncisos no coração e na carne para dentro do meu santuário, profanando o meu templo enquanto me ofereciam comida, gordura e sangue, e assim vocês romperam a minha aliança.
8 Dem nor dey kare for di holy place for my temple, instead na strenjas dey lead dem for my temple.
8 Ao invés de cumprirem seu dever quanto às minhas coisas sagradas, vocês encarregaram outros do meu santuário.
9 Mi wey bi God wey get pawa, dey kommand una sey, strenjas wey neva sekonsaiz; doz wey nor dey obey mi, make dem nor ever enter my temple, even if na strenjas wey dey stay with my pipol.”
9 Assim diz o Soberano Senhor: Nenhum estrangeiro incircunciso no coração e na carne entrará no meu santuário, nem tampouco os estrangeiros que vivem entre os israelitas.
10 God tell mi, “I dey ponish Levi tribes wey join Israel pipol sin kon still woship juju.
10 " ‘Os levitas que tanto se distanciaram de mim quando Israel se desviou e que vaguearam para longe de mim, indo atrás de seus ídolos, sofrerão as conseqüências de sua iniqüidade.
11 Dem fit still serve mi for di temple kon stand for di gate den do di temple work. Dem fit kill di animals wey pipol kom offa as sakrifice and dem must dey to serve di pipol.
11 Poderão servir no meu santuário, como encarregados das portas do templo e servindo nele; poderão matar os animais dos holocaustos e outros sacrifícios em lugar do povo e colocar-se diante do povo e servi-lo.
12 But bikos dem follow odas go serve juju kon make Israel pipol sin, mi God wey get pawa dey swear sey I must ponish dem.
12 Mas, porque os serviram na presença de seus ídolos e fizeram a nação de Israel cair em pecado, jurei de mão erguida que eles sofrerão as conseqüências de sua iniqüidade, palavra do Soberano Senhor.
13 Dem nor go serve as priest or go near anytin wey dey holy to mi or enter my Most holy place. Dis ponishment na for di yeye tins wey dem don do.
13 Não se aproximarão para me servir como sacerdotes nem se aproximarão de nenhuma de minhas coisas sagradas e das minhas ofertas santíssimas; carregarão a vergonha de suas práticas repugnantes.
14 Na di work wey dem go do for di temple, I dey tell dem so.”
14 Contudo, eu os encarregarei dos deveres do templo e de todo o trabalho que nele deve ser feito.
15 God wey get pawa sey, “All di priests from Levi tribe wey bi Zadok shidren-shidren must kontinue to serve mi, even wen all di odas for Israel nor gri serve mi again. So naw, na dem go serve, enter my present kon offa di animals and di blood for di sakrifice, give mi.
15 " ‘Contudo, os sacerdotes levitas e descendentes de Zadoque e que fielmente executaram os deveres do meu santuário quando os israelitas se desviaram de mim, se aproximarão para ministrar diante de mim; eles ficarão diante de mim para oferecer sacrifícios de gordura e de sangue, palavra do Soberano Senhor.
16 Na only dem go enter my temple; serve mi for my altar kon lead odas to woship mi.
16 Só eles entrarão em meu santuário e se aproximarão da minha mesa para ministrar diante de mim e realizar o meu serviço.
17 “Wen dem enter di gate where dem go pass go di kourtyard for inside di temple, dem must wear linen klot. Anytime dem dey work for di kourtyard or di temple, make dem nor wear anytin wey dem make with wool.
17 " ‘Quando entrarem pelas portas do pátio interno, estejam vestindo roupas de linho; não usem nenhuma veste de lã enquanto estiverem ministrando junto às portas do pátio interno ou dentro do templo.
18 Dem must wear turban and linen trousers without belt, so dat dem nor go sweet.
18 Usarão turbantes de linho na cabeça e calções de linho na cintura. Não vestirão nada que os faça transpirar.
19 Before dem go-go di kourt for outside where pipol dey, dem go first pul dia klot wey dem wear take work inside di temple kon leave am for di holy rooms. Dem go wear anoda klot, so dat dia holy klot nor go tosh pipol.
19 Quando saírem para o pátio externo onde fica o povo, tirarão as roupas com que estiveram ministrando e as deixarão nos quartos sagrados, e vestirão outras roupas, para que não consagrem o povo por meio de suas roupas sacerdotais.
20 “Make priest nor barb en hair or let am grow too mush. Dem must let am grow rish one stage kon maintain am like dat.
20 " ‘Não raparão a cabeça nem deixarão o cabelo comprido, mas o manterão aparado.
21 Priests nor go drink any wine before e go inside di kourt.
21 Nenhum sacerdote beberá vinho quando entrar no pátio interno.
22 Priests nor go marry woman wey nor dey with en husband again; na only Israel woman wey neva sleep with man before, e go marry or anoda priests wey don die, wife.
22 Eles não se casarão com viúva ou divorciada; só poderão casar-se com mulher virgem, de ascendência israelita, ou com viúva de sacerdote.
23 Na priests go tish my pipol di difren between wetin dey holy and wetin nor dey holy; wetin dey klean and wetin nor klean.
23 Eles ensinarão ao meu povo a diferença entre o santo e o comum e lhe mostrarão como fazer distinção entre o puro e o impuro.
24 “Wen any kase dey kourt, na di priests go judge am akordin to my law. Dem go make sure sey dem kontinue di festival akordin to my rules and laws and dem must keep di Sabat Day holy.
24 " ‘Em qualquer disputa, os sacerdotes servirão como juízes e a decisão será tomada de acordo com as minhas sentenças. Eles obedecerão às minhas leis e aos meus decretos com respeito a todas as minhas festas fixas, e manterão santos os meus sábados.
25 “Anybody wey bi priest must nor tosh dead body, if not, e nor go dey klean again. Unless di dead body na en mama, papa, pikin, broda or sista wey neva marry before.
25 " ‘O sacerdote não se contaminará por aproximar-se do cadáver de alguém; no entanto, se o morto for seu pai, sua mãe, seu filho, sua filha, seu irmão ou sua irmã não-casada, ele poderá contaminar-se.
26 Afta e don dey klean again, e must wait for seven days
26 Depois de se purificar, esperará sete dias.
27 den kon go di kourt for di temple go offa sakrifice to klean ensef, so dat e go fit serve for di temple again.
27 No dia em que entrar no pátio interno do santuário para ministrar no santuário, ele oferecerá em favor de si mesmo uma oferta pelo pecado, palavra do Soberano Senhor.
28 “Na mi bi di priests propaty for life and una nor go give dem any propaty; I bilong to dem and evritin wey dem wont, na mi.
28 " ‘Eu serei a única herança dos sacerdotes. Vocês não lhes darão propriedade alguma em Israel; eu serei a sua herança.
29 Di korn ofrin, di sin ofrin and all di oda ofrins; dem go bi di priests own and evritin for Israel wey di pipol give mi, go bi di priests own too.
29 Eles comerão as ofertas de cereal, as ofertas pelo pecado e as ofertas pela culpa; e tudo o que em Israel for consagrado ao Senhor será deles.
30 Di priests go get di betta part for evry first fruit or food for Israel and evritin where Israel pipol go offa give mi. Anytime di pipol bake bread, dem must give di priests di first bread as ofrin and my blessing go dey dia house.
30 O melhor de todos os primeiros frutos e de todas as contribuições que vocês fizerem pertencerá aos sacerdotes. Vocês darão a eles a primeira porção de sua refeição de cereal moído, para que haja bênçãos sobre as suas casas.
31 Di priests nor go chop bird or animal wey die on dia own or wey anoda animal kill.”
31 Os sacerdotes não comerão a carne de aves ou de animais, encontrados mortos ou despedaçados por animais selvagens.
Atalhos do teclado
- Capítulo anterior←
- Próximo capítulo→
- Versículo anteriork
- Próximo versículoj
- Limpar seleçãoEsc
- Esta ajuda?
Estude este capítulo no WhatsApp
Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Ezequiel 44, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.