Êxodo 8
Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs NAA
1 Den God tell Moses, “Go tell Fero sey, ‘Dis na wetin God tok, “Make yu let my pipol go serve mi!
1 Depois o Senhor disse a Moisés: — Vá falar com Faraó e diga-lhe: Assim diz o
2 But if yu nor gri release dem, den I go make frog kover una land and una go sofa.
2 Se você não quiser deixá-lo ir, eis que castigarei com rãs todo o seu território.
3 Frog go full River Nile and dem go still dey inside una house, bedroom, on-top una bed, inside una savants and una pipol house; una pots and di kontaina wey una take dey fetch wota.
3 O rio produzirá rãs em abundância, que subirão e entrarão em sua casa, no seu quarto de dormir, sobre a sua cama, nas casas dos seus oficiais, sobre o seu povo, nos seus fornos e nas suas amassadeiras.
4 Di frog go trobol yu, yor pipol and all yor savants for dis land.” ’ ”
4 As rãs virão sobre você, sobre o seu povo e sobre todos os seus oficiais.”
5 God tell Moses, “Go tell Aaron, ‘Take di stik wey dey yor hand take face di river, creek and di ponds and frog go full evriwhere for Egypt.’ ”
5 O Senhor disse ainda a Moisés: — Diga a Arão que estenda a mão com o seu bordão sobre os rios, sobre os canais e sobre as lagoas e faça subir rãs sobre a terra do Egito.
6 So as Aaron stresh di stik on-top di wota wey dey Egypt, frog kom full evriwhere for di land.
6 Arão estendeu a mão sobre as águas do Egito, e subiram rãs e cobriram a terra do Egito.
7 Di juju-men sef kon use dia juju pawa take bring frog join di ones wey dey di land.
7 Então os magos fizeram o mesmo com as suas ciências ocultas e fizeram aparecer rãs sobre a terra do Egito.
8 Den Fero koll Moses and Aaron kon tell dem, “Make una pray to God make E remove all di frog from mi and my pipol and I go allow una go sakrifice to am for di wildaness.”
8 Faraó chamou Moisés e Arão e lhes disse: — Peçam ao
9 So Moses tell Fero, “I go dey happy to pray for yu, yor savants and yor pipol, so dat di frog go komot from yor land go back to di river. So na wish time yu wont make I pray.”
9 Moisés disse a Faraó: — Tenha a bondade de me dizer quando é que devo orar por você, pelos seus oficiais e pelo seu povo, para que as rãs sejam retiradas de você e das suas casas e fiquem somente no rio.
10 Fero ansa, “Na tumoro.”
10 Faraó respondeu: — Amanhã. Moisés disse: — Seja conforme a sua palavra, para que você saiba que não há ninguém como o
11 Di frog go komot from yu, all yor savants and yor pipol house and na only di frog dem for inside River Nile, go remain.”
11 As rãs se afastarão de você, das suas casas, dos seus oficiais e do seu povo; ficarão somente no rio.
12 Moses and Aaron kon waka leave Fero. Den Moses pray to God make E remove di frog wey E send kon meet Fero.
12 Então Moisés e Arão saíram da presença de Faraó. E Moisés clamou ao Senhor por causa das rãs, conforme havia combinado com Faraó.
13 God do as Moses wont and all di frog inside dia house, village and farms, kon die.
13 E o Senhor fez conforme a palavra de Moisés: morreram as rãs nas casas, nos pátios e nos campos.
14 Egypt pipol gada di frog and dem nor fit kount am, den evriwhere kon dey smell for di land.
14 Os egípcios ajuntaram as rãs em montões e montões, e a terra cheirou mal.
15 But wen Fero si sey di wahala don end, en heart kon strong more and e nor gri listin to dem, just as Oga God tok.
15 Vendo, porém, Faraó que havia alívio, continuou de coração endurecido e não os ouviu, como o Senhor tinha dito.
16 God kon tell Moses, “Make yu tell Aaron sey, ‘Nak di san with di stik wey dey yor hand and plenty san-san fly go kom out for evriwhere for Egypt.’ ”
16 O Senhor disse a Moisés: — Diga a Arão que estenda o seu bordão e bata no pó da terra, para que se transforme em piolhos por toda a terra do Egito.
17 So Aaron nak di san with en stik and san-san fly kon full evriwhere for Egypt.
17 Eles assim fizeram. Arão estendeu a mão com seu bordão e bateu no pó da terra, e houve muitos piolhos nas pessoas e no gado; todo o pó da terra se transformou em piolhos por toda a terra do Egito.
18 Wen di juju-men try to bring out san-san fly with dia juju pawa, dem nor fit do am. So san-san fly kon dey gada both Egypt pipol and dia animals.
18 E os magos fizeram o mesmo com as suas ciências ocultas para produzirem piolhos, mas não conseguiram. E havia piolhos nas pessoas e no gado.
19 Di juju-men kon tell Fero, “Dis na God handwork!” But Fero heart still strong and sturbon and e nor gri listin to dem, just as God tok.
19 Então os magos disseram a Faraó: — Isto é o dedo de Deus. Porém o coração de Faraó se endureceu, e não os ouviu, como o
20 God tell Moses, “Make yu wake-up for early morning go meet Fero as e dey go di river kon tell am, ‘God sey, “Make yu let my pipol go serve mi!
20 O Senhor disse a Moisés: — Levante-se de manhã cedo e apresente-se a Faraó. Eis que ele sairá às águas. Diga-lhe: Assim diz o
21 If yu nor gri let dem go, I go send plenty fly kom meet yu, yor savants, yor pipol and for inside una house. All Egypt pipol house and di groun go full with fly.
21 Se você não deixar o meu povo ir, eis que eu enviarei enxames de moscas sobre você, sobre os seus oficiais, sobre o seu povo e nas suas casas. As casas dos egípcios se encherão destes enxames, e também a terra em que eles estiverem.
22 And for dat day, I nor go let di fly dem rish Goshen land where my pipol dey, so dat yu go know sey na mi, di Oga God dey do dis tins.
22 Naquele dia, separarei a terra de Gósen, onde mora o meu povo, para que nela não haja enxames de moscas, e você saiba que eu sou o Senhor no meio desta terra.
23 I go divide my pipol from yor pipol. Dis sign go happen tumoro.” ’ ”
23 Farei distinção entre o meu povo e o seu povo; amanhã se dará este sinal.”
24 God do as E tok and fly wey dem nor fit kount kon full Fero, en savants and Egypt pipol house and many tins spoil, bikos of di fly dem.
24 Assim fez o Senhor , e vieram grandes enxames de moscas à casa de Faraó, às casas dos seus oficiais e sobre toda a terra do Egito. E a terra ficou arruinada com estes enxames.
25 Den Fero koll Moses and Aaron kon sey, “Make una go sakrifice to una God inside di land.”
25 Faraó chamou Moisés e Arão e disse: — Vão e ofereçam sacrifícios ao seu Deus, mas sem sair desta terra.
26 But Moses sey, “Dat nor bi wetin wi suppose do, di kind sakrifice wey wi won do for di Oga awa God na wetin Egypt pipol dey forbid. If wi make sakrifice wey Egypt pipol dey forbid for dia face, dem nor go stone us die?
26 Moisés respondeu: — Não convém que façamos assim porque ofereceríamos ao
27 So wi must travel for three days go inside di wildaness go sakrifice to di Oga awa God, just as E don dey tell us since.”
27 Temos de ir caminho de três dias ao deserto e ofereceremos sacrifícios ao Senhor , nosso Deus, como ele nos disser.
28 Fero kon sey, “I go let una go sakrifice give di Oga una God inside di wildaness, but una nor go-go too far. Make una pray for mi too.”
28 Então Faraó disse: — Eu os deixarei ir, para que ofereçam sacrifícios ao
29 Moses ansa, “I go leave yu go pray to God and tumoro, all di fly go komot from Fero, en savants and en pipol, so-far yu nor go deceive us again or nor let us go sakrifice to awa God.”
29 Moisés respondeu: — Eis que saio da sua presença e orarei ao
30 So Moses komot from where Fero dey kon go pray
30 Então Moisés saiu da presença de Faraó e orou ao Senhor .
31 and Oga God do as Moses ask. E remove all di fly from Fero, en savants and en pipol.
31 E o Senhor fez conforme a palavra de Moisés, e os enxames de moscas se afastaram de Faraó, dos seus oficiais e do seu povo; não ficou uma só mosca.
32 But Fero heart still dey strong and sturbon as before and e nor gri free di pipol.
32 Mas ainda desta vez Faraó endureceu o coração e não deixou o povo ir.
Atalhos do teclado
- Capítulo anterior←
- Próximo capítulo→
- Versículo anteriork
- Próximo versículoj
- Limpar seleçãoEsc
- Esta ajuda?
Estude este capítulo no WhatsApp
Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Êxodo 8, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.