Êxodo 3

Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs VC

Sair da comparação
VC Versão Católica
1 One day wen Moses dey kare for di sheep and goat wey bi en wife papa, Jetro wey bi priest for Midian own, e kon karry di animals go far for anoda side for di wildaness till e rish di holy mountin for Horeb.
1 Moisés apascentava o rebanho de Jetro, seu sogro, sacerdote de Madiã. Um dia em que conduzira o rebanho para além do deserto, chegou até a montanha de Deus, Horeb.
2 Den God angel appear to am like fire for inside di bush. Wen Moses look, e si sey di fire dey katch, but di bush nor dey burn!
2 O anjo do Senhor apareceu-lhe numa chama {que saía} do meio a uma sarça. Moisés olhava: a sarça ardia, mas não se consumia.
3 So Moses tok for en mind sey, “I neva si dis kind tin before. I go waka near kon si why di bush nor dey burn?” Moses si di bush wey dey burn|alt="Moses and di burning bush" src="CO00782B.TIF" size="col" loc="EXO 3:1-3" copy="Cook" ref="3:1-3"
3 "Vou me aproximar, disse ele consigo, para contemplar esse extraordinário espetáculo, e saber porque a sarça não se consome."
4 Wen God si sey Moses don near di bush, E kon koll am, “Moses, Moses!”
4 Vendo o Senhor que ele se aproximou para ver, chamou-o do meio da sarça: "Moisés, Moisés!" "Eis-me aqui!" respondeu ele.
5 God tell am, “Make yu nor waka near dis place. Remove di shoe wey dey yor leg, bikos di groun wey yu stand put so, dey holy.”
5 E Deus: "Não te aproximes daqui. Tira as sandálias dos teus pés, porque o lugar em que te encontras é uma terra santa.
6 E still tell am, “Na mi bi yor papa Abraham, Isaak and Jakob God.” Den Moses hide, bikos e dey fear to look God face.
6 Eu sou, ajuntou ele, o Deus de teu pai, o Deus de Abraão, o Deus de Isaac e o Deus de Jacó". Moisés escondeu o rosto, e não ousava olhar para Deus.
7 God kon tell am, “True-true, I don si how my pipol dey sofa for Egypt. I don hear dia kry for help and I know how dia sofa big rish.
7 O Senhor disse: "Eu vi, eu vi a aflição de meu povo que está no Egito, e ouvi os seus clamores por causa de seus opressores. Sim, eu conheço seus sofrimentos.
8 I don kom diliver dem from Egypt pipol, den karry dem go anoda land wey dey good and big. Di land wey milk and honey dey flow for di aria where Kanaan, Hit, Amor, Periz, Hiv and Jebus pipol dey stay.
8 E desci para livrá-lo da mão dos egípcios e para fazê-lo subir do Egito para uma terra fértil e espaçosa, uma terra que mana leite e mel, lá onde habitam os cananeus, os hiteus, os amorreus, os ferezeus, os heveus e os jebuseus.
9 True-true, Israel pipol kry don rish my ear and I don si how Egypt pipol dey sofa and opress dem.
9 Agora, eis que os clamores dos israelitas chegaram até mim, e vi a opressão que lhes fazem os egípcios.
10 So naw, make yu go, bikos na mi dey send yu go meet Fero and make yu take my pipol Israel, komot from Egypt.”
10 Vai, eu te envio ao faraó para tirar do Egito os israelitas, meu povo".
11 But Moses tell God, “Na who I bi to go meet Fero or to karry Israel pipol komot from Egypt?”
11 Moisés disse a Deus: "Quem sou eu para ir ter com o faraó e tirar do Egito os israelitas?"
12 God ansa am, “True-true, I go dey with yu and dis go bi di sign to show sey na mi send yu: wen yu take di pipol komot from Egypt, yu and dem go kom serve mi for dis mountin.”
12 "Eu estarei contigo, respondeu Deus; e eis aqui um sinal de que sou eu que te envio: quando tiveres tirado o povo do Egito, servireis a Deus sobre esta montanha".
13 But Moses ansa God, “If I go meet Israel pipol kon tell dem, ‘Na una grand-grand papa God send mi kom meet una.’ Den dem ask mi, ‘Wetin bi en name?’ Na wetin I go ansa dem?”
13 Moisés disse a Deus: "Quando eu for para junto dos israelitas e lhes disser que o Deus de seus pais me enviou a eles, que lhes responderei se me perguntarem qual é o seu nome?"
14 God ansa, “I bi Who I bi. Dis na wetin yu go tell dem, ‘Na di God wey bi who E bi send mi kom meet una.’ ”
14 Deus respondeu a Moisés: "EU SOU AQUELE QUE SOU". E ajuntou: "Eis como responderás aos israelitas: {Aquele que se chama} EU SOU envia-me junto de vós."
15 God still tell Moses, “Yu must tell Israel pipol sey, ‘God wey bi una grand-grand papa God; di Pesin wey bi Abraham, Isaak and Jakob God, na-im send mi kom meet una.’ Dis na my name forever and dis na wetin pipol go take remember mi from one generashon go rish anoda.
15 Deus disse ainda a Moisés: "Assim falarás aos israelitas: É JAVÉ, o Deus de vossos pais, o Deus de Abraão, o Deus de Isaac e o Deus de Jacó, quem me envia junto de vós. Este é o meu nome para sempre, e é assim que me chamarão de geração em geração".
16 “So make yu go gada di eldas for Israel kon tell dem sey, ‘God wey bi una grand-grand papa dem, Abraham, Isaak and Jakob God appear to mi kon sey, “I don kom meet una and I si as una dey sofa.
16 "Vai, reúne os anciãos de Israel e dize-lhes: o Senhor, o Deus de vossos pais, o Deus de Abraão, de Isaac e de Jacó apareceu-me. E disse-me: eu vos visitei, e vi o que se vos faz no Egito,
17 I don promise sey na from Egypt where una dey sofa naw, I go for take karry una go take-ova Kanaan, Hit, Amor, Periz, Hiv and Jebus pipol land, di place where milk and honey full.” ’
17 e disse: tirar-vos-ei do Egito onde sois oprimidos, para fazer-vos subir para a terra dos cananeus, dos hiteus, dos amorreus, dos ferezeus, dos heveus e dos jebuseus, terra que mana leite e mel.
18 “Di eldas go agri with yu, so yu and di eldas for Israel must go si Egypt king kon tell am, ‘God, wey bi Hibru pipol God don kom meet us. Naw, make yu allow us travel for three days go inside di wildaness, so dat wi go fit go offa sakrifice give di Oga awa God.’
18 Eles ouvirão a tua voz. Irás então com os anciãos de Israel à presença do rei do Egito e lhe direis: o Senhor, o Deus dos hebreus, nos apareceu. Deixa-nos, pois, ir para o deserto, a três dias de caminho, para oferecer sacrifícios ao Senhor, nosso Deus.
19 “But I know sey Egypt king nor go let una go, unless I force am.
19 Eu sei que o rei do Egito não vos deixará partir, se ele não for obrigado pela força.
20 So I go use my hand skata Egypt with all di wonders wey I go do among dem and afta all doz tins, e go let una go.
20 Mas estenderei a mão e ferirei o Egito com toda sorte de prodígios que farei no meio deles. Depois disso, o faraó vos deixará partir.
21 I go make Egypt pipol favor una, so dat una go karry tins follow body wen una dey komot from di land.
21 Farei com que esse povo ganhe as boas graças dos egípcios, e, quando partirdes, não ireis com as mãos vazias:
22 All di wimen for Israel go ask dia neighbour and Egypt neighbour for gold, silva and fine-fine klot. Una and una shidren go wear dem and like dis, una go finish all di tins wey Egypt pipol get!”
22 cada mulher pedirá à sua vizinha e àquela que mora em sua casa objetos de prata e de ouro, e vestidos que poreis sobre vossos filhos e sobre vossas filhas. Assim despojareis os egípcios."

Ler em outra tradução

Comparar com outra

Estude este capítulo no WhatsApp

Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Êxodo 3, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.