Êxodo 5
Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs NAA
1 Den Moses and Aaron go meet Fero kon tell am, “Israel God sey, ‘Make yu allow my pipol travel go di wildaness go woship and honor mi.’ ”
1 Depois Moisés e Arão foram e disseram a Faraó: — Assim diz o
2 But Fero ask dem, “Who bi dis God wey go make mi fear am kon let Israel pipol go? I nor know am, so I nor go let Israel pipol go.”
2 Faraó respondeu: — Quem é o
3 Moses and Aaron kon sey, “Hibru pipol God don show ensef to us. So make yu allow us go di wildaness for three days go do sakrifice to awa God, so dat E nor go kill us with sickness or war.”
3 Eles prosseguiram: — O Deus dos hebreus veio ao nosso encontro; portanto, deixe-nos ir caminho de três dias ao deserto, para que ofereçamos sacrifícios ao
4 Den di king tell dem, “Moses and Aaron, na una dey make di pipol nor gri do dia work, abi? Make una go back go kontinue una work.
4 Então o rei do Egito disse: — Moisés e Arão, por que estão afastando o povo das suas tarefas? Voltem ao trabalho!
5 Una pipol don too many for dis land pass Egypt pipol. And naw, una wont stop work.”
5 E Faraó disse também: — O povo da terra já é muito e vocês ainda querem que eles descansem de suas tarefas!
6 For dat di same day, Fero kon kommand di slave oga dem sey,
6 Naquele mesmo dia Faraó deu uma ordem aos feitores do povo e aos seus capatazes, dizendo:
7 “Make una stop to give di pipol wetin dem take dey make block. But make only dem go find kon make block.
7 — Daqui em diante não forneçam mais palha ao povo, para fazer tijolos, como antes; que eles mesmos ajuntem para si a palha.
8 And una go force dem make plenty block, just as dem dey do before. Na bikos dem nor get enough work naim make dem dey kom ask mi sey, ‘Make yu let us go sakrifice give awa God.’
8 Mas exijam deles a mesma quantidade de tijolos que antes faziam. Não diminuam a cota. Eles estão desocupados e, por isso, gritam: “Vamos e sacrifiquemos ao nosso Deus.”
9 Make una give dem strong work, so dat dem nor go get shance to listin to lie-lie word!”
9 Imponham mais serviço a esses homens, para que se mantenham ocupados e não deem ouvidos a palavras mentirosas.
10 So all di slave oga kon go tell Israel pipol, “Fero sey: ‘I nor go give una wetin dem take dey make block again.
10 Então os feitores do povo e seus capatazes foram e falaram ao povo: — Assim diz Faraó: “Não fornecerei mais palha para vocês.
11 But na only una go-go find dem and di block wey una go make must bi di same as before.’ ”
11 Vão vocês mesmos e ajuntem palha onde a puderem achar; porque não haverá redução no trabalho de vocês.”
12 So di pipol kon bigin waka for inside Egypt dey find wetin dem take dey make block.
12 Então o povo se espalhou por toda a terra do Egito para ajuntar restolho em lugar de palha.
13 Di slave oga still dey force and tell dem, “Una must finish evriday work, just as e bi wen wi dey give una dry stik take work!”
13 Os feitores os pressionavam, dizendo: — Terminem o trabalho de vocês, a tarefa do dia, como quando havia palha.
14 Fero pipol kon bigin beat Israel pipol wey dem take do oga ova dia own pipol, den dem ask dem, “Why una nor komplete una work yestiday and today, just as una dey do before?”
14 E os capatazes dos filhos de Israel, que os feitores de Faraó tinham posto sobre eles, foram açoitados. Os feitores perguntavam aos capatazes: — Por que não terminaram nem ontem nem hoje a tarefa de vocês, fazendo tijolos como antes?
15 Israel pipol wey dem take do oga ova dia own pipol kry go meet Fero kon sey, “Why yu dey sofa yor savants like dis?
15 Então os capatazes dos filhos de Israel foram se queixar a Faraó, dizendo: — Por que o senhor trata assim estes seus servos?
16 Dem nor gri give us, yor savants dry stik, instead dem dey beat and tell us sey make wi make plenty block, even doh na dem dey wrong.”
16 Já não nos fornecem palha, mas nos dizem: “Façam tijolos.” Eis que estes seus servos são açoitados; porém o seu próprio povo é que tem a culpa.
17 Den Fero ansa, “Una lazy and nor won work, if not una nor go sey, ‘Make yu allow us go sakrifice give awa God.’
17 Mas Faraó respondeu: — Vocês são uns desocupados! Vocês estão desocupados e, por isso, dizem: “Vamos e sacrifiquemos ao
18 So make una go back go work. Dem nor go give una dry stik again and una must still make di block rish as una dey do am before!”
18 Voltem, agora, ao trabalho. Vocês não receberão palha, mas terão de produzir a mesma quantidade de tijolos.
19 Israel pipol wey dem take make oga ova dia own pipol kon know sey dem don enter trobol as di king sey, “Una must make di block rish as una bin dey do am.”
19 Então os capatazes dos filhos de Israel se viram em aperto, porque diziam a eles: “Não haverá redução na quantidade de tijolos, na tarefa diária de vocês.”
20 Afta dem leave Fero, dem kon go meet Moses and Aaron wey bin dey wait for dem kon
20 Quando saíram da presença de Faraó, encontraram Moisés e Arão, que estavam à espera deles,
21 sey, “Make God judge una, bikos una don make di king and en workers hate us and una don give dem shance to kill us!”
21 e lhes disseram: — Que o
22 Moses go back go meet God kon sey, “God! Why Yu kon kause trobol for dis pipol? Wetin make Yu send mi kom?
22 Então Moisés, voltando-se ao Senhor , disse: — Ó Senhor, por que afligiste este povo? Por que me enviaste?
23 Since I go tok to Fero with yor name, di kind sofa wey e dey sofa yor pipol kon worse pass as e bi before and Yu neva still kom save dem!”
23 Pois, desde que me apresentei a Faraó, para falar-lhe em teu nome, ele tem maltratado este povo; e tu nada fizeste para livrar o teu povo.
Atalhos do teclado
- Capítulo anterior←
- Próximo capítulo→
- Versículo anteriork
- Próximo versículoj
- Limpar seleçãoEsc
- Esta ajuda?
Estude este capítulo no WhatsApp
Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Êxodo 5, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.