Êxodo 24

Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs NVI

Sair da comparação
NVI Nova Versão Internacional
1 Den God tell Moses, “Make yu klimb kom meet mi; both yu, Aaron, Nadab, Abihu and di seventy eldas for Israel and wen una still dey far from where I dey, make una bow woship mi.
1 Depois Deus disse a Moisés: "Subam o monte para encontrar-se com o Senhor, você e Arão, Nadabe e Abiú, e setenta autoridades de Israel. Adorem à distância.
2 Na only Moses go kom near mi, but make di odas nor kom near and make di rest pipol nor klimb with am.”
2 Somente Moisés se aproximará do Senhor; os outros não. O povo também não subirá com ele".
3 So Moses tell di pipol wetin God tok and di pipol ansa, “Wi dey ready to do evritin wey di Oga awa God kommand.”
3 Quando Moisés se dirigiu ao povo e transmitiu-lhes todas as palavras e ordenanças do Senhor, eles responderam em uníssono: "Faremos tudo o que o Senhor ordenou".
4 Den Moses rite di word wey God tok. For early morning, e build altar for under di mountin kon arrange and stand twelf stones; one for each of di twelf tribes.
4 Moisés, então, escreveu tudo o que o Senhor dissera. Na manhã seguinte Moisés levantou-se, construiu um altar ao pé do monte e ergueu doze colunas de pedra, representando as doze tribos de Israel.
5 E send some yong Israel men and dem go offa burn ofrin kon sakrifice one yong melu as peace ofrin to God.
5 Em seguida enviou jovens israelitas, que ofereceram holocaustos e novilhos como sacrifícios de comunhão ao Senhor.
6 Moses take half of di blood, pour am inside some basin, den e sprinkol di remainin half on-top di altar.
6 Moisés colocou metade do sangue em tigelas e a outra metade derramou sobre o altar.
7 So e take di Kovenant Book kon read am make all di pipol hear and dem sey, “Wi dey ready to do and obey all di word wey di Oga awa God tok.”
7 Em seguida, leu o Livro da Aliança para o povo, e eles disseram: "Faremos fielmente tudo o que o Senhor ordenou".
8 So Moses take di blood and e sprinkol am for di pipol body kon sey, “Dis na di kovenant blood wey God don make with una akordin to dis word.”
8 Depois Moisés aspergiu o sangue sobre o povo, dizendo: "Este é o sangue da aliança que o Senhor fez com vocês de acordo com todas essas palavras".
9 Moses and Aaron, Nadab and Abihu and di seventy eldas for Israel kon go di mountin
9 Moisés, Arão, Nadabe, Abiú e setenta autoridades de Israel subiram
10 and dem si Israel God. Sometin wey bi like karpet wey dem take safaya stone make dey under en leg and e klear like sky.
10 e viram o Deus de Israel, sob cujos pés havia algo semelhante a um pavimento de safira, como o céu em seu esplendor.
11 But God nor distroy Israel leaders even doh dem si am kon chop and drink for en present.
11 Deus, porém, não estendeu a mão para punir esses líderes do povo de Israel; eles viram a Deus, e depois comeram e beberam.
12 Den God tell Moses, “Make yu klimb di mountin and I go give yu di law and kommand wey I rite for small flat stone, so dat yu go fit tish di pipol.”
12 Disse o Senhor a Moisés: "Suba a mim, ao monte, e fique aqui; e lhe darei as tábuas de pedra com a lei e os mandamentos que escrevi para a instrução do povo".
13 So Moses and Joshua wey dey follow am kon go di mountin, den Moses klimb go meet God.
13 Moisés partiu com Josué, seu auxiliar, e subiu ao monte de Deus.
14 Before Moses go, e tell di eldas sey, “Make una wait for mi for here, until I go kom back. Aaron and Hur dey with una. Anybody wey get matter against anoda pesin, make e go meet dem and dem go setol am.”
14 Disse ele às autoridades de Israel: "Esperem-nos aqui, até que retornemos. Arão e Hur ficarão com vocês; quem tiver alguma questão para resolver, poderá procurá-los".
15 Moses klimb go di mountin wey di kloud kover.
15 Quando Moisés subiu, a nuvem cobriu o monte,
16 God glory dey on-top Mount Sinai and di kloud kover am for six days. For di sevent day, God kon koll Moses from inside di kloud.
16 e a glória do Senhor permaneceu sobre o monte Sinai. Durante seis dias a nuvem cobriu o monte. No sétimo dia o Senhor chamou Moisés do interior da nuvem.
17 From where di pipol dey, dem si God glory on-top di mountin like fire wey dey burn.
17 Aos olhos dos israelitas a glória do Senhor parecia um fogo consumidor no topo do monte.
18 Moses enter inside di kloud wen e klimb di mountin and e stay der for forty days and forty nites.
18 Moisés entrou na nuvem e foi subindo o monte. E permaneceu no monte quarenta dias e quarenta noites.

Ler em outra tradução

Comparar com outra

Estude este capítulo no WhatsApp

Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Êxodo 24, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.