Ezequiel 33
Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs NTLH
1 God kon tell mi.
1 O Senhor me disse o seguinte:
2 “Man pikin, go tell yor pipol wetin go happen. Den tell dem sey: ‘If I bring war kom di land and di pipol choose one man wey go dey wosh for di gate.
2 — Homem mortal , diga ao seu povo o que acontece quando eu faço vir a guerra a um lugar. O povo desse lugar escolhe alguém para ser vigia.
3 Wen e si dia enemies dey kom, e go ring di bell to warn evribody.
3 Quando vê o inimigo chegando, o vigia dá o alarme para avisar toda a gente.
4 If anybody hear and nor gri listin to am and di enemies kon kill-am, na-im kause en deat by ensef.
4 Se alguém ouve o aviso, porém não se importa, e o inimigo vem e o mata, esse alguém é responsável pela sua própria morte.
5 En deat na-im own fault, bikos e nor gri listin to di warnin. If to sey e listin, e for run go hide.
5 Ele é culpado da sua própria morte porque não se importou com o alarme. Se tivesse se importado, poderia ter escapado.
6 But if di wosh-man si di enemies dey kom and e nor ring di bell, di enemies go kill di pipol bikos of dia sin, but I go whole di wosh-man for dia deat bikos e nor warn dem.’
6 Mas, se o vigia vê o inimigo se aproximando e não dá o alarme, o inimigo vem e mata aqueles pecadores. Nesse caso, eu considerarei o vigia como responsável pela morte deles.
7 “Naw, man pikin, I dey put yu as wosh-man for Israel. Yu must go tell dem di warnin wey I dey tell yu so.
7 — Agora, homem mortal, eu estou pondo você como vigia de toda a nação de Israel. Você dará a eles os avisos que eu lhe der.
8 If I sey wiked pesin go die and yu nor warn am to shange, so dat e go save en life, den e kon die as sina, I go whole yu for en deat.
8 Se eu disser que um homem mau vai morrer, mas você não o avisar para que mude o seu modo de agir e assim salve a sua vida, aí ele morrerá, sendo ainda pecador. Nesse caso, eu considerarei você como responsável pela morte dele.
9 But if yu warn am and e nor gri stop to do bad tins before e die, den yor hand nor dey for en deat.”
9 Porém, se você avisar o homem mau, e ele não parar de pecar, ele morrerá como pecador, mas você viverá.
10 God kon tell mi. “Man pikin, go tell Israel pipol wetin dem dey tok: ‘Na awa sins and di wrong tins wey wi dey do, dey ponish us so. Wi don die finish so how wi won take survive naw?’
10 O Senhor me disse o seguinte: —
11 Tell dem sey, ‘God sey, “As long as mi wey get pawa dey alive, I nor dey happy to si doz wey dey sin, dey die. I prefer make dem stop to sin, so dat dem go get life wey nor dey end. So, Israel pipol, make una stop di wiked tins wey una dey do. Na wetin make una won kill unasef finish?” ’
11 Diga-lhes que juro pela minha vida que eu, o Senhor Deus, não me alegro com a morte de um pecador. Eu gostaria que ele parasse de fazer o mal e vivesse. Povo de Israel, pare de fazer o mal. Por que é que vocês estão querendo morrer?
12 “Naw, man pikin, go tell Israel pipol sey wen good pesin sin, di good wey e do, nor go save am. Like dis too, if wiked man stop to do bad, I nor go ponish am, but if good man start to sin, I nor go sorry for am at-all.
12 — Agora, homem mortal, diga aos israelitas que, quando um homem correto pecar, o bem que ele fez não o salvará. Se um homem mau parar de fazer o mal, ele não será castigado; e, se um homem correto começar a pecar, ele não continuará vivendo.
13 I fit promise good man good life, but if e bigin tink sey di good wey e do before go save am, den e start to sin, I nor go remember all di good wey e do. E go die, bikos of en sins.
13 Se eu prometer dar a vida a um homem correto, e se ele começar a pecar porque pensa que a sua bondade passada o salvará, aí eu não lembrarei de nenhuma das boas ações que praticou. Ele morrerá por causa dos seus pecados.
14 Like dis too, I fit warn wiked pesin sey e go die, but if e stop di bad tins wey e dey do kon dey do wetin good and rite;
14 Se eu avisar um homem mau, dizendo que vai morrer, e se ele parar de pecar e fizer o que é bom e correto —
15 for ezample, if e riton di propaty wey e take from pesin, bikos e borrow am money or give pipol back wetin e tif from dem kon stop to sin, den bigin follow di law wey dey give life, e nor go die and e go get long life.
15 por exemplo, se devolver o objeto que lhe deram como garantia de pagamento de uma dívida ou se devolver o que roubou — se ele parar de pecar e seguir as leis que dão vida, ele não morrerá, mas viverá.
16 I go forgive en sins and e go get di life wey nor dey end, bikos e don do wetin dey rite and good.
16 Eu perdoarei os pecados que cometeu. Ele viverá porque fez o que é bom e correto.
17 “With all dis, yor pipol dey sey wetin I dey do nor dey rite. No! Na dia ways nor dey rite.
17 — No entanto, o seu povo diz que o que eu, o Senhor, faço não está certo! São eles que não estão certos!
18 Wen pesin wey good for God eye stop to do good kon dey do bad tins, e go die bikos of di bad tins wey e dey do.
18 Quando um homem correto para de fazer o bem e começa a fazer o mal, ele morrerá por causa disso.
19 But wen wiked pesin stop to sin kon dey do wetin dey good for God eye, e don save en life bi dat.
19 Quando um homem mau para de pecar e faz o que é bom e correto, ele salvou a sua vida.
20 But Israel pipol, una sey wetin I do, nor good. So I go judge una with wetin una dey do.”
20 Mas você, povo de Israel, diz que o que eu faço não está certo. Eu os julgarei por aquilo que fazem.
21 Twelf years afta King Jehoiashin and Israel pipol dey Babilon as prisonas, for di fift day for di tent mont, one man wey eskape from Jerusalem, kom tell mi sey, “Di town don fall.”
21 No ano décimo segundo do nosso cativeiro , no dia cinco do décimo segundo mês , um homem que havia escapado de Jerusalém veio e me contou que a cidade tinha sido tomada.
22 But for di evening before e kom, I feel as God present strong rish. So wen di man kom di next morning, God kon give mi di pawa to tok.
22 Na noite antes da chegada dele, eu tinha sentido a presença poderosa de Deus, o Senhor . E na manhã seguinte, quando o homem chegou, o Senhor me deu de novo a fala .
23 God kon tell mi.
23 O Senhor me disse o seguinte:
24 “Man pikin, di pipol wey dey stay di empty town for Israel dey sey: ‘Abraham na just one man and dem gi-am di whole land. So naw wey wi many well-well, na wi get di land too.’
24 — Homem mortal , os moradores das cidades arrasadas na terra de Israel estão dizendo o seguinte: “Abraão era um homem só, e toda esta terra foi dada a ele. Nós somos muitos, e por isso agora a terra é nossa.”
25 Naw, make yu tell dem wetin mi God wey get pawa dey tok: ‘Una dey chop meat with dia blood; dey woship juju and dey kill pipol. So wetin make una tink sey na una get di land?
25 — Diga a essa gente o que eu, o Senhor Deus, estou dizendo: “Vocês comem carne com sangue , adoram ídolos e cometem crimes de morte. Por que é que estão pensando que a terra é de vocês?
26 Una bilive sey una get pawa; dey bihave anyhow and evribody dey sleep with who nor bi dia husband or wife. So wetin make una dey tink sey na una get di land?’
26 Vocês confiam nas suas espadas. O seu modo de agir é nojento. Todos cometem adultério. Por que estão pensando que a terra é de vocês?”
27 “Go tell dem sey mi, God dey warn dem sey, ‘As long as I bi di God wey dey alive, di pipol wey dey stay for di main field, go die. Wiked animals go chop doz wey dey stay for di kountry and na diziz go kill doz wey hide for mountin and whole.
27 — Diga a essa gente que eu, o Senhor Deus, estou avisando: Juro que os moradores das cidades arrasadas serão mortos. Os que vivem no campo serão comidos por animais selvagens. Os que estão escondidos nas montanhas e cavernas ficarão doentes e morrerão.
28 I go make di kountry empty finish kon end di pawa wey make dem dey proud before. Israel mountins go empty and nobody go fit travel pass der again.
28 Farei com que o país vire um deserto abandonado. O poder de que se orgulhavam acabará. As montanhas de Israel ficarão tão desertas, que ninguém passará por elas.
29 Wen I ponish di pipol for dia sin kon make di kountry empty, den dem go know sey na mi bi God.’ ”
29 Quando eu castigar o povo pelos seus pecados e fizer com que o país vire um deserto, aí eles ficarão sabendo que eu sou o Senhor .
30 God sey, “Man pikin, yor pipol dey tok about yu wen ever dem meet for di town wall or for dia house door-mot. Dem dey tell each oda sey, ‘Make wi go hear wetin God tok.’
30 O Senhor disse: —
31 So all di pipol gada kom listin to yu, but dem nor gri do wetin yu tell dem. Dem sey dem dey do di rite tin, but dem dey always dey shit and tif pipol money.
31 Assim o meu povo se ajunta em grande número para ouvir o que você tem para dizer, mas eles não querem pôr em prática o que você diz. “Ele fala bonito” — eles dizem, mas o que querem é ganhar dinheiro.
32 To dem, yu bi like pesin wey dey joke, sing love song or play harp. Dem dey listin to evry word wey yu tok, but dem nor dey obey any one.
32 Para eles você não passa de um cantor de canções de amor ou tocador de harpa . Eles ouvem o que você diz, porém não fazem nada daquilo que você manda.
33 But wen wetin yu tok don happen and e go happen, den dem go know sey na profet dey with dem since.”
33 Porém, quando acontecer tudo o que você diz — e vai acontecer mesmo —, aí eles ficarão sabendo que um profeta esteve no meio deles.
Atalhos do teclado
- Capítulo anterior←
- Próximo capítulo→
- Versículo anteriork
- Próximo versículoj
- Limpar seleçãoEsc
- Esta ajuda?
Estude este capítulo no WhatsApp
Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Ezequiel 33, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.