Ezequiel 16
Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs NVT
1 God kon tell mi again sey:
1 Então recebi outra mensagem do S enhor :
2 “Man pikin, go meet Jerusalem pipol about di bad tins wey dem do kon tell dem sey
2 “Filho do homem, faça Jerusalém ver como são detestáveis seus pecados.
3 ‘Dis na wetin God wey get pawa dey tell Jerusalem: “Na Kanaan land dem for born yu. Yor papa kom from Amor and yor mama na from Hit.
3 Transmita-lhe esta mensagem do S enhor Soberano: Você não passa de uma cananeia! Seu pai era amorreu, e sua mãe era hitita.
4 Wen dem born yu, nobody kut di rope wey join yu and yor mama togeda or sey dem wosh and rub yu with salt or wrap yu put inside klot.
4 No dia em que você nasceu, ninguém cortou seu cordão umbilical, nem a lavou, nem a esfregou com sal, nem a enrolou em panos.
5 Nobody sorry for yu kon do any of dis tins for yu. Wen dem born yu, nobody love yu and dem trowey yu for open field.
5 Ninguém teve compaixão nem cuidou de você. No dia em que nasceu, você foi rejeitada e abandonada num campo.
6 “ ‘ “Den wen I dey pass, I si yu dey roll for inside yor own blood for groun. Blood kover yor full body, but I nor fit look make yu dey die.
6 “Mas eu passei por lá e a vi, indefesa, esperneando em seu sangue, e lhe disse: ‘Viva!’.
7 So I make yu grow like betta seed wey dem plant. Yu strong as yu dey grow and yu tall like fine woman. Yor breast dey okay and yor hair fine well-well, but yu dey naked.
7 Eu a fiz desenvolver-se, como uma planta no campo. Você cresceu e se tornou uma linda joia. Seus seios se formaram e seu cabelo cresceu, mas você continuava nua.
8 “ ‘ “As I dey waka pass again, I kon si sey di time wey yu suppose to undastand wetin love mean, don rish. So, I kover yor naked body with my klot kon promise sey I go always love yu. Yes, I marry yu and yu kon bi my own.” ’ ”
8 Quando passei por você outra vez, vi que já tinha idade suficiente para amar. Eu a envolvi com meu manto para cobrir sua nudez e pronunciei meus votos de casamento. Fiz uma aliança com você, diz o S enhor Soberano, e você se tornou minha.
9 “Leta, I take wota wosh di blood komot yor body kon rub olive oil for yor skin.
9 “Então lavei você, limpei o sangue e passei óleo perfumado em sua pele.
10 I dress yu with klot wey dem design well kon give yu shoe wey dem make with betta leader, den I put priest kap wey dem make with linen for yor head.
10 Eu lhe dei roupas caras de linho fino e de seda com lindos bordados e sandálias feitas do mais excelente couro de cabra.
11 I still wear jewel and difren shains for yor neck.
11 Também lhe dei belas joias, pulseiras e lindos colares,
12 I give yu one nose ring, ear-ring and one fine crown make yu wear.
12 uma argola para o nariz, brincos para as orelhas e uma bela coroa para a cabeça.
13 Yu get difren gold and silva and yu always dey wear klot wey dem make with betta linen and silk. Yu dey chop bread wey dem make with di best flower and yu get many honey and olive oil to drink. Yor beauti dey shine and yu bi kween.
13 Assim, você foi enfeitada com ouro e prata. Suas roupas eram feitas de linho fino e seda e tinham lindos bordados. Você comia os alimentos mais seletos — farinha da melhor qualidade, mel e azeite — e se tornou mais linda que nunca. Parecia uma rainha, e de fato era!
14 Bikos of di wey yu fine rish, evribody know yu for evriwhere, bikos na mi make yu fine well-well.
14 Sua fama logo se espalhou por todo o mundo, por causa de sua beleza. Eu a vesti com meu esplendor e aperfeiçoei sua beleza, diz o S enhor Soberano.
15 “Bikos yu fine, yu kon bigin do anyhow and dey sleep with anybody wey yu si.
15 “No entanto, você pensou que era dona de sua fama e de sua beleza. Então, entregou-se como prostituta a todo homem que passava. Sua beleza estava à disposição de quem a pedisse.
16 Yu design di place where yu for dey woship yor juju with yor klot like sey na ashawo house and yu kon dey sleep with evribody for der.
16 Usou os presentes lindos que lhe dei para fazer altares para seus ídolos e ali se prostituiu. Nunca se viu uma coisa dessas!
17 I give yu fine silva and gold make yu dey wear, but naw, yu don use dem make juju wey yu dey sleep with.
17 Pegou as joias e os enfeites de ouro e prata que lhe dei, fez estátuas de homens e as adorou. Desse modo, cometeu adultério contra mim.
18 Yu take di fine-fine klot wey I give yu kon wear dem give di juju and di olive oil wey I give yu, yu still dey offa am give di juju.
18 Com as lindas roupas bordadas que lhe dei, vestiu seus ídolos e usou meu óleo perfumado e meu incenso para adorá-los.
19 I give yu food; di best flower, olive oil and honey, but yu sakrifice dem give di juju sey, Make yu protet mi.”
19 Colocou diante deles como sacrifício a farinha da melhor qualidade, o azeite e o mel com que cuidei de você, diz o S enhor Soberano.
20 “Den di shidren wey yu born for mi, yu sakrifice dem give di juju too. Like sey di ashawo wey yu dey do nor bad rish,
20 “Depois, pegou seus filhos e suas filhas, que havia gerado para mim, e os sacrificou a seus deuses. Acaso não bastou você se prostituir?
21 yu still go sakrifice my shidren give juju.
21 Também teve de matar meus filhos como sacrifício a ídolos?
22 Even as yu dey do ashawo waka, yu nor remember di days wen yu dey small, naked for groun and dey roll for yor blood.”
22 Em todo o seu pecado detestável e em seu adultério, você não se lembrou daqueles dias, muito tempo atrás, em que estava nua e abandonada, esperneando em seu sangue.
23 God sey, “Si di kind sofa wey dey wait yu bikos of yor many evil and as
23 “Que aflição a espera!, diz o S enhor Soberano. Além de todas as suas maldades,
24 yu build where dem go for woship yor juju for evry street for di town.
24 você construiu um lugar de adoração e ergueu altares a ídolos em todas as praças da cidade.
25 Yu trowey yor beauti for portor-portor, bikos anybody wey kom meet yu, yu dey sleep with am and yor ashawo dey strong evriday.
25 Em cada esquina, contaminou sua beleza e ofereceu seu corpo a todos que passavam, aumentando sua prostituição.
26 Yor ashawo friends wey kom from Egypt, yu let dem sleep with yu and naw, yor ashawo life dey make mi vex.
26 Então acrescentou a seus amantes o lascivo Egito e provocou minha ira com promiscuidade cada vez maior.
27 Naw, I don raiz my hand won ponish yu kon take yor share for di blessing, komot yor hand. I don give yu to Filistia pipol; pipol wey hate yu and dem nor like di life wey yu dey live.
27 Por isso eu a feri com minha mão e reduzi seu território. Entreguei-a a seus inimigos, os filisteus, e até eles ficaram espantados com sua conduta depravada.
28 Bikos nor-tin dey rish yu, yu kon dey follow Assyria pipol. Even doh yu bi dia ashawo, dem nor still dey okay for yu.
28 Você também se prostituiu com os assírios. Parece que nunca se cansa de procurar amantes! E, mesmo depois de se prostituir com eles, não ficou satisfeita.
29 Yu still bi ashawo for Babilon wey get business men, but dem nor rish yu too.”
29 Acrescentou a seus amantes a Babilônia, terra de comerciantes, mas ainda assim não se contentou.
30 So dis na wetin God wey get pawa dey tok: “Yu don do all dis tins like ashawo wey nor get shame for eye.
30 “Como seu coração é fraco, diz o S enhor Soberano, para fazer essas coisas e se comportar como uma prostituta desavergonhada!
31 For evry street, yu build where pipol go for dey woship juju and learn ashawo. But yu still betta pass ordinary ashawo, bikos yu get money.
31 Constrói lugares de adoração em todas as esquinas e altares a seus ídolos em todas as praças. Na verdade, você foi pior que uma prostituta, pois nem exigiu pagamento.
32 “Yu bi like wife wey nor love en husband, instead e dey sleep with strenjas anyhow.
32 Sim, você é uma esposa adúltera que acolhe estranhos em vez do marido.
33 Pipol dey pay ashawo, but yor own difren, bikos na yu dey give pipol gift make dem for kom sleep with yu.
33 As prostitutas cobram por seus serviços, mas você não! Oferece presentes a seus amantes e os suborna para adulterarem com você.
34 Yor ashawo dey difren, bikos nobody sey yu must bi ashawo. Nobody dey pay, instead na yu dey pay dem! True-true, yor ashawo dey difren.”
34 Faz, portanto, o contrário de outras prostitutas. Paga seus amantes em vez de eles pagarem você!”
35 So, Jerusalem, make yu hear mi naw! Hear wetin God dey tok.
35 “Portanto, prostituta, ouça esta mensagem do S enhor .
36 Dis na wetin God wey get pawa dey tok: “Yu tear yor klot komot body kon give yor body to yor lovers dem and all yor juju, den yu kill and sakrifice yor shidren give juju too.
36 Assim diz o S enhor Soberano: Visto que você derramou sua lascívia e se expôs em prostituição a todos os seus amantes, adorou ídolos detestáveis e matou seus filhos como sacrifícios a seus deuses,
37 Bikos of dis, I go bring all di pipol wey yu love togeda; di ones wey yu like and doz wey yu hate. Dem go round yu like circol, den I go tear yor klot komot yor body kon let dem si yor nakednes.
37 ouça o que farei. Reunirei todos os seus aliados — seus amantes com os quais você teve prazer, os que você amou e também os que odiou — e a deixarei nua diante deles, para que todos a vejam.
38 I go distroy yu, bikos of yor ashawo life and doz wey yu kill. Den with my vexnashon, I go ponish yu till yu die.
38 Eu a castigarei por homicídio e adultério e, na fúria de meu ciúme, a cobrirei de sangue.
39 I go put yu for dia hand and dem go skata di place where yu for dey serve juju and do ashawo. Dem go take yor klot and gold go and yu go dey naked.
39 Então a entregarei a esses muitos povos que são seus amantes, e eles a destruirão. Derrubarão seus lugares de adoração e os altares de seus ídolos. Arrancarão suas roupas, levarão suas lindas joias e a deixarão completamente nua.
40 Dem go gada crowd kon stone yu, den dem go use dia swod take kut yu to pieces.
40 Eles se juntarão e formarão uma multidão violenta que a apedrejará e a cortará com espadas.
41 Dem go burn yor house and many wimen go si as dem dey ponish yu. I go make yu stop ashawo work and doz wey love yu, yu nor go give dem gift again.
41 Queimarão suas casas e a castigarão diante de muitas mulheres. Eu porei fim à sua prostituição, e você não pagará mais seus muitos amantes.
42 Den I nor go vex again and I go kwayet. I nor go dey vex or jealous again.
42 “Por fim, satisfarei minha fúria contra você, e meu ciúme se acalmará. Ficarei tranquilo e já não ficarei irado com você.
43 “Since yu don forget how I kare for yu wen yu bi small pikin and yu don make bi vex with all di tins wey yu dey do, I must pay yu back for all dis bad tins. But, wetin make yu dey do ashawo join di bad-bad tins wey yu do?”
43 Primeiro, porém, uma vez que você não se lembrou de sua juventude, mas provocou minha ira com todas as suas maldades, eu lhe darei o castigo merecido por sua conduta, diz o S enhor Soberano. Pois a todos os seus pecados detestáveis você acrescentou a depravação.
44 God sey, “Jerusalem, pipol go use dis tins take tok about yu: ‘Like mama, like pikin.’
44 Todos que inventam provérbios dirão a seu respeito: ‘Tal mãe, tal filha’.
45 Yu really bi yor mama pikin. Yor mama run leave en husband and shidren. Yu bi like yor sista wey hate en husband and shidren too. Yu and Hit wey bi di oda town get di same mama and na Amor bi una papa.
45 Pois sua mãe detestava o marido e os filhos, e você faz o mesmo. É exatamente como suas irmãs, que também desprezaram marido e filhos. De fato, sua mãe era hitita, e seu pai, amorreu.
46 Yor senior sista na Samaria for nort. Yor yonga sista na Sodom for sout.
46 “Sua irmã mais velha era Samaria, que vivia com as filhas ao norte. Sua irmã mais nova era Sodoma, que vivia com as filhas ao sul.
47 Yu like as yu dey do di bad tins wey dem do? No! But e nor even tey before yor own worse pass dia own.
47 Mas você não apenas imitou sua conduta e seus pecados detestáveis; em pouco tempo, você as superou em sua depravação.
48 So as long as mi wey bi God dey alive, I dey sey, ‘Yor sista, Sodom and en village nor ever do di wiked tins wey yu and yor village don do.’
48 Tão certo como eu vivo, diz o S enhor Soberano, Sodoma e suas filhas nunca foram tão perversas quanto você e suas filhas.
49 “Yor sista and en pikin dey karry body up, bikos dem get enough to chop and dem dey stay for peace, but dem nor gri kare for poor pipol and doz wey nor get to chop.
49 Sodoma cometia os pecados de orgulho, glutonaria e preguiça, enquanto os pobres e necessitados sofriam.
50 Dem proud and sturbon kon dey do tins wey I nor like and na dis make mi distroy dem, just as all of yu know.
50 Era arrogante e cometia pecados detestáveis, por isso eu a exterminei, como você viu.
51 Samaria nor do half of di bads tins wey yu do. Yu ways bad well-well pass dia own. Bikos of di bad tins wey yu dey do, e kon bi like sey yor sistas nor even do any bad tin at-all.
51 “Nem mesmo Samaria cometeu metade dos pecados que você cometeu. Você fez coisas muito mais detestáveis que suas irmãs. Comparadas a você, elas parecem justas.
52 So naw, make yu bear di shame wey dey kom. Yor sins bad pass yor sistas own, sotey if dem look yu, dem go sey, ‘Wi nor even do anytin.’ Naw, make yu bear yor shame and pain, bikos yu don make yor sistas bi like good pesin.”
52 Você deveria se envergonhar. Seus pecados são tão terríveis que fazem suas irmãs parecerem justas, e até mesmo puras. Que coisa vergonhosa!
53 God tell Jerusalem, “Sodom and Samaria town, I go make una grow and prosper again.
53 “Um dia, porém, restaurarei Sodoma e Samaria, e você também.
54 Yu go shame for yorsef and yor disgrace go show yor sistas sey dem even dey good pass yu.
54 Então você ficará verdadeiramente envergonhada de tudo que fez, pois seus pecados fazem suas irmãs se sentirem bem em comparação com você.
55 But wen di time don rish, I go make dem prosper again and I go ribuild yu and yor town.
55 Quando suas irmãs, Sodoma e Samaria, e todos os seus habitantes forem restaurados, você também será restaurada.
56 Dat time wey yu dey proud, shebi yu dey laf Sodom
56 Você, em seus dias de arrogância, desprezava Sodoma.
57 wen yor wikedness neva bring yu kom out? Naw, yu just bi like am, bikos Edom, Filistia pipol and yor neighbours wey hate yu, dey laf yu naw.
57 Agora, porém, sua perversidade se tornou evidente para todo o mundo, e você é desprezada por Edom, por todos os vizinhos dele e pela Filístia.
58 Yu must sofa for all di wiked and bad tins wey yu don do.”
58 Esse é o castigo por sua depravação e seus pecados detestáveis, diz o S enhor .
59 God kon sey, “Na as I suppose trit yu, I go trit yu, bikos yu nor gri do wetin yu promise and yu break di kovenant.
59 “Assim diz o S enhor Soberano: Eu lhe darei o que você merece, pois não levou a sério seus votos solenes e quebrou sua aliança.
60 But I go still do di kovenant wey I make with yu wen yu dey small. I go make kovenant with yu wey go last forever.
60 Contudo, me lembrarei da aliança que fiz com você em sua juventude e estabelecerei com você uma aliança permanente.
61 Yu go remember how yu bihave, den shame go katch yu wen yor senior and yonga sista go kom back kon meet yu. I go let dem bi like yor pikin.
61 Então você se lembrará com vergonha de tudo que fez. Farei que suas irmãs, Samaria e Sodoma, se tornem suas filhas, embora elas não façam parte de nossa aliança.
62 I go renew my kovenant with yu and yu go know sey na mi bi God.
62 Reafirmarei minha aliança com você, e você saberá que eu sou o S enhor .
63 I go forgive yu all di bad tins wey yu don do, but wen yu remember dem, shame nor go let yu open yor mout.”
63 Você se lembrará de seus pecados e ficará calada de tanta vergonha quando eu perdoar tudo que fez. Eu, o S enhor Soberano, falei!”.
Atalhos do teclado
- Capítulo anterior←
- Próximo capítulo→
- Versículo anteriork
- Próximo versículoj
- Limpar seleçãoEsc
- Esta ajuda?
Estude este capítulo no WhatsApp
Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Ezequiel 16, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.