Ezequiel 1
Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs NVI
1 Thirty years afta dem karry us go Babilon as slave, wen I dey stay with my pipol near Chebar River, for di fift day for di fourt mont, heaven open and I kon si one vishon.
1 Era o quinto dia do quarto mês do trigésimo ano, e eu estava entre os exilados, junto ao rio Quebar. Abriram-se os céus, e eu tive visões de Deus.
2 (Dis tin happen for di fift day for di mont wey bi di fift year wey King Jehoiashin bi prisona for Babilon.
2 Foi no quinto ano do exílio do rei Joaquim, no quinto dia do quarto mês.
3 Na God give dis message to mi Ezekiel Buzi pikin, wey bi priest, near Chebar River for Babilon and I feel en hand for my body.)
3 A palavra do Senhor veio ao sacerdote Ezequiel, filho de Buzi, junto ao rio Quebar, na terra dos caldeus. Ali a mão do Senhor esteve sobre ele.
4 As I dey look, I si strong breeze dey blow kom from nort and tick kloud with tonda lite dey round am. Fire still dey der too and I si one tin dey shine inside di fire.
4 Olhei e vi uma tempestade que vinha do norte: uma nuvem imensa, com relâmpagos e faíscas, e cercada por uma luz brilhante. O centro do fogo parecia metal reluzente,
5 I still si four creatures wey dey alive inside di fire and dem bi like human being.
5 e no meio do fogo havia quatro vultos que pareciam seres viventes. Na aparência tinham forma de homem,
6 But each of dem get four face and four feadas.
6 mas cada um deles tinha quatro rostos e quatro asas.
7 Dia legs strait well-well, but dia toe bi like melu own and e dey shine like bronze wey dem polish.
7 Suas pernas eram retas; seus pés eram como os de um bezerro e reluziam como bronze polido.
8 Under dia feadas for di four side, dem get human being hand. All of dem get four face and four feadas
8 Debaixo de suas asas, nos quatro lados, tinham mãos humanas. Os quatro tinham rostos e asas,
9 and dia feadas dey tosh each oda. Each one dey waka go strait and dem nor dey turn as dem dey waka.
9 e as suas asas encostavam umas nas outras. Quando se moviam andavam para a frente, e não se viravam.
10 Dis na how dia face bi like: Human being face for front, lion face for di rite side, melu face for di left side and eagle face for back.
10 Quanto à aparência dos seus rostos, os quatro tinham rosto de homem, rosto de leão no lado direito, rosto de boi no lado esquerdo, e rosto de águia.
11 Each of dem get two-two feadas wey dey tosh di oda creature feadas and di oda two feadas dey kover dia body.
11 Assim eram os seus rostos. Suas asas estavam estendidas para cima; cada um deles tinha duas asas que se encostavam na de outro ser vivente, de um lado e do outro, e duas asas que cobriam os seus corpos.
12 Each of di creature face di four direcshon, so wen dia spirit won waka go anywhere, dem dey waka without sey dem turn.
12 Cada um deles ia sempre para a frente. Para onde quer que fosse o Espírito eles iam, e não se viravam quando se moviam.
13 Among di creatures, e get sometin wey bi like tosh or tick fire and e just dey move. Di fire dey move from front go back, e dey shine well-well and dey bring out tonda lite.
13 Os seres viventes pareciam carvão aceso; eram como tochas. O fogo ia de um lado a outro entre os seres viventes, e do fogo saíam relâmpagos e faíscas.
14 Di creatures dey waka go front and back kwik-kwik like tonda lite.
14 Os seres viventes iam e vinham como relâmpagos.
15 As I dey look di creatures, I kon si four wheel for di eart and one dey near each of dem.
15 Enquanto eu olhava para eles, vi uma roda ao lado de cada um deles, diante dos seus quatro rostos.
16 All di four wheel bi like jasper and each one dey shine like gold and dem build dem like sey one wheel dey inside anoda one.
16 Esta era a aparência das rodas e a sua estrutura: Reluziam como o berilo; e as quatro tinham aparência semelhante. Cada roda parecia estar entrosada na outra.
17 Wen dem dey move, dem fit go any of di four direcshon wey dem face and dem nor dey turn as dem dey move.
17 Quando se moviam, seguiam nas quatro direções dos quatro rostos, e não se viravam enquanto iam.
18 Eyes full di rims wey dey di four wheel and dem high well-well kon make pipol dey fear.
18 Seus aros eram altos e impressionantes e estavam cheios de olhos ao redor.
19 Wen di creatures dey move, di wheels dey move too. Wen di creatures raiz-up komot groun, di wheel go-go up too.
19 Quando os seres viventes se moviam, as rodas ao seu lado se moviam; e, quando se elevavam do chão, as rodas também se elevavam.
20 Anywhere di spirit won go, dem go-go too and di wheel go follow dem, bikos di creatures spirit dey inside di wheel.
20 Para onde quer que o Espírito fosse, os seres viventes iam, e as rodas os seguiam, porque o mesmo Espírito estava nelas.
21 Wen di creatures move, di wheels go move too and wen dem stop to waka, di wheels go stop. Wen dem raiz komot groun, di wheels go raiz too, bikos dia spirit dey inside di wheels.
21 Quando os seres viventes se moviam, elas também se moviam; quando eles ficavam imóveis, elas também ficavam; e quando os seres viventes se elevavam do chão, as rodas também se elevavam com eles, porque o mesmo Espírito deles estava nelas.
22 Sometin wey flat wey dem make with crystal glass, dey on-top di creatures head.
22 Acima das cabeças dos seres viventes estava o que parecia uma abóboda, reluzente como gelo, e impressionante.
23 Under di flat crystal glass, dia feadas stresh kom out kon face each oda. Two feadas kover outside, while two dey kover dia body.
23 Debaixo dela cada ser vivente estendia duas asas ao que lhe estava mais próximo, e com as outras duas asas cobria o corpo.
24 Wen dem dey waka, I dey hear dia feadas sound. Di sound bi like God vois or wota wey dey rush pass with pawa or like sojas wey gada dey go war. Wen dem stop to waka, dem kon bring dia feadas down.
24 Ouvi o ruído de suas asas quando voavam. Parecia o ruído de muitas águas, parecia a voz do Todo-poderoso. Era um ruído estrondoso, como o de um exército. Quando paravam, fechavam as asas.
25 Den, one vois kon tok from di flat crystal wey dey on-top dem.
25 Então veio uma voz de cima da abóboda sobre as suas cabeças, enquanto eles ficavam de asas fechadas.
26 On-top di flat crystal wey dey dia head, e get one tin wey bi like throne wey dem make with safaya. On-top di throne, wetin dey der, bi like human being.
26 Acima da abóboda sobre as suas cabeças havia o que parecia um trono de safira, e, bem no alto, sobre o trono, havia uma figura que parecia um homem.
27 I si sometin wey bi like fire wey dey burn from en waist go up. And from en waist kom down, I still si sometin wey bi like fire wey dey burn and di lite wey dey round am, dey shine well-well.
27 A parte de cima do que parecia ser a cintura dele, vi que parecia metal brilhante, como que cheia de fogo, e que a parte de baixo parecia fogo; e uma luz brilhante o cercava.
28 Di lite wey dey shine round am bi like rainbow afta rain don fall. Dis na di lite wey dey show how God glory bi. Wen I si am, I fall face groun and I kon hear somebody dey tok.
28 Tal como a aparência do arco-íris nas nuvens de um dia chuvoso, assim era o resplendor ao seu redor. Essa era a aparência da figura da glória do Senhor. Quando a vi, prostrei-me com o rosto em terra, e ouvi a voz de alguém falando.
Atalhos do teclado
- Capítulo anterior←
- Próximo capítulo→
- Versículo anteriork
- Próximo versículoj
- Limpar seleçãoEsc
- Esta ajuda?
Estude este capítulo no WhatsApp
Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Ezequiel 1, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.