Ezequiel 39

Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs VC

Sair da comparação
VC Versão Católica
1 God wey get pawa sey, “Man pikin, go tok against Gog wey dey rule Meshak and Tubal sey, ‘I bi en enemy.
1 E tu, filho do homem, profetiza contra Gog nestes termos: eis o que diz o Senhor Javé: é contra ti que venho, Gog, príncipe soberano de Mosoc e de Tubal.
2 I go take am go anoda place for nort until e rish Israel mountin.
2 Eu te vou fazer ir e vir, eu te conduzirei, eu te transportarei dos confins do norte contra as montanhas de Israel.
3 Den I go nak en bow komot from en left hand and di arrow wey dey en rite hand.
3 De tua mão esquerda escapará teu arco, que eu quebrarei, e de tua mão direita farei cair tuas flechas.
4 Gog, en sojas and all di pipol wey dey stay with am go die finish for Israel mountin and I go let bird and wiked animals chop dia body.
4 Tombarás sobre os montes de Israel, com tuas tropas e as hordas que te seguirem. Dar-te-ei por pasto às aves de rapina, aos voláteis de toda espécie e às feras.
5 Dem go die for war.
5 Serás estirado na terra, porquanto eu disse - oráculo do Senhor Javé.
6 “I go set fire put for Magog land and land near di river where pipol dey stay for peace. Den evribody go know sey na mi bi God.
6 Expedirei fogo a Magog e entre aqueles que ocupam tranqüilamente as praias marinhas; eles saberão que sou eu o Senhor.
7 I go make sure sey Israel, my pipol know my holy name and I nor go let dem disgrace my name again. Den di pipol go know sey na mi bi di God wey dey holy.”
7 Farei assim conhecer meu santo nome no meio do meu povo de Israel, sem mais deixá-lo profanar. As nações saberão assim que sou eu o Senhor, santo em Israel.
8 God wey get pawa sey, “Wetin I dey tok about, go must kom.
8 Ora, eis o que irá suceder, e isso está próximo - oráculo do Senhor Javé -, eis o dia que eu havia predito.
9 Di pipol wey dey stay Israel town go-go kollect doz tins wey dem take dey kill pipol kon use am do firewood and dem bi: di swod, di shield, di bow, di arrow, di spear and dem go use dem as firewood for seven years.
9 De todas as cidades de Israel sairão cidadãos para acender um fogo onde hão de queimar as armas: capacetes, escudos, arcos, flechas, lanças, dardos, dos quais se fará uma fogueira durante sete anos.
10 Dem nor nid to go gada wood for di field or go kut tree for forest, bikos di swods go rish dem take make fire. Doz wey tif and karry my pipol propaty before, my pipol go kollect di load back from dia hand.”
10 Não mais irão aos campos amontoar lenha, não mais hão de fazer derrubada na floresta, porque com as armas é que se farão fogueiras. Pilharão os saqueadores, destruirão os destruidores - oráculo do Senhor Javé.
11 God sey, “Wen all dis tins dey happen, I go give Gog one grave for Travelas Valley wey dey di Dead Sea for Israel east. Dem go beri Gog and all en sojas for der and dem go koll am ‘Hamon-Gog Valley.’
11 Naquele dia, assinalarei a Gog o local da sepultura em Israel, o vale dos viandantes, a oriente do mar, que tapará o caminho aos passantes. Aí se enterrará Gog e toda a horda de suas gentes, e chamar-se-á esse vale Hamon-Gog.
12 Na seven mont e go take Israel pipol to beri all di dead body kon make di land klean again.
12 Os israelitas gastarão sete meses para enterrá-los e para limpar a terra.
13 Evribody for di land go join beri dem, den pipol go respet dem afta dem don win di fight.
13 Todas as gentes da terra trabalharão nessa sepultura e hão de orgulhar-se do dia em que eu manifestar a minha glória - oráculo do Senhor Javé.
14 “Afta di sevent monts, dem go choose men wey go travel round di land, so dat dem go fine and beri di dead body wey remain, so dat di land go dey klean.
14 Designar-se-ão homens encarregados de percorrer continuamente a terra para a limparem, enterrando os cadáveres que ficarem distendidos pelo solo: essa procura durará sete meses.
15 As dem dey travel round di kountry, wons dem si human being bone, dem go mark dat place, so dat doz wey dey beri go si di bones kon beri dem for Hamon-Gog Valley.
15 Quando em suas caminhadas virem eles ossos humanos, de todo lado farão sinal até que os coveiros os tenham enterrado no vale de Hamon-Gog.
16 (E get one town for der and dem go gi-am Gog sojas name wey bi Hamonah.) So di land go dey klean again.”
16 Uma cidade terá o nome de Hamona. É assim que se purificará a terra.
17 God wey get pawa kon tell mi, “Man pikin, go koll all di birds and animals make dem kom from evriwhere kon chop di sakrifice food wey I dey make for dem. Na party dem won do on-top Israel mountin so and dem go chop and drink blood.
17 E tu, filho do homem, escuta o que diz o Senhor Javé: dize às aves de toda espécie e a todos os animais dos campos: ajuntai-vos! Vinde, reuni-vos para o sacrifício que vos preparo, um grande sacrifício nas montanhas de Israel: comereis carne e bebereis sangue.
18 Dem go chop sojas body kon drink ruler and leaders blood; all dis pipol go die like ram, sheep, goat or like big melu.
18 Ireis comer a carne dos heróis e beber o sangue dos príncipes da terra: carneiros, cordeiros, cabritos, touros robustos de Basã.
19 Wen I kill dis pipol as sakrifice, di birds and animals go chop evry part wey dem fit chop kon drink blood until dem nor fit drink again.
19 Nesse sacrifício ao qual vos convido, comereis gordura até vos fartardes, e bebereis sangue até a embriaguez.
20 For my tabol, dem go chop all wetin dem fit chop from shariot and from all di sojas body.
20 À minha mesa vos saciareis de corcéis, cavaleiros, heróis e guerreiros de toda espécie - oráculo do Senhor Javé.
21 God sey, “I go let di kountry si my glory and I go show dem how I dey judge well with my pawa.
21 Desse modo, manifestarei minha glória entre as nações: todas elas me hão de ver executar os meus atos de justiça e pôr a mão sobre elas.
22 Den from dat day go, Israel pipol go know sey na mi bi di Oga wey bi dia God.
22 E, a partir daquele dia, os israelitas saberão que sou eu o Senhor, seu Deus.
23 All di kountries go know sey Israel go Babilon as slave, bikos of sin and I turn leave dem kon let dia enemies beat and kill dem for war.
23 As nações reconhecerão que é por causa da sua iniqüidade que Israel foi deportado, e que é por causa da sua infidelidade que lhes tenho ocultado a minha face e as tenho entregue nas mãos dos seus inimigos, para que pereçam pela espada.
24 I give dem wetin dem ask for and bikos of dia sin and wikedness, I waka leave dem.”
24 Escondendo-lhes minha face, só lhes fiz o que mereciam por suas iniqüidades e prevaricações.
25 God wey get pawa sey, “But naw, I go sorry for Jakob shidren wey bi Israel pipol kon make dem prosper again. Yes! I go guide my holy name.
25 E, por isso, eis o que diz o Senhor Javé: dentro em breve vou reconduzir os cavalos de Jacó e apiedar-me de toda a casa de Israel; vou mostrar-me cioso do meu santo nome.
26 Wen dem don dey stay dia on land with peace and nobody dey treaten dem again, den dem go forget how dem sofa before wen dem dey sin against mi.
26 E serão livres de toda vergonha e das infidelidades de que se tornaram culpados para comigo, quando habitarem de novo tranqüilamente sua terra, sem que ninguém os inquiete.
27 For all di enemies land where my pipol dey stay, I go bring dem kom back to dia own land, den evribody go know sey I dey holy.
27 Logo que os houver reconduzido dentre as nações e reunido dos países inimigos, e que houver manifestado a minha santidade aos olhos das nações numerosas por meu proceder a seu respeito,
28 Den my pipol go know sey na mi bi di Oga wey bi dia God. Dem go know, bikos I send dem go anoda land prisonas before, but naw, I don gada dem from all di kountries where I skata dem go before kon bring dem back to dia land and I nor forget or leave anybody for der.
28 reconhecerão eles que sou eu o Senhor, que sou seu Deus, porque depois de tê-los exilado entre as nações, eu os reunirei no seu solo sem lá deixar um só.
29 I go pour my Spirit put for Israel pipol body and I nor go leave dem again.
29 Não esconderei mais deles a minha face, porque espargirei meu Espírito sobre toda a casa de Israel - oráculo do Senhor Javé.

Ler em outra tradução

Comparar com outra

Estude este capítulo no WhatsApp

Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Ezequiel 39, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.