Ezequiel 34
Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs NAA
1 God kon tell mi.
1 A palavra do Senhor veio a mim, dizendo:
2 “Man pikin, go tok against di leaders for Israel. Tell dem sey mi wey bi God sey: ‘Una wey dey kare for Israel pipol, una own don finish! Una guide unasef kon leave Israel pipol on dia own.
2 — Filho do homem, profetize contra os pastores de Israel; profetize e diga-lhes: Assim diz o Senhor Deus: “Ai dos pastores de Israel que apascentam a si mesmos! Será que os pastores não deveriam apascentar as ovelhas?
3 Una drink milk kon wear klot wey dem make with wool, den una kill and chop di sheep wey fine pass. But una nor gri kare for una pipol.
3 Vocês comem a gordura, vestem-se da lã e matam as melhores ovelhas para comer, mas não apascentam o rebanho.
4 Una nor gri kare for di ones wey dey weak; heal di ones wey dey sick; bandage di sore wey some get; go find di ones wey waka anyhow or look for di ones wey lost. Instead, una dey trit dem with wikedness.
4 Vocês não fortaleceram as fracas, não curaram as doentes, não enfaixaram as quebradas, não trouxeram de volta as desgarradas e não buscaram as perdidas, mas dominam sobre elas com força e tirania.
5 Bikos di sheep nor get shepad, dem kon skata for evriwhere and wiked animal kon dey kill and chop dem.
5 Assim, elas se espalharam, por não haver pastor, e se tornaram pasto para todos os animais selvagens.
6 So my sheep kon dey waka anyhow on-top di hills and mountins. Dem skata for evriwhere for di eart and nobody dey to guide or look for dem.
6 As minhas ovelhas andam desgarradas por todos os montes e por todas as colinas. As minhas ovelhas andam espalhadas por toda a terra, sem haver quem as procure ou quem as busque.”
7 “ ‘Naw, una wey bi shepad, make una listin to wetin mi, God dey tell una.
7 — Por isso, pastores, ouçam a palavra do Senhor :
8 As long as I bi di God wey nor dey die, e go betta for una if una listin to mi. Wiked animals attack my sheep kon kill and chop dem, bikos dem nor get who dey guide dem. My shepads nor even try to look for di sheep, instead na diasef dem kare about.
8 Tão certo como eu vivo, diz o Senhor Deus, visto que as minhas ovelhas foram entregues à rapina e se tornaram pasto para todos os animais selvagens, por não haver pastor, e que os meus pastores não procuram as minhas ovelhas, pois apascentam a si mesmos e não apascentam as minhas ovelhas,
9 So make una listin to mi.
9 por isso, pastores, ouçam a palavra do Senhor :
10 Mi wey bi God wey get pawa dey sey I bi una enemy. I go take my sheep from una hand and una nor go bi dia shepad again; I nor go let una kare for unasef again. I go save my sheep from una and una nor go chop dem again.
10 Assim diz o Senhor Deus: Eis que estou contra os pastores e lhes pedirei contas das minhas ovelhas. Farei com que deixem de apascentar ovelhas, e não apascentarão mais a si mesmos. Livrarei as minhas ovelhas da sua boca, para que já não lhes sirvam de comida.
11 “ ‘Mi wey bi God wey get pawa dey tell unasef sey, mi mysef go look and kare for my sheep,
11 — Porque assim diz o Senhor Deus: Eis que eu mesmo procurarei as minhas ovelhas e as buscarei.
12 just as shepad dey kare for dia sheep wey skata kon gada dem again. For dat day wen di wahala go start, I go bring dem kom back from where dem skata go.
12 Como o pastor busca o seu rebanho, no dia em que encontra ovelhas dispersas, assim buscarei as minhas ovelhas. Eu as livrarei de todos os lugares por onde foram espalhadas no dia de nuvens e densas trevas.
13 I go remove dem from strenja land; gada dem togeda kon bring dem back to dia own kountry. I go lead dem go back to di mountin and Israel river wey dey flow kon give dem betta food chop.
13 Vou tirá-las do meio dos povos, e as congregarei dos diversos países, e as trarei de volta à sua terra. Vou apascentá-las nos montes de Israel, junto às correntes de água e em todos os lugares habitados da terra.
14 I go let dem stay for peace for di mountins, valleys and all di fine field.
14 Deixarei que pastem em bons pastos, e nos altos montes de Israel será a sua pastagem. Ali elas se deitarão em boa pastagem e terão pastos bons nos montes de Israel.
15 Na mi mysef go bi dia shepad and I go give dem place to rest.
15 Eu mesmo apascentarei as minhas ovelhas e as farei repousar, diz o Senhor Deus.
16 “Doz wey don lost and wey waka anyhow, I go find and bring dem kom back. Doz wey get sore, I go bandage am for dem kon heal doz wey dey sick; but doz wey fat and strong, I go distroy dem, bikos I bi shepad wey dey do wetin dey rite.
16 Buscarei as perdidas, trarei de volta as desgarradas, enfaixarei as quebradas e curarei as doentes; mas destruirei as gordas e fortes. Eu as apascentarei com justiça.
17 “Naw my sheep, mi wey bi God wey get pawa dey tell una sey I go judge each of una kon separate di good ones from di bad ones; dat is, di sheep from di goat.
17 — Quanto a vocês, minhas ovelhas, assim diz o Senhor Deus: “Eis que julgarei entre ovelhas e ovelhas, entre carneiros e bodes.
18 Some of una nor dey beleful; even doh una dey chop betta grass, una still dey mash wetin una chop remain! Una dey drink klean wota kon dirty di ones wey una drink remain!
18 Será que não lhes basta a boa pastagem? Ainda precisam pisar aos pés o resto do seu pasto? E não lhes basta o fato de terem bebido a água limpa? Ainda precisam turvar o resto com os pés?
19 Na my oda sheep go kom chop di grass wey una don mash and drink di wota wey una don dirty?
19 As minhas ovelhas têm de comer o que vocês pisaram com os pés e beber o que vocês turvaram com os pés.”
20 “So naw, mi God wey get pawa dey tell una sey, I go judge both di strong and di weak sheep.
20 — Por isso, assim lhes diz o Senhor Deus: “Eis que eu mesmo julgarei entre ovelhas gordas e ovelhas magras.
21 Yes! Una push di ones wey dey sick kon drive dem komot from where di oda sheep der.
21 Visto que, com o lado e com o ombro, vocês dão empurrões e, com os chifres, rechaçam todas as ovelhas fracas até que as tenham espalhado por toda parte,
22 But I go save my sheep and I nor go let una trit dem anyhow again. I go judge my sheep dem kon separate di good ones from di bad ones.
22 eu livrarei as minhas ovelhas, para que não mais sirvam de rapina, e julgarei entre ovelhas e ovelhas.
23 “I go give dem king wey bi like my savant David, wey go bi dia shepad and e go kare for dem.
23 Porei sobre elas um só pastor, e ele as apascentará: o meu servo Davi. Ele as apascentará e será o seu pastor.
24 Mi God go bi dia God and one king like my savant David go rule dem.
24 Eu, o Senhor , serei o seu Deus, e o meu servo Davi será príncipe no meio delas. Eu, o Senhor , falei.”
25 “I go make kovenant wey go guide and protet dem. I go distroy all di wiked animals for di land, so dat my sheep go fit stay for peace as dem dey di field and forest.
25 — Farei uma aliança de paz com as minhas ovelhas. Livrarei a terra de animais selvagens, para que as minhas ovelhas vivam em segurança no deserto e durmam nos bosques.
26 I go bless dem kon let dem stay near my holy hill and for der, I go bless dem with betta rain anytime wey dem wont am.
26 Delas e dos lugares ao redor do meu monte, eu farei uma bênção. Farei descer a chuva a seu tempo; serão chuvas de bênção.
27 Dia tree go bear fruits; dia fields go bear betta plant and evribody go stay for peace for en land. Wen I don break di shain wey dem take tie my pipol kon free dem from pipol wey dey trit dem like slave, den dem go know sey na mi bi God.
27 As árvores do campo darão o seu fruto, e a terra dará as suas colheitas. As ovelhas estarão seguras na sua terra e saberão que eu sou o Senhor , quando eu quebrar o jugo que pesava sobre elas e as livrar das mãos dos que as escravizavam.
28 Di kountries wey hate dem nor go disturb dem again and wiked animals nor go kill or chop dem again. Dem go stay for peace and nobody go make dem fear again.
28 Já não servirão de rapina aos gentios, nem serão devoradas por animais selvagens. Viverão em segurança, e não haverá quem as espante.
29 I go make dia groun dey bear betta plant and honga nor go dey again. Di oda kountries nor go laf dem again.
29 Eu lhes darei plantação memorável, e nunca mais serão vítimas de fome na terra, nem terão de suportar a zombaria das outras nações.
30 Evribody go know sey na mi dey protet Israel and dem bi my pipol.
30 Saberão que eu, o Senhor , seu Deus, estou com elas e que elas são o meu povo, a casa de Israel, diz o Senhor Deus.
31 God wey get pawa sey, “Una bi my sheep; di animals wey I dey feed! Na una bi my pipol and na mi bi una God.”
31 — “Vocês são as minhas ovelhas, ovelhas do meu pasto. Vocês são o meu povo, e eu sou o seu Deus”, diz o Senhor Deus.
Atalhos do teclado
- Capítulo anterior←
- Próximo capítulo→
- Versículo anteriork
- Próximo versículoj
- Limpar seleçãoEsc
- Esta ajuda?
Estude este capítulo no WhatsApp
Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Ezequiel 34, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.