Ezequiel 20

Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs NAA

Sair da comparação
NAA Nova Almeida Atualizada 2017
1 Seven years afta dem karry Israel pipol go Babilon as prisonas, for di tent dey for di fift mont, some leaders for Israel kom my house kon sidan for my front dey ask mi sey wetin God wont.
1 No sétimo ano, no quinto mês, aos dez dias do mês, alguns dos anciãos de Israel vieram consultar o Senhor e se assentaram diante de mim.
2 Den God kon tell mi:
2 Então a palavra do Senhor veio a mim, dizendo:
3 “Man pikin, tell dis men wetin God wey get pawa dey tok: Una don kom ask wetin I wont, abi? As long as I bi di God wey dey alive, I nor go let una ask mi anytin.
3 — Filho do homem, fale com os anciãos de Israel e diga-lhes: Assim diz o Senhor Deus: “Por acaso vocês vieram para me consultar? Tão certo como eu vivo, diz o Senhor Deus, vocês não me consultarão.”
4 “Man pikin, yu don ready to judge dem? Yu don ready to judge all of dem naw? Den, make yu judge dem. Remind dem about all di bad-bad tins wey dia papa don do before.
4 — Você está pronto para julgá-los, filho do homem? Você está pronto para julgá-los? Mostre-lhes as abominações que os pais deles praticaram
5 Tell dem wetin I dey tok. Wen I choose Israel, I promise Jakob shidren-shidren kon show mysef and tell dem wen dem dey Egypt sey: ‘Na mi bi di Oga wey bi dia God.’
5 e diga-lhes: Assim diz o Senhor Deus: “No dia em que escolhi Israel, levantando a mão, jurei à descendência da casa de Jacó e me dei a conhecer a eles na terra do Egito; levantei a mão e jurei, dizendo: ‘Eu sou o Senhor , seu Deus.’
6 Dat time, I promise sey I go take dem komot from Egypt go di land wey I don choose for dem. Di land wey dey okay, good and e fine well-well.
6 Naquele dia, jurei tirá-los da terra do Egito e levá-los para uma terra que lhes tinha previsto, uma terra que mana leite e mel, coroa de todas as terras.
7 I tell dem sey make dem trowey all dia juju and make dem nor dirty demsef with Egypt juju, bikos na mi bi di Oga wey bi dia God.
7 Então eu lhes disse: ‘Cada um de vocês deve jogar fora as abominações de que se agradam os seus olhos. Não se contaminem com os ídolos do Egito; eu sou o Senhor , seu Deus.’
8 But dem rijet mi and nor gri listin to mi. Dem nor gri trowey dia juju or stop to woship Egypt gods and naw, I dey ready to make dem feel as my vexnashon strong rish.
8 Mas eles se rebelaram contra mim e não quiseram me ouvir. Ninguém jogava fora as abominações de que se agradavam os seus olhos, nem abandonava os ídolos do Egito. Então eu disse que derramaria sobre eles o meu furor, para cumprir a minha ira contra eles, no meio da terra do Egito.
9 But I nor do am, bikos I nor won disgrace my name. I nor go spoil my name give doz nashons wey si mi wen I dey take my pipol komot Egypt
9 Mas agi por amor do meu nome, para que não fosse profanado diante das nações no meio das quais eles estavam, diante das quais eu me dei a conhecer a eles, para os tirar da terra do Egito.”
10 and true-true, I take dem komot Egypt go inside di wildaness.
10 — “Eu os tirei da terra do Egito e os levei para o deserto.
11 “I give dem my kommand kon tell dem my laws wey dey give life to doz wey obey am.
11 Dei-lhes os meus estatutos e lhes fiz conhecer os meus juízos, pelos quais o ser humano viverá, se os cumprir.
12 I still give dem my Sabat wey go show my promise with dem, so dat dem go remember sey na mi make dem dey holy.
12 Também lhes dei os meus sábados, para servirem de sinal entre mim e eles, para que soubessem que eu sou o Senhor que os santifica.
13 “But even as dem dey wildaness, dem rijet mi. Dem break my laws kon rijet my kommand wey dey give life to doz wey dey obey am. Dem distroy di Sabat finish. Wen dem dey di wildaness, I dey ready to make dem feel as my vexnashon strong rish.
13 Mas a casa de Israel se rebelou contra mim no deserto, não andando nos meus estatutos e rejeitando os meus juízos, pelos quais viverá aquele que os cumprir; e profanaram grandemente os meus sábados. Então eu disse que derramaria sobre eles o meu furor no deserto, para os consumir.
14 But I nor distroy dem since dat one fit stop pipol to obey mi, bikos some kountry don si and hear as I take-take Israel pipol komot from Egypt.
14 Mas agi por amor do meu nome, para que não fosse profanado aos olhos das nações diante das quais os tirei do Egito.”
15 So, I kon swear for dem di wildaness sey, I nor go take dem go di land wey I don promise dem; land wey dey okay, good and fine well-well.
15 — “Além disso, no deserto, jurei que não os levaria à terra que lhes tinha dado, uma terra que mana leite e mel, coroa de todas as terras.
16 I tok like dat, bikos dem don break my law, rijet my kommand kon distroy di Sabat. Dem like to woship juju well-well.
16 Porque rejeitaram os meus juízos, não andaram nos meus estatutos e profanaram os meus sábados, pois o seu coração se voltava para os seus ídolos.
17 But I still sorry for dem kon gri sey I nor go kill dem for di wildaness.
17 Mas os meus olhos tiveram piedade deles e eu não os destruí, nem os consumi totalmente no deserto.”
18 Instead, I warn di yong pipol wey dey with dem sey: ‘Make una nor follow di laws wey una papa dem make or follow wetin dem dey do or serve di juju wey dem dey serve.
18 — “Então eu disse aos seus filhos no deserto: ‘Não andem nos estatutos de seus pais, nem guardem os seus juízos, nem se contaminem com os seus ídolos.
19 Na mi bi una Oga and God, so make una obey my laws and kommand.
19 Eu sou o Senhor , seu Deus. Andem nos meus estatutos, guardem os meus juízos e coloquem-nos em prática.
20 Make una keep di Sabat holy, so dat e go bi sign for di kovenant wey wi make and e go remind una sey na mi bi di Oga wey bi una God.’
20 Santifiquem os meus sábados, pois servirão de sinal entre mim e vocês, para que saibam que eu sou o Senhor , seu Deus.’
21 “But dat generashon still rijet mi. Dem break my laws and dem nor gri keep my kommand wey dey give life to doz wey obey am. Dem distroy di Sabat finish. So, I dey ready to make dem feel as my vexnashon strong rish and I like to kill all of dem as dem dey di wildaness,
21 Mas também os filhos se rebelaram contra mim e não andaram nos meus estatutos, nem guardaram os meus juízos, pelos quais o ser humano viverá, se os cumprir; pelo contrário, eles profanaram os meus sábados. Então eu disse que derramaria sobre eles o meu furor, para cumprir contra eles a minha ira no deserto.
22 but I nor distroy dem since dat one fit stop pipol to obey mi, bikos some kountry don si and hear as I take-take Israel pipol komot from Egypt.
22 Mas contive a minha mão e agi por amor do meu nome, para que não fosse profanado aos olhos das nações diante das quais os tirei do Egito.”
23 So I kon swear again for di wildaness. I swear sey I go skata dem for evriwhere for di world.
23 — “Mais uma vez, no deserto, jurei dispersá-los entre as nações e espalhá-los por outras terras,
24 I do like dis, bikos dem don rijet my kommand, break my law kon distroy di Sabat Day and dey serve di same juju wey dia grand-grand papa dem serve.
24 porque não executaram os meus juízos, rejeitaram os meus estatutos, profanaram os meus sábados, e os seus olhos se voltavam para os ídolos de seus pais.
25 Den I give dem wiked laws and kommand wey nor dey give life.
25 Por isso também lhes dei estatutos que não eram bons e juízos pelos quais não haviam de viver.
26 I allow dem distroy dia life with dia own ofrin kon let dem sakrifice and kill dia first pikin. Dis na to ponish and show dem sey na mi bi God.
26 Permiti que eles se contaminassem com as suas dádivas, como quando queimavam os seus filhos primogênitos. Fiz isso para que ficassem horrorizados e para que soubessem que eu sou o Senhor .”
27 “Naw, man pikin, make yu go tell Israel pipol wetin mi God wey get pawa dey tell dem, Na so una papa dem take curse mi wen dem nor gri do di rite tin.
27 — Portanto, fale à casa de Israel, ó filho do homem, e diga-lhes: Assim diz o Senhor Deus: “Ainda nisto os pais de vocês blasfemaram contra mim, na infidelidade que cometeram contra mim:
28 I bring dem kom di land wey I don promise sey I go give dem. Wen dem si how di tree for der fine and how di mountin tall rish, dem kon bigin sakrifice give di tree and mountins. Dem make mi vex, bikos of di sakrifice wey dem dey burn and di wine wey dem dey offa as ofrin.
28 quando eu os introduzi na terra que havia jurado dar-lhes, onde quer que viam um monte alto e uma árvore frondosa, aí ofereciam os seus sacrifícios, apresentavam suas ofertas provocantes, punham os seus aromas agradáveis e ofereciam as suas libações.
29 I kon ask dem: ‘Wetin bi dis high place wey una dey go?’ (Dis na pagan shrine and na Bama wey mean high place dem dey koll am kon rish today.)
29 Eu lhes perguntei: ‘Que lugar alto é esse, aonde vocês vão?’ Por isso, o seu nome tem sido Lugar Alto até o dia de hoje.”
30 “Naw, make yu tell Israel pipol wetin I dey tok: Why una dey kommit di same sin wey una papa kommit kon dey run follow dia juju.
30 — Portanto, diga à casa de Israel: Assim diz o Senhor Deus: “Será que vocês não estão se contaminando a exemplo dos pais de vocês, e se prostituindo com as suas abominações?
31 Even till today, dem still dey offa di same sakrifice and dey distroy demsef with di juju, bikos dem dey burn dia shidren for fire gi-am as sakrifice. Den Leta, una go still kom ask sey wetin I wont! But as long as I bi God wey get pawa and di God wey nor dey die, I nor go let una ask mi anytin.
31 Quando oferecem as suas dádivas e queimam os seus filhos como sacrifício, vocês se contaminam com todos os seus ídolos, até o dia de hoje. Será que eu devo deixar que vocês me consultem, ó casa de Israel? Tão certo como eu vivo, diz o Senhor Deus, vocês não me consultarão.
32 “Una gri sey una won bi like di oda kountries; like pipol for oda kountry wey dey woship three and mountin. But una plan nor go work.
32 O que vocês têm em mente jamais acontecerá, ou seja, isso de dizer: ‘Seremos como as nações, como os povos de outras terras, adorando as árvores e as pedras.’”
33 True-true, mi wey bi God wey get pawa, na mi bi di God wey nor dey die and I dey warn una sey if I vex, I go rule una with strong hand and with all my pawa.
33 — “Tão certo como eu vivo, diz o Senhor Deus, hei de reinar sobre vocês com mão poderosa, com braço estendido e derramado furor.
34 Bikos I dey vex, I go use my strong hand take gada una togeda kom back from di kountries where I bin skata una go.
34 Vou tirá-los do meio dos povos e congregá-los das terras por onde vocês foram espalhados, com mão forte, com braço estendido e derramado furor.
35 I go take una enter di wildaness wey dey di nashons and wi go stand face-to-face as I dey judge una.
35 Vou levá-los ao deserto dos povos e ali entrarei em juízo com vocês, face a face.
36 As I take kondemn una grand-grand papa for Sinai wildaness, na so too, I go take kondemn una. Na God wey get pawa tok like dis.
36 Como entrei em juízo com os pais de vocês no deserto da terra do Egito, assim entrarei em juízo com vocês, diz o Senhor Deus.
37 Na mi, God dey kontrol una, so dat una go obey my kommand.
37 Eu os farei passar debaixo do meu cajado e os farei entrar no vínculo da aliança.
38 Doz wey bi sinnas, I go take dem komot from where una dey. I go take dem komot from di land where dem dey stay naw and dem nor go ever kom back to Israel land again. Den una go know sey na mi bi God wey get pawa.”
38 Tirarei do meio de vocês os rebeldes e os que transgrediram contra mim. Eu os farei sair da terra onde estão morando, mas eles não entrarão na terra de Israel. E vocês saberão que eu sou o Senhor .”
39 God wey get pawa sey, “Israel pipol, make una dey do wetin una like! Make una kontinue to serve una juju! But I dey warn una sey, afta una don serve juju finish, una go must obey mi kon stop to rijet my name wey dey holy, bikos una dey ofrin to juju.
39 — “Quanto a vocês, ó casa de Israel, assim diz o Senhor Deus: Que cada um vá e adore os seus ídolos, agora e mais tarde, já que vocês não querem me ouvir! Mas não profanem mais o meu santo nome com as suas dádivas e com os ídolos de vocês.
40 All of una for Israel go woship mi for di land wey dey on-top my holy mountin. I go dey good to una, so I espect una to give mi una sakrifice, betta ofrin and gifts wey dey holy.
40 Porque no meu santo monte, no monte alto de Israel, diz o Senhor Deus, ali toda a casa de Israel me adorará, toda a casa de Israel, naquela terra. Ali me agradarei deles. Ali requererei as ofertas de vocês, as primícias das dádivas e todas as coisas sagradas.
41 Afta I don bring una kom back from di kountries where I skata una go before, I go asept di sakrifice wey una go give and evribody go si sey I dey holy.
41 Eu me agradarei de vocês como de aroma agradável, quando eu os tirar do meio dos povos e os congregar das terras por onde vocês foram espalhados; e serei santificado diante das nações por meio de vocês.
42 Wen I don bring una kom back to Israel; di land wey I promise una grand-grand papa, den una go know sey na mi bi God.
42 Vocês saberão que eu sou o Senhor , quando eu os fizer entrar na terra de Israel, na terra que jurei dar aos pais de vocês.
43 Den una go remember all di yeye tins wey una do and di bad ones wey una do with una body. Una go vex for unasef, bikos of all di bad tins wey una bin do.
43 Ali, vocês se lembrarão dos seus caminhos e de todas as ações com que se contaminaram e terão nojo de vocês mesmos, por todas as maldades que fizeram.
44 Dat time, bikos of who I bi, I nor go ponish una as e suppose bi, den una wey bi Israel pipol go know sey na mi bi God.”
44 Saberão que eu sou o Senhor , quando eu agir com vocês por amor do meu nome, não segundo os seus maus caminhos, nem segundo as suas ações corruptas, ó casa de Israel”, diz o Senhor Deus.
45 God tell mi:
45 A palavra do Senhor veio a mim, dizendo:
46 “Man pikin, look di sout-side for di kountry. Tok against di sout-side and en forest.
46 — Filho do homem, vire o seu rosto para o Sul e fale contra ele. Profetize contra a floresta do campo do Sul
47 Tell di forest for sout sey make e hear wetin God dey tok: Look! I won start fire wey go burn all di tree wey dey inside yu; weda dem fresh or dry. Nor-tin go fit kwensh di fire. Di fire go from sout go nort and evribody go feel as di fire hot rish.
47 e diga à floresta do Sul: “Ouça a palavra do Senhor ! Assim diz o Senhor Deus: Eis que acenderei em você um fogo que consumirá todas as árvores, tanto as verdes como as secas. A chama desse fogo não se apagará e todos os rostos, desde o Sul até o Norte, se queimarão.
48 All of dem go si sey na mi wey bi God start di fire and nobody go fit off am.”
48 E todos verão que eu, o Senhor , o acendi; não se apagará.”
49 But I tell God, “Oga God wey get pawa, nor let mi do like dis, bikos di pipol don already dey komplain sey dem nor undastand wetin I dey tok.”
49 Então eu disse: — Ah!

Ler em outra tradução

Comparar com outra

Estude este capítulo no WhatsApp

Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Ezequiel 20, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.