Êxodo 19
Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs NVI
1 Israel pipol rish Sinai Wildaness for di first day for di third mont afta dem komot from Egypt.
1 No dia em que se completaram três meses que os israelitas haviam saído do Egito, chegaram ao deserto do Sinai.
2 Afta dem travel komot from Refidim, dem rish Sinai Wildaness kon stay for di mountin front.
2 Depois de saírem de Refidim, entraram no deserto do Sinai, e Israel acampou ali, diante do monte.
3 God koll Moses from di mountin kon tell am, “Dis na wetin yu go tell Jakob house and Israel pipol:
3 Logo Moisés subiu o monte para encontrar-se com Deus. E o Senhor o chamou do monte, dizendo: "Diga o seguinte aos descendentes de Jacó e declare aos israelitas:
4 ‘Una don si wetin I do Egypt pipol. Una si as I take karry una for eagle feada kon bring una kom meet mi.
4 ‘Vocês viram o que fiz ao Egito e como os transportei sobre asas de águias e os trouxe para junto de mim.
5 And naw, if una go obey and keep my kovenant, una go bi special pipol wey I selet from di oda pipol for dis world, bikos na mi get di whole world.
5 Agora, se me obedecerem fielmente e guardarem a minha aliança, vocês serão o meu tesouro pessoal dentre todas as nações. Embora toda a terra seja minha,
6 Una go bi my kingdom priests and holy nashon wey dem dedikate give mi.’ Dis na wetin yu go tell Israel pipol.”
6 vocês serão para mim um reino de sacerdotes e uma nação santa’. Essas são as palavras que você dirá aos israelitas".
7 So Moses koll all di eldas for Israel kon tell dem wetin Oga God kommand am.
7 Moisés voltou, convocou as autoridades do povo e lhes expôs tudo o que o Senhor havia-lhe mandado falar.
8 All di pipol ansa, “Wi go do evritin wey di Oga awa God don kommand us.” So Moses go back go meet God kon tell am wetin di pipol tok.
8 O povo todo respondeu unânime: "Faremos tudo o que o Senhor ordenou". E Moisés levou ao Senhor a resposta do povo.
9 Den God tell Moses, “I go kom meet yu inside tick kloud, so dat di pipol go hear wen I dey tok to yu and dem go always bilive yu.”
9 Disse o Senhor a Moisés: "Virei a você numa densa nuvem, a fim de que o povo, ouvindo-me falar-lhe, passe a confiar sempre em você". Então Moisés relatou ao Senhor o que o povo lhe dissera.
10 God tell Moses, “Make yu use today and tumoro take santify di pipol kon tell dem make dem wosh dia klot
10 E o Senhor disse a Moisés: "Vá ao povo e consagre-o hoje e amanhã. Eles deverão lavar as suas vestes
11 and ready for di third day, bikos for dat third day, I go kom from Mount Sinai and all di pipol go si mi.
11 e estar prontos no terceiro dia, porque nesse dia o Senhor descerá sobre o monte Sinai, à vista de todo o povo.
12 Tell evribody where dem go waka rish kon sey, ‘Make anybody nor klimb di mountin or tosh en korna. Anybody wey tosh di mountin, go die!
12 Estabeleça limites em torno do monte e diga ao povo: Tenham o cuidado de não subir ao monte e de não tocar na sua base. Quem tocar no monte certamente será morto;
13 Nobody go tosh di pesin, but dem go stone am or shot am with arrow. E must die, weda na human being or animal.’ Wen dem blow di ram horn, di pipol go-go di mountin front.”
13 será apedrejado ou morto a flechadas. Ninguém deverá tocá-lo com a mão. Seja homem, seja animal, não viverá. Somente quando a corneta soar um toque longo eles poderão subir ao monte".
14 Den Moses kom down from di mountin go meet di pipol. E santify and make dem wosh dia klot.
14 Tendo Moisés descido do monte, consagrou o povo; e eles lavaram as suas vestes.
15 E tell dem, “Make una dey ready for di third day and make di men nor sleep with dia wifes.”
15 Disse ele então ao povo: "Preparem-se para o terceiro dia, e até lá não se acheguem a mulher".
16 For morning for di third day, tonda, lite and one tick kloud kon appear on-top di mountin, so dem blow di horn well-well. Fear katch all di pipol for di kamp.
16 Ao amanhecer do terceiro dia houve trovões e raios, uma densa nuvem cobriu o monte, e uma trombeta ressoou fortemente. Todos no acampamento tremeram de medo.
17 Moses take di pipol komot from di kamp go meet God and dem stand for di mountin front.
17 Moisés levou o povo para fora do acampamento, para encontrar-se com Deus, e eles ficaram ao pé do monte.
18 Smoke kover Mount Sinai, bikos God land on-top di mountin with fire. Di smoke dey go up like oven own and di mountin kon dey shake well-well.
18 O monte Sinai estava coberto de fumaça, pois o Senhor tinha descido sobre ele em chamas de fogo. Dele subia fumaça como que de uma fornalha; todo o monte tremia violentamente,
19 Wen dem blow di horn well-well, Moses start to tok and God kon dey ansa am.
19 e o som da trombeta era cada vez mais forte. Então Moisés falou, e a voz de Deus lhe respondeu.
20 God kom on-top di mountin kon sey make Moses kom meet am for der, so Moses kon go up.
20 O Senhor desceu ao topo do monte Sinai e chamou Moisés para o alto do monte. Moisés subiu
21 God tell Moses, “Make yu go down go warn di pipol sey make dem nor waka pass where yu tell dem, bikos dem won si wetin dey happen and anybody wey nor listin to yu, go die.
21 e o Senhor lhe disse: "Desça e alerte o povo que não ultrapasse os limites, para ver o Senhor, e muitos deles pereçam.
22 Even di priests wey dey near mi, make yu tell dem make dem wosh demsef well-well, if not I go distroy dem too.”
22 Mesmo os sacerdotes que se aproximarem do Senhor devem consagrar-se; senão o Senhor os fulminará".
23 Moses kon tell God, “Di pipol nor go fit kom Mount Sinai, bikos Yu really warn us sey, ‘Di mountin na where dey holy, so make una nor waka near am.’ ”
23 Moisés disse ao Senhor: "O povo não pode subir ao monte Sinai, pois tu mesmo nos avisaste: ‘Estabeleça um limite em torno do monte e declare-o santo’ ".
24 But God tell Moses, “Make yu go down, den kom back again with Aaron, but nor let any priests or di pipol waka pass or near di mountin, bikos I go ponish dem.”
24 O Senhor respondeu: "Desça e depois torne a subir, acompanhado de Arão. Quanto aos sacerdotes e ao povo, não devem ultrapassar o limite para subir ao Senhor; senão, o Senhor os fulminará".
25 So Moses go down go meet di pipol kon tell dem wetin God tok.
25 Então Moisés desceu e avisou o povo.
Atalhos do teclado
- Capítulo anterior←
- Próximo capítulo→
- Versículo anteriork
- Próximo versículoj
- Limpar seleçãoEsc
- Esta ajuda?
Estude este capítulo no WhatsApp
Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Êxodo 19, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.