Êxodo 23
Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs ACF
1 “Make una nor dey tok wetin una eye nor si. Make una nor join wiked pipol lie for pesin head.
1 Não admitirás falso boato, e não porás a tua mão com o ímpio, para seres testemunha falsa.
2 “Make una nor follow pipol do wiked tins; for inside yard, make una nor tok wetin una eye nor si, bikos plenty pipol dey tok am to take win dia kase
2 Não seguirás a multidão para fazeres o mal; nem numa demanda falarás, tomando parte com a maioria para torcer o direito.
3 and make una nor lie against poor pesin for kourt.
3 Nem ao pobre favorecerás na sua demanda.
4 “If una si una enemy melu or donkey wey waka lost, make una do evritin to make sure sey una return am to di owner.
4 Se encontrares o boi do teu inimigo, ou o seu jumento, desgarrado, sem falta lho reconduzirás.
5 Pesin wey hate una, if una si en donkey dey struggol bikos of di load wey e karry, make una nor waka pass, but make una help am.
5 Se vires o jumento, daquele que te odeia, caído debaixo da sua carga, deixarás pois de ajudá-lo? Certamente o ajudarás a levantá-lo.
6 “Make una nor give bad judgement to poor pesin for kourt.
6 Não perverterás o direito do teu pobre na sua demanda.
7 “Make una nor akuiz pesin for wetin e nor do and make una nor kill good pesin, bikos I nor go free anybody wey do like dat.
7 De palavras de falsidade te afastarás, e não matarás o inocente e o justo; porque não justificarei o ímpio.
8 “Make una nor take bribe, bikos bribe dey blind pesin eye and spoil good pipol.
8 Também suborno não tomarás; porque o suborno cega os que têm vista, e perverte as palavras dos justos.
9 “Make una nor sofa or opress strenjas wey dey stay with una. Unasef know wetin e mean to bi strenja, bikos una bi strenja before for Egypt.
9 Também não oprimirás o estrangeiro; pois vós conheceis o coração do estrangeiro, pois fostes estrangeiros na terra do Egito.
10 “For six years, make una plant and harvest wetin una plant.
10 Também seis anos semearás tua terra, e recolherás os seus frutos;
11 But for di sevent year, una must allow di land rest and make una leave am, so dat poor pipol wey dey with una, go chop wetin grow for di land and di animals go chop wetin remain. Una must still do like dis for una vineyard and olive farm.
11 Mas ao sétimo a dispensarás e deixarás descansar, para que possam comer os pobres do teu povo, e da sobra comam os animais do campo. Assim farás com a tua vinha e com o teu olival.
12 “Una go work for six days, but make una nor work for di sevent day, so dat una melu, donkey, slave and strenjas wey dey work for una, go rest.
12 Seis dias farás os teus trabalhos, mas ao sétimo dia descansarás; para que descanse o teu boi, e o teu jumento; e para que tome alento o filho da tua escrava, e o estrangeiro.
13 “Make una do evritin wey I tell una and una nor go pray or swear to any oda god. Make I nor ever hear dia name for una mout.
13 E em tudo o que vos tenho dito, guardai-vos; e do nome de outros deuses nem vos lembreis, nem se ouça da vossa boca.
14 “Evry year, una go celebrate three times to take honor mi.
14 Três vezes no ano me celebrareis festa.
15 For di mont wey dem dey koll Abib, una go celebrate di bread wey nor get yist feast and for seven days, una go dey chop bread wey nor get yist, just as I kommand una wen una komot from Egypt. Nobody go kom meet mi with empty hand.
15 A festa dos pães ázimos guardarás; sete dias comerás pães ázimos, como te tenho ordenado, ao tempo apontado no mês de Abibe; porque nele saíste do Egito; e ninguém apareça vazio perante mim;
16 Make una still celebrate Harvest Feast wey bi di first fruit from evritin wey una plant for una land. Una go still celebrate Tanksgivin Feast wey bi di Shelta Feast wen di year end and for dis time, una go don gada all una harvest from di farm.
16 E a festa da sega dos primeiros frutos do teu trabalho, que houveres semeado no campo, e a festa da colheita, à saída do ano, quando tiveres colhido do campo o teu trabalho.
17 Three times for di year, all doz wey bi man go-go meet di Oga dia God.
17 Três vezes no ano todos os teus homens aparecerão diante do Senhor DEUS.
18 “Make una nor offa my sakrifice blood with bread wey get yist. And di animal fat wey dem sakrifice, must nor remain till di next morning.
18 Não oferecerás o sangue do meu sacrifício com pão levedado; nem ficará a gordura da minha festa de noite até pela manhã.
19 “Una must bring di first fruit wey una harvest from una farm to di Oga una God house.
19 As primícias dos primeiros frutos da tua terra trarás à casa do Senhor teu Deus; não cozerás o cabrito no leite de sua mãe.
20 “I go send one angel wey go protet una for front as una dey go and e go bring una kom di place wey I don prepare for una.
20 Eis que eu envio um anjo diante de ti, para que te guarde pelo caminho, e te leve ao lugar que te tenho preparado.
21 Make una listin and obey en vois; make una nor disobey am, bikos e nor go forgive una sins and e dey ansa my name too.
21 Guarda-te diante dele, e ouve a sua voz, e não o provoques à ira; porque não perdoará a vossa rebeldia; porque o meu nome está nele.
22 But if una obey am kon do all di tins wey I tell una, den I go bi enemy to doz wey bi una enemies and I go fight doz wey dey fight against una.
22 Mas se diligentemente ouvires a sua voz, e fizeres tudo o que eu disser, então serei inimigo dos teus inimigos, e adversário dos teus adversários.
23 My angel go-go for una front till una rish Amor, Hit, Periz, Kanaan, Hiv and Jebus pipol land and I go distroy dem for una.
23 Porque o meu anjo irá adiante de ti, e te levará aos amorreus, e aos heteus, e aos perizeus, e aos cananeus, heveus e jebuseus; e eu os destruirei.
24 Make una nor bow or serve dia gods kon do wetin dem dey do. But una must distroy dem finish kon skata dia juju to pieces.
24 Não te inclinarás diante dos seus deuses, nem os servirás, nem farás conforme às suas obras; antes os destruirás totalmente, e quebrarás de todo as suas estátuas.
25 “If una serve di Oga una God, E go bless una bread and wota kon remove all una sickness.
25 E servireis ao Senhor vosso Deus, e ele abençoará o vosso pão e a vossa água; e eu tirarei do meio de vós as enfermidades.
26 Evry woman go get shidren and doz wey get belle for una land, go must born pikin and una go get long life.
26 Não haverá mulher que aborte, nem estéril na tua terra; o número dos teus dias cumprirei.
27 “I go put my fear for inside doz wey una go fight kon distroy dem; I go make all una enemies run from una.
27 Enviarei o meu terror adiante de ti, destruindo a todo o povo aonde entrares, e farei que todos os teus inimigos te voltem as costas.
28 I go send fear like ant go drive Hiv, Kanaan and Hit pipol komot before una go rish der.
28 Também enviarei vespões adiante de ti, que lancem fora os heveus, os cananeus, e os heteus de diante de ti.
29 I nor go take one year drive all of dem komot, so dat di land nor go turn to wildaness and wild animals nor go plenty for der.
29 Não os lançarei fora de diante de ti num só ano, para que a terra não se torne em deserto, e as feras do campo não se multipliquem contra ti.
30 Na small-small I go take drive dem komot until una go plenty kon take-ova.
30 Pouco a pouco os lançarei de diante de ti, até que sejas multiplicado, e possuas a terra por herança.
31 Una land go start from di Red Sea go rish Filistia pipol sea and from di wildaness go rish di river. I go give una di pipol wey dey di land and una go drive dem komot from der.
31 E porei os teus termos desde o Mar Vermelho até ao mar dos filisteus, e desde o deserto até ao rio; porque darei nas tuas mãos os moradores da terra, para que os lances fora de diante de ti.
32 “Make una nor enter kovenant with dem or with dia gods.
32 Não farás aliança alguma com eles, ou com os seus deuses.
33 Make dem nor stay una land, so dat dem nor go make una sin against mi, bikos if una serve dia gods, I go distroy una.”
33 Na tua terra não habitarão, para que não te façam pecar contra mim; se servires aos seus deuses, certamente isso será um laço para ti.
Atalhos do teclado
- Capítulo anterior←
- Próximo capítulo→
- Versículo anteriork
- Próximo versículoj
- Limpar seleçãoEsc
- Esta ajuda?
Estude este capítulo no WhatsApp
Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Êxodo 23, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.