Ezequiel 12
Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs NAA
1 God kon tell mi.
1 A palavra do Senhor veio a mim, dizendo:
2 “Man pikin, na where sturbon pipol der yu dey stay. Dem get eye, but dem nor dey si; dem get ear, but dem nor der hear, bikos dem sturbon well-well.
2 — Filho do homem, você mora no meio da casa rebelde, que tem olhos para ver e não vê, tem ouvidos para ouvir e não ouve, porque é casa rebelde.
3 “So man pikin, make yu pak yor load like sey yu dey komot di town. For aftanoon wen pipol still dey look, pritend like sey yu dey go Babilon. Komot from where yu dey kon go anoda place. May bi dia mind go tell dem wetin dey happen, even doh dem sturbon well-well.
3 — Filho do homem, prepare a bagagem de exílio e durante o dia, à vista deles, vá para o exílio. Do lugar onde você está, vá para outro lugar, à vista deles. Talvez eles entendam, embora sejam casa rebelde.
4 For aftanoon wen dem still dey look yu, karry di tins wey yu pak like sey yu dey go Babilon. Wen dem still dey look yu, komot der for evening like sey yu dey go anoda place.
4 À vista deles, durante o dia, traga para fora a sua bagagem de exílio. Depois, à tarde, saia, à vista deles, como se estivesse indo para o exílio.
5 Break di wall open as dem dey look yu kon trow yor load pass am.
5 Abra um buraco na parede, à vista deles, e saia por ali.
6 As dem still dey look yu, karry yor load for shoulder, den make yu waka enter darkness. Yu must kover yor face, so dat yu nor go si di land and dis go bi warnin to Israel pipol.”
6 À vista deles, ponha a bagagem nos ombros e saia com ela quando já for escuro. Cubra o rosto para que você não possa ver o chão, porque eu fiz de você um sinal para a casa de Israel.
7 So, I do as God kommand mi. For day time wen dem dey look mi, I pak my load kon karry am like sey I dey go Babilon and for evening, I break di wall with my hand. Den I go out for nite kon karry my load for shoulder and dem still dey look mi.
7 Como me foi ordenado, assim eu fiz: de dia, levei para fora a minha bagagem de exílio. Depois, à tarde, com as minhas mãos abri um buraco na parede. Saí quando já era escuro, levando nos ombros a bagagem, à vista deles.
8 For morning, God kon tell mi:
8 Pela manhã, a palavra do Senhor veio a mim, dizendo:
9 “Man pikin, naw wey dem don dey ask yu wetin yu dey do,
9 — Filho do homem, a casa de Israel, aquela casa rebelde, não lhe perguntou o que você estava fazendo?
10 make yu tell dem wetin mi wey bi God tell yu. ‘Dis message na for di priest wey dey rule for Jerusalem and for all di pipol wey dey stay der.’
10 Pois diga-lhes: Assim diz o Senhor Deus: “Esta sentença refere-se ao que governa em Jerusalém e a toda a casa de Israel, que está no meio dela.”
11 Tell dem sey, ‘I bi warnin to una. Just as I don do, na so too God go do una. Dem go katch and karry una go Babilon as slaves.’
11 Diga: “Eu sou um sinal para vocês. Como eu fiz, assim será feito com eles; irão para o exílio, para o cativeiro.
12 “Di priest among una go karry en load put for shoulder kon waka enter darkness. E go break di wall where e go trow en load pass. E go kover en face, so dat e nor go si di land with en eye.
12 O príncipe que está no meio deles levará nos ombros a bagagem e, no escuro, sairá. Abrirá um buraco na parede para sair por ele. Cobrirá o rosto para que os seus olhos não vejam o chão.
13 Den I go trow my net on-top am kon katch am with my trap. I go take am go Babilon wey bi Kaldea pipol land (but e nor go si am) and na der e go for die.
13 Também estenderei a minha rede sobre ele, e será apanhado nas minhas malhas. Eu o levarei para a Babilônia, à terra dos caldeus, mas ele não a verá, ainda que venha a morrer ali.
14 So I go skata en ofisas and sojas go difren place and mi God go katch and kill dem.
14 Espalharei aos quatro ventos todos os que, para o ajudarem, estão ao redor dele, e todas as suas tropas; irei atrás deles com a espada na mão.
15 “Wen I don skata dem among di nashons and for strenja land, den dem go know sey na mi bi God.
15 Saberão que eu sou o Senhor , quando eu os dispersar entre as nações e os espalhar por outras terras.
16 But I go let some of dem survive di war, honga and diziz, so dat dem go tell di nashon where dem dey stay naw, about all di yeye tins wey dem do. Den, dem go know sey na mi bi God.”
16 Deixarei que alguns poucos escapem da espada, da fome e da peste, para que publiquem todas as suas coisas abomináveis entre as nações para onde forem; e saberão que eu sou o Senhor .”
17 God still tell mi sey:
17 Então a palavra do Senhor veio a mim, dizendo:
18 “Man pikin, kry as yu dey chop yor food. Dey shake as yu dey drink wota.
18 — Filho do homem, você comerá o seu pão com tremor e beberá a sua água com estremecimento e ansiedade.
19 Den make yu tell di pipol for di land sey, ‘Dis na wetin God tok about una wey dey stay for Jerusalem and Israel. Una go chop una bread with pain kon drink wota with fear. Bikos of di wahala wey una kause, I go take evritin wey dey una land.
19 E você dirá ao povo da terra: Assim diz o Senhor Deus a respeito dos moradores de Jerusalém, na terra de Israel: “Eles comerão o seu pão com ansiedade e beberão a sua água com espanto, porque a terra deles será despojada de tudo o que contém, por causa da violência de todos os que nela habitam.
20 Pipol wey dey stay der go sofa and di land go skata finish. Den, una go know sey na mi bi God.’ ”
20 As cidades habitadas cairão em ruínas, e a terra se tornará em desolação; e vocês saberão que eu sou o Senhor .”
21 Den God tell mi:
21 A palavra do Senhor veio a mim, dizendo:
22 “Man pikin, wetin make Israel pipol dey always tok like dis: ‘Di days dey pass dey go, yet all dis vishons nor mean anytin to dem?’
22 — Filho do homem, que provérbio é esse que vocês têm na terra de Israel: “Os dias passam, e as profecias fracassam”?
23 So make yu tell dem sey: ‘Dis na wetin God wey get pawa tok: I go stop all di word wey di pipol dey tok and dem nor go tok like dis for Israel again.’ But make yu tell dem, ‘Di day don rish wen evry vishon wey dem tok, go happen.
23 Portanto, diga-lhes: Assim diz o Senhor Deus: “Darei um basta nesse provérbio, e ele não será mais usado em Israel.” Mas diga-lhes: “Os dias vêm vindo, e as profecias vão se cumprindo.”
24 Bikos dat time, di yeye vishon or words wey Israel pipol dey tok, nor go dey again.
24 Porque não haverá mais nenhuma profecia falsa nem adivinhação lisonjeira no meio da casa de Israel.
25 Bikos mi wey bi God go tok anytin wey I like and e go happen, just as I tok am: E nor go waste time again and na wen wiked pipol still dey alive. Yes! I go tok di word and e go happen just as I tok am.’ ”
25 Porque eu, o Senhor , falarei, e a palavra que eu falar se cumprirá e não será adiada. Porque falarei a palavra e a cumprirei, diz o Senhor Deus, enquanto vocês, que são casa rebelde, ainda estiverem vivos.
26 Den God tell mi:
26 A palavra do Senhor veio a mim, dizendo:
27 “Man pikin, Israel house dey sey, ‘Di vishon wey God dey tell us nor go happen naw; E dey tok about tin wey go happen tumoro.’
27 — Filho do homem, eis que os da casa de Israel dizem: “As visões que esse homem tem se referem a dias futuros, e as suas profecias tratam de tempos distantes.”
28 So make yu tell dem, ‘Dis na wetin God wey get pawa dey tok: Evritin wey I tok, nor go tey before dem go happen! Evry word wey I tok, go must happen.’ ”
28 Portanto, diga-lhes: Assim diz o Senhor Deus: “Nenhuma das minhas palavras será adiada, e a palavra que eu falar se cumprirá”, diz o Senhor Deus.
Atalhos do teclado
- Capítulo anterior←
- Próximo capítulo→
- Versículo anteriork
- Próximo versículoj
- Limpar seleçãoEsc
- Esta ajuda?
Estude este capítulo no WhatsApp
Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Ezequiel 12, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.