Ezequiel 37
Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs ARA
1 Den God pawa enter my body and en spirit kon karry mi go one valley where dry bones full.
1 Veio sobre mim a mão do Senhor ; ele me levou pelo Espírito do Senhor e me deixou no meio de um vale que estava cheio de ossos,
2 E take mi waka round di place and I kon si sey di bones many and dem dry well-well.
2 e me fez andar ao redor deles; eram mui numerosos na superfície do vale e estavam sequíssimos.
3 E kon tell mi, “Man pikin, yu bilive sey dis bones fit turn to human being again?” I kon ansa, “God wey get pawa, na only Yu fit ansa dat kind kweshon!”
3 Então, me perguntou: Filho do homem, acaso, poderão reviver estes ossos? Respondi: Senhor Deus, tu o sabes.
4 E kon sey, “Tok to di bones. Tell di bones sey make dem listin to wetin God dey tok.
4 Disse-me ele: Profetiza a estes ossos e dize-lhes: Ossos secos, ouvi a palavra do Senhor .
5 Make yu tell dem wetin mi God wey get pawa dey tell dem: I go give una life again.
5 Assim diz o Senhor Deus a estes ossos: Eis que farei entrar o espírito em vós, e vivereis.
6 I go give una flesh kon kover una body with skin. I go bring una kom back to life. Den una go know sey na mi bi God.”
6 Porei tendões sobre vós, farei crescer carne sobre vós, sobre vós estenderei pele e porei em vós o espírito, e vivereis. E sabereis que eu sou o Senhor .
7 So I tok to di bones just as God tell mi. As I dey tok, I hear one strong nois and di bones kon dey join togeda.
7 Então, profetizei segundo me fora ordenado; enquanto eu profetizava, houve um ruído, um barulho de ossos que batiam contra ossos e se ajuntavam, cada osso ao seu osso.
8 As I dey look, flesh kon kover di bones, den dem kon get skin. But dia body nor get life.
8 Olhei, e eis que havia tendões sobre eles, e cresceram as carnes, e se estendeu a pele sobre eles; mas não havia neles o espírito.
9 God kon tell mi, “Man pikin, tok to di breeze. Tell di breeze sey God wey get pawa dey kommand am to kom from difren place kon give life to dis body dem wey dey groun, so dat dem go get life.”
9 Então, ele me disse: Profetiza ao espírito, profetiza, ó filho do homem, e dize-lhe: Assim diz o Senhor Deus: Vem dos quatro ventos, ó espírito, e assopra sobre estes mortos, para que vivam.
10 So I kon tok as God don tell mi. Life kon enter di body dem and dem kon stand up. Dem many well-well like sojas.
10 Profetizei como ele me ordenara, e o espírito entrou neles, e viveram e se puseram em pé, um exército sobremodo numeroso.
11 God kon tell mi, “Man pikin, Israel pipol bi like dis bones. Dem sey dem don dry finish, dem nor get hope or bilive sey dia future dey brite.
11 Então, me disse: Filho do homem, estes ossos são toda a casa de Israel. Eis que dizem: Os nossos ossos se secaram, e pereceu a nossa esperança; estamos de todo exterminados.
12 So, go tell Israel pipol sey mi wey bi dia Oga God go open dia graves kon take dia dead body kom out; give dem life, den bring dem kom back to Israel land.
12 Portanto, profetiza e dize-lhes: Assim diz o Senhor Deus: Eis que abrirei a vossa sepultura, e vos farei sair dela, ó povo meu, e vos trarei à terra de Israel.
13 Wen I open di grave where dem beri my pipol put kon bring dem out, na den dem go know sey na mi bi God.
13 Sabereis que eu sou o Senhor , quando eu abrir a vossa sepultura e vos fizer sair dela, ó povo meu.
14 I go give dem my own Spirit kon make dem stay for dia own land. Den, dem go know sey na mi bi God. I don promise sey I go do wetin I tok and I go do am.
14 Porei em vós o meu Espírito, e vivereis, e vos estabelecerei na vossa própria terra. Então, sabereis que eu, o Senhor , disse isto e o fiz, diz o Senhor .
15 God kon tell mi again:
15 Veio a mim a palavra do Senhor , dizendo:
16 “Man pikin, take one stik make yu rite dis word put, ‘Judah kingdom.’ Den take anoda stik kon rite dis word put too, ‘Israel kingdom.’
16 Tu, pois, ó filho do homem, toma um pedaço de madeira e escreve nele: Para Judá e para os filhos de Israel, seus companheiros; depois, toma outro pedaço de madeira e escreve nele: Para José, pedaço de madeira de Efraim, e para toda a casa de Israel, seus companheiros.
17 Den hold di two for hand, so dat dem go look like one stik.
17 Ajunta-os um ao outro, faze deles um só pedaço, para que se tornem apenas um na tua mão.
18 Wen yor pipol ask yu sey make yu tell dem wetin dis tin mean,
18 Quando te falarem os filhos do teu povo, dizendo: Não nos revelarás o que significam estas coisas?
19 tell dem sey, ‘God wey get pawa go take di stik wey dem rite Israel put kon join am with di one wey dem rite Judah put. E go use di two make one stik kon hold am for en hand.’
19 Tu lhes dirás: Assim diz o Senhor Deus: Eis que tomarei o pedaço de madeira de José, que esteve na mão de Efraim, e das tribos de Israel, suas companheiras, e o ajuntarei ao pedaço de Judá, e farei deles um só pedaço, e se tornarão apenas um na minha mão.
20 So, make yu hold di two stik for yor hand, so dat di pipol go si dem.
20 Os pedaços de madeira em que houveres escrito estarão na tua mão, perante eles.
21 Den make yu tell dem sey, ‘God wey get pawa go-go bring all en pipol for evriwhere wey dem skata go. E go bring dem kom back to dia own land.
21 Dize-lhes, pois: Assim diz o Senhor Deus: Eis que eu tomarei os filhos de Israel de entre as nações para onde eles foram, e os congregarei de todas as partes, e os levarei para a sua própria terra.
22 For di land wey dey Israel mountin, God go turn all of dem to one nashon. Dem go get one king wey go rule dem and dem nor go skata again.
22 Farei deles uma só nação na terra, nos montes de Israel, e um só rei será rei de todos eles. Nunca mais serão duas nações; nunca mais para o futuro se dividirão em dois reinos.
23 Dem nor go spoil dia body with juju or anytin wey go make dem dirty or sin again. God go free dem from evritin wey dey make dem sin. E go klean dem; dem go bi en pipol and E go bi dia God.’
23 Nunca mais se contaminarão com os seus ídolos, nem com as suas abominações, nem com qualquer das suas transgressões; livrá-los-ei de todas as suas apostasias em que pecaram e os purificarei. Assim, eles serão o meu povo, e eu serei o seu Deus.
24 “Na from my savant David house, dia king go from kom. All of dem go dey happy under one king and dem go obey and respet all my laws.
24 O meu servo Davi reinará sobre eles; todos eles terão um só pastor, andarão nos meus juízos, guardarão os meus estatutos e os observarão.
25 Dem go stay for di land wey I give Jakob wey bi my savant; di land where dia grand-grand papa dey before. Dem with dia shidren and grand-shidren go stay der forever. Na from my savant David house, dia king go always kom from.
25 Habitarão na terra que dei a meu servo Jacó, na qual vossos pais habitaram; habitarão nela, eles e seus filhos e os filhos de seus filhos, para sempre; e Davi, meu servo, será seu príncipe eternamente.
26 I go make kovenant with dem wey go make dem dey save forever. I go make dem prosper and dem go many well-well. I go make sure sey my temple dey for dia land forever.
26 Farei com eles aliança de paz; será aliança perpétua. Estabelecê-los-ei, e os multiplicarei, e porei o meu santuário no meio deles, para sempre.
27 I go stay der with dem; I go bi dia God and dem go bi my pipol.
27 O meu tabernáculo estará com eles; eu serei o seu Deus, e eles serão o meu povo.
28 Wen I don build my temple for dia land forever, den di oda nashons go know sey, mi God don choose Israel as my own pipol.”
28 As nações saberão que eu sou o Senhor que santifico a Israel, quando o meu santuário estiver para sempre no meio deles.
Atalhos do teclado
- Capítulo anterior←
- Próximo capítulo→
- Versículo anteriork
- Próximo versículoj
- Limpar seleçãoEsc
- Esta ajuda?
Estude este capítulo no WhatsApp
Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Ezequiel 37, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.