Ezequiel 22

Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs NVT

Sair da comparação
NVT Nova Versão Transformadora
1 God kon tell mi:
1 Recebi esta mensagem do S enhor :
2 “Man pikin, yu don ready to judge di town wey dead body full? Tell dem all di bad-bad tins wey dem do.
2 “Filho do homem, você está preparado para pronunciar julgamento sobre Jerusalém, esta cidade de assassinos? Faça que ela veja como são detestáveis seus pecados
3 Tell di town wetin mi God wey get pawa dey tok: Bikos una don kill many of una own pipol kon make unasef dirty as una dey serve juju; I go soon get una time.
3 e transmita-lhe esta mensagem do S enhor Soberano: Ó cidade de assassinos, condenada e maldita, cidade de ídolos imundos e repugnantes,
4 Una really kill pipol and na di juju wey una dey serve, dey dirty una. So una day dey kom and una time go soon end! Na dis make mi allow nashons and kountries dey laf and fool una.
4 você é culpada pelo sangue que derramou e está contaminada pelos ídolos que fez. Seu dia de castigo se aproxima! Você chegou ao fim de seus anos, e farei de você objeto de zombaria no mundo inteiro.
5 Di kountries wey dey far and di ones wey dey near, go laf una, bikos una nor konfuse well-well.
5 Ó cidade infame, cheia de confusão, povos distantes e próximos zombarão de você!
6 “All di leaders for Israel trust dia pawa and dem dey kill pipol.
6 “Todo líder de Israel que vive dentro de seus muros está decidido a derramar sangue.
7 Nobody for di town dey respet dia papa or mama again. Una dey shit strenjas; wimen wey dia husband don die and shidren wey nor get papa and mama again.
7 Pais e mães são tratados com desprezo, estrangeiros são obrigados a pagar por proteção, órfãos e viúvas são oprimidos em seu meio.
8 Una nor dey respet di holy place or keep di Sabat holy.
8 Você despreza minhas coisas santas e profana meus sábados.
9 Some of una dey lie for pipol head, so dat dem go kill dem. Some dey chop food wey dem don sakrifice give juju and some like ashawo life.
9 Pessoas acusam outras falsamente e as condenam à morte. Em seu meio há idólatras e gente que faz coisas obscenas.
10 Some dey sleep with dia papa wife, while odas dey force and sleep with woman wey dey si en period.
10 Homens têm relações sexuais com a esposa do próprio pai e se impõem sobre mulheres menstruadas.
11 Some dey sleep with pipol wife or husband and odas dey sleep with dia pikin wife or dia half sistas.
11 Há quem cometa adultério com a esposa do vizinho, quem contamine sua nora e quem violente a própria irmã.
12 Some of una dey kill pipol, bikos of money. Some dey put intrest for di money wey dem borrow dia kountry man and dem dey get plenty gain thru dat one. Dem don forget mi.”
12 Por toda parte há assassinos de aluguel, agiotas que cobram juros abusivos e sujeitos que praticam extorsão. Não se lembram de mim, diz o S enhor Soberano.
13 “Si, I dey klap my hand as una dey tif and kill.
13 “Agora, porém, bato as mãos com indignação por causa do ganho desonesto e do derramamento de sangue em seu meio.
14 Wen I don finish with una, una tink sey una go get strent or pawa to karry una hand? Mi God don tok and I go do wetin I tok.
14 Quão forte e corajosa você será no dia do acerto de contas? Eu, o S enhor , falei e cumprirei o que prometi.
15 I go skata una go difren kountries and I go stop all dis bad tins wey una dey do.
15 Espalharei você entre as nações e acabarei com sua perversidade.
16 So di oda nashons nor go respet una and una go know sey na mi bi God.”
16 E, quando você tiver sido desonrada entre as nações, saberá que eu sou o S enhor ”.
17 God tell mi:
17 Então recebi esta mensagem do S enhor :
18 “Man pikin, Israel pipol nor dey yuzful to mi. Dem bi like iron, milk cup and sometin wey dem use remain.
18 “Filho do homem, o povo de Israel é a coisa desprezível, sem valor, que resta depois de fundir a prata. São refugo, uma mistura inútil de cobre, estanho, ferro e chumbo.
19 Mi God wey get pawa dey sey, dem dey yuzles like di yeye tin wey dey kom out from iron afta dem don melt am. So, I go gada all of dem kom Jerusalem.
19 Portanto, diga-lhes: ‘Assim diz o S enhor Soberano: Porque vocês são coisa desprezível, sem valor, eu os reunirei em Jerusalém.
20 Just as dem dey put silva, koppa, iron, lead and milk cup for fire wey go melt dem, na so too I go vex gada una put for hot fire.
20 Como a prata, o cobre, o ferro, o chumbo e o estanho são derretidos na fornalha, assim eu os derreterei com o calor de minha ira ardente.
21 Yes! I go gada dem for Jerusalem kon put fire under where dem dey, den melt dem with my vexnashon.
21 Eu os reunirei e soprarei sobre vocês o fogo de minha fúria,
22 Just as silva dey melt for fire, na so too dem go melt for Jerusalem, den dem go know and feel my vexnashon.”
22 e vocês derreterão como a prata derrete no calor intenso. Então saberão que eu, o S enhor , derramei sobre vocês a minha fúria’”.
23 God tell mi again sey:
23 Recebi outra mensagem do S enhor :
24 “Man pikin, tell Israel pipol sey dia land dey dry and rain nor go fall, bikos I dey vex.
24 “Filho do homem, transmita esta mensagem a Israel: No dia de minha indignação, vocês serão como uma terra contaminada, uma terra sem chuva.
25 Dia leaders bi like lion wey dey happy for di animal wey e kill. Dem kill pipol, take all dia money kon kollect di propaty wey dem fit kollect and naw, many wimen nor get husband again, bikos of dis tin wey dem do so.
25 Seus príncipes tramam conspirações, como leões à espreita da presa. Devoram inocentes, apropriam-se de tesouros, obtêm riquezas por extorsão e fazem muitas viúvas na terra.
26 Di priests break my law and dem nor dey respet anytin wey dey holy. Dem nor know wetin dey holy or not. Dem forget di Sabat; dem nor dey tish about wetin dey klean again. So bikos of dis, Israel pipol nor dey gri respet mi again.
26 Seus sacerdotes não guardaram minha lei e profanaram minhas coisas santas. Não fazem distinção entre sagrado e profano e não ensinam meu povo a distinguir entre cerimonialmente puro e impuro. Desrespeitam meus sábados, de modo que sou desonrado no meio deles.
27 Pipol wey dey rule bi like wolf wey tear animal into too. Dem dey kill pipol, so dat dem go get money.
27 Seus líderes são como lobos que despedaçam as vítimas. Destroem a vida das pessoas por dinheiro!
28 Dia profets hide dis tins like wall wey dem kover with paint. Dem dey si wrong vishon and wetin dem sey go happen, na lie. Dem dey sey na God word dem dey tok, but mi God, nor tok to dem.
28 E seus profetas encobrem tudo isso com visões falsas e previsões mentirosas. Dizem: ‘Recebi esta mensagem do S enhor Soberano’, quando, na verdade, o S enhor não lhes disse coisa alguma.
29 Doz wey get money dey shit and tif from oda pipol. Dem dey ponish poor pipol and dey kollect strenjas propaty.
29 Até mesmo o povo oprime os pobres, rouba dos necessitados e nega justiça aos estrangeiros.
30 “I fine pesin wey fit build di wall; pesin wey fit stand for where di wall for fall kon tok for di town wen my vexnashon won distroy am, but I nor si anybody.
30 “Procurei alguém que reconstruísse o muro que guarda a terra, que se pusesse na brecha para que eu não a destruísse, mas não encontrei ninguém.
31 So, I go pour my vexnashon for dia head kon distroy dem with fire, bikos of di bad tins wey dem do.”
31 Agora, portanto, derramarei minha fúria sobre eles e os consumirei com o fogo de minha ira. Farei cair sobre sua cabeça o castigo merecido por tudo que fizeram. Eu, o S enhor Soberano, falei!”.

Ler em outra tradução

Comparar com outra

Estude este capítulo no WhatsApp

Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Ezequiel 22, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.