Ezequiel 23
Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs NTLH
1 God tell mi:
1 O Senhor me disse o seguinte:
2 “Man pikin, e get two sistas like dat.
2 — Homem mortal , era uma vez duas irmãs
3 Wen dem dey yong for Egypt, dem kon stay to do ashawo.
3 que moravam no Egito. Quando eram jovens, elas perderam a virgindade e se tornaram prostitutas.
4 Di senior one name na Oholah (wey bi Samaria) while di yonga one na Oholibah (wey bi Jerusalem). I marry dem two and dem born shidren for mi.
4 A mais velha se chamava Oolá (que representa Samaria), e a mais nova, Oolibá (que representa Jerusalém). Eu casei com as duas, e elas me deram filhos.
5 Even doh e bi my wife, Oholah still dey do ashawo and e dey run follow Assyria sojas
5 Embora fosse minha, Oolá continuou a ser prostituta e estava louca pelos seus amantes da Assíria.
6 wey wear purpol uniform; pipol wey dem dey respet, honor and wey fine well-well.
6 Eles eram soldados de uniformes vermelhos, nobres e oficiais graduados, todos eles jovens atraentes, oficiais da cavalaria.
7 Na Oholah all di ofisas for Assyria dey sleep with, so e kon dirty ensef as e dey woship Assyria juju.
7 Oolá foi prostituta de todos os oficiais assírios, e a paixão dela a levou a se tornar impura , adorando os ídolos assírios.
8 E still dey do ashawo and na from Egypt e for start to sleep with difren pipol. Na since e yong, men don dey sleep with am and dem dey trit am like ashawo.
8 Ela continuou o que havia começado como prostituta, no Egito, onde tinha perdido a virgindade. Desde os seus tempos de mocinha, os homens dormiam com ela e a tratavam como prostituta.
9 So I kon gi-am to Assyria pipol wey e love well-well.
9 Por isso, eu a entreguei aos seus amantes assírios, a quem ela tanto desejava.
10 Dem naked am kon take en shidren komot en hand, den dem kill-am with dia swod. E kon turn who nor get shidren again and dem dey ponish am for evriwhere for di world.
10 Eles a deixaram nua, prenderam os seus filhos e filhas e depois a mataram com uma espada. Em toda parte, as mulheres falavam a respeito do fim que ela teve.
11 Even doh en sista Oholibah si wetin happen, en own ashawo kon strong well-well pass Oholah own.
11 — Apesar de ter visto isso, Oolibá se tornou uma prostituta ainda mais sem-vergonha e imoral do que a irmã.
12 En too love Assyria ofisas; di sojas wey wear fine uniform and e even love di main ofisas and all di men wey fine.
12 Ela também se apaixonou pelos nobres e pelos oficiais assírios — soldados de uniformes vistosos — e pelos oficiais da cavalaria, todos eles jovens simpáticos.
13 I si sey e bad well-well. Dat is, di sekond sista kon dey do like di first one.
13 Vi que ela era totalmente imoral; assim a segunda irmã seguiu o mesmo caminho da primeira.
14 Dis one ashawo kon worse well-well. E even won sleep with di ofisas image wey dem karve for wall wey bi; Kaldea image wey dem karve; paint with red
14 — ausente —
15 kon tie belt for en waist with fine priest kap for en head.
15 — ausente —
16 As e just si dia image, e love dem kon send messenjas go meet and koll dem kom from Babilon.
16 Logo que viu as figuras desses oficiais, Oolibá apaixonou-se por eles e mandou que mensageiros fossem falar com eles na Babilônia.
17 Babilon pipol kom sleep with am. Dem use am anyhow kon make am dirty sotey e kon taya for dem.
17 Os babilônios vieram para ter relações com Oolibá. Eles se aproveitaram dela e cometeram com ela tantas imoralidades, que ela ficou com nojo deles.
18 E naked kom out kon let evribody know sey e bi ashawo. I vex for am, just as I vex for en sista.
18 Oolibá ficou nua em público, e todo o mundo ficou sabendo que era prostituta. Eu fiquei revoltado contra ela, como havia ficado contra a sua irmã.
19 En own ashawo dey worse evriday; e dey do tins wey e dey do since wen e start ashawo work for Egypt.
19 Ela afundou cada vez mais na prostituição, fazendo como nos tempos de moça, quando era prostituta no Egito.
20 Just like donkey or horse, na so too e nor dey fit kontrol ensef wons e si man wey fine well-well.
20 Ela ficou apaixonada por homens sensuais, de membros grandes e tão fogosos no seu desejo como jumentos e cavalos.
21 Oholibah, yu won still do di ashawo wey yu do for Egypt wen yu bi small girl? Where men for dey play with yor breast and sleep with yu.
21 — Assim, Oolibá, você quis repetir a imoralidade dos seus tempos de moça no Egito, quando os homens apalpavam os seus seios, e você perdeu a virgindade.
22 “Naw, Oholibah, dis na wetin God wey get pawa dey tell yu. Yu don taya for yor lovers, but I go make dem vex and gada round yu.
22 — Por essa razão, eu, o Senhor Deus, estou dizendo isto a você, Oolibá. Você está enjoada desses amantes, mas eu farei com que eles fiquem com raiva de você e os trarei para que a cerquem.
23 All di men for Babilon and Kaldea, I go bring dem kom from Pekod, Shoa, Koa and Assyria. I go gada doz fine men togeda.
23 Vou trazer todos os babilônios e todos os caldeus das cidades de Pecode, de Soa e de Coa e todos os assírios. Todos eles são jovens oficiais, nobres e simpáticos. Todos eles são graduados e altos oficiais da cavalaria.
24 Dem go attack yu from nort with many sojas and shariot. Dem wear shield and helmet for head and dem go gada round yu. I go give yu to dem and dem go judge yu with dia own law.
24 Do Norte, eles atacarão, trazendo um grande exército com carros de guerra e carretas de mantimentos. Armados com escudos e capacetes, eles cercarão você. Eu a entregarei a eles, e eles a julgarão pelas leis deles.
25 Bikos I dey vex for yu, I go let dem ponish yu as dem dey vex. Dem go kut yor nose and ear komot and dem go kill yor shidren. Yes! Dem go take yor shidren from yor hand kon burn dem alive.
25 Deixarei que eles a tratem com ódio, pois estou irado com você. Eles cortarão o seu nariz e as suas orelhas e matarão os seus filhos. Sim! Eles tirarão de você os seus filhos e filhas e os queimarão vivos.
26 Dem go tear yor klot kon take all yor gold.
26 Eles arrancarão as suas roupas e tirarão as suas joias.
27 I go stop yor yeye life and all di nonsense wey yu don do since wen yu bi small girl for Egypt. Yu nor go look anytin wey bi like juju again or tink about Egypt.”
27 Eu acabarei com a sua imoralidade e com a prostituição que você tem praticado desde que estava no Egito. Nunca mais você olhará para nenhum ídolo, nem pensará mais no Egito.
28 Dis na wetin God wey get pawa dey tok: “I go give yu to pipol wey yu hate well-well.
28 O que o Senhor Deus diz é isto: — Eu a entregarei nas mãos daqueles que você odeia e de quem você tem nojo.
29 Bikos dem hate yu, dem go take evritin wey yu don work for and yu nor go get anytin again; yu go dey naked like ashawo. Na yor yeye and ashawo life
29 E, porque eles a odeiam, tirarão tudo aquilo que você conseguiu com o seu trabalho e a largarão completamente nua, como se fosse uma prostituta. Por causa da sua imoralidade e da sua prostituição,
30 make all dis tins dey happen to yu. Yu bi dia ashawo and yu don spoil yor body with dia juju.
30 esses castigos caíram sobre você. Você foi prostituta dos povos e ficou impura por causa dos ídolos deles.
31 Yu dey do as yor sista dey do and I go give yu dis ponishment cup wey I give yor sista make e drink from.”
31 Você seguiu o exemplo da sua irmã; por isso, castigarei você também, como castiguei a sua irmã.
32 God wey get pawa sey, “Yu go drink from yor sista cup; e dey big and deep. Evribody go laf yu well-well, bikos yor cup don full.
32 O Senhor Deus diz: “Você beberá o copo da sua irmã, que é largo e fundo. Todos vão caçoar e zombar de você; o copo está cheio.
33 Di cup go make life taya yu and yu go bi like man wey don drink well-well. Dis cup get fear; wahala full am and na yor sista, Samaria, get am.
33 O copo da sua irmã Samaria, cheio de medo e desgraça, vai trazer para você embriaguez e dor.
34 Yu go drink am dry, break am to pieces kon use am take tear yor breast.”
34 Você beberá até esvaziá-lo. Depois, o quebrará e com os cacos rasgará os seus seios. Eu, o
35 Naw, dis na wetin God wey get pawa dey tok: “Bikos yu forget and turn from mi, yu go sofa for yor ashawo life.”
35 Agora, o que o Senhor Deus está dizendo é isto: — Você me esqueceu e me virou as costas; portanto, sofrerá por causa da sua imoralidade e da sua prostituição.
36 God tell mi, “Man pikin, yu dey ready to judge Oholah and Oholibah? Judge dem for di yeye life wey dem live.
36 O Senhor me disse: —
37 Dem sleep with pipol husband kon kill many pipol. Dem sleep with juju kon kill di boys wey dem born for mi. Dem sakrifice my shidren give juju.
37 Elas cometeram adultério e assassinato. Cometeram adultério com ídolos e mataram filhos que geraram para mim. Elas ofereceram os meus filhos para serem mortos em sacrifício aos seus ídolos.
38 Since dat one nor rish dem, dem dirty my temple kon skata di Sabat wey I make holy.
38 E isso ainda não foi tudo o que fizeram. Também profanaram o meu Templo e quebraram o sábado, que eu havia mandado guardar.
39 Di day wey dem sakrifice my shidren give juju, na dat day dem still dirty my temple!
39 Mataram os meus filhos como sacrifícios aos ídolos; e naquele mesmo dia vieram ao meu Templo e o profanaram.
40 Evritime, dem go send pipol go invite men kom from far. Di two sistas go baf kon take difren tins with gold take design dia face.
40 — Oolá e Oolibá enviaram mensageiros para convidar homens de longe, e eles vieram. Elas tomaram banho, pintaram os olhos e se enfeitaram com joias.
41 Dem go sidan for betta chair and for dia front, fine-fine tins like incense and olive oil wey I give dem, dey di tabol.
41 Sentaram-se numa bela cama, com uma mesa bem-posta diante delas. E sobre a mesa puseram o incenso e o azeite que eu lhes tinha dado.
42 Pipol wey nor kare dey der dey shaut and na wildaness dem from bring dis pipol. Dem put shain for di wimen hand kon wear betta crown for dia head.
42 Então ouviu-se o barulho de uma multidão alegre, e entrou um grupo de homens do deserto. Colocaram pulseiras nos braços das mulheres e lindas coroas nas cabeças.
43 Den I tok about dis ashawo woman sey, ‘Dem go sleep with am naw.’
43 E eu disse a mim mesmo que eles estavam usando como prostituta uma mulher gasta pelo adultério.
44 Dem dey sleep with am just as dem dey sleep with ashawo. Like dis, dem don sleep with Oholah and Oholibah wey bi ashawo.
44 Muitas vezes, eles voltaram a estar com essas prostitutas. Tornaram a se encontrar com Oolá e Oolibá, essas mulheres imorais.
45 Pipol wey dey do good go ponish dem, bikos dem kill and sleep with pipol and di pipol blood dey dia hand.”
45 Os homens direitos vão condená-las por adultério e assassinato porque elas adulteram, e as suas mãos derramam sangue.
46 So, dis na wetin God wey get pawa dey tok: “Make yu bring pipol wey go give dem wahala and tif from dem.
46 O que o Senhor Deus diz é isto: — Tragam uma multidão para pôr medo nelas e roubar o que elas têm.
47 Make dem stone and attack dem with swods; kill dia shidren kon burn dia house rish groun.
47 Que a multidão jogue pedras nessas duas mulheres e as ataque com espadas, mate os seus filhos e ponha fogo nas suas casas!
48 I go stop all dis yeye life for dis land and e go bi warnin to wimen sey, make dem nor sleep with who nor bi dia husband, bikos dis na wetin dem dey do.
48 Acabarei com a imoralidade que há no país inteiro, como um aviso para que nenhuma mulher cometa adultério como essas duas cometeram.
49 But for dis two sistas; I go ponish dem for dia ashawo life and di juju wey dem dey serve. Den una go know sey na mi bi God wey get pawa.”
49 Quanto a vocês, as duas irmãs, eu as castigarei pela sua imoralidade e pelo seu pecado de adorar ídolos. Então vocês saberão que eu sou o Senhor Deus.
Atalhos do teclado
- Capítulo anterior←
- Próximo capítulo→
- Versículo anteriork
- Próximo versículoj
- Limpar seleçãoEsc
- Esta ajuda?
Estude este capítulo no WhatsApp
Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Ezequiel 23, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.