Êxodo 29

Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs NTLH

Sair da comparação
NTLH Nova Tradução na Linguagem de Hoje 2000
1 “Dis na how yu go take dedikate Aaron and en sons as my priest. Yu go take one yong melu and two ram wey dey okay.
1 O Senhor disse a Moisés: — A fim de separar Arão e os seus filhos como sacerdotes para o meu serviço, faça o seguinte: pegue um touro novo e dois carneiros sem defeito.
2 Den make bread wey nor get yist; kake wey dem mix with olive oil and biscuit wey dem rub with oil kon
2 Pegue farinha de trigo e faça alguns pães com azeite e outros sem azeite, todos sem fermento. Faça também alguns pães achatados e passe azeite em cima.
3 put all of dem inside one basket with di melu and di two ram.
3 Ponha tudo isso numa cesta e ofereça a mim quando você fizer o sacrifício do touro novo e dos dois carneiros.
4 “Yu go bring Aaron and en sons near di door-mot for di tent where dem for dey do meetin kon wosh dem with wota.
4 — Traga Arão e os filhos dele para a entrada da Tenda da Minha Presença e mande que eles se lavem.
5 Di garment wey bi tunik, di priest garment dress, di main priest garment and di breast plate, yu go wear dem for Aaron. Yu go use waistband wey dem weave well-well, take tie di priest garment for en body.
5 Depois vista Arão com as suas roupas de sacerdote, isto é, a túnica , o manto sacerdotal , a sobrepeliz , o peitoral e o cinto que passa pela cintura do manto.
6 Make yu put di priest kap for en head and di holy crown go dey on-top di priest kap.
6 Ponha nele a mitra e amarre nela a placa sagrada em que estão gravadas as palavras “Separado para o Senhor ”.
7 Yu go pour and anoint am with di anointin oil.
7 Em seguida ponha na cabeça dele o azeite de ungir.
8 Den yu go bring en sons kon wear di tunik for dem.
8 — Traga os filhos de Arão e vista túnicas neles.
9 Put sash round dia waist kon wear head-band for dem, so dat dem go serve as priest, just as God kommand dem. Na so yu go take klean Aaron and en sons.
9 Ponha faixas em volta da sua cintura e mitra na sua cabeça. É assim que você consagrará Arão e os seus filhos. Ele e os seus descendentes deverão me servir para sempre como sacerdotes.
10 “Make yu bring di melu kom di tent front where dem for dey do meetin, den Aaron and en sons go put dia hand on-top di melu head.
10 — Traga também o touro novo para a frente da Tenda da Minha Presença, e Arão e os seus filhos porão as mãos na cabeça dele.
11 Dem go kill di melu for where God dey for di tent door-mot where dem for dey do meetin.
11 Mate o touro ali na minha presença, na entrada da Tenda.
12 Yu go take some of di melu blood with yor finger kon put am for di altar horn, den yu go pour di remainin blood under di altar.
12 Depois pegue o sangue do touro e, com o dedo, ponha sobre as pontas do altar e derrame o resto na base do altar.
13 Di fat wey dey inside di intestine; di part wey dey di liver top; di two kidney and dia fat, make yu take dem follow Aaron and en sons, den yu go burn dem for di altar.
13 Em seguida queime no altar, como oferta para mim, as seguintes partes do animal: toda a gordura que cobre os miúdos, a melhor parte do fígado, os dois rins e a gordura que os cobre.
14 But di melu flesh, en skin and en shit, yu go-go burn dem outside di kamp.
14 Mas queime fora do acampamento a carne do animal, o couro e as tripas. Essa é uma oferta para tirar os pecados dos sacerdotes.
15 Yu go take one ram kon sey make Aaron and en sons go put dia hand on-top en head.
15 — Depois pegue um dos carneiros, e Arão e os seus filhos porão as mãos na cabeça dele.
16 Den yu go kill di ram kon rub en blood round di altar.
16 Mate o carneiro, pegue o sangue e com ele borrife os quatro lados do altar.
17 Den yu go kut di ram into pieces, wosh di intestine and en two legs kon put dem on-top en head and di oda part.
17 Corte o carneiro em pedaços, lave os miúdos e as pernas traseiras e ponha em cima da cabeça e dos outros pedaços.
18 Yu go burn all di ram for di altar. Na burnt ofrin to God and Oga God like di smell well-well; bikos na ofrin wey dem make with fire.
18 Queime o carneiro inteiro em cima do altar como uma oferta de alimento. O cheiro dessa oferta me agrada.
19 Yu go take di sekond ram, den Aaron and en sons go put dia hand on-top en head.
19 — Depois pegue o outro carneiro, e Arão e os seus filhos porão as mãos na cabeça dele.
20 Den yu go kill-am, take some of en blood put for di korna for di sons rite ear, di first big finger for dia rite hand and di big toe for dia rite leg, den sprinkol di blood round di altar.
20 Mate esse carneiro e ponha uma parte do sangue dele na ponta da orelha direita de Arão e na ponta da orelha direita dos seus filhos. Também ponha o sangue sobre o dedo polegar da mão direita deles e sobre o dedão do pé direito; e com o resto do sangue borrife os quatro lados do altar.
21 Make yu take some blood wey dey di altar and some anointin oil, den sprinkol dem for Aaron and en sons body, so dat Aaron and en sons with dia garments, go dey holy.
21 Pegue um pouco do sangue que está no altar e o azeite de ungir e com eles borrife Arão, e as suas roupas, e os seus filhos, e as roupas deles. Então ele, os seus filhos e as roupas de todos eles estarão separados para mim.
22 “Since dis na di ram to take santify Aaron and en sons, yu go remove di fat for di tail, di fat for di intestine; di fat for di liver and di fat for di kidney. Yu go still remove di fat for di rite leg from di knee go up.
22 Esse carneiro é oferecido para a ordenação dos sacerdotes. Retire a gordura desse carneiro, o rabo, a gordura que cobre os miúdos, a melhor parte do fígado, os dois rins com a gordura que os cobre e a coxa direita.
23 Make yu take one bread wey get olive oil; anoda one wey nor get and one biscuit from di bread basket wey dem give di Oga awa God.
23 — Da cesta de pães sem fermento que foram oferecidos a mim, pegue um pão de cada tipo: um pão feito com azeite, outro pão sem azeite e um pão achatado.
24 Yu go put all dis tins for Aaron and en sons hand kon karry dem as special ofrin go give awa God.
24 Ponha esses pães nas mãos de Arão e dos filhos dele e faça com que eles os separem para mim como oferta especial.
25 Den yu go take di bread from dia hand kon burn dem for di altar as ofrin wey get betta smell to God.
25 Depois pegue os pães das suas mãos e queime em cima do altar, como alimento oferecido a mim. O cheiro dessa oferta me agrada.
26 Di ram wey yu use take klean Aaron, make yu take di breast kon karry am as betta ofrin to God and e go bi yor share.
26 Pegue o peito do carneiro e o separe para mim como oferta especial. Essa parte do animal ficará para você.
27 “Make yu keep di part for di ram wey bilong to Aaron and en sons and na di breast and di lap wey dem karry give God as holy ofrin.
27 — Na cerimônia de ordenação de um sacerdote, o peito e a coxa do carneiro deverão ser separados para mim como oferta especial e deverão ser dados para os sacerdotes.
28 Anytin Israel pipol give God as dia peace ofrin, go bi Aaron and en sons share and nobody go shange dis law.
28 As ofertas de paz dos israelitas serão feitas assim, para sempre. O peito e a coxa do animal pertencem aos sacerdotes. Essa é a oferta do povo para mim, o Senhor .
29 “Dem go take Aaron holy garment give en pikin afta en don die, so dat dem go anoint and make di pikin dey klean.
29 — Depois da morte do sacerdote Arão, as suas roupas passarão para os seus filhos, e eles as usarão quando forem ordenados.
30 Anybody wey go take-ova from Aaron as priest among en sons, go wear di garment for seven days as e dey serve for di Tabanako and di Holy Place.
30 O filho de Arão que ficar no lugar dele como sacerdote e que entrar na Tenda da Minha Presença para servir no Lugar Santo deverá usar essas roupas sete dias.
31 “Yu go take di ram kon kook en flesh for di Holy Place.
31 — A carne do carneiro usado na ordenação de Arão e dos seus filhos deverá ser cozida num lugar sagrado.
32 Aaron and en sons go chop di ram meat and di bread wey dey inside di basket for di door-mot for di tent where dem for dey do meetin.
32 Na entrada da Tenda da Minha Presença eles deverão comer essa carne com o pão que ficar na cesta.
33 Na dem go still chop di bread and meat wey dem take klean and santify dem. No oda pesin go chop from dem, bikos di food dey holy.
33 Quando eles forem ordenados, comerão o que foi oferecido como sacrifício para tirar os seus pecados. Somente os sacerdotes poderão comer esse alimento, pois ele é sagrado.
34 And if any of di ofrin meat or di bread remain till morning, den yu go burn wetin remain with fire. Nobody must chop am, bikos e dey holy.
34 Por isso a carne ou o pão que não forem comidos naquele mesmo dia deverão ser queimados. Não deverão ser comidos, pois são sagrados.
35 “Yu go anoint Aaron and en sons for seven days, just as I kommand yu.
35 — Conforme eu mandei, faça durante sete dias as cerimônias para ordenar Arão e os seus filhos.
36 Evriday, yu go prepare one melu as sin ofrin to klean dem. Yu go make sakrifice for di altar to klean am and yu go anoint and santify am.
36 Cada dia ofereça um touro novo como sacrifício para conseguir o perdão dos pecados de todos. Com um sacrifício para tirar pecados você purificará o altar e depois o ungirá a fim de torná-lo santo.
37 For seven days, yu go make sakrifice for di altar kon santify am, den di altar go dey holy and anytin wey tosh di altar, go dey holy too.
37 Faça isso todos os dias, durante sete dias. Então o altar ficará completamente santo, e qualquer pessoa ou coisa que tocar nele sofrerá por causa do poder da sua santidade.
38 “Naw, dis na wetin yu go prepare for di altar evriday: two lamb wey bi one year old.
38 — Todos os dias, e para sempre, sacrifique dois carneirinhos de um ano.
39 Yu go prepare one among di lamb for morning and di sekond lamb, for evening.
39 Sacrifique um deles de manhã e o outro à tarde.
40 Dis na di tin wey yu go offa give mi with di first lamb: yu go offa am with di Tabanako efah wey get fine flower wey dem mix with one kwota of oil wey dem press komot from some olives and one kwota of wine as drink ofrin.
40 Junto com o primeiro carneirinho ofereça um quilo de farinha de trigo misturada com um litro de azeite. E, como oferta, derrame um litro de vinho.
41 Den di sekond lamb wey yu go offa for evening; yu go prepare am like di morning own, with drink ofrin wey get betta smell; ofrin wey dem make with fire for God.
41 À tarde ofereça outro carneirinho e junto com ele a mesma quantidade de farinha, azeite e vinho, como de manhã. Essa é uma oferta de alimento trazida para mim, o Senhor , e o seu cheiro me agrada.
42 “Dis one go bi burnt ofrin for God and dem go dey do am evritime for di Tabanako door-mot where dem for dey do meetin thru-out una generashon; bikos na dat place I go for meet and tok to yu.
42 E essa oferta a ser queimada deve ser oferecida para sempre na minha presença, na entrada da Tenda da Minha Presença . Ali eu me encontrarei com o meu povo e falarei com você.
43 I go meet Israel pipol for der too, bikos my present wey karry glory don make am holy.
43 Ali me encontrarei com o povo de Israel, e a minha glória fará com que esse lugar fique santo.
44 I go santify di tent where dem for dey do meetin, di altar, Aaron and en sons, so dat dem go fit serve mi as priest.
44 Eu farei com que a Tenda e o altar fiquem santos e separarei Arão e os seus filhos para me servirem como sacerdotes.
45 I go stay with Israel pipol and I go bi dia God.
45 Morarei no meio do povo de Israel e serei o Deus deles.
46 Den dem go know sey na mi bi dia God, wey take dem komot from Egypt, so dat I go fit stay with dem. Na mi bi di Oga wey bi dia God.”
46 Eles ficarão sabendo que eu, o Senhor , sou o Deus que os tirou do Egito para morar entre eles. Eu sou o Senhor , o Deus deles.

Ler em outra tradução

Comparar com outra

Estude este capítulo no WhatsApp

Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Êxodo 29, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.