Ezequiel 11

Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs ARIB

Sair da comparação
ARIB Almeida Revisada Imprensa Bíblica
1 God Spirit kon karry mi go di east gate for di temple. For near di gate, I kon si twenty-five men, plus Jaazanaya, wey Azzur born and Pelataya wey bi Benaya pikin and di two of dem na leaders for di land.
1 Então me levantou o Espírito, e me levou à porta oriental da casa do Senhor, a qual olha para o oriente; e eis que estavam à entrada da porta vinte e cinco homens, e no meio deles vi a Jaazanias, filho de Azur, e a Pelatias, filho de Benaías, príncipes do povo.
2 So God tell mi, “Dis men dey plan evil and na wiked advise dem dey give Jerusalem pipol.
2 E disse-me: Filho do homem, estes são os homens que maquinam a iniqüidade, e dão ímpio conselho nesta cidade;
3 Dem sey, ‘E neva rish wen wi go ribuild awa house. Di town bi like pot and na wi bi di meat wey dey inside di pot, but at least di fire nor dey tosh or burn us.’
3 os quais dizem: Não está próximo o tempo de edificar casas; esta cidade é a caldeira, e nós somos a carne.
4 So, Man pikin, go tok against wetin dem dey do.”
4 Portanto, profetiza contra eles; profetiza, ó filho do homem.
5 God Spirit kon dey kontrol mi and E give mi message make I go tell Israel pipol sey: “I know wetin una dey tok and wetin una dey plan to do.
5 E caiu sobre mim o Espírito do Senhor, e disse-me: Fala: Assim diz o Senhor: Assim tendes dito, ó casa de Israel; pois eu conheço as coisas que vos entram na mente.
6 Una don kill many pipol for dis town, sotey dead body don full evriwhere for di street.
6 Multiplicastes os vossos mortos nesta cidade, e enchestes as suas ruas de mortos.
7 So dis na wetin mi God dey tell una. ‘I gri sey di town na pot and na pipol wey una kill bi di meat! So, una nor go stay here again, bikos I go remove una from di town!
7 Portanto, assim diz o Senhor Deus: Vossos mortos que deitastes no meio dela, esses são a carne, e ela é a caldeira; a vós, porém, vos tirarei do meio dela.
8 Shebi una dey fear swod? So, I go fight una with men wey karry swods.
8 Temestes a espada, e a espada eu a trarei sobre vós, diz o Senhor Deus.
9 I go take una komot di town kon give una to strenjas. Yes! I go judge una
9 E vos farei sair do meio dela, e vos entregarei na mão de estrangeiros, e exercerei juízos entre vós.
10 and una go die wen una dey fight war for una kountry. Den evribody go know sey na mi bi God.
10 Caireis à espada; nos confins de Israel vos julgarei; e sabereis que eu sou o Senhor.
11 Dis town nor go bi pot for una again and una nor go bi meat inside am. So, anywhere wey una dey for Israel, I go judge and ponish una.
11 Esta cidade não vos servirá de caldeira, nem vós servirei de carne no meio dela; nos confins de Israel vos julgarei;
12 Den una go know sey na mi bi God! Una dey keep oda nashon law, but una dey break my own and nor dey obey my kommand.’ ”
12 e sabereis que eu sou o Senhor; pois não tendes andado nos meus estatutos, nem executado as minhas ordenanças; antes tendes procedido conforme as ordenanças das nações que estão em redor de vós.
13 As I still dey tok, Pelataya wey bi Benaya pikin, kon fall die. I fall face groun kon shaut, “God wey get pawa well-well, nor bi so o-o! Yu won kill evribody wey remain for Israel?”
13 E aconteceu que, profetizando eu, morreu Pelatias, filho de Benaías. Então caí com o resto em terra, e clamei com grande voz, e disse: Ah Senhor Deus! darás fim cabal ao remanescente de Israel?
14 God kon tell mi:
14 Então veio a mim a palavra do Senhor, dizendo:
15 “Man pikin, di pipol where dey Jerusalem dey tok about yu and di odas wey dey for strenjas land. Dem dey sey, ‘Doz wey dey dem karry go Babilon nor go fit woship God, bikos of where dem dey. So God don give us di land.’
15 Filho do homem, teus irmãos, os teus próprios irmãos, os homens de teu parentesco, e toda a casa de Israel, todos eles, são aqueles a quem os habitantes de Jerusalém disseram: Apartai-vos para longe do Senhor; a nós se nos deu esta terra em possessão.
16 “Naw, make yu tell doz wey dey with yu wetin I dey tok so. Na mi send dem go stay for strenj land kon skata dem for evriwhere. Yes, I go still dey with dem for di land wey dem dey.
16 Portanto, dize: Assim diz o Senhor Deus: Ainda que os mandei para longe entre as nações, e ainda que os espalhei pelas terras, todavia lhes servirei de santuário por um pouco de tempo, nas terras para onde foram.
17 “So, make yu tell dem wetin mi wey bi God dey tok. I go gada dem kom back from di land where I skata dem go kon give dem Israel land again.
17 Portanto, dize: Assim diz o senhor Deus: Hei de ajuntar-vos do meio dos povos, e vos recolherei do meio das terras para onde fostes espalhados, e vos darei a terra de Israel.
18 “Wen dem kom back, dem must skata all di rubbish tins wey dem dey do before kon skata any juju wey dem si for der.
18 E virão ali, e tirarão dela todas as suas coisas detestáveis e todas as suas abominações.
19 I go give dem new heart and mind. I go komot dia sturbon heart wey bi like stone kon put anoda heart wey dey gentol and dey obey.
19 E lhes darei um só coração, e porei dentro deles um novo espírito; e tirarei da sua carne o coração de pedra, e lhes darei um coração de carne,
20 Dat time, dem go keep my law and obey my kommand with all dia heart. Dem go bi my pipol and I go bi dia God.
20 para que andem nos meus estatutos, e guardem as minhas ordenanças e as cumpram; e eles serão o meu povo, e eu serei o seu Deus.
21 But pipol wey still like to woship juju and do bad tins, I go ponish dem. I go ponish dem for di tins wey dem don do.”
21 Mas, quanto àqueles cujo coração andar após as suas coisas detestáveis, e das suas abominações, eu farei recair nas suas cabeças o seu caminho, diz o Senhor Deus.
22 Di creatures kon dey fly and di wheel follow dem too.
22 Então os querubins elevaram as suas asas, estando as rodas ao lado deles; e a glória do Deus de Israel estava em cima sobre eles.
23 God glory kon komot di town go di east side for di mountin.
23 E a glória do Senhor se alçou desde o meio da cidade, e se pôs sobre o monte que está ao oriente da cidade.
24 Leta, God Spirit karry mi go meet di odas for Babilon.
24 Então o Espírito me levantou, e me levou na visão pelo Espírito de Deus para a Caldéia, para os exilados. Assim se foi de mim a visão que eu tinha visto.
25 and I tell di pipol evritin wey God don show mi.
25 E falei aos do cativeiro todas as coisas que o Senhor me tinha mostrado.

Ler em outra tradução

Comparar com outra

Estude este capítulo no WhatsApp

Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Ezequiel 11, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.