Êxodo 33
Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs VC
1 God tell Moses, “Make yu and di pipol wey yu take komot from Egypt go di land wey I promise Abraham, Isaak and Jakob sey, ‘I go give una shidren-shidren.’
1 O Senhor disse a Moisés: "Vai, parte daqui com o povo que tiraste do Egito; ide para a terra que prometi a Abraão, a Isaac e a Jacó, com o juramento de dá-la à sua posteridade.
2 And I go send one angel go before una rish der kon drive Kanaan, Amor, Hit, Periz, Hiv and Jebus pipol komot der.
2 Enviarei um anjo adiante de ti, e expulsarei os cananeus, os amorreus, os hiteus, os ferezeus, os heveus e os jebuseus.
3 Una dey go di land where milk and honey full. But I nor go dey with una, bikos una bi sturbon pipol and if I travel with una, I fit go distroy una for road.”
3 Ide para essa terra que mana leite e mel. Mas não subirei convosco, porque sois um povo de cabeça dura; eu vos aniquilaria em caminho."
4 Wen di pipol hear dis word, dem kon start to mourn and dem nor gri wear ear-ring or gold again.
4 Ouvindo o povo estas duras palavras, pôs-se a chorar e cada um tirou os seus enfeites.
5 God tell Moses, “Make yu tell Israel pipol sey, ‘Una too sturbon. So, if I go with una, I fit vex distroy una. Naw make una remove all una gold and fine klot, even doh I still dey tink wetin I go do with una.’ ”
5 Então o Senhor disse a Moisés: "Dize aos israelitas: vós sois um povo de cabeça dura; se eu viesse um só instante no meio de vós, eu vos aniquilaria. Arrancai, pois, todos os vossos enfeites e verei o que posso fazer por vós."
6 So from di time wey Israel pipol komot from Mount Horeb, dem nor ever wear gold or ear-ring again.
6 Os israelitas despojaram-se de seus enfeites ao partir do monte Horeb.
7 Moses take di tent kon stand am for outside for di place wey far pass for di kamp and e koll am, “Di tent where dem go for dey meet.” Anybody wey won si God, go-go di tent for outside di kamp.
7 Moisés foi levantar a tenda a alguma distância fora do acampamento. {E chamou-a tenda de reunião.} Quem queria consultar o Senhor, dirigia-se à tenda de reunião, fora do acampamento.
8 Wen Moses go di tent, all di pipol go get up kon stand for di gate for dia tent door and dem go dey look Moses until e enter di tent.
8 Quando Moisés se dirigia para a tenda, todo mundo se levantava, cada um diante da entrada de sua tenda, para segui-lo com os olhos até que entrasse na tenda.
9 Anytime Moses enter di tent, di pila with kloud go kom down kon stand for di gate and God go tok to Moses.
9 E logo que ele acabava de entrar, a coluna de nuvem descia e se punha à entrada da tenda, e o Senhor se entretinha com Moisés.
10 Wen all di pipol si di pila with kloud for di gate, each pesin for en gate go stand up kon woship God.
10 À vista da coluna de nuvem, todo o povo, em pé à entrada de suas tendas, se prostrava no mesmo lugar.
11 God go tok to Moses face-to-face, just as man dey tok to en friend. Den Moses go-go back to di kamp; but en yong savant Joshua wey bi Nun son, nor go komot from di tent.
11 O Senhor se entretinha com Moisés face a face, como um homem fala com seu amigo. Voltava depois Moisés ao acampamento, mas seu ajudante, o jovem Josué, filho de Nun, não se apartava do interior da tenda.
12 Moses kon tell God, “Si, Yu don dey always tell mi sey, ‘Take dis pipol go dat land,’ but Yu neva let mi know who Yu go send follow mi. But Yu sey, ‘I know Yu by yor name and Yu always dey good for my eye.’
12 Moisés disse ao Senhor: "Vós dizeis-me que faça subir o povo, mas não me fazeis saber quem haveis designado para acompanhar-me. E, entretanto, dissestes-me: 'Conheço-te pelo teu nome' e: 'Tens todo o meu favor.'
13 Naw, if really sey I dey good for yor eye, make Yu show mi yor way; so dat I go know Yu more-more kon kontinue to dey good for yor eye. Den I go si sey dis pipol, na yor pipol.”
13 Se é verdade que tenho todo o vosso favor, dai-me a conhecer os vossos desígnios, para que eu saiba que tenho todo o vosso favor; e considerai que esta nação é o vosso povo."
14 God ansa, “My present go-go with yu and I go give yu rest.”
14 O Senhor respondeu: "Minha face irá contigo, e serei o teu guia."
15 Moses sey, “If Yu know sey yor present nor go-go with us, den make Yu nor take us komot from here.
15 "Se vossa face não vier conosco, disse Moisés, não nos façais partir deste lugar.
16 How I go take know sey I dey good for yor eye, both mi and yor pipol, Israel? Nor bi if Yu go with us (dat is, mi and yor pipol), wi go dey difren from all di oda pipol for di world?”
16 Por onde se saberá que temos todo o vosso favor, eu e o vosso povo? Porventura, não é necessário para isso justamente que marcheis conosco? É o que nos distinguirá, eu e o vosso povo, de todas as outras nações da terra."
17 God tell Moses, “I go still do wetin yu tok, bikos yu dey good for my eye and I know yu by yor name.”
17 "O que pedes, replicou o Senhor, fá-lo-ei, porque tens todo o meu favor, e te conheço pelo teu nome."
18 Den Moses sey, “Make Yu show mi yor glory.”
18 Moisés disse: "Mostrai-me vossa glória."
19 God ansa, “I go make all my goodness pass yor front and I go announce my name as Oga God to yu. I go show kindness to who I choose and I go show mesi to who I like show am to.”
19 E Deus respondeu: "Vou fazer passar diante de ti todo o meu esplendor, e pronunciarei diante de ti o nome de Javé. Dou a minha graça a quem quero, e uso de misericórdia com quem me apraz.
20 God still sey, “Yu nor go fit si my face, bikos nobody wey si my face go survive.”
20 Mas, ajuntou o Senhor, não poderás ver a minha face, pois o homem não me poderia ver e continuar a viver.
21 God kon sey, “E get one place near mi where yu fit stand put on-top one rock.
21 Eis um lugar perto de mim, disse o Senhor; tu estarás sobre a rocha.
22 And wen my glory dey pass, I go put yu for where open for di rock kon kover yu with my hand until I don pass.
22 Quando minha glória passar, te porei na fenda da rocha e te cobrirei com a mão, até que eu tenha passado.
23 Den I go take my hand komot and yu go si my back, but yu nor go si my face.”
23 Retirarei depois a mão, e me verás por detrás. Quanto à minha face, ela não pode ser vista".
Atalhos do teclado
- Capítulo anterior←
- Próximo capítulo→
- Versículo anteriork
- Próximo versículoj
- Limpar seleçãoEsc
- Esta ajuda?
Estude este capítulo no WhatsApp
Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Êxodo 33, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.