Êxodo 9
Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs BKJ
1 Den Oga God tell Moses, “Go meet and tell Fero sey, ‘God wey bi Hibru pipol God sey, “Make yu let my pipol go serve mi!
1 Então disse o SENHOR a Moisés: Vai à presença de Faraó, e dize-lhe: Assim diz o SENHOR Deus dos hebreus: Deixa o meu povo ir, para que me sirva.
2 Bikos if yu nor gri let dem go and yu kontinue to hold dem,
2 Porque se te recusares a deixá-los ir, e os detiveres por força,
3 I go use my pawa bring sickness kom meet una animals for fields, una horse, donkey, kamel, kattle, sheep and goat dem.
3 eis que a mão do SENHOR será sobre teu gado que está no campo, sobre os cavalos, sobre os jumentos, sobre os camelos, sobre os bois, e sobre as ovelhas; haverá uma grande praga.
4 But I go separate Israel animals from Egypt pipol own. No Israel animal go die.” ’
4 E o SENHOR separará o gado de Israel e o gado do Egito; e não morrerá nada de tudo o que for dos filhos de Israel.
5 “Mi wey bi Oga God don sey na tumoro I go do dis tin wey I tok.”
5 E o SENHOR determinou um tempo certo, dizendo: Amanhã o SENHOR fará isto na terra.
6 True-true God do dis tin for di next day. All di animals for Egypt pipol farm die, but no one for Israel pipol own, die.
6 E o SENHOR o fez no dia seguinte, e todo o gado do Egito morreu, mas do gado dos filhos de Israel não morreu nenhum.
7 Fero kon send pipol go find out and true-true, Israel pipol animal nor die. With all dis tins wey dey happen so, Fero heart still strong and e nor gri free di pipol.
7 E Faraó mandou ver, e eis que do gado dos israelitas nenhum morrera. E o coração de Faraó foi endurecido, e ele não deixou o povo ir.
8 Den Oga God tell Moses and Aaron sey, “Make una gada ashes from where dem for dey burn firewood, den make Moses blow dem for air for di king front.
8 E disse o SENHOR a Moisés e a Arão: Tomai para vós mãos cheias de cinzas do forno, e que Moisés as espalhe para o céu à vista de Faraó.
9 Di ashes go skata like dust for Egypt and e go kause boil wey go turn to sore for Egypt pipol and dia animals body.”
9 E se tornará em pó fino sobre toda a terra do Egito, e furúnculos que arrebentarão em úlcera sobre o homem, e sobre o animal, em toda a terra do Egito.
10 So dem gada di ashes from di firewood kon stand for Fero front. Den Moses blow di ashes for air and e kon turn to boil for both Egypt pipol and dia animals body.
10 E eles tomaram as cinzas do forno, e puseram-se diante de Faraó. E Moisés as espalhou para o céu, e elas se tornaram em feridas que arrebentavam em úlceras sobre o homem e sobre o animal.
11 Di juju-men nor fit stand for where Moses dey, bikos of di boil wey full dia body and Egypt pipol own.
11 E os magos não conseguiram ficar diante de Moisés por causa das feridas, pois a ferida estava sobre os magos, e sobre todos os egípcios.
12 But God still make Fero heart strong and e nor gri listin to dem, just as Oga God sey e go bi.
12 E o SENHOR endureceu o coração de Faraó, e ele não os ouviu, como o SENHOR havia dito a Moisés.
13 God kon tell Moses, “Make yu get up for early morning go meet Fero kon tell am, ‘God wey bi Hibru pipol God sey, “Make yu let my pipol go woship mi!
13 E o SENHOR disse a Moisés: Levanta-te de manhã cedo, e coloca-te diante de Faraó, e dize a ele: Assim diz o SENHOR Deus dos hebreus: Deixa o meu povo ir, para que me sirva.
14 Bikos dis time, I nor go only ponish yor savant and pipol, but I go ponish yu too, so dat yu go know sey nobody bi like mi for di whole world.
14 Porque desta vez enviarei todas as minhas pragas sobre o teu coração, e sobre os teus servos, e sobre o teu povo, para que saibas que não há ninguém como eu em toda a terra.
15 If to sey I take sickness attack yu and yor pipol, all of una for don die finish.
15 Porquanto agora estenderei a minha mão, para que eu fira a ti e a teu povo com peste, e tu serás cortado da terra.
16 Dis na di rizin why I neva kill yu. I just won show yu my pawa, so dat pipol go praiz my name for evriwhere for di eart.
16 E na verdade é por esta causa que eu te levantei, para mostrar o meu poder em ti, e para que o meu nome seja declarado em toda a terra.
17 Yu still dey karry body up and yu nor gri free my pipol.
17 Ainda te exaltas contra o meu povo, não o deixando ir?
18 So, by dis time tumoro, I go make strong ice-blok rain wey dem dey koll ‘hail’, fall as e neva fall for Egypt before.
18 Eis que amanhã a essa hora, farei chover um grande granizo, tal como não houve no Egito, desde a sua fundação até agora.
19 So naw, make yu go tell yor pipol make dem gada all dia animal and evritin wey dem get komot from di field kon kover dem for house. Dis na bikos anybody wey di ice-blok rain fall meet for outside, go die!” ’ ”
19 Por isso, envia agora, e ajunta o teu gado, e tudo que tens no campo; pois sobre todo homem e todo animal que for encontrado no campo, e não for trazido para casa, cairá o granizo, e morrerão.
20 Doz wey bi Fero savants wey dey fear God word kon rush go gada dia savant and animals enter house.
20 Aquele que temeu a palavra do SENHOR entre os servos de Faraó fez seus servos e seu gado fugir para dentro das casas,
21 But di rest ones wey nor bilive Oga God word kon leave dia savant and kattles for outside.
21 e aquele que não considerou a palavra do SENHOR deixou os seus servos e o seu gado no campo.
22 Den God tell Moses, “Stresh yor hand go heaven make di ice-blok rain fall for Egypt; on-top di pipol, animals and evritin wey dey grow for Egypt.”
22 E o SENHOR disse a Moisés: Estende a tua mão para o céu, para que haja granizo em toda a terra do Egito, sobre o homem, e sobre o animal, e sobre toda erva do campo na terra do Egito.
23 Wen Moses stresh di stik wey dey en hand go heaven, God kon send tonda and plenty ice-blok and fire kon dey fall for groun: so Oga God make ice-blok fall like rain for Egypt.
23 E Moisés estendeu seu cajado para o céu, e o SENHOR enviou trovão e granizo, e o fogo desceu à terra; e o SENHOR fez chover granizo sobre a terra do Egito.
24 Fire wey mix with ice-blok kon dey fall too. Di rain strong well-well and Egypt pipol neva ever si dis kind rain before.
24 Assim houve granizo, e fogo misturado com granizo, muito grave, tal como não houve em toda a terra do Egito desde que se tornou uma nação.
25 Di ice-blok distroy evritin wey dey di field, both pipol and animals. Di rain distroy evritin wey dey grow for di field kon break di trees to pieces.
25 E o granizo feriu, em toda a terra do Egito, tudo que estava no campo, tanto homem como animal; e o granizo feriu toda erva do campo, e quebrou cada árvore do campo.
26 But di ice-blok rain nor fall for Goshen land where Israel pipol dey stay.
26 Somente na terra de Gósen, onde os filhos de Israel estavam, não houve granizo.
27 So Fero send for Moses and Aaron kon tell dem, “Dis time I gri sey I don sin! God dey holy and na mi and my pipol dey guilty.
27 E Faraó enviou, e chamou Moisés e Arão, e lhes disse: Pequei desta vez; o SENHOR é justo, e eu e meu povo somos ímpios.
28 So make una help mi beg God, bikos di strong tonda and ice-blok too mush and I go free una and una nor go stay here again.”
28 Rogai ao SENHOR (pois é o suficiente) para que não haja mais trovões fortes e granizo, e eu vos deixarei ir, e não ficareis mais aqui.
29 Moses ansa am, “Wen I komot go inside town I go stresh my two hand go heaven to di Oga wey bi God, den di tonda go stop and di ice-blok nor go fall again, so dat yu go know sey na Oga God get di whole world.
29 E Moisés lhe disse: Assim que eu sair da cidade, estenderei minhas mãos ao SENHOR; e o trovão cessará, nem haverá mais granizo, para que saibas que a terra é do SENHOR.
30 But I know sey yu and yor savants neva still dey fear God.”
30 Mas quanto a ti e a teus servos, sei que não temereis o SENHOR Deus.
31 (For dis time, di plant wey dem dey koll flax and barley don skata and die, bikos di barley don ripe and di flax dem just dey won get flower.
31 E o linho e a cevada foram feridos, porque a cevada já estava na espiga, e o linho estava enrolado.
32 But e nor get any wheat wey distroy, bikos dem neva grow kom out.)
32 Mas o trigo e o centeio não foram feridos, pois não eram crescidos.
33 So Moses waka leave Fero kon go inside di town stresh en two hand go heaven as e dey pray and di tonda, di ice-blok and di rain kon stop to fall.
33 E Moisés saiu da presença de Faraó e de sua cidade, e estendeu suas mãos ao SENHOR, e os trovões e o granizo cessaram, e a chuva não foi derramada sobre a terra.
34 Wen Fero si sey di rain, ice-blok and di tonda don stop, e kon still sin again: both en and en savants kon get strong heart.
34 E quando Faraó viu que a chuva e o granizo e os trovões haviam cessado, pecou ainda mais, e endureceu seu coração, ele e os seus servos.
35 So Fero heart still dey strong and e nor gri release Israel pipol, just as God tok.
35 E o coração de Faraó foi endurecido, e não deixou os filhos de Israel ir, como o SENHOR havia dito por Moisés.
Atalhos do teclado
- Capítulo anterior←
- Próximo capítulo→
- Versículo anteriork
- Próximo versículoj
- Limpar seleçãoEsc
- Esta ajuda?
Estude este capítulo no WhatsApp
Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Êxodo 9, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.