Êxodo 18
Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs ARC
1 Jetro, Moses wife papa, wey bi priest for Midian kon hear all di tins wey God don do for Moses and Israel pipol. How God take free dem from Egypt.
1 Ora, Jetro, sacerdote de Midiã, sogro de Moisés, ouviu todas as coisas que Deus tinha feito a Moisés e a Israel seu povo; como o Senhor tinha tirado a Israel do Egito.
2 So Jetro kon bring Zipporah, Moses wife wey Moses bin live for Midian
2 E Jetro, sogro de Moisés, tomou a Zípora, a mulher de Moisés, depois que ele lha enviara,
3 and en two sons, Gershom (bikos Moses sey, “I bi strenja for anoda land”);
3 com seus dois filhos, dos quais um se chamava Gérson, porque disse: Eu fui peregrino em terra estranha;
4 and Elieza (wey mean, “Na awa papa God help and save mi from Fero”).
4 e o outro se chamava Eliézer, porque disse: O Deus de meu pai foi minha ajuda e me livrou da espada de Faraó.
5 Jetro karry Moses wife and en two sons go meet Moses for inside di wildaness, where dem dey for God mountin.
5 Vindo, pois, Jetro, o sogro de Moisés, com seus filhos e com sua mulher a Moisés no deserto, ao monte de Deus, onde se tinha acampado,
6 But e first send message to Moses sey, “I dey kom with yor wife and yor two pikin.”
6 disse a Moisés: Eu, teu sogro Jetro, venho a ti, com tua mulher e seus dois filhos com ela.
7 So Moses go meet en wife papa, bow kon kiss am. Dem greet each oda kon enter house.
7 Então, saiu Moisés ao encontro de seu sogro, e inclinou-se, e beijou-o, e perguntaram um ao outro como estavam, e entraram na tenda.
8 Moses tell en wife papa evritin wey God do to Fero and Egypt pipol, bikos of Israel pipol; di tins wey dem sofa for road and how God take save dem.
8 E Moisés contou a seu sogro todas as coisas que o Senhor tinha feito a Faraó e aos egípcios por amor de Israel, e todo o trabalho que passaram no caminho, e como o Senhor os livrara.
9 Den Jetro kon dey happy for all di good tins wey Oga God do for Israel pipol wey E save from Egypt.
9 E alegrou-se Jetro de todo o bem que o Senhor tinha feito a Israel, livrando-o da mão dos egípcios.
10 Jetro kon sey, “Make una bless Oga God wey save una from Fero and Egypt pipol. Di God wey save en pipol from sofa.
10 E Jetro disse: Bendito seja o Senhor , que vos livrou das mãos dos egípcios e da mão de Faraó; que livrou a este povo de debaixo da mão dos egípcios.
11 Naw, I know sey God big pass all di gods, bikos en pipol don dey save from Egypt pipol pawa; Egypt pipol wey wiked and like yanga well-well.”
11 Agora sei que o Senhor é maior que todos os deuses; porque na coisa em que se ensoberbeceram, os sobrepujou.
12 Den Jetro sakrifice and burn ofrin for God. So Aaron and all di eldas for Israel join Moses wife papa chop di food for God present.
12 Então, tomou Jetro, o sogro de Moisés, holocausto e sacrifícios para Deus; e veio Arão, e todos os anciãos de Israel, para comerem pão com o sogro de Moisés diante de Deus.
13 Di next day, Moses sidan to judge kase and pipol gada round am from morning till evening.
13 E aconteceu que, ao outro dia, Moisés assentou-se para julgar o povo; e o povo estava em pé diante de Moisés desde a manhã até à tarde.
14 Wen en wife papa si all di tins wey Moses dey do for di pipol, e kon ask am, “Why yu dey do all dis tins for dis pipol? Na only yu sidan dey judge from morning go rish evening?”
14 Vendo, pois, o sogro de Moisés tudo o que ele fazia ao povo, disse: Que é isto que tu fazes ao povo? Por que te assentas só, e todo o povo está em pé diante de ti, desde a manhã até à tarde?
15 Moses ansa am, “Dis pipol dey kom meet mi, so dat dem go know wetin God tok.
15 Então, disse Moisés a seu sogro: É porque este povo vem a mim para consultar a Deus.
16 Wen dem get any matter, di pipol go kom and I go judge and let dem know God kommand, en rules and law.”
16 Quando tem algum negócio, vem a mim, para que eu julgue entre um e outro e lhes declare os estatutos de Deus e as suas leis.
17 Den Moses wife papa tell am, “Di tins wey yu dey do so good o-o.
17 O sogro de Moisés, porém, lhe disse: Não é bom o que fazes.
18 But yu go taya one day; both yu and di pipol wey dey with yu, bikos dis tin too heavy for yu and only yu nor go fit karry di load.
18 Totalmente desfalecerás, assim tu como este povo que está contigo; porque este negócio é mui difícil para ti; tu só não o podes fazer.
19 So, I go advise yu and make God dey with yu. Na yu go stand before God for dis pipol kon take dia matter go meet am.
19 Ouve agora a minha voz; eu te aconselharei, e Deus será contigo. Sê tu pelo povo diante de Deus e leva tu as coisas a Deus;
20 Make yu tish dem God kommand and law. And make dem know how to live and work as God wont am.
20 e declara-lhes os estatutos e as leis e faze-lhes saber o caminho em que devem andar e a obra que devem fazer.
21 But make yu choose good men from di pipol. Men wey dey fear God; dey tok true; doz wey nor dey play wayo kon make dem rulers ova di pipol. Some fit rule tazons, odas hundred, some fifty, while some go rule ten.
21 E tu, dentre todo o povo, procura homens capazes, tementes a Deus, homens de verdade, que aborreçam a avareza; e põe-nos sobre eles por maiorais de mil, maiorais de cem, maiorais de cinquenta e maiorais de dez;
22 Dem go judge di pipol and any matter wey big pass dem, dem go bring am kom meet yu, but na dem go dey judge all di small-small matter. Like dis, dem go follow yu share for di load.
22 para que julguem este povo em todo o tempo, e seja que todo negócio grave tragam a ti, mas todo negócio pequeno eles o julguem; assim, a ti mesmo te aliviarás da carga, e eles a levarão contigo.
23 If yu do dis tin and if na God really kommand yu, den di work go eazy for yu and di pipol go happy go house.”
23 Se isto fizeres, e Deus to mandar, poderás, então, subsistir; assim também todo este povo em paz virá ao seu lugar.
24 So Moses listin to en wife papa kon do all di tins wey e tell am.
24 E Moisés deu ouvidos à voz de seu sogro e fez tudo quanto tinha dito;
25 Moses choose men wey fit do di work among Israel pipol kon make dem oga ova di pipol. Some dey rule tazons, odas hundred, some fifty and some ten.
25 e escolheu Moisés homens capazes, de todo o Israel, e os pôs por cabeças sobre o povo: maiorais de mil e maiorais de cem, maiorais de cinquenta e maiorais de dez.
26 Dem always dey judge di pipol and any matter wey dem nor fit handle, dem go take am go meet Moses. But na only dem dey judge all di small-small matter.
26 E eles julgaram o povo em todo tempo; o negócio árduo traziam a Moisés, e todo negócio pequeno julgavam eles.
27 Den Moses escort Jetro, en wife papa as e dey go back to en house for Midian.
27 Então, despediu Moisés o seu sogro, o qual se foi à sua terra.
Atalhos do teclado
- Capítulo anterior←
- Próximo capítulo→
- Versículo anteriork
- Próximo versículoj
- Limpar seleçãoEsc
- Esta ajuda?
Estude este capítulo no WhatsApp
Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Êxodo 18, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.