Êxodo 20
Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs ARA
1 God kon sey:
1 Então, falou Deus todas estas palavras:
2 “Na mi bi di Oga una God wey take una komot from Egypt, where una for bi slave.
2 Eu sou o Senhor , teu Deus, que te tirei da terra do Egito, da casa da servidão.
3 Make una nor serve any oda God apart from mi.
3 Não terás outros deuses diante de mim.
4 Make una nor do any image like wetin dey heaven, eart or inside wota.
4 Não farás para ti imagem de escultura, nem semelhança alguma do que há em cima nos céus, nem embaixo na terra, nem nas águas debaixo da terra.
5 Make una nor bow or serve dem, bikos na mi bi di Oga una God and I dey jealous well-well. I bi God wey dey ponish shidren and dia shidren-shidren, bikos dia papa Rijet mi.
5 Não as adorarás, nem lhes darás culto; porque eu sou o Senhor , teu Deus, Deus zeloso, que visito a iniquidade dos pais nos filhos até à terceira e quarta geração daqueles que me aborrecem
6 But I go show my love to many generashon, bikos dem love and keep my kommand.
6 e faço misericórdia até mil gerações daqueles que me amam e guardam os meus mandamentos.
7 Make una nor use di Oga una God name take make yeye, bikos I go ponish anybody wey do like dat.
7 Não tomarás o nome do Senhor , teu Deus, em vão, porque o Senhor não terá por inocente o que tomar o seu nome em vão.
8 Make una remember to keep di Sabat Day holy.
8 Lembra-te do dia de sábado, para o santificar.
9 Una get six days to do all una work,
9 Seis dias trabalharás e farás toda a tua obra.
10 but for di sevent day wey bi di Oga una God Sabat Day, make nobody do any work; both una, una shidren, una savants, una animals or di strenjas for una kountry.
10 Mas o sétimo dia é o sábado do Senhor , teu Deus; não farás nenhum trabalho, nem tu, nem o teu filho, nem a tua filha, nem o teu servo, nem a tua serva, nem o teu animal, nem o forasteiro das tuas portas para dentro;
11 Bikos na six days God take make heaven, eart and all di tins wey dey inside dem and E rest for di sevent day. So God bless di Sabat Day kon make am holy.
11 porque, em seis dias, fez o Senhor os céus e a terra, o mar e tudo o que neles há e, ao sétimo dia, descansou; por isso, o Senhor abençoou o dia de sábado e o santificou.
12 Shidren! Make una respet una papa and mama, so dat una days for di land wey di Oga una God dey give una, go long well-well.
12 Honra teu pai e tua mãe, para que se prolonguem os teus dias na terra que o Senhor , teu Deus, te dá.
13 Make una nor kill.
13 Não matarás.
14 Make una nor sleep with who nor bi una husband or wife.
14 Não adulterarás.
15 Make una nor tif.
15 Não furtarás.
16 Make una nor lie for una neighbour head.
16 Não dirás falso testemunho contra o teu próximo.
17 Make una nor get long-trot for una neighbour propaty; en wife, savants, melu, donkey or anytin wey bi en own.”
17 Não cobiçarás a casa do teu próximo. Não cobiçarás a mulher do teu próximo, nem o seu servo, nem a sua serva, nem o seu boi, nem o seu jumento, nem coisa alguma que pertença ao teu próximo.
18 Den di pipol si di tonda and di lite. Dem hear di horn sound kon si di mountin wey smoke kover and wen di pipol si all dis tins, fear katch dem, so dem kon waka far from di place.
18 Todo o povo presenciou os trovões, e os relâmpagos, e o clangor da trombeta, e o monte fumegante; e o povo, observando, se estremeceu e ficou de longe.
19 Dem kon tell Moses, “Make yu tok to us and wi go listin, but make yu nor let God tok to us, so dat wi nor go die.”
19 Disseram a Moisés: Fala-nos tu, e te ouviremos; porém não fale Deus conosco, para que não morramos.
20 Moses tell di pipol, “Make una nor fear, God just kom test una, so dat una go fear and always dey obey en kommand.”
20 Respondeu Moisés ao povo: Não temais; Deus veio para vos provar e para que o seu temor esteja diante de vós, a fim de que não pequeis.
21 Di pipol stay far from di place, but Moses waka near di tick kloud, where God dey.
21 O povo estava de longe, em pé; Moisés, porém, se chegou à nuvem escura onde Deus estava.
22 God tell Moses, “Make yu go tell Israel pipol: ‘Una don si by unasef sey, I dey tok to una from heaven.
22 Então, disse o Senhor a Moisés: Assim dirás aos filhos de Israel: Vistes que dos céus eu vos falei.
23 So make una nor use silva or gold take make any oda god join mi.
23 Não fareis deuses de prata ao lado de mim, nem deuses de ouro fareis para vós outros.
24 “ ‘Make una use mud build altar for mi kon sakrifice una animals and do peace ofrins for mi. Anywhere wey una for honor my name, I go kom meet and bless una for der.
24 Um altar de terra me farás e sobre ele sacrificarás os teus holocaustos, as tuas ofertas pacíficas, as tuas ovelhas e os teus bois; em todo lugar onde eu fizer celebrar a memória do meu nome, virei a ti e te abençoarei.
25 And if una take stone build altar for mi, una must nor use stone wey dem kut, bikos if una kut di stones, una don spoil di altar bi dat.
25 Se me levantares um altar de pedras, não o farás de pedras lavradas; pois, se sobre ele manejares a tua ferramenta, profaná-lo-ás.
26 Make una nor build altar wey get step, so dat nobody go si una nakednes wen una dey klimb kon offa sakrifice give mi.’ ”
26 Nem subirás por degrau ao meu altar, para que a tua nudez não seja ali exposta.
Atalhos do teclado
- Capítulo anterior←
- Próximo capítulo→
- Versículo anteriork
- Próximo versículoj
- Limpar seleçãoEsc
- Esta ajuda?
Estude este capítulo no WhatsApp
Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Êxodo 20, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.