Êxodo 22
Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs NVI
1 “If pesin tif one melu or sheep kon kill or sell am, e must use five kattle take pay for di melu and four sheep, for di sheep wey e sell or kill.
1 "Se alguém roubar um boi ou uma ovelha e abatê-lo ou vendê-lo, terá que restituir cinco bois pelo boi e quatro ovelhas pela ovelha.
2 “If dem katch tif dey enter pesin house kon nak am die, en blood nor go dey anybody head.
2 "Se o ladrão que for pego arrombando for ferido e morrer, quem o feriu não será culpado de homicídio,
3 “But if na for day time dem kill di tif, di tif blood go dey who kill-am head.
3 mas se isso acontecer depois do nascer do sol, será culpado de homicídio. "Um ladrão terá que restituir o que roubou, mas se não tiver nada, será vendido para pagar o roubo.
4 If dem si wetin e tif for en hand; weda na melu, donkey or sheep and di animal neva die, di tif must pay doubol.
4 Se o que foi roubado for encontrado vivo em seu poder, seja boi, seja jumento, seja ovelha, ele deverá restituí-lo em dobro.
5 “Anybody wey allow en animals wey dey chop grass for field go chop wetin anoda man plant for en farm, e must pay back with wetin good pass for en own farm.
5 "Se alguém levar seu rebanho para pastar num campo ou numa vinha e soltá-lo de modo que venha a pastar no campo de outro homem, fará restituição com o melhor do seu campo ou da sua vinha.
6 “If fire dey burn for pesin farm kon spread and distroy plant for anoda pesin farm, di pesin wey start di fire go pay evritin wey distroy.
6 "Se um fogo se espalhar e alcançar os espinheiros, e queimar os feixes colhidos ou o trigo plantado ou até a lavoura toda, aquele que iniciou o incêndio restituirá o prejuízo.
7 “If pesin give en neighbour money or propaty to keep for am and dem kon tif di tin for di man house, if dem katch di tif, e must pay doubol.
7 "Se alguém entregar ao seu próximo prata ou bens para serem guardados e estes forem roubados da casa deste, o ladrão, se for encontrado, terá que restituí-los em dobro.
8 But if dem nor katch di tif, den di owner of di house go-go stand make dem judge am, weda naim take en neighbour propaty.
8 Mas se o ladrão não for encontrado, o dono da casa terá que comparecer perante os juízes para que se determine se ele não lançou mão dos bens do outro.
9 “If two pipol dey drag propaty, weda na melu, donkey, sheep, dress or any kind tin wey lost, di two of dem go kom meet di judge and anybody wey dem sey dey guilty, go pay doubol.
9 Sempre que alguém se apossar de boi, jumento, ovelha, roupa ou qualquer outro bem perdido, mas alguém disser: ‘Isto me pertence’, as duas partes envolvidas levarão o caso aos juízes. Aquele a quem os juízes declararem culpado restituirá o dobro ao seu próximo.
10 “If pesin give en neighbour one donkey, melu, sheep or any oda animal to keep for am and e kon die, wound or pesin tif am and e nor know,
10 "Se alguém der ao seu próximo o seu jumento, ou boi, ou ovelha ou qualquer outro animal para ser guardado, e o animal morrer, for ferido ou for levado, sem que ninguém o veja,
11 di neighbour must swear to God sey, e nor get hand for di matter and di owner go asept en word and e nor go pay anytin.
11 a questão entre eles será resolvida prestando-se um juramento diante do Senhor de que um não lançou mão da propriedade do outro. O dono terá que aceitar isso e nenhuma restituição será exigida.
12 But if dem tif am from am, e must pay di owner back.
12 Mas se o animal tiver sido roubado do seu próximo, este terá que fazer restituição ao dono.
13 If na wiked animal kill-am, di man go bring di meat pieces wey skata for groun to show and klear ensef and e nor go pay anytin.
13 Se tiver sido despedaçado por um animal selvagem, ele trará como prova o que restou dele; e não terá que fazer restituição.
14 “If pesin borrow animal from en neighbour and e kon wound or die wen di owner nor dey with am, di man must pay back.
14 "Se alguém pedir emprestado ao seu próximo um animal, e este for ferido ou morrer na ausência do dono, terá que fazer restituição.
15 If di owner dey with am, di man nor go pay anytin, bikos wetin e pay take hire am kover di money.
15 Mas se o dono estiver presente, o que tomou emprestado não terá que restituí-lo. Se o animal tiver sido alugado, o preço do aluguel cobrirá a perda.
16 “If pesin deceive girl wey neva no man and e kon sleep with am, e must pay di bride prize kon marry di girl.
16 "Se um homem seduzir uma virgem que ainda não tenha compromisso de casamento e deitar-se com ela, terá que pagar o preço do seu dote, e ela será sua mulher.
17 But if di girl papa nor gri gi-am to di man, di man must pay di prize wey dem dey pay for woman wey neva sleep with man before.
17 Mas se o pai recusar-se a entregá-la, ainda assim o homem terá que pagar o equivalente ao dote das virgens.
18 “Make una nor allow witch live.
18 "Não deixem viver a feiticeira.
19 “Anybody wey follow animal sleep, dem must kill-am.
19 "Todo aquele que tiver relações sexuais com animal terá que ser executado.
20 “Anybody wey sakrifice give anoda god wey nor bi di Oga awa God, dem must distroy am.
20 "Quem oferecer sacrifício a qualquer outro deus, e não unicamente ao Senhor, será destruído.
21 “Make una nor sofa or opress strenja, bikos una bi strenja before for Egypt.
21 "Não maltratem nem oprimam o estrangeiro, pois vocês foram estrangeiros no Egito.
22 “Make una nor sofa wimen wey dia husband don die or shidren wey nor get papa and mama.
22 "Não prejudiquem as viúvas nem os órfãos;
23 If una sofa dem and dem kry kom meet mi, I go listin to dem.
23 porque se o fizerem, e eles clamarem a mim, eu certamente atenderei ao seu clamor.
24 I go vex and kill una with swod and una wifes go turn who nor get husband again; una pikin nor go get papa too.
24 Com grande ira matarei vocês à espada; suas mulheres ficarão viúvas e seus filhos, órfãos.
25 “If una borrow money give poor pipol wey dey among una, make una nor do like sey una borrow money and make una nor add join di money wen dem won pay back.
25 "Se fizerem empréstimo a alguém do meu povo, a algum necessitado que viva entre vocês, não cobrem juros dele; não emprestem visando lucro.
26 If una take una neighbour klot as shorti, una must return am gi-am for evening,
26 Se tomarem como garantia o manto do seu próximo, devolvam-no até o pôr-do-sol,
27 bikos dat na di only klot wey una neighbour get to wear, so dat kold nor go katch am. E get any oda klot wey e go take sleep? And wen e kry kon meet mi, I go listin to am, bikos I dey pity for pesin well-well.
27 porque o manto é a única coberta que ele possui para o corpo. Em que mais se deitaria? Quando ele clamar a mim, eu o ouvirei, pois sou misericordioso.
28 “Make una nor tok bad about God or curse who dey rule una.
28 "Não blasfemem contra Deus nem amaldiçoem uma autoridade do seu povo.
29 “Make una give mi una plant and wine ofrin.
29 "Não retenham as ofertas de suas colheitas. "Consagrem-me o primeiro filho de vocês
30 “Una go still do like dis for una animals; dem fit dey with dia mama for seven days, but una go give dem to mi for di eight day.
30 e a primeira cria das vacas, das ovelhas e das cabras. Durante sete dias a cria ficará com a mãe, mas, no oitavo dia, entreguem-na a mim.
31 “Una go bi my holy pipol, so make una nor chop any animal wey anoda animal kill for bush. Una must trow di animal meat give dogs.
31 "Vocês serão meu povo santo. Não comam a carne de nenhum animal despedaçado por feras no campo; joguem-na aos cães. "
Atalhos do teclado
- Capítulo anterior←
- Próximo capítulo→
- Versículo anteriork
- Próximo versículoj
- Limpar seleçãoEsc
- Esta ajuda?
Estude este capítulo no WhatsApp
Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Êxodo 22, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.