Êxodo 2

Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs NVI

Sair da comparação
NVI Nova Versão Internacional
1 For dis time, one man from Levi tribe marry one woman wey kom from di same tribe.
1 Um homem da tribo de Levi casou-se com uma mulher da mesma tribo,
2 Di woman get belle kon born boy. Wen e si sey di pikin fine well-well, e kon hide am for three mont,
2 e ela engravidou e deu à luz um filho. Vendo que era bonito, ela o escondeu por três meses.
3 but as e nor fit hide am again, e take basket wey dem make with soft wood kon wrap am, so dat wota nor go enter inside. E put di pikin inside kon put am near di grass dem wey dey River Nile korna.
3 Quando já não podia mais escondê-lo, pegou um cesto feito de junco e o vedou com piche e betume. Colocou nele o menino e deixou o cesto entre os juncos, à margem do Nilo.
4 Di boy sista stand for far dey look, so dat e go si wetin go happen to am.
4 A irmã do menino ficou observando de longe para ver o que lhe aconteceria.
5 Den Fero dota kom di river kon baf and as en savants dey waka for di river korna, at wons di king dota kon si di basket for where di grass dem dey. So e send one among en savants go bring am kom.
5 A filha do faraó descera ao Nilo para tomar banho. Enquanto isso as suas servas andavam pela margem do rio. Nisso viu o cesto entre os juncos e mandou sua criada apanhá-lo.
6 Wen e open di basket, e kon si di boy inside dey kry. Fero dota sorry for di pikin kon sey, “Dis go bi one Hibru woman pikin.”
6 Ao abri-lo viu um bebê chorando. Ficou com pena dele e disse: "Este menino é dos hebreus".
7 Den di pikin sista kon ask Fero dota, “Yu wont make I go find one woman among di Hibru wimen wey go fit kare for dis pikin for yu?”
7 Então a irmã do menino aproximou-se e perguntou à filha do faraó: "A senhora quer que eu vá chamar uma mulher dos hebreus para amamentar e criar o menino? "
8 Fero dota ansa, “Make yu go.” So di yong girl kon go bring di pikin mama kom.
8 "Quero", respondeu ela. E a moça foi chamar a mãe do menino.
9 Fero dota tell di woman, “Go take kare of dis pikin for mi and I go pay yu for di work.” So di pikin mama karry am kon go kare for am.
9 Então a filha do faraó disse à mulher: "Leve este menino e amamente-o para mim, e eu lhe pagarei por isso". A mulher levou o menino e o amamentou.
10 Wen di pikin don big rish, di woman kon karry am go give di king dota as en pikin and e name am, “Moses” bikos e sey, “Na wota I for si am.”
10 Tendo o menino crescido, ela o levou à filha do faraó, que o adotou e lhe deu o nome de Moisés, dizendo: "Porque eu o tirei das águas".
11 Wen Moses don mature, e komot go visit en Hibru pipol. For der, e kon si how en pipol dey sofa, bikos of di work wey dem dey do. Den Moses si as one Egypt man dey beat one Hibru man wey bi en own pesin.
11 Certo dia, sendo Moisés já adulto, foi ao lugar onde estavam os seus irmãos hebreus e descobriu como era pesado o trabalho que realizavam. Viu também um egípcio espancar um dos hebreus.
12 As Moses si sey nobody dey look dem, e attack, kill and beri di Egypt man.
12 Correu o olhar por todos os lados e, não vendo ninguém, matou o egípcio e o escondeu na areia.
13 Wen e kom outside di next day, e si two Hibru men dey fight. So e kon tell di one wey do bad sey, “Wetin make yu dey beat yor broda like dat.”
13 No dia seguinte saiu e viu dois hebreus brigando. Então perguntou ao agressor: "Por que você está espancando o seu companheiro? "
14 Di man ansa, “Who sey make yu kom judge us? Yu dey plan to kill mi as yu take kill dat Egypt man?”
14 O homem respondeu: "Quem o nomeou líder e juiz sobre nós? Quer matar-me como matou o egípcio? " Moisés teve medo e pensou: "Com certeza tudo já foi descoberto! "
15 Wen Fero hear about di matter, e kon dey fine Moses make e kill-am.
15 Quando o faraó soube disso, procurou matar Moisés, mas este fugiu e foi morar na terra de Midiã. Ali assentou-se à beira de um poço.
16 Naw, Midian priest get seven girls wey dey kom draw wota from di well to take feed dia papa animals.
16 Ora, o sacerdote de Midiã tinha sete filhas. Elas foram buscar água para encher os bebedouros e dar de beber ao rebanho de seu pai.
17 So some shepad kom drive di girls komot from di well, but Moses fight for dem kon give dia animals wota.
17 Alguns pastores se aproximaram e começaram a expulsá-las dali; Moisés, porém, veio em auxílio delas e deu água ao rebanho.
18 Wen di girls rish house, Jetro, dia papa kon ask, “Wetin make una kwik kom house today?”
18 Quando as moças voltaram a seu pai Reuel, este lhes perguntou: "Por que voltaram tão cedo hoje? "
19 Dem ansa, “Na one Egypt man save us from doz shepad, den e draw wota for us kon still give di animals drink.”
19 Elas responderam: "Um egípcio defendeu-nos dos pastores e ainda tirou água do poço para nós e deu de beber ao rebanho".
20 Di man ask en dotas, “Na where dis man dey and wetin make una leave am for der? Make una go koll am kom, so dat e go follow us chop today.”
20 "Onde está ele? ", perguntou o pai a elas. "Por que o deixaram lá? Convidem-no para comer conosco. "
21 Moses agri to stay with dem and di man kon give en dota, Zipporah to Moses as en wife.
21 Moisés aceitou e concordou também em morar na casa daquele homem; este lhe deu por mulher sua filha Zípora.
22 Moses wife born boy and Moses koll am, “Gershom” bikos e sey, “Na strenja I bi for dis land.”
22 Ela deu à luz um menino, a quem Moisés deu o nome de Gérson, dizendo: "Sou imigrante em terra estrangeira".
23 Afta sometaim, Egypt king kon die, but Israel pipol still dey kry, bikos dem dey sofa well-well. So dem kry well-well to God for heaven.
23 Muito tempo depois, morreu o rei do Egito. Os israelitas gemiam e clamavam debaixo da escravidão; e o seu clamor subiu até Deus.
24 God hear dia kry and E remember en kovenant wey E make with Abraham, Isaak and Jakob.
24 Ouviu Deus o lamento deles e lembrou-se da aliança que fizera com Abraão, Isaque e Jacó.
25 God si as dem dey sofa, so E kon dey sorry for dem.
25 Deus olhou para os israelitas e viu qual era a situação deles.

Ler em outra tradução

Comparar com outra

Estude este capítulo no WhatsApp

Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Êxodo 2, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.