Êxodo 4
Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs ARA
1 Moses ansa again, “Na wetin I go do if dem nor bilive or listin to mi, but kon dey sey, ‘God nor appear to yu’?”
1 Respondeu Moisés: Mas eis que não crerão, nem acudirão à minha voz, pois dirão: O Senhor não te apareceu.
2 So God ask Moses, “Wetin dey yor hand?”
2 Perguntou-lhe o Senhor : Que é isso que tens na mão? Respondeu-lhe: Um bordão.
3 God tell am, “Make yu trow am for groun.” So Moses trow di stik for groun and e turn to snake, den Moses run komot der.
3 Então, lhe disse: Lança-o na terra. Ele o lançou na terra, e o bordão virou uma serpente. E Moisés fugia dela.
4 But God tell am, “Make yu hold am for en tail.” So e hold am for en tail and di snake kon turn stik for en hand.
4 Disse o Senhor a Moisés: Estende a mão e pega-lhe pela cauda (estendeu ele a mão, pegou-lhe pela cauda, e ela se tornou em bordão);
5 God sey, “Dis na wetin yu go do, so dat Israel pipol go bilive sey na di Oga God wey bi dia grand-grand papa, Abraham, Isaak and Jakob God, appear to yu.”
5 para que creiam que te apareceu o Senhor , Deus de seus pais, o Deus de Abraão, o Deus de Isaque e o Deus de Jacó.
6 God still tell am, “Make yu put yor hand inside yor dress.” So e put en hand inside en dress and wen e bring am kom out, e kon get diziz and di hand dey white like snow!
6 Disse-lhe mais o Senhor : Mete, agora, a mão no peito. Ele o fez; e, tirando-a, eis que a mão estava leprosa, branca como a neve.
7 God tell am, “Put yor hand back inside yor dress.” So e put am back, den e bring am kom out and di hand kon dey okay again.
7 Disse ainda o Senhor : Torna a meter a mão no peito. Ele a meteu no peito, novamente; e, quando a tirou, eis que se havia tornado como o restante de sua carne.
8 So God sey, “If dem nor bilive yu or bilive di first sign, dem go bilive dis sekond one.
8 Se eles te não crerem, nem atenderem à evidência do primeiro sinal, talvez crerão na evidência do segundo.
9 And if dem nor bilive dis two signs or listin to yu, make yu take small wota from River Nile kon pour am for dry groun. Den di wota wey yu fetch from di river go turn to blood as yu dey pour am.”
9 Se nem ainda crerem mediante estes dois sinais, nem te ouvirem a voz, tomarás das águas do rio e as derramarás na terra seca; e as águas que do rio tomares tornar-se-ão em sangue sobre a terra.
10 Den Moses tell God, “My Oga God, Yu know sey I nor sabi tok well since dem born mi kon rish naw wey Yu dey tok to mi, yor savant.”
10 Então, disse Moisés ao Senhor : Ah! Senhor! Eu nunca fui eloquente, nem outrora, nem depois que falaste a teu servo; pois sou pesado de boca e pesado de língua.
11 God ask am, “Na who give man mout or na who dey make pesin fit tok, hear or si? Nor bi mi wey bi God?
11 Respondeu-lhe o Senhor : Quem fez a boca do homem? Ou quem faz o mudo, ou o surdo, ou o que vê, ou o cego? Não sou eu, o Senhor ?
12 Naw, make yu go and I go help yu tok kon tell yu wetin yu go tok.”
12 Vai, pois, agora, e eu serei com a tua boca e te ensinarei o que hás de falar.
13 But Moses sey, “My Oga God, abeg make Yu send anoda pesin wey Yu go like to send.”
13 Ele, porém, respondeu: Ah! Senhor! Envia aquele que hás de enviar, menos a mim.
14 Den Oga God kon dey vex with Moses, so E ask am, “Wot about yor broda Aaron wey kom from Levi tribe? I know sey e sabi tok well-well. E dey kom meet yu and wen e si yu, e go happy well-well.
14 Então, se acendeu a ira do Senhor contra Moisés, e disse: Não é Arão, o levita, teu irmão? Eu sei que ele fala fluentemente; e eis que ele sai ao teu encontro e, vendo-te, se alegrará em seu coração.
15 Den yu go tell am wetin e go tok. As for mi, I go tok thru una and I go tish two of una wetin to do.
15 Tu, pois, lhe falarás e lhe porás na boca as palavras; eu serei com a tua boca e com a dele e vos ensinarei o que deveis fazer.
16 E go help yu tok to di pipol and e go bi like sey naim bi yor mout and yu go bi like God to am.
16 Ele falará por ti ao povo; ele te será por boca, e tu lhe serás por Deus.
17 Yu go still karry di stik follow body, bikos naim yu go take do many signs and wonders.”
17 Toma, pois, este bordão na mão, com o qual hás de fazer os sinais.
18 Den Moses go back go meet en wife papa, Jetro kon tell am, “Make yu allow mi go back to my family for Egypt kon shek if dem still dey alive.” Jetro ansa Moses, “Make peace follow yu go.”
18 Saindo Moisés, voltou para Jetro, seu sogro, e lhe disse: Deixa-me ir, voltar a meus irmãos que estão no Egito para ver se ainda vivem. Disse-lhe Jetro: Vai-te em paz.
19 God tell Moses for Midian, “Make yu go Egypt back, bikos all di pipol wey get mind to kill yu, don die.”
19 Disse também o Senhor a Moisés, em Midiã: Vai, torna para o Egito, porque são mortos todos os que procuravam tirar-te a vida.
20 Den Moses take en wife and pikin, karry dem put on-top donkey kon go Egypt. Moses hold di stik wey God gi-am for en hand.
20 Tomou, pois, Moisés a sua mulher e os seus filhos; fê-los montar num jumento e voltou para a terra do Egito. Moisés levava na mão o bordão de Deus.
21 God tell Moses, “Wen yu go back to Egypt, yu must do all dis mirakle and sign for Fero front, bikos I don put pawa for yor hand. But I go make Fero heart strong well-well and e nor go gri free my pipol.
21 Disse o Senhor a Moisés: Quando voltares ao Egito, vê que faças diante de Faraó todos os milagres que te hei posto na mão; mas eu lhe endurecerei o coração, para que não deixe ir o povo.
22 Yu must tell Fero, ‘God sey, Israel na my first pikin
22 Dirás a Faraó: Assim diz o Senhor : Israel é meu filho, meu primogênito.
23 and I tell yu sey, “Make yu allow my pikin dem go, so dat dem go-go serve mi, but since yu nor gri make dem go, I go kill yor own son!” ’ ”
23 Digo-te, pois: deixa ir meu filho, para que me sirva; mas, se recusares deixá-lo ir, eis que eu matarei teu filho, teu primogênito.
24 Naw, nite meet dem for road, so dem stop for one house kon sleep der. For nite wen dem dey sleep, God won kon kill Moses for di place.
24 Estando Moisés no caminho, numa estalagem, encontrou-o o Senhor e o quis matar.
25 But en wife Zipporah kut en son skin with knife kon take am tosh Moses leg, den e sey, “True-true, I don take yu from deat hand and yu bi my husband wey I marry with blood.”
25 Então, Zípora tomou uma pedra aguda, cortou o prepúcio de seu filho, lançou-o aos pés de Moisés e lhe disse: Sem dúvida, tu és para mim esposo sanguinário.
26 So God leave Moses. (From dat time, en wife kon dey koll am, “Blood husband” and e take am mean sekonsishon.)
26 Assim, o Senhor o deixou. Ela disse: Esposo sanguinário, por causa da circuncisão.
27 God tell Aaron, “Make yu go di wildaness go meet Moses.” So Aaron go der go meet am for God mountin kon kiss am.
27 Disse também o Senhor a Arão: Vai ao deserto para te encontrares com Moisés. Ele foi e, encontrando-o no monte de Deus, o beijou.
28 Moses tell Aaron evritin wey God tell am and all di mirakle and sign wey God kommand am sey make e do.
28 Relatou Moisés a Arão todas as palavras do Senhor , com as quais o enviara, e todos os sinais que lhe mandara.
29 Den Moses and Aaron kon go gada all di eldas for Israel togeda.
29 Então, se foram Moisés e Arão e ajuntaram todos os anciãos dos filhos de Israel.
30 Aaron tell dem wetin God tell Moses and Moses do di mirakles and signs for di pipol front,
30 Arão falou todas as palavras que o Senhor tinha dito a Moisés, e este fez os sinais à vista do povo.
31 so di pipol bilive Moses. Wen dem hear sey God don kom save Israel pipol and E don si as dem dey sofa rish, dem kon bow woship am.
31 E o povo creu; e, tendo ouvido que o Senhor havia visitado os filhos de Israel e lhes vira a aflição, inclinaram-se e o adoraram.
Atalhos do teclado
- Capítulo anterior←
- Próximo capítulo→
- Versículo anteriork
- Próximo versículoj
- Limpar seleçãoEsc
- Esta ajuda?
Estude este capítulo no WhatsApp
Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Êxodo 4, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.